Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,151,885 members, 7,814,000 topics. Date: Wednesday, 01 May 2024 at 12:01 AM

Best New Year Message Ever - Politics - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Politics / Best New Year Message Ever (910 Views)

We Can Only Make Progress In Equality & Unity- Best Independence Message Ever / President Buhari's New Year Message For 2017 / Goodluck Jonathan New Year Message To Nigerians (2) (3) (4)

(1) (Reply) (Go Down)

Best New Year Message Ever by FoxyFlow(m): 4:18pm On Dec 31, 2015
To all of you posting stuffs about the new year
and forgiveness, continue. Una no go see my
own. Me na to wait make una Bleep up then I go
remind una una new year resolution. Another
thing, those of una wey I do bad to or feel say I
do una bad, if una like make una keep am for
belle, I no send. I don forget the matter. In fact,
no be only you I wrong, if God wey be say I dey
fall him hands daily dey forgive me each time I
say Baba sorry, who are you?

For those wey dey owe me, I no be world bank
so I no fit pardon the debt. Just arrange my bar
dey wait for me. Next year we go settle the
matter. But truly, from my heart, if you know say
you do me bad, I forgive you but I am only
human o... I fit revenge tomorrow.

Meanwhile, I no believe in love again. Just the
love wey God get for me through him pikin
Jesus. All other love wey involve girls, park
aside, na heaven be target now. We dey perilous
times. I no fit because of one karashika go hell
fire after the hell wey I don face and experience
for earth. Nah, I no fit.

Biko, my brothers and sisters, make una draw
closer to God wo. The angel wey hold final
trumpet fit wan test am if e still dey work o. No
let Satan come jam you for earth. Him go
revenge all those false accusations wey you dey
place for him head all in the name of blames.
And for those of una wey dey pray make una
enemies fall and die, na for which person front
God wan prepare table before una? Una no wise
pass Jesus wey say love your enemies and pray
for those who despitefully use you.

All in all, may the peace of the Lord be with you
now and forever. Lest I forget, I tell my ex last
night say "good night, have a blissful night
rest..." for chat. Na so she reply, "good night
bae, rest in peace..."

Biko God forbid. I go flex 2016 because God don
sign am so.

Happy new year my friends and God keep us
all...
# ProudlyAdeyi

2 Likes

Re: Best New Year Message Ever by domopps(m): 4:25pm On Dec 31, 2015
FoxyFlow:

Hmmmmmmm ! Comment latter on my way to canaaland for cross over service night

Cheeeers
Re: Best New Year Message Ever by praise007: 5:50pm On Dec 31, 2015
typing.........................
Re: Best New Year Message Ever by FoxyFlow(m): 10:12pm On Dec 31, 2015
praise007:
typing.........................
Ki le le yi?
Re: Best New Year Message Ever by Pavore9: 10:22pm On Dec 31, 2015
Already past midnight here in Nairobi. Wishing everyone the best in this new year, may our focus be directed towards all that is good. Happy New Year.
Re: Best New Year Message Ever by Idiataqueen(f): 3:38am On Jan 01, 2016
Am Coming

(1) (Reply)

Should NASS Summon Buhari Over Dss/court Orders? / Metuh, Kanu And Dasuki Still Detained As Buhari’s Associate Is Released 24hrs Af / The Real Reason Why The 2016 Budget Is Delayed

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 25
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.