Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,152,004 members, 7,814,425 topics. Date: Wednesday, 01 May 2024 at 12:42 PM

Naija Love Rhymes For Valentine - Literature (38) - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Literature / Naija Love Rhymes For Valentine (61144 Views)

Must Read: Naija Love Part 1 (one) / Re: Naija Love Rhymes For Valentine / A Space For Peoms, Hot Rhymes, Quotes And General Sayings (2) (3) (4)

(1) (2) (3) ... (35) (36) (37) (38) (39) (40) (Reply) (Go Down)

Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 7:39pm On Nov 12, 2010
@All, I happy say una dey show face
No let anything slow d pace
No need for dance partner, feel free to dey ride solo cheesy
Love no need too much crowd, no be say we dey play polo cheesy


I hail oooh!
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by Joecoollorenzo(m): 4:44am On Nov 20, 2010
*OUR CONVERSATION*

Me: Na u who dey here?
All: Na who dey nock for there?
Me: na me o, lorenzo
all: arh arh were u bin go
me: my dear i just dey like say i no dey
all: whil u decide to show today
me: after i run fins, fin come dey run me
all: so u decide to com rerun fins abi?
Me: i just wan com see whether we stil b family
all:,



(fill d blank abeg)
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 2:00pm On Nov 22, 2010
Joecoollorenzo:

*OUR CONVERSATION*

Me: Na u who dey here?
All: Na who dey nock for there?
Me: na me o, lorenzo
all: arh arh were u bin go
me: my dear i just dey like say i no dey
all: whil u decide to show today
me: after i run fins, fin come dey run me
all: so u decide to com rerun fins abi?
Me: i just wan com see whether we stil b family
all:,

(fill d blank abeg)

dem: ehn, if u still be millionaire like emily. . . .

========================= *filling the blanks*-

me: as u see me so na management i dey
dem: omo dat mean sey u no go fit stay
me: but babe rememeber say na 4 better & worse
dem: u are on your own now oh bros
me: things go always betta u no believe so
dem: make i old here dey wait u to blow?
me: na in front of papa God we sign to dance twan'ka
dem: & na 4 im front so i dey tell u sey make u waka
me: paseru mi na so u wan take lock me door!?
dem: u s'pose dey glad sef sey i no nack u join 4 floor
me: but shey u know sey i still love u
dem: shuo, na love na im we go chew!?
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 11:35pm On Nov 24, 2010
nowadays i no fit sleep,
turn turn for bed like dem wa'ya me whip,
food now na container of drip,
i don be like ma'sa wen loss im sheep,
e don pass me to even weep,
& na so everyday e dey continue deep,
cuz my fone lai-lai again no go see ur beep. . . . .
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by firestar(f): 10:55am On Nov 26, 2010
''Ehen, shey yu love me?''
-
En~en.
-
''A-ahh!
Yu no ask say,
wetin I mean by 'love', by di way.''
-
Okay.
Salaye.
-
''Eh. . . Like say, if I travul or go away. Shey yu go miss ma brake light or dey miss me sha. Wheda yu feel say yu go feel me die patapata? Sometin like dat sha. . .''
-
Hhn.
-
''. . . Na yes be dat?''
-
Hnm.
-
''Mmm. No be lie, I love yu die!''
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 7:05pm On Nov 26, 2010
\


I jus say make I pop in come congratulate
All those wey dey show face dey regulate cheesy
No how, no how, this thread go always be,
So long as we dey get feed from both oldies and newbies cheesy
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by lindalee(f): 10:37pm On Nov 26, 2010
My girl maedan your rhymes are tight
your flow eversince, dey make my heart delight
abeg no stop to the shine your light
cos your future em dey super bright
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 11:17pm On Nov 28, 2010
firestar:

''Ehen, shey yu love me?''
-
En~en.
-
''A-ahh!


shuo. . . . dat na queshun,
babie no even menshun,
abegi u go jus gimme hypertenshun,
see how my kini don stand attenshun,
brain don sharge like electric high tension,
dis crase wey u dash me so na no prevenshun,
u don catch me put for detenshun
omo make i wrong i no want correcshun,
my brake light dey on full C-caution,
as i dey so na u get all my allawee plus pension!

