Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,153,729 members, 7,820,522 topics. Date: Tuesday, 07 May 2024 at 04:27 PM

Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) - Literature (8) - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Literature / Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) (61918 Views)

Water Strike- A Comedy (18+) / FRESH Toto(adventure Of Prick Master And Miss Young Toto? / Innocent Ilo Wins 2020 Commonwealth Short-story For African Region (2) (3) (4)

(1) (2) (3) ... (5) (6) (7) (8) (9) (10) (11) ... (22) (Reply) (Go Down)

Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 1:13pm On Dec 01, 2018
Episode 37

(youngzubi birthday part 2)

ahhhh people shout,
come o
wetin nepa people self enter here dey fine Umoren Elisha Lishakeyz for?

Naso the nepa people shout say baba never pay dem since for two years now,

say anytime make dem come cut him light,
baba go lock him gate from the inside.
With that him two useless dogs make no dey chop belleful dey roam about for the compound

And the pole dem need climb dey inside him compound,
which kind thing be that?

Naso nepa people vex shout
enough is enough nahim make we come find the idiot for here so

before we know everybody shout
come o wetin be this for here?

Wetin be all this shit for here so,
naso people vex carry the nepa people dey go gate

chaiii laugh won kill me
as dem reach naso dem jack dem up troway all of them comot go outside from on top of the gate,

haahhahhahaaa laugh won kill everybody

as we dey laugh
naso one guy make dem dey call Sekpe Timothy come shout
come o where the celebrant dey na?

Ahhhh people shout wetin happen?

Oboy we no believe say dem follow troway youngzubi baba go outside ontop gate with dem the nepa people dem o

chaiiii people shout
but we think say na Umoren Elisha Lishakeyz and dem the nepa people we jack go gate na

naso crowd rush go outside
chaiii we no believe say youngzubi fall inside gotter with dem the nepa people

ahhhh people shout carry youngzubi enter inside rumours hotel go clean am up for toilet

chaiii see comotion for rumours hotel here so,
come o
na youngzubi be this?

As things come take be for here
naso one guy make dem dey call Undisputable Tollified Dee start to dey laugh youngzubi

hahahahahaha
i don die wetin be this make happen for here?

Hahahahahah

Oboy the thing vex me baba olowo

naso i face am
see come u this great fool make do face like handkerchief make dem dey share for cannaanland winners chapel church so

Undisputable Tollified Dick abi wetin be your long name self?

na ur type dem suppose use exchange collect one bag of beans on loan,
use am take celebrate Sekpe Timothy birthday chop finish troway the sack

ahhhh the thing vex Sekpe Timothy

see come baba olowo na thunder go help me fire your half yansh comot for there idiot

naso i vex
see come Sekpe Timothy
u do face like all those aboki make dey roam about for the street make no get work so

before u go resemble rex v eddie black yansh

see ur name self Sekpe Timothy
u be like all those old men make dey give out ciggar on loan,
if the person smoke finish anytime make him like him go come pay the money

na ur type dey go thief person boxers go sell

u do face like old akwa ibom road

ahhhh naso Sekpe Timothy, Umoren Elisha Lishakeyz and Undisputable Tollified Dee shout
see come wetin be this?

Oboy before i know
like so dem jack me up baba olowo dey go gate

chaiiii laugh won kill everybody wetin be this?

As dem carry me reach the gate

naso dem tell me say,
since make dem dey troway people go outside from ontop the gate so

dem never troway me baba olowo

say na me dem suppose to dey troway go outside comot pass everyday self

chaiii before i know i see my self for air

hahaahahhahaha

wetin surprise everybody pass na

as dem trow me up
the three fools Undisputable Tollified Dee, Sekpe Timothy, and Umoren Elisha Lishakeyz na dem see their self for outside dey shout dey land with neck

hahahhhaaa
come o wetin happen here so?
Even me self i surprise o

how manage dem no see me troway comot?

Haahahahhahaa
laugh won kill everybody
hahahhahahahaaa
hahahahhahahahhahaaa

abeg this is really funny Olalekan Adeleye shout

na dem troway theirselfs go outside from ontop the gate

chaiiiii all this once na three useless fools
hahahhahahahaaa
laugh won kill everybody

but people come dey ask
how manage dem no see baba olowo troway comot go outside so?

