Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,151,706 members, 7,813,337 topics. Date: Tuesday, 30 April 2024 at 11:00 AM

These Pidgin Proverbs Will Surely Crack Your Ribs - Romance - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Romance / These Pidgin Proverbs Will Surely Crack Your Ribs (3362 Views)

The Funny Story That Broke The Internet: You Will Surely Laugh (pictures) / This Pictures Of Megan Will Surely Erect Your Thing / That Moment When You Have To Woo A Lady In Pidgin Language. (2) (3) (4)

(1) (2) (Reply) (Go Down)

These Pidgin Proverbs Will Surely Crack Your Ribs by Demichaels: 10:17pm On Sep 11, 2015
Pidgin Proverbs
1. Na for old age ashawo dey know the value of
pikin.


2. Woman wey never see problem... Na im dey
still hold breast run



3. Woman wey dey find pikin no dey wear pant
sleep


4. Rat wey follow lizard enter rain, Na later é go
hear am.


5. Na for afternoon dem dey find black goat.


6. Weather hot!! É No mean say fowl go lay
boiled egg.


7. EYE WEY DEY CRY DEY SEE ROAD.


8. Pikin wey him mama back cross water, wey
say him march fish, wetin him mama go march?


9. Small pikin wey dem carry for back no know
say the journey far.

10. Person wey don faint before no be stranger
to death.

11. Person wey chop belle full, no know wetin
hungry man dey see.


12. No be as woman dey close eye enjoy sex she
dey enjoy labour pains.


13. Yansh no get teeth but e dey cut shit.
14. Lizard wey fall from tall iroko tree, if nobody
hail am!! é go hail himself


15. Toto water small, but é reach prick take baff.
16. IF GIRL TAKE HUSBAND DO BOYFRIEND,
She GO TAKE BOYFRIEND DO HUSBAND.


17. Cockroach wey jam fowl, jam bad luck

18. Na cricket tell him children say, No matter
how ground strong, Them no go sleep outside.


19. Pikin wey say him mama no fine they use
style call him papa blind man.


20. No be eye wey dem take chop eba dem take
dey share meat.


21. Person wey use Elephant set trap, na him
know wetin he wan Catch.


22. When Breeze Blow Fowl Yash Go Open.


23. STUDENT WEY READ NA HIM SERIOUS, BUT
STUDENT WEY PASS NA HIM KNOW BOOK.


24. Dem no dey tell tortoise say race don start.
25. Dem no dey tell blind man say salt no dey for
food.


26. Before you see monkey, monkey don see you.
27. Thief wey jump fence enter house where
owner dey wait for am, no go jump again.
28. If pikin say he sabi die, him papa sef go tell
am say him sabi bury.


29. Na wetin dey sweet for goat mouth, Na im
dey kill am


30. If e be like say everybody dey craze" na you
dey craze.
31. Meat wey you dey forbid, no use your teeth
cut am.
32. My thing and our thing no be the same oh.
33. Na happiness dey make prick stnd

9 Likes 2 Shares

Re: These Pidgin Proverbs Will Surely Crack Your Ribs by ladyF(f): 10:19pm On Sep 11, 2015
grin person wey never get FTC, no fit know how e dey sweet for belle grin

Oya make una add ur own

1 Like

Re: These Pidgin Proverbs Will Surely Crack Your Ribs by jennamarv(f): 10:20pm On Sep 11, 2015
Mhew.......anyways FTC.
Re: These Pidgin Proverbs Will Surely Crack Your Ribs by peeparty(m): 10:20pm On Sep 11, 2015
'A child can play with its mother's breasts, but not its father's
testicles'

4 Likes

Re: These Pidgin Proverbs Will Surely Crack Your Ribs by peeparty(m): 10:21pm On Sep 11, 2015
jennamarv:
Mhew.......anyways FTC.
lol indian weed don blind you sheybi you know see that F for your front ni?

3 Likes 1 Share

Re: These Pidgin Proverbs Will Surely Crack Your Ribs by jaymichael(m): 10:25pm On Sep 11, 2015
grin op, your head is there.
Re: These Pidgin Proverbs Will Surely Crack Your Ribs by lekjons(m): 10:33pm On Sep 11, 2015
"if a Calabar woman marries an Edo man, na bed go suffer!"

9 Likes 2 Shares

Re: These Pidgin Proverbs Will Surely Crack Your Ribs by Nobody: 10:33pm On Sep 11, 2015
Lmfao !! So on point jere.

Let me kindly add my favorite ;

A madman no go craze sotey hin no go sabi how to commot for road for moto to pass grin
Re: These Pidgin Proverbs Will Surely Crack Your Ribs by Nobody: 10:35pm On Sep 11, 2015
lekjons:
"if a Calabar woman marries an Edo man, na bed go suffer!"

Epic! cool ... Like say male horse marry bulldog grin

2 Likes

Re: These Pidgin Proverbs Will Surely Crack Your Ribs by Nobody: 10:35pm On Sep 11, 2015
peeparty:
shocked
Please [abeg] kindly vote for me here https://mobile.twitter.com/runzlord/status/639602054546255872?p=v
The link to the voting page is in that status, cos I can't post the link directly on Nairaland.