grin grin grin
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 12:00pm On Nov 29, 2010
lindalee:

My girl maedan your rhymes are tight
your flow eversince, dey make my heart delight
abeg no stop to the shine your light
cos your future em dey super bright


wow, many thanks to my babe lindalee
the more you look, the more you go see grin
as you come show a token of your appreciation
I go receive the compliment with plenty jubilation wink
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by firestar(f): 12:15pm On Nov 30, 2010
Ruudie. . . Hold on bro,
-
Di meds wey yu take ehn,
-
Hope say na doctor prescribe am o?
-
Ehen make I scatter yua yarn,
'Cos I no be boti and dem no born me for barn!
-
Yu go get correcshun o!
Yu
Go
Get!
-
All join di advice wey elders give me,
Yu
Go
Collect!
-
First,
Yu no go get hypertenshun: na ma praya be dat.
Second,
Now e be like I get yua 'attenshun': Go hug one of PHCN's faulty high tension.
Shebi yua brain don sharge?
Oya nau, no say I harsh,
na ma request be dat.
-
If I say:
I love yu,
No be dat one wey yu write.
Asha sef sing dat kain 'luv' for 'Subway',
Or na lie she dey lie?
-
Yu be ma broda as ma sista Maedan dey too.
-
If yu catch ma drift ma broda,
Know say I love her and odas as I love yu.

1 Like 1 Share

Re: Naija Love Rhymes For Valentine by depojones: 4:04pm On Nov 30, 2010
yea right
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 1:59pm On Dec 01, 2010
firestar:

Ruudie. . . Hold on bro,
-
Di meds wey yu take ehn,
-
Hope say na doctor prescribe am o?
-
Ehen make I scatter yua yarn,
'Cos I no be boti and dem no born me for barn!
-
Yu go get correcshun o!
Yu
Go
Get!
-
All join di advice wey elders give me,
Yu
Go
Collect!
-
First,
Yu no go get hypertenshun: na ma praya be dat.
Second,
Now e be like I get yua 'attenshun': Go hug one of PHCN's faulty high tension.
Shebi yua brain don sharge?
Oya nau, no say I harsh,
na ma request be dat.
-
If I say:
I love yu,
No be dat one wey yu write.
Asha sef sing dat kain 'luv' for 'Subway',
Or na lie she dey lie?
-
Yu be ma broda as ma sista Maedan dey too.
-
If yu catch ma drift ma broda,
Know say I love her and odas as I love yu.





thanks firestar for your nice pidgin pile
e be like say i dey enjoy this your new style
u don bring a different flavour to our local jive
make you no stop, still dey drop am for us live!!!

grin grin grin

1 Like

Re: Naija Love Rhymes For Valentine by firestar(f): 12:47pm On Dec 02, 2010
Heh.
Maedan:
Ma sista,
-
Ma head dey swell. . .
I beg, make I bash ma head ontop congo drum make dat koko go down well.
-
As for Rotimi
Where im dey?
I miss ma egbon from anoda mista.
.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 4:58pm On Dec 02, 2010
firestar:

Heh.
Maedan:
Ma sista,
-
Ma head dey swell. . .
I beg, make I bash ma head ontop congo drum make dat koko go down well.
-
As for Rotimi
Where im dey?
I miss ma egbon from anoda mista.
.