Ahhhh naso i stand up clean my body go sidon for my seat for inside rumours hotel here

chaiiii laugh won kill people
hahhahahhaha
i never see this kind strange thing for my life here before

hahahahaha

but come o
baba olowo all your things funny o

as things come take be for here
guys dem dey high for youngzubi birthday here
even babes dem dey wine yansh, dey dance for here dey happy

ahhh today is a happy day for me baba olowo as me and my guy half kilo we dey high dey talk rubish

before we know one group of dancers dem rush come outside start to dey dance

oboy dem sabi dance die,
rude king baba u be the boss
na your music dey blow like this?

Men dem dey spray money
chaiii wat a happy day for youngzubi birthday here so

naso i rush grab one babe start to dey rock her big yansh

oboy my guy half kilo self no dull o,
baba rush carry one fine yellow babe dey rock self

see noise for rumours hotel here so,
youngzubi don freshen up self come outside with new shirt make dem write rex v eddie is wanted

come o
na the hotel management shirt dem give youngzubi make him wear so?

Laugh won kill me
hahhahahaaha

chaii what a crazy world

episode 38 coming soon live on Hd
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 10:11pm On Dec 02, 2018
Episode 38

(who wants to be a millionaire)

oboy the thing surprise everybody here say youngzubi wear t-shirt make dem write rex v eddie is wanted

come o
laugh won kill everybody

wetin surprise me pass be say the rex v eddie make dem dey fine sidon oposite me for my table here dey sip mait and bread,

baba bone face sidon no laugh,

even me self look am troway face wetin consine me

naso people shout see come yongzubi which kind wide shirt make dey shapeless this people give u wear so?

hahahahhahahaa
laugh won kill me

see as the t-shirt big like john arigu primary school uniform,
when baba still dey go school those days

chaiii laugh won kill people
see as the t-shirt wide like sekpe timothy their bedsheet

hahahahahahhaa
as we dey laugh

naso one guy make dem dey call Yvnq Silva carry plenty gala for head enter rumours hotel dey shout buy your gala here

as baba enter naso some guys dem show am road
abeg follow us we go show u where you go sell am plenty pass

naso dem direct Yvnq Silva dey go the gate make dey for backyard side of rumours hotel

chaiii laugh won kill me

as baba take enter here na like so dem excort am sharp sharp go troway comot from backyard go outside

the only thing make we see na the guys dem make excort am go backyard

naso all of them come back go sidon for their seats,
chaiii we no see the gala guy again o

as things come take be for here
naso 2face run come outside say make youngzubi and him crew dem no vex o

say the program make dem dey call who wants to be a millionaire don already rent out their hotel today

and youngzubi birthday for here na even un expected to dem

youngzubi birthday na guys just shout enter here dey shine teeth say na baba birthday be today

sharp sharp drinks don dey fall out without even booking the place self

naso one guy make dem dey call Timmy Blvk stand up shout 2face na thunder go fire you

chaiii laugh won kill everybody
hahahahaha
wetin be this?

Come o
na 2face u dey talk to like this?

Before we know the host for the
program who wants to be a millionaire rush come outside

hello everyone and good evening to you all
my name is KingJunior John
i am your host for today on who wants to be a millionaire

and i will be calling out the man who will be on the hot seat tonight and will be playing to win 10 million naira

chaiiii people shout
woooooooooow
thats really huge

naso the host continue
and the lucky contestant is ITz Oluwa Thunder

chaiiii see shout for rumours hotel here
see standing ovation for ITz Oluwa Thunder

baba rush come outside dey shine teeth

sharp sharp ITz Oluwa Thunder sidon for the hot seat

naso dem start

the host tell am i will ask you only 10 questions tonight

and if you get them correctly then you will win a wooping sum of 10 million naira cash

chaiii ITz Oluwa Thunder bone face look the host
baba mind fly with fear

the host ask am are you ready
naso him reply yes am ready

ok question one

how many episodes has baba olowo the long prick droped so far?
(A) 18
(B) 72
(C) 38
(D) 220

naso one guy make dem dey call Itz Mhiztar Holuwarseun shout from where fans dem sidon

