Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,150,729 members, 7,809,793 topics. Date: Friday, 26 April 2024 at 03:02 PM

7 Tins Wey You No Know About Young John Da Wicked Producer - Celebrities - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Celebrities / 7 Tins Wey You No Know About Young John Da Wicked Producer (2011 Views)

She No Know Sey I Be Celebrity- Regina Daniels Says As Mom Makes Her Wash Plates / [biography] Young John The Wicked Producer / Lil Kesh And Young John Fell Twice While Performing On Stage (2) (3) (4)

(1) (Reply)

7 Tins Wey You No Know About Young John Da Wicked Producer by NewsinPidgin(f): 9:37am On Aug 22, 2017
Young John The Wicked Producer na record producer and audio engineer for Naija. For plenty plenty songs, you go dey hear "It's young d wicked producer" and him don dey make wave for Naija sotey even for NET list of Naija top 7 biggest producers, dem rank am No. 3

Check out seven tins wey you no know about Young John The Wicked Producer

1. Plenty plenty people know am as Young John but d name wey him mama and papa give am wen dem born am na Udomboso John Saviours.

2. Him na just 22 years as dem born am for February 16, 1995 wey make am the youngest Producer for Naija.

3. Young John na correct Akwa ibom boy. The only tin be say dem born am for Ibadan and na dia him live most of him life but now him dey Lagos.

4. Him still be student. As him dey take manage school with him producer life, I no sabi but Young John na student of Communication and Language Arts for the University of Ibadan.

5. Even as Young John never dey endorsed by any company yet, him don already dey No.3 for the list of top 10 best producers for Naija. And at the age of 22, Young John still dey work on improving him career, him know as the beat making business dey change over time. Young John no dey charge anything less dan 500,000 to 700,000 Naira for beat production.
And as industry report take put am, him worth up to 15million Naira.

6. Young John don produce plenty songs especially for dem YBNL people. Some of the hit songs wey him don produce na:

Lil Kesh - Gbese and Efejoku

Davido - Biggest Backside and The Badest

Olamide - Bobo, Story for the gods and Eyan
Mayweather

Olamide ft Phyno - 2Kings

Kiss Daniel - Mama

7. Him bin be Nominee for Best Producer for Nigerian Entertainment Awards (NET) for 2015. Headies nominate am again for best producer for 2015. Finally, him come win Best Producer for Headies for 2016.


Source: http://newsinpidgin.ng/7-tins-wey-u-no-know-about-young-john/

#confamtori

For plenty plenty hot tori : www.newsinpidgin.ng

Re: 7 Tins Wey You No Know About Young John Da Wicked Producer by dotunbekro06(m): 10:04am On Aug 22, 2017
Me when i hear.. Its Young John the wicked producer.....




Koni baje fun e..

Re: 7 Tins Wey You No Know About Young John Da Wicked Producer by sluvy4tune(m): 12:59pm On Aug 22, 2017
Its Young John tha wickedest producer


Dat Akwa Ibom boy

(1) (Reply)

Davido Ft Wizkid Titled "Don't Care". You need to watch this! / Photo Of American Rapper, Cardi B Rocking A Native Attire Hits The Internet / Top 5 Most Popular Nigerian Celebrities Who Have No Tattoos

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 14
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.