It a a palm selfie contest by samsung.
Re: These Pidgin Proverbs Will Surely Crack Your Ribs by Demichaels: 10:38pm On Sep 11, 2015
runzlord:

Please [abeg] kindly vote for me here https://mobile.twitter.com/runzlord/status/639602054546255872?p=v
The link to the voting page is in that status, cos I can't post the link directly on Nairaland.

It a a palm selfie contest by samsung.


Na your own pidgin proverb be this?

1 Like

Re: These Pidgin Proverbs Will Surely Crack Your Ribs by 2dice(m): 10:40pm On Sep 11, 2015
Person WEy n.aked no fit chuk hand for pocket

1 Like

Re: These Pidgin Proverbs Will Surely Crack Your Ribs by Nobody: 10:49pm On Sep 11, 2015
Lol cheesy
Toto water small, but é reach prick take baffcheesy

6 Likes

Re: These Pidgin Proverbs Will Surely Crack Your Ribs by Nobody: 10:52pm On Sep 11, 2015
peeparty:
lol indian weed don blind you sheybi you know see that F for your front ni?
Haha cheesy. E be like say she wear bra for face
Re: These Pidgin Proverbs Will Surely Crack Your Ribs by misspicy(f): 10:53pm On Sep 11, 2015
Mt own...

Na person wey wan die go find bad mouth people trouble for nairaland.....lol
Re: These Pidgin Proverbs Will Surely Crack Your Ribs by Truckpusher(m): 10:54pm On Sep 11, 2015
Number 15 sha. cheesy

1 Like

Re: These Pidgin Proverbs Will Surely Crack Your Ribs by sulmeza(m): 10:54pm On Sep 11, 2015
lol...funny
Re: These Pidgin Proverbs Will Surely Crack Your Ribs by peeparty(m): 10:57pm On Sep 11, 2015
profojah:
Haha cheesy. E be like say she wear bra for face
no myn am.

1 Like

Re: These Pidgin Proverbs Will Surely Crack Your Ribs by gebest: 10:58pm On Sep 11, 2015
GREAT, u are blessed
Re: These Pidgin Proverbs Will Surely Crack Your Ribs by nely(m): 11:04pm On Sep 11, 2015
person wey no know where nairaland start, no go know where e end
Re: These Pidgin Proverbs Will Surely Crack Your Ribs by Rapmoney(m): 11:10pm On Sep 11, 2015
So so funny proverbs you got here, Op! cheesy
Re: These Pidgin Proverbs Will Surely Crack Your Ribs by ramatintin(m): 11:10pm On Sep 11, 2015
eye wen de cry De see road
Re: These Pidgin Proverbs Will Surely Crack Your Ribs by gebest: 11:11pm On Sep 11, 2015
OP U MUST BE AN EDO PIKIN
Re: These Pidgin Proverbs Will Surely Crack Your Ribs by mikron(m): 11:15pm On Sep 11, 2015
My favorites
*Who say ur water no go boil him own no go hot
*Goat wey dey take swagger cross road the village wey e dey go no far
*Person wey too tey for party dey follow wash plate.
*Madman say madness sweet only say d trecking too much
*Pepper wey dem plant for road side na every body get am
*e go better na poor man prayer

1 Like

Re: These Pidgin Proverbs Will Surely Crack Your Ribs by Nature8(m): 11:18pm On Sep 11, 2015
Lol.. Na as goat dey stand for market dem dey price am..

Craze no hard to form, na the trekking be wahala..

It's a small world no mean say you fit trek from Naija go London..
Re: These Pidgin Proverbs Will Surely Crack Your Ribs by igraman(m): 11:21pm On Sep 11, 2015
e funny die ..i swear
Re: These Pidgin Proverbs Will Surely Crack Your Ribs by lekjons(m): 11:28pm On Sep 11, 2015
Sabrwahaqqo:

Epic! cool ... Like say male horse marry bulldog grin
gringringringrin
Re: These Pidgin Proverbs Will Surely Crack Your Ribs by sinaj(f): 11:38pm On Sep 11, 2015
cheesy cheesy cheesy LWKMD


Pbs4real come o!
Re: These Pidgin Proverbs Will Surely Crack Your Ribs by abdulhadi101(m): 11:51pm On Sep 11, 2015
grin grin[url][/url]
Re: These Pidgin Proverbs Will Surely Crack Your Ribs by sawhite: 11:57pm On Sep 11, 2015
I was here
Re: These Pidgin Proverbs Will Surely Crack Your Ribs by zinachidi(m): 12:17am On Sep 12, 2015
lol,,

yansh no get teeth, but e dey cut sh*t..

Epic..grin
Re: These Pidgin Proverbs Will Surely Crack Your Ribs by Ginaz(f): 12:25am On Sep 12, 2015
embarassed

(1) (2) (Reply)

How Long Should One Chase A Lady / No Matter The Status, A Woman Can Get Jealous - Watch The Obamas (photos) / What Is The Biggest Amount You Have Given A Girl You Dated Or Flirted With?

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 23
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.