say the answer na 220 episodes

chaiii the thing surprise me baba olowo

naso i tell am
see come Itz Mhiztar Holuwarseun as u do face like old transformer make dem won change buy new one so

na ur type people dey use as collateral take rent person bicycle drive am finish no gree return am

which time i take post reach 220 episodes
see come mind ur self o

naso ITz Oluwa Thunder look the idiot hiss
sorry sir the answer is 38 episodes

chaiiii people shine teeth clap for am

the host con tell am ok you are correct ITz Oluwa Thunder
now u have won for your self 50,000 naira

question two

who is the grandfather of sekpe timothy

(A) madman F kennedy
(B) linus K coward
(C) longthroat B oshiomole
(D) rex v buffalo

chaiii which kind useless question be this one na?

Naso ITz Oluwa Thunder tell the host abeg i want to make a phone call

ahhh a phone call to who?

Naso baba tell dem
please help me call sekpe timothy himself

sharp sharp dem make call to sekpe timothy but na him junior brother pick the call

hello is this sekpe timothy on the line?

Naso the junior talk
wetin happen oga,
yes am sekpe timothy abeg wetin sup

please you are live on who wants to be a millionaire
and your friend ITz Oluwa Thunder needs your help on a particular question

naso ITz Oluwa Thunder rush ask am the question make the host been ask am

naso the guy shout for phone
see come na thunder go help me fire your butt hole there idiot
wetin consine me with say u won win 10 million naira,

after all if i tell u the answer
even 10 naira i no go see from u fool
sharp sharp the guy cut the call o

chaiii laugh won kill everybody
hahahahhahaa

that guy get bad mouth o
i for say why him name na sekpe timothy

u do face like wetin dem dey use as curse take swear give person,

see as this coward don blow up this guy chance

chaiii

episode 39 coming soon live on Hd
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 7:57am On Dec 03, 2018
Abeg make una dey drop una comments for here

more funny episodes of baba olowo d long prick will be coming soon live on Hd

if possible abeg i go need una votes for this month literature 5k award
abeg all for the fun so we can laugh out the days stress

baba olowo
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 1:53pm On Dec 04, 2018
Episode 39

(who wants to be a millionaire part 2)

naso everybody for rumours hotel shout
see come sekpe timothy u dey very useless and stupid for cutting that call,
before we know like so ITz Oluwa Thunder shout like person make won cry,

ahhhh sekpe timothy see why i no like you since when i know you
you just dey very useless to me,
you never even add any meaningfull thing to my life idiot,

chaiii laugh won kill everybody for here
hahahhahahahhaha

inshort sekpe timothy na fully grown he-goat

naso ITz Oluwa Thunder manage try him luck say the answer na
madman F kennedy,

ahhh people shout how you take know?

But the thing surprise everybody as the host shout,
now you have won for yourself 150,000 naira

ahhhh people shout
woooooowww
chaiii
see narrow excape
but come o
na madman F kennedy be sekpe grandfather name?

The host continue again
question 3

who was the first person to defraud 2face rumours hotel, from only
declaring free drinks for everybody

(A) yougzubi
(B) rex v eddie
(C) john arigu
(D) small doctor

chaiii we no believe ITz Oluwa Thunder answer the question sharp sharp
the answer is small doctor
chaiii the host shout
u have won for your self 300,000 naira

aaaah everybody shout
that answer dey very easy na

naso the host continue again
question four

who is the father of all rapist?

(A) Aikoriegie Solomon
(B) D blacc
(C) half kilo baba
(D) Bamidele Edreez Olumide

chaiii which kind useless question be this one na?

Naso ITz Oluwa Thunder tell the host abeg i want to ask the audience?

Chaiii even audience dem surprise o
before we know one guy make dem dey call John Oyeniyi shout from the fans dem
see come ITz Oluwa Thunder
u do face like back of pot so

na your type dey enter bush go kidnap bush baby pikin sell am use the money go sing music for studio

as your name take answer thunder for the ending so
na thunder make wear short nicker nahim go fire your left eye there idiot

chaii laugh won kill everybody
hahahhahahaha

which kind John Oyeniyi be this one self?

