Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / NewStats: 3,150,645 members, 7,809,433 topics. Date: Friday, 26 April 2024 at 09:32 AM |
Nairaland Forum / Entertainment / Literature / Poems For Review / Nice Poetry In Pidgin English (11968 Views)
. / A Poem In Pidgin Language: Temptations In Our Nation / Can I Publish My Poetry In An Ebook Format? (2) (3) (4)
Re: Nice Poetry In Pidgin English by layi(m): 11:07pm On Mar 30, 2007 |
@misright U sure say u fit handle me? |
Re: Nice Poetry In Pidgin English by misright(f): 10:03am On Mar 31, 2007 |
layi: Why i no go fit? I don buy people wey i pass you. I get money fa!! But tell me, how much make i pay you abi you no get price? |
Re: Nice Poetry In Pidgin English by denex: 3:02am On Jul 24, 2007 |
WHITE SKIN, BLACK MAN. So I fair? Who come bad patapata? I still dey try Who come worst pass? I yellow na im make me fair My brother different so therefore E bad Na you come good because you white Thank God I manage fair, my own don better. My sister, you no fit white sh`a try fair If you no fit fly, shey you go still jump? Take wig make you wear,see cream sef make you rub No be God? Black na disease wey get drugs. Thank you Oyibo, you too try for us If no be you, we still for dey mad Thank you say this blackness go soon stop Thank you O, this madness go soon cure. But no mind me O, I jus wan ask No jus mind me at all, but why you dey tan? If black so bad, why you like am. E wan come be say na you sef dey mad. Sorry O, but E dey somehow You no like black but you wan black Na white better pass, you born half caste Which kain palaver come be all that? Oyibo sir, abeg I know understand. Master please help me explain Jesus, God, Angel: all na white. This your wayo sef, na today? Everything wey black jus bad Black magic, black leg, even black heart sef With your skin like overall eczema, Na you still wan dey criticize. But me I never see person wey black before Me na yellow, my wife brown, my pickin chocolate. E come be like say na ya own brain black you no see black but you think black, you imagine black. So now who come black? Your coat, your car, everything black Dye you hair black, smoke your air black, wear dark shade make you dey see black. So bros, tell me who come bad. You wan' come brainwash your slave: "Black is beautiful"; "black n proud" you forget say black na state of mind. You don already black finish You jus dey shame to talk am But as you dey resist na ya sef you dey punish. You wan black, you dey try, so claim am with pride. Crazeman wey gree don already cure. So go ask John Hawkins, ask Lord Lugard. Who come kill my papa, who thief my land? Black Man! NEX. 1 Like |
Re: Nice Poetry In Pidgin English by RuuDie(m): 9:51am On Jul 31, 2007 |
@Layi, would u like 2 be a part of the "Poetry Book" project crew? we could have some of ur poems in the book and publish it. . . there's a group of N.Landers who've signified interest already; whadya say? |
Re: Nice Poetry In Pidgin English by layi(m): 10:20am On Aug 03, 2007 |
Ok. I'm in |
Re: Nice Poetry In Pidgin English by firestar(f): 4:30pm On Feb 28, 2012 |
Dayum! Angst for pidgin na wetin kill am. E fly, E tight die! |
Re: Nice Poetry In Pidgin English by alanrewaju: 7:22am On Mar 23, 2012 |
@denex nice !!! U try no b small. |
Re: Nice Poetry In Pidgin English by Isao(m): 7:52pm On Jun 06, 2012 |
@man-eater 'na tyson blow uncle take reply' is how e contakt d patch4ey |
A Voice That Speaks / Today Is World Poetry Day: Write Something / Love is Like a Rose
(Go Up)
Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 14 |