Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,154,182 members, 7,821,999 topics. Date: Thursday, 09 May 2024 at 12:31 AM

You Go Sleep For Couch Today!! - Politics - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Politics / You Go Sleep For Couch Today!! (457 Views)

Ganduje: 'I Don't Sleep At Public Functions, I Only Pretend'' / Must Watch Video For Political Junkies - Watch, Go Sleep And Await INEC / I Need A Sleeping Drug To Sleep For The Next 5weeks (2) (3) (4)

(1) (Reply)

You Go Sleep For Couch Today!! by easystudy101: 7:07am On May 21, 2015
For some of my old post, I don talk as how de babes for hia dey behave different from naija babes. For hia de babes open eye well well, and like I don talk before, de laws hia dey side with dem too much. Dis one don give dem too much freedom to do anyhow when dem like.

My friend tell me wetin happen to am recently wey make me laff well well. Him and him girlfriend been get small quarrel and den de babe tell am to go sleep for couch wey dey for palour. When I hia dis one, laff no gree me breath at all.

I ask am wetin him come do? Him tell me say "man pikin been no get any choice!". For house wey you dey pay rent too? And ya girl go tell you when to sleep for bed and when you go sleep for chair! Na wa for some people oo!

But na later I come find out say na normal tin for hia. Na normal tin for women to punish dia men with exile from bedroom. Most men for hia dey try very hard to no make dia woman vex too much. Because if she vex, she fit troway you from bedroom for days or weeks sef. And den you go pray to God make she no too vex and den ask you to pack comot de house for sometime.

No be small tin oo! Woman ask me to comot for bedroom for my own house? Onto which levels? My mama no born woman wrapper.., lol. But on a serious note, dat kind tin no sweet my belle at all. Me personally no too like wahala, den for my woman to tell me say I no go sleep for awa bedroom, no go funny at all.

As a typical naija man wey I be, I get strong head like odas get too. Us wey awa ego no dey let us tink well some times. I know say some of de tins I go tell her na 'you mean a whole me go sleep for couch?', 'look me well well, shebi you know who you dey talk to?', 'dem no born you well to tell me dat kind RUBISH!!'.

Well de unfortunate tin be say, all dos initial gra-gra go only work for naija. For hia if you no wan make police come escort you comot for de house, you go just comply with anytin ya woman tell you to do. All man know say 911 no hard to press for phone.

Na im make mos naija guys still dey go back naija to go find wife. Nobody wan any kind yankee woman extra wahala. But de tin be say most of awa sistas dey come hia come copy all de bad bad tins wey dey happen hia. But wetin man go do na, we dey for rome, so we get to obey roman laws.., abi?!

Pessin no get any choice for dis one!!

1 Like

(1) (Reply)

Hilarious, Girl Forced Man To Propose...!!! (video) / Akwa Ibom State Trekkers (trek Team 31) Closer To Uyo (pics) / NELEA Defiles Court Order, Still Lay Seige At Kashamu's Resident

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 14
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.