Before we know the whole audience dem don vote finish with their phones

chaiii naso ITz Oluwa Thunder tell the host anybody make get the
highest vote from the audience, him also go choose as the answer

oboy we no believe say na D blacc name nahim get the highest vote pass o

the host ask ITz Oluwa Thunder is your final answer D blacc baba
naso him reply the host yes am ok with that

chaiii the host shout you have won for yourself 500,000 naira cash

aaaahhh the whole crowd shout
before we know everybody grab their babes tight o

D blacc baba even dey for here self,
baba sidon also with them the audience dey vote

baba troway face dey lick sweet and biscuit

chaiii so D blacc na grand master of rapist?

Naso the host continue
question five

who is the first person that has yabbed baba olowo that made him laugh himself

(A) devilmaycry= baba olowo u do face like juju pot
(B) iambees baba = baba olowo the 14 inch prick
(C) youngzubi = baba olowo you do neck like cranshaft
(D) ann2012 = who is this mugu bikonu?

laugh won kill everybody for here
hahahahhahahahahha
hahhahahahahhahaha

dem laugh me baba olowo sotey my pant won tear like the one make D blacc wear come the hotel

hahahhaha
come o
baba olowo na you be this?
Chaiii see bad bad yabbings

naso ITz Oluwa Thunder say him go try him luck again

the answer is youngzubi = baba olowo u do neck like cranshaft

we no believe as the host shout
now you have won for yourself 1 million nara cash

chaiiii see shout for rumours hotel here so
hahahahhahaaa dem won use laugh take break my waist

naso the host say now we will be going for a break
we will return to you soon to finish off this program

chaiii naso the host and ITz Oluwa Thunder enter inside go rest
naso the thing vex me baba olowo
sharp sharp i rush climb the stage collect mic

see come youngzubi no be say wetin you yab me then really pain me o

but the thing really make me laugh myself really hard,
chaiiii na me be this?
That yab na matured man yabbing be that

but see come as u do face like old bicycle so
na your type people dey use take exchange collect bitter cola use am take welcome their visitors for olden days so

u carry neck like bag of beans,
well i no blame u na rex v eddie cause am that day

see come rex v eddie u do eye like owl make hungry won kill so,
na your type your people for take exchange collect walking stick,
you carry face like devil handbag

chaiiii see as everybody burst laugh for here
hahahhahahhhaaaa
baba olowo you be truelly madman
abeg entertain us more abeg

see as fans dey shout dey hail me
king baba olowo d long prick
naso one guy make dem dey call Kvñg Sãvãgë stand up shout

abeg na baba olowo d very long prick

chaiii see as everybody burst laugh
hahahhahahaah
naso i face am

see come Kvñg Sãvãgë u do face like simbi goes to school so
na your type madmen go see get hope
as you carry face like D blacc inner boxers make don tear so

episode 40 coming soon
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 11:18am On Dec 05, 2018
Episode 40

(who wants to be a millionaire part 3)

hahaaahahahaaa
everybody burst laugh
come o
baba olowo your mouth no good
abeg you go school of yabbing?

Chaiii wetin be this?

Abeg baba olowo continue abeg
we no want that program who wants to be a millionaire again abeg,

we prefer all this your jokes pass the program die

hahhahahahaaaa
everybody just dey speechless hold their belle dey laugh
hahahahhahahaaa
i don die

come o
why here be like where dem dey train mad people?

Chaiiii wetin be this
hahahahahhahahhahaa

naso the tv camera show rex v eddie dey laugh fall for ground hold belle dey scatter everywhere

na rope people use take tie baba
before him go mad enter street

come o
no be rex v eddie make dem declare wanted be this?

Even 2face self dey there self dey laugh hold him shine shine head like wetin cow lick remain,

chaiiii baba olowo you too funny
abeg no kill people with all this your jokes o

naso i continue
abeg if you prefer baba olowo story than this who wants to be a millionaire program abeg try raise your hand up?

