Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,153,806 members, 7,820,820 topics. Date: Tuesday, 07 May 2024 at 10:31 PM

Nice Poetry In Pidgin English - Poems For Review - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Literature / Poems For Review / Nice Poetry In Pidgin English (11994 Views)

. / A Poem In Pidgin Language: Temptations In Our Nation / Can I Publish My Poetry In An Ebook Format? (2) (3) (4)

(1) (2) (Reply) (Go Down)

Nice Poetry In Pidgin English by layi(m): 4:08pm On Jan 23, 2007
I got this from a pal and i think its an interesting read,

Oya listen
as u dey see me with patch for eye
I know say some of una go dey wonder why
Well, d story dey long oh but I go sha try
N when I don yarn finish sum things go clarify
Na so in happen
I get one big uncle him name na mbong malai
Everybody know am for ikorodu na 1 vicious guy
Anyway im get 5 wives
Number five na aunty mai
One fine woman like this wey him jam when he dey live for shanghai
Now he dey keep her in one bonz house for V.I
So one day uncle send me go VI say make I collect something from aunty Mai
When I reach there na so I knock door say aunty it is I
As d door open my eye just magnify
Aunty mai dey stand there in one towel wey never reach her thigh
And when I dey come see her with uncle she dey shy!
As I follow her go kitchen d story come intensify
She come bend pick something for floor
She bend oh! Abi u no understand my guy?
The thing wey I come see for that place make my kini high
plus my heartbeat don multiply
I say ahn ahn now! Aunty mai ! chei!
Na so she turn face me open the towel and re-tie
I no fit talk again oh! My mouth don dry
She look me n say na wa for u oh
I dey offer u something for free wey governor no fit buy
Small boys no dey do me like this for shangai
Abi Nigerian boys no fit handle woman like I
Na that one she talk wey shake me, I quick quick reply
Bcoz I see e be like say opportunity dey pass me by
Aunty mai I just dey pity u walai
Bcoz if I handle u small na so u go cry
D pound I go pound u go defy
Anything wey u don collect for shangai
your opinion of naija boys go modify
She laugh small rotate and sigh
She come bend over the sink,said come and try, 

Na so i dey look the white pant wey just face d sky
she come hurry me say make i quick comply
abi I dey fear say my kini no fit supply
I laugh, me? maga why
Mr Man always dey on standby
I only dey pray make u know just kpai
I commot my kini, Anti Mai shout "Kai"
As a fast guy, i just ram her begin pound like die
Na when she began speak in tounges- adraotabatabai
kitchen door just dissect and i no wetin that imply
My brain fly, no lie to falsify
As Uncle just grab me for tie
Na with one mike tyson blow im take reply
Well I escape sha but na how i take get patch for eye.

4 Likes

Re: Nice Poetry In Pidgin English by Zebedee(m): 6:45pm On Jan 23, 2007
shie you come try
or you still shy
make i tell you my guy
HIV no be lie
i don see person die
plus sey if u no hold side
n her tin make u high
na so u go just kpai
my guy
so think twice
Re: Nice Poetry In Pidgin English by goodguy(m): 9:54pm On Jan 23, 2007
Wow! That's a lovely and funny one there, Layi. That pal of yours must be really talented. cheesy

And that's a superb addendum there, Zebedee. wink
Re: Nice Poetry In Pidgin English by showbobo(m): 11:13pm On Jan 23, 2007
@Layi
grin grin Thats hilariuos,raw though.NIce ones you guys got there.
Re: Nice Poetry In Pidgin English by ufot(m): 1:55am On Jan 24, 2007
@ zebedee

add
before u try
Re: Nice Poetry In Pidgin English by magneto(m): 8:45am On Jan 24, 2007
grin funny isht there layi, i feel am!
Re: Nice Poetry In Pidgin English by Maneater1(f): 9:03am On Jan 24, 2007
Abi e no finish d poem?
so hoe im come get d patch for eye?
wetin in do? wetin cause am?

Tlee ur frend say d tori sweet
but mak im try finish am.
i get amebo now.
Re: Nice Poetry In Pidgin English by freemanj(m): 9:48am On Jan 24, 2007
@layi walahi,that poem na die,to God i no lie,the guy too try
Re: Nice Poetry In Pidgin English by LoverBwoy(m): 11:01am On Jan 24, 2007
Nice poems cheesy cheesy cheesy
Re: Nice Poetry In Pidgin English by indo(f): 11:35am On Jan 24, 2007
no loooong thing, layi 10 mikes there,y u no talk in details hw u take get d patch!!!!!!!!!! wink
Re: Nice Poetry In Pidgin English by justkunmi(m): 3:04pm On Jan 24, 2007
u wan know im take get the patch? maybe uncle malai catch them for kitchen.!! grin
im come carry omorogun nack am for eye grin

abi layi, i lie?
Re: Nice Poetry In Pidgin English by naijagal(f): 8:18am On Jan 25, 2007
layi, where is the part 2 of dis poem undecided undecided undecided
Re: Nice Poetry In Pidgin English by layi(m): 9:22am On Jan 25, 2007
I just completed it
Re: Nice Poetry In Pidgin English by goodguy(m): 9:47am On Jan 25, 2007
Cool. Very cool. grin
Re: Nice Poetry In Pidgin English by kellorah: 5:14pm On Jan 25, 2007
LMFAO!!