Abeg oh, babes, no bang ur head for congo cheesy
As u dey add sweetness to dis our pidgin bongo
U know oyibo talk say, the more the merrier
Na for here pple dey come cool off from NL mass hysteria cheesy

1 Like

Re: Naija Love Rhymes For Valentine by firestar(f): 11:56am On Dec 03, 2010
Okay.
Make I drop dis one sake of say today na 'Fry-day':
-
Dis love ehn, I no fit analyse;
E no dey rest for lip or for eye,
Even for kiss join caress.
Na Ssssmall I sabi im gentleness.
-

And understanding for one word,
Or short-short leta.
E dey preserved,
By trust, respect & awe.
Na dis yarn I dey feel for.
-

To people dem, yes o,
To lasting friends:
Di giving go come,
di taking go end.
For dis kain love, yu no fit measure anytin.
Na becos of dis, even Nature sef go go~slow- dey sing.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 2:22am On Dec 05, 2010
Nice one firestar but I no jus dey in d mood
I come hear one news wey no too good
One of our brother for this NL family
Lose im life to some unseen wicked enemy
Anyway e go remind us to always dey careful
To love eachother and to always dey respectful
All those yeye beef and ranting for here
Make we stop am and show say we care!!
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 12:41pm On Dec 06, 2010
see as i come heavy mutu'rere
jonez like sey i shack buruk'tere. . . .
no be lie ur name dey ring my head bell,
like dat lappie wey dem call dell. . . .
i look u na so i dey melt,
na small remain trouser 4 jabor' if not'o belt. . . .
from right to left,
e don dey be likematta wey oyibo go call theft. . . .
cuz u don catch my heart 4 inside net,
b4 now d sign ontop my door na "to let". . . . .
but tori' don grow wing, head, leg & tail,
now omo boy dey carr'ey "beware dis heart is not for sale. . . ."

grin grin grin
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 9:02pm On Dec 06, 2010
to our NL broda,
na so u don take cross d border,
but we know sey na onto baba God order,
otherwise u go dey hia now dey ta'asi 1 another.

as i dey type now ontop my lappie,
e dey wee'da me as u take wipey,
i no even sabi u but i no dey happy,
cuz i fit imagine how e dey pain your mami & papi.

although we cry, we heart no go too break,
olodu'mare na im give us u na im sef join take,
becuz we know sey Allah wen dash us cake,
if e collect am back e no mean sey im do mistake.

give dawg betta bone,
lef' am je'je make im parol alone,
give am enuf allowance to roam,
& wen im time reash na Baba God go carr'ey am go home!


R.I.P
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 5:13am On Dec 07, 2010
e too soon,
time no even dey 4 u to see moon,
jus now jus now u don waka lef we 4 earth,
but i with last coin i fit bet,
where u dey now ground over-level,
na confirm no-go-area 4 devil,
as Baba God tanda u dey im right hand,
jollification flu'kpor dey throwey like bar beach sand,
as e come be sey u be gunner,
i know sey u go pick like 4-runner,
& e no get as e wan be u go dey 1st eleven,
of dat galacticos squad wen dey heaven grin