Oboy i no believe say the whole crowd for rumours hotel carry their hands up still dey laugh

hahahhahahahahha
hahahahahahahahhaha

even some people dem no know how to laugh again naso dem change their laugh to

kikikikkkkiiiiikikkkkik
kikikiikkkkiiiiiiikikikik

come o
na motor engine we dey try start so for here

naso i tell the crowd
abeg since when anybody here dey go secondary school make dem been dey teach us french language

abeg which any of us for here now sabi speak french?

chaiii dem just dey waist their time dey teach us french language like say we go use am for this our country make we dey so

as i still dey talk
before i know that mental bouncer make dey for rumours hotel climb stage

the bouncer really get mental problem

naso him rush carry me baba olowo troway comot from stage go meet fans dem

chaiiii
laugh won kill everybody
hahahahhahahahahahhahah

come o
baba olowo na you be this?
I swear na the only way to troway this fool comot from stage be that

hahahhahahahaaa
hahhahahhahahhaa

we no believe say the mental bouncer make troway me comot fall for stage start to dey laugh like mad dog make go lick oil

hahahahhahahhaa
hahahhahahahaaaa

oboy see another round of laughing o

come o
this fool make dey ontop stage dey laugh like this

before we know people climb ontop stage go tie the mental bouncer carry am comot

chaiiii laugh won kill everybody
baba olowo you too funny

hahahhahahahhahah
as people still dey laugh

dem dey shout we still need baba olowo
bring back baba olowo on top the stage abeg

but as dem dey shout
naso the host and ITz Oluwa Thunder come outside

see come una make do face like back of cloth so

make una do fast abeg make baba olowo come still entertain us for here abeg

naso the program who wants to be a millionaire start again

naso the host shout

ok viewers and everyone seated here we are back from the break

so we will continue on this show to see if the contestant will win the jackpot prize of 10 million naira cash

ok lets begin

question six

in which words can you best decribe youngzubi
(A) youngzubi is a goat
(B) youngzubi is a butt hole
(C) youngzubi is a thief
(D) youngzubi is a boy

chaiii laugh won kill everybody
hahahhahahahahaa

even the tv camera show youngzubi dey laugh

hahahahhahaa
which kind useless question be this one self?

See come youngzubi as u dey laugh so like antelop make dey beg for return match so,
say na ojoro dem do am for the last match, him need return leg

chaiiii wetin be this?
Naso the whole crowd shout youngzubi we love you!

Ahhh baba get fans die for here

before we know ITz Oluwa Thunder shout
the answer is youngzubi is a boy

chaiii naso the host shout
you have won for yourself 2 million naira cash

aahhahhh see shout for rumours hotel here
keep it up ITz Oluwa Thunder baba you are getting there

come o
so una mean say youngzubi is a mere boy?

See come baba olowo dem no shook your mouth for this matter so
before you do neck like cow teeth

chaiiii everybody burst laugh
hahahahhahahahahhaaaa
hahahahhahahahhahaa

naso i look the guy make yab me
make dem dey call AY Lambo

as i won yab am naso crowd rush tie my mouth with rope

abeg no yab am o
abeg we no won laugh troway chair make we sidon o

hahahhahahaa
hahahhahahahahhahha

before we know one bros troway chair make him sidon fall for groud dey laugh
hahahhahahahhaa

naso dem ask the bros abeg wetin happen na?

Naso the bros tell dem
abeg this thing go sound stupid to una o
but i just dey imagine the kind of yab baba olowo for yab this guy AY Lambo now self

abeg make una leave am make him yab this guy abeg make my laugh increase pass like this abeg

hahhahahahahaaahahaa
the whole crowd burst laugh

come o
baba olowo na you we come watch abi na who wants to be a millionaire show?

Everybody dey laugh except D blacc and the guy make be the host for the show

baba dem serious bone face

Episodoe 41 coming soon live on Hd
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 8:25am On Dec 06, 2018
baba olowo
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by mirabel9(f): 1:31pm On Dec 23, 2018
Ride on, the story is intresting
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 11:41pm On Dec 26, 2018
https://emeka10..com