shocked shocked shocked who wrote this? the person deserves a medal!!!
Re: Nice Poetry In Pidgin English by layi(m): 9:11am On Jan 26, 2007
A friend wrote the first few lines a nd i completed it. grin
Re: Nice Poetry In Pidgin English by dammeg: 3:42pm On Jan 26, 2007
dat joke was tite, u must be rily talented kip it up layi
Re: Nice Poetry In Pidgin English by omo(f): 7:52pm On Jan 26, 2007
mehn dat ur poem na die, 4 real!
but dat blow wey u collect, d thing don dey heal?
Re: Nice Poetry In Pidgin English by Lalas(m): 11:33pm On Jan 26, 2007
blend it all!! nice one oo!! kai, wetin dey interest me na that aunty from shangai,
Re: Nice Poetry In Pidgin English by kellorah: 4:44pm On Jan 27, 2007
layi, for real? shocked
dat was clever!! cool
Re: Nice Poetry In Pidgin English by omogenaija(f): 4:27am On Jan 28, 2007
do u have more poetry ?
Re: Nice Poetry In Pidgin English by oIo(m): 7:09am On Jan 28, 2007
chai,
i wan laf die
but e be like say dis layi guy dey lie
becos no be only 4 eye him get scar
i sure say d scar na 4 d eye of him "down"
becos if i be uncle malai,
i 4 don kill am,
well sha, d poem's tite,
Re: Nice Poetry In Pidgin English by Zebedee(m): 2:24pm On Jan 29, 2007
haba lai
the sharp guy
shei i warned ya
but u thro wey eye
until uncle brush ur eye
i wan laf die
wen i imagine ur eye
as e red black n dry
i no sey nexy time
u no go near anti from shanghai
even if ur tin over high
u go tell sey chill guy
or go find ur type

once again lai
shey u go tire
if anti from shanghai
come meet u for nite
with her eyes red from cry
sey inside her belle na ur child

i dey wait for ur answer, rite?

1 Like

Re: Nice Poetry In Pidgin English by segoye2(m): 11:08am On Feb 01, 2007
Man Layi,

This peom too tite, I get high respect for oyinbo man peom, but the first look at this pigdin poem, men is great!.
I belif wit complete coporation from our brothers in Waffi and Effa, we go build a strong home of pidgin  poem, D best over on nairaland.

Na great thing u get bro. keep it up!

I dey enjoy all D poems, e dey flow like shaw!
Re: Nice Poetry In Pidgin English by afrikangal(f): 1:42pm On Feb 02, 2007
it,s too funny and interesting.i hope u no go catch aidsl ol.too talented and extra smiley smileycorrupt.i can,t stop laughin 2 ma self takia smiley smiley smiley
Re: Nice Poetry In Pidgin English by nike4luv(f): 1:49pm On Feb 02, 2007
omg, thats soo hilarious.
Re: Nice Poetry In Pidgin English by teno(f): 8:19pm On Feb 14, 2007
i luv the pidgin poem concept. that's great
Re: Nice Poetry In Pidgin English by saintsam(m): 12:59pm On Feb 15, 2007
nice flows, nice rhymes
Dem talk am say na hard situation na person take dey discover im talent,
layi keep it up, I hope u don treat that patch 4 ur eye,abi na patch 4 beneath?
if na patch 4 beneath (clears throat) I nor fit shout,
anyhow, next time, u go tell bros make im cool down, if im wan show imself. lol.

I FEEL U LAYE.GIVE ME MORE.
Re: Nice Poetry In Pidgin English by LondonCool(m): 2:39pm On Feb 15, 2007
Can I buy the copyright to the Poem, I have a Dj/producer who is ready to add some cool lyrics and background dubs/vocals to the poem at our Underground Studio ??
Re: Nice Poetry In Pidgin English by naijagal(f): 2:58pm On Feb 17, 2007
layi, good job with da poem

got another one, doesn't have to be bout shagging though! wink
Re: Nice Poetry In Pidgin English by layi(m): 3:37am On Feb 19, 2007
LondonCool:

Can I buy the copyright to the Poem, I have a Dj/producer who is ready to add some cool lyrics and background dubs/vocals to the poem at our Underground Studio ??

Sure i can sell u the copyright if your offer is good. I got some more. Send an Email to
Re: Nice Poetry In Pidgin English by misright(f): 11:20am On Mar 30, 2007
Layi, no be lie; i wan buy de hol of u go because yr poem, cai, i like kan no be small. How much u fit cost? angel4_mii@yahoo.com

(1) (2) (Reply)

Today Is World Poetry Day: Write Something / A Voice That Speaks / Love is Like a Rose

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 32
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.