Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,158,296 members, 7,836,296 topics. Date: Wednesday, 22 May 2024 at 03:33 AM

Are U Proud Of Ya Country ? - Nairaland / General - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Are U Proud Of Ya Country ? (341 Views)

Are U Proud Of your Native Name, Drop It Here in The Comment Box / Photos: See This Pretty Girl That Sells Tomato And Very Proud Of It! / Four Foolish And Wicked Things That Men Are Always Proud Of. (2) (3) (4)

(1) (Reply)

Are U Proud Of Ya Country ? by ifeoluwa237(m): 1:06pm On May 13, 2015
ILOVE NAIJA I NO GO LIE!!! God Bless
Nigeria!!! Na only for Nigeria you fit win
Aeroplane by loading N200 MTN Recharge
Card.
Very soon Etisalat go say recharge N200 and
win a big ship.
Then Airtel go com follow sey, recharge
N100 and win Benin Republic.
Glo, go just kuku say... Recharge N500 and
win Nigeria because their colour na Green.
Na only for Nigeria you go see fish
inside"MEATPIE"
Na only for Nigeria we dey count money
after we withdraw am from ATM because
we no even trust ATM machines.
Na only for Nigeria PHCN dey sey:-
Win a brand new GENERATOR if you pay your
light bill (wat a pity)
Na only for Naija people dey horn for traffic
light make e quick change from Red to
Green.
Na only for Nigeria Pharmacy dey sell Coke,
Recharge Card, Chin chin,
Puff puff and beer.
Wetin you no see for Naija, you no fit see am
anywhere in d world...
Trust me.
Na only 4 naija you go find a graduate of
Mechanical
Engineering dey do him NYSC 4 Police
station.
na only 4 naija you go see one person dey
use Bold5, X3, Ipad2 and Nokia N8 all at
once.You be Bill Gates? Abi na you invent
internet?
Na only 4 naija you go see a graduate of law
dey work as generator repairer.
Na only for Naija u go buy coke, dem go say
make u no forget to return d bottle.
Na 4 only Naija, you go see
madman dey control traffic,
people wey their head correct dey
obey...
Na 4 only Naija, you go see advert from
native doctor on how to make quick money.
Na only for Naija u go wish somebody
'happy birthday', he go answer 'same to u'.
Na 4 Naija obituary poster dem go say
"MAMA HAS RELOCATED"
.. im proud of dis my country we dey unik.
I take God beg u to SHARE dis message to
reach every body to love dis nation.

(1) (Reply)

8 Signs Your Ex Wants You Back / BREAKING NEWS: Blatter Resigns As Fifa President / HOTOS: See How Mother Treat Her Own Child In Benin

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 9
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.