Its been a long road, but we are here now. maywether vs pacquio (the fight of the century)

abeg all my fans dem baba olowo is back and better with a new blog

dem say dem bad but i swear dem do noting o,
dem say dem go trow me punch but i swear dem no reach o
twenty man shall fall that day if you cross my lane o
all your man shall fall that day if you cross my lane o
oya back to the matter open and close, touch your toes oya baby oya, see come sekpe timothy abeg help me complete the song abeg

wixkid back to the matter don make me remember my blog,
naso sharp sharp i complete am under one day,

abeg now make i don get new blog una know say i must dey update am with new episodes dem everyday,

some guys now go dey happy dey shine teeth,
i no been believe say a lot of people here are really in love with my story baba olowo,

chaii see as i dey use una sweet feelings for the story dey play

please accept my apologies,
i no believe as people dey yan me say dem really love my story,

anyways i go continue from where i been stop since baba olowo no travel go village again o

abeg laugh responsibly

https://emeka10..com

baba olowo
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 8:44am On Dec 27, 2018
I Will be posting my next episode 41 very soon on my new blog, do check back to read baba olowo new latest episode thanks

all for the fun

https://emeka10..com

baba olowo
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 1:15am On Dec 28, 2018
Episode 41
(who wants to be a millionaire part 4)

naso the whole crowd dey laugh like mad person make win 2 million naira for bet9ja,

chaiii baba olowo you too funny abeg,

as everybody just dey laugh dey catch fun,
naso d blacc baba shout

abeg whats funny here?
Why cant we all concentrate on what we are all here to do?
And stop listening to morons like this fool baba olowo,

chaiii i don suffer,
people won use laugh break my waist,
hahhahahhahaahhaha
hahahhahahahhahahaha

come o,
baba olowo na you be this?

Ahhh the thing pain me die
naso i face am

see come d blacc,
as you do face like motuary attendant so

na your type dey go kidnap person small goat go rape for bush,

see as you serious like say dem dey pay you money,

na thunder make wear short nicker nahim go fire you there idiot

hahahhahahahhaha
the whole crowd burst laugh

chaiii d blacc na you be this?

Naso i still continue

see come d blacc,
as you take resemble wetin dem use take stone devil so,

na people like you go visit my blog, read my funny story finish laugh as you want,

then you go come here bone face like say nothing happen,

mind yourself o,
or else you go smell buffalo yansh

oboy see laugh for rumours hotel
hahahhahahahhahhaa

abeg baba olowo leave am o,
e don do,
make we no laugh too much vex carry d blacc go trowey comot from fence go outside

hahahahahahhahaha
naso one bros stand up shout,

see come d blacc,
you no know say all work and no play make jack a dull boy?

Naso d blacc answer the bros,
is that why we all will be embarrasing ourselves and be laughing like fully grown fools?

Chaiiii the thing pain guys dem,
wetin this bitch ass dey talk self?

Before we know,
one babe carry bottle stone d blacc gbosa!!

Baba faint once,

Chaiii laugh won kill everybody
hahhahhahahahahahah

na wetin fit this idiot be that,

naso the babe para,
anybody make go deny me my happiness to dey laugh for baba olowo jokes, i swear na kill i go kill the person

chaiii but this one don go too far o

naso the babe continue,

do you think its easy composing funny jokes and stories for everyone to read and laugh?

If its easy den go and start your own fool,

chaiii naso people con calm the babe down o

ahhh d blacc don faint chaiii,

na some people rush baba dey go hospital,

oboy na later we con dey here say the hospital make dem carry am go reject am o,

dem say dem no fit treat am,
because how him go dey spoil the fun make we dey get from baba olowo

chaiiii so even doctors dem dey read baba olowo funny episodes?

Oboy naso rumours hotel come back to normal,
who wants to be a millionaire show con resume their program

naso the host shout,

question seven,

why did baba olowo failed to travel to his village this christmas, after when he told us he would be traveling?

(A) baba no get transport money
(B) baba no like village
(C) baba no just know wetin dey worry am
(D) baba na fool

chaiii which kind useless question be this one na?

Hahahahahahahahhahaaha
hahahahahahahahahhaha

see as everybody dey laugh me baba olowo

chaiii i no believe some bros make dey my back shout

abeg the answer na
(A) baba olowo no get transport money,

hahahhahahahhahahahha
hahhaahahahahhahahahha

see laugh for rumours hotel
chaiii baba olowo na you be this?

Naso one babe make get long mouth like peacork ask me

abeg baba olowo na true say you no get transport take travel down to your village this christmas?

