Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,156,315 members, 7,829,754 topics. Date: Thursday, 16 May 2024 at 11:21 AM

Mary And Peter, A Very Touching Story In (pidgin English) - Romance - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Romance / Mary And Peter, A Very Touching Story In (pidgin English) (1399 Views)

That Moment When You Have To Woo A Lady In Pidgin Language. / Ekene And Judith, A True Life Sexual Story In Pidgin English / Love Story: I Wish I Had Held Back ( Very Touching) (2) (3) (4)

(1) (Reply)

Mary And Peter, A Very Touching Story In (pidgin English) by Iceking1(m): 5:52pm On Feb 01, 2015
TRUE LIFE STORY Many women nor come this life say dem go dey shit waka like goat.



Dem come to born all their pikin for one man. But becos of one problem or the other, when some born one or two finish, dem go carry load go another man house go dey born.



Some own na maybe -the first man die. -the first man drive dem. -dem nor love the man again. But for Mary own case, after she don born one for Peter finish, Peter family pipo nor let her drink water drop cup.



She dey DELSU when she get belle for Peter. Initially, she decide to stay Peter house, but when Peter family show her their colour, only she nai park. She born the pikin finish, still, she nor fit stay Peter house.



As a woman, she need a man wey go fit show her and her pikin love. So, she cum fall in love with another guy.



Becos say Peter love her one kain, e nor dey let any body play cum Mary territory. Na so e go give the person trouble till the person go park face for Mary. At the same time, e dey beg Mary say he dey talk small small with e family make dem for gree accept her. And after sometime, e go cum pay her brideprice. Base on this arrangement, Mary say she nor get problem.



Na Peter she cum dey wait make e cum pay her bride price till she graduate go service come back. When Mary papa calculate the matter, e cum tell Mary say, e nor go fit train her finish, cum dey train her pikin join when the pikin papa dey alive. So, make she park go meet who she born for.



Nor be small water flow from Mary eyes that day when her father dey vibrate tell her her life. How she take waka ashewo waka wey make her go born for man wey nor dey proud of her and her baby.



Her own mama dey beg the father say dem nor dey pursue pikin from house go outside, but the father nor gree listen. When he notice say Dem feel say e dey joke, this one wey I dey talk so, compound don gather dey talk put o, her father don rush enter house carry obledi.



Na there dem for know say nor be joke issue. Na so Mary look her mama, tears nor make her mama dey see well again. She just dey cry.



She don carry her baby for back, one bag of clothes dey her hand. For her mind "God, see me through this dark path" For Peter house, Peter just dey think how e wan take feed Mary and her son cos he nor get good job.



Na that one e just dey sound for Mary ears. Mary cum tell am say right now, if e ready to accept her and her son wey she born for am, she believe say dem two go weather the storm together. Men! Sometimes, we know say e hard to bear responsibilities when babe get belle for you when you norva prepare for marriage.



We know, but sometimes, use your brain. When e happen say pikin don involve, swallow your pride and find a way out. The first step na to call your lady and plan things with her.



Then think and plan for your new kid. E don be e don be. Nor let anybody spoil your mind about the woman. Na your cross, God nor go let am heavy pass wetin you go fit carry. Amen. God cum touch Peter heart and e cum allow dem to say.



The week wey dem two park cum nai Peter take get better job. Money cum dey come. Unu know say, when man get nai e true nature dey come out. God cum bless dem with another pikin. Befor Mary know wetin dey happen, outside babes nor dey let Peter number rest again.



E dey come house late. Mary don confront am many times about the issue. But e deny am. One day, one babe cum call Peter phone, na Mary answer the call.



Nai be shout wey she begin shout for the girl wey dey call say make she leave her man alone. The babe, whether she ready for combat, na only God know. Nai be curse wey she begin curse Mary. Na so she tell Mary her full life history.



Everything wey dey happen for her house na so the babe dey vomit am. How her father take drive her comot from house. Befor the phone fall from her hands she nor know.



Mary sidon for chair, water der drop from her eyes when Peter rush cum say e wan collect e phone. When Peter enter the house, e see Mary dey cry. E phone dey ground. Na so e use slow motion pick the phone.



E don code say yawa don gas. As e scroll the log call. Na Edith name e see... Mary stand up, look Peter for eyes nai she burst into fresh tears...



E get one mumu thing wey some men dey do. If dem dey friend babe, dem go dey spoil their woman for the babe. Dey tell the babe everything wey dey happen for their house. E bad o. E dey vey bad. Nor be that one go let the babe love you. So, stop to spoil your woman for your babe. Some go dey talk foolishly like goat. Hear some of the ekpa things some men dey tell their babes
# you sabi cook pass my wife.
# you sabi straff pass my woman.
# you get style pass my woman.
# na manage I dey manage my wife. # na my papa say make I marry my



wife and I nor wan offend am nai make me marry her. Etc. Men! Men! Nor be so. If you wan be a player, play by the rules. One of which: never discus your woman negatively with your babe. Now, Peter just dey look Mary as she dey waka enter room. Now, put yourself for Peter shoes. Wetin you feel say be the best or right thing to do? Put yourself for Mary shoe. Wetin you go do? Make I dey eat my groundnut and drink my palmy as I tanda dey read advice.
Re: Mary And Peter, A Very Touching Story In (pidgin English) by Chizzy20(f): 6:03pm On Feb 01, 2015
Dis ur story dey intrestin ooh.
Re: Mary And Peter, A Very Touching Story In (pidgin English) by LewisO: 6:08pm On Feb 01, 2015
I think i should try and read this!

(1) (Reply)

How To Get A Guy Attention In Any Circumstance / She's Now Fufilling Her Promise Of Frustrating My Life / See What Toyin Aimakhu Shared On Her Instagram

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 35
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.