R.I.P son!
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by Nobody: 7:27am On Dec 11, 2010
NL n my studies no b best of frnds.
I nid 2 leav 1 4 d oda n coz d joy of success is d bginin 4 handwork.As i don finish my xams na 2 draw NL close 2 my hart.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 3:34am On Dec 12, 2010
Gosh pple are WICKED!
Na so this world just dey crooked!
Person born pickin, na another person wipe am out
Na to enter my room go pray cos I no fit shout
All the hala for this world no go bring Bawo back
Make I just carry all my vex put inside sack
Chrismass dey come, make we put smile for we face
And make we hope say dis world go be a beta place!!!
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by efepro(m): 1:10pm On Dec 25, 2010
@Maedan,thank u for ur last messages, I don comot 4 here e be like ages,
Make una no vex,
man need to hustle and flex
I dey use my head calculate like calculus,
Xmas don show,money must enta purse
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by Nobody: 8:28am On Dec 26, 2010
no b say i dey form boss?
No b say i stronq 2 cari bros J cross?
Buh wen lyf wn wound u fiqht am by force,
use al ur strenqth,blow n even curse,
if na word 2 word say 'watsz d fuss'?
Y others dey buy car u dey rent bus?
Y u qo senior pesin stil dey cal am bros?
B4 u act make u pause!!
Mayb wen u dey come world ur destiny lose!!
B4 u reash ur ma'le bele dem chanqe ur course,
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by Claraphil: 1:10pm On Dec 26, 2010
From the bottom of my heart i send you the best gift a lover deserves. Take this novel The African Mafia - Global message on fraud. Tell all your friends to demand it from their lovers. love ya forever.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by Nobody: 3:41pm On Dec 26, 2010
Te te i don dey folo dis thread,
dey watch as una dey join piqin lyk needle n thread,
even wit luv n hate una no stil bend,
come tiqht wela lyk butter n bread,
how Ruudie tak start i no fit comprehend,
e pain me because my power no reash 2 contend,
i luv meadie poem self i no qo pretend,
tru tru i b amateur but make una try luk me send.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by Nobody: 3:48pm On Dec 26, 2010
C as i dey church dey pray,
begin ask baba y fud no dey my tray?
Upon say i dey hussul wen al ma mate dey play,
i finish uni. find brktru stil no way,
shey i supose leave 9ja go away?
Or enter cafe tak hand dribble mugu until em pay?
E fit work oh! buh me no wn go astray!
Cos e go jaga'jaga my hrt sotey my lyf go turn fray.
Abi make i blame my papa! Cos wen sun dey shine em 4get 2 make hay,
now na poor man em b 4 wer em dey push dray.
BROS J,i no fit dey lyk dis turn qray!!
I no fit dey luk pple drive pas inside moto while me dey treck unda sun ray!
Make u ans my bray,
as i don siddon beqin wait 4 next year.
Cos al d bad belle pple u must do dem slay.
Buh try undastnd cos na d name 'chinedu' i wn portray#
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by adebayo201: 10:11pm On Dec 27, 2010
I read thru,i kno no wetin i wan write,
shey na pason wey die abi na abt xmaz eve nite,
wey sum aproko pple kil pple 4 Jos witout seein lite,
fud i kno fit chop even biscuit i kno fit bite,
fear grip my heart as bad tin dey happen 4 my cite,
evrytin just dey luk like sey world go end like kite,
abiola,yetundey,bolanley,titilola dey complain sey i don gain hite,
dem kno kno sey na wetin dey du man pikin pax mite,
God,abeg cum helep uz b4 enemy attak 4 nite,
cum me kno want stand 1 minute silent 4 anybdy 4diz site,
now nd byond mak we dey tite!

Luv u all!
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by Nebulae: 11:06pm On Dec 27, 2010
embarassed
na wa o.
wich kain palava be dis?
wit all dis yeye briz,
wey dey flow 4rm north to east
my heart don ciss.
i hear say we lose our bros. cry
now wetin be dis nonsense i dey hear from jos? shocked
ma brosis 'an sists dem kill like fowl angry angry angry
thru some gbas-gbas knockout an' spill ma peepu blood anyhow??!!!!! angry angry shocked angry angry angry
wetin be dat kain rubbish na?!!!
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by adebayo201: 8:26am On Dec 28, 2010
Ur luv no fit make me kolo,
just carry ur wahala dey go solo,
if nt i go show u sey i dey drink enuf milo,
go luk aminat wetin i show am,she don go below,
abi na muyiwa wey i lock inside silo,
so carry u palava go frnt mak i rest,
i dön taya 4 diz ur luv least,
mak i luk 4 beta pason me kno want best,
adebayo201 me kno go eva involve in diz e-luv test.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 5:22pm On Dec 29, 2010
E no good if I forget to drop in some wishes
To all who dey flex for snow or inside d sunny beaches grin
Merry Xmas, Happy New Year in advance
Make you continue to enjoy d holiday dance cheesy
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by adebayo201: 5:50pm On Dec 31, 2010
i know say u go drop season greeting,
weda na rain, sun or harmattan or august meeting
dey jolly dey go,no ahala 4 diz surfing
weda devil like or not diz year we are all leavin

(1) (2) (3) ... (35) (36) (37) (38) (39) (40) (Reply)

Shadows From The Past....[The Past Came Haunting]-- A Short Story. / Nephilim / Wole Soyinka: Things You Never Knew About Him

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 75
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.