Hahahahahahahhah
see laugh for everywhere

to read more to the end do visit my blog https://emeka10..com
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 2:40pm On Dec 28, 2018
Abeg all my fans dem episode 42 will be posted soon,
do check back my main blog https://emeka10..com

i will be posting this baba olowo commedy story everyday from now so do visit my blog anytime you like for my new update

baba olowo
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 5:09pm On Dec 28, 2018
Do visit my blog to read all my episodes of baba olowo

baba olowo
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 6:14pm On Dec 28, 2018
Its been a long road but we are here now,

do check out my new blog
https://emeka10..com

i will be posting baba olowo new episodes everyday here, but i will be posting half of it here ,
so if you want to read my full complete episode everyday then you really need to visit my new blog and read it there thanks

do watch out for episode 42 coming soon on my new blog

baba olowo
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 11:33am On Dec 29, 2018
Episode 42
(who wants to be a millionaire part 5)
chaiii see as the whole crowd just dey point me dey laugh me
hahhaahahhaha
hahhahahahha
naso you take broke reach baba olowo?
Ahhh i no just fit talk anything shame won just kill me,
naso the host shout,
question eight,
which country was sekpe timothy born?
(A) kenya
(B) burkina faso
(C) mozambique
(D) guinea bisua
hahahahahhahaha
see as the whole crowd burst laugh,
chaiii so sekpe timothy no be even nigerian?
I for say,because i dey imagine why person papa go look him pikin finish name am sekpe timothy,
hahahhahahahahha
see laugh for rumours hotel
chaiii sekpe timothy na great fool,
naso ITz Oluwa Thunder tell the host,
abeg can i still make a call to sekpe timothy?
Naso the host tell am you are free
sharp sharp dem call sekpe timothy
the phone dey ring but the guy no gree pick am,
before we know person pick,
as ITz Oluwa Thunder won ask am the question,
naso we hear from the phone, na thunder go fire your yansh there idiot,
sharp sharp the guy hiss cut the call,

abeg na the half story be this, to read the complete story do visit my blog https://emeka10..com

this story na daily i go dey post am for my blog so watch out for episode 43

baba olowo
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 9:53am On Dec 30, 2018
Episode 43
(who wants to be a millionaire past 6)

chaiii we no believe as one bros stand up shout say baba olowo episode 1 no sweet abeg,

ahhh people shock,

come o,
this bros so, abeg where dem born am?
Na for this earth here abi na for pluto?
Because i no sure say this bros na human being,

naso one babe shout,
abeg una sure say this bros no be alien?

Oboy people shout, even though him be alien we go help am beat out that alien spirit comot from him body,

before we know naso crowd rush the bros,
oboy see beating, dem beat am like person make go thief pepper,

hahhahahahahaaha
laugh won kill me,

to tell you how the thing take worst reach,
sharp sharp dem hand am over to soldiers dem make been dey guide the show,

na the soldiers dem tell us say na for barracks dem go continue the second round of beating for am,

but come o,
how normal person go talk say baba olowo story no sweet?

That person must be spiritually mad,

naso the host shout

question ten,
please you know this is the final question for you to win 10 million naira cash,

so here it is,

who is the greatest person,
nepa company has employed to be helping them to carry their ladder every time they want to disconnect peoples light,

(A) youngzubi
(B) sekpe timothy
(C) optimis prime
(D) rex v eddie

hahahhahahahahaha
hahahhaahahahahahha
see as everybody for rumours hotel burst laugh,

chaiii which kind useless question be this one self?

Naso people start to dey shout,
woooooooooo
ahhhhhhhhhhh

hahahahahahahahahaa
laugh won kill me die here o,

chaiii which kind nominees dem be all this one self?

Naso people start to dey guest o,
some say na sekpe timothy,
some say na rex v eddie,

naso one guy stand up shout say,
i swear i been don see youngzubi carry ladder for some nepa people
come disconnect light for our area before,

after the whole suffer make youngzubi don suffer carry heavy ladder for nepa people finish na 500 naira dem give baba,

hahahahahahhahahah
hahhaaahhahahahhahaa
laugh won kill everybody

to be continued in my blog https://emeka10..com
if you want to read the complete story do visit my blog,

baba olowo
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 7:51am On Dec 31, 2018
Episode 44
(baba olowo you too much abeg)

as people dey hail optimis prime baba,
naso one guy run go outside go check the kind better ride optimis prime go don dey drive by now,

since make baba don dey carry ladder for nepa people, since all this days of him youth,

chaiii the guy no believe him eyes,

ahhhh wetin be this?
The guy run come back con dey cry o,

naso people ask am wetin happen?

The guy shout,
chaiii optimis prime na disapointment o,

the only thing make i see for outside there na one heavy old ladder nahim i see o,

chaiii people surprise o,

come o optimis prime,
u mean say upon all the whole ladder make you dey carry for dem nepa people, na old ladder dem use take dash you as compensation?

hahahahahahhhhahaa
everybody for rumours hotel burst laugh,

haahahahaahaha
hahhahahhahaaa

naso one long mouth babe shout, so optimis prime no achieve any thing to dey carry ladder?

Hahahahahahahahahha
hahahahahaaaahah

people won use laugh break optimis prime waist

chaii what a shame,

naso me baba olowo stand up tell the babe,
if na you, shey you go fit achieve anything to dey carry ladder for nepa people?

Hahhahahahhahaa
everybody burst laugh
chaiiii no body for this life go fit achieve anything to dey carry ladder for nepa people,

but why dem con dey call optimis prime as the greatest person make carry ladder so?

Hahhahahahhahaha
this nepa people wicked o

as everybody dey laugh
naso one bros shout,
abeg baba long prick shey be you know say this show who wants to be a millionaire don finish?

Abeg climb stage go entertain us abeg,
naso i trowey face bone dey sip my malt and gala,

before i know,
that mental bouncer for rumours hotel grab me for neck jack me up dey climb on top stage,

hahahhahahahhaa
laugh won kill everybody

hahahhahhahahahaa
naso one bros shout abeg na just now the show won start self,

i shout you say wetin?

Imagine say time now na after 12 for night nahim person dey talk say na just now the show start,

una go pay me to entertain una?

As i look rumours hotel gate,
oboy na crowds dem dey enter o

guys dem don even call all their other friends dem say baba olowo won perform for rumours hotel
to be continued in my blog https://emeka10..com
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 10:45pm On Jan 01, 2019
Abeg all my readers them,
my episode 45 of my story is out already so if you want to read it please do visit my new blog https://emeka10..com

baba olowo
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 7:53am On Jan 04, 2019
Episode 46
(baba olowo you too much abeg part 2)
hahhahahhhahahhaa
see as everybody for rumours hotel burst laugh
chaiii so baba olowo, so na we you dey call bat make no dey gree confess all him sins abi?
but na half of him sins baba go confess, say make the priest manage am abeg,
naso one bros shout,
see come baba olowo,
as you do face like aboliki balm so,
na your type your people for take exchange collect one tuber of yam,cook am chop finish also share am for all their neighbours,
hahhahahahhahaa
see as people dey laugh
chaiii my belle o,
naso i answer the bros,
see come,
as you do face like saint vincent de poor society so,
na your type dey do yahoo for 12 years and you never still hit anytin,
common $20 dollars you never still see online since when you start idiot,
inshort for this whole crowd make dey here na you stupid pass,
naso i vex shout,
abeg bouncers dem make una help me carry that bros come outside make i see am yab so abeg,
before we know bouncers dem don go jack the bros one leg draw baba come outside,
baba dey shout,
ahhh i don die today o,
naso dem troway baba on top stage gbosa!!
Hahhahahahhahaha
everybody laugh tire,
so na you get mind yab baba olowo abi?
Oboy the bros start to dey beg o,
naso i ask am abeg wetin be your name self?
Baba tell me say,
my name na young wyzad
people burst laugh,
hahhahahahahhaha
abeg which one be young wyzad again na?
Ahhh baba start to dey beg,
abeg baba olowo na play i been dey follow you play o,
i no really mean am abeg,
make i go sit down for my seat abeg no yab me as i dey ontop stage here so,
naso people laugh shout,
abeg baba olowo yab am abeg make we laugh small

to read more do visit my blog https://emeka10..com
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 2:31pm On Jan 04, 2019
Coming soon episode 47
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 8:12am On Jan 05, 2019
Episode 47 of baba olowo d long prick,
(come o,na new year be this? A dedication to pat ogidi baba )

naso people laugh tire
hahahahahahaa
abeg baba olowo continue abeg,
naso i continue,
i know say some of una go dey wonder which kind mad stories this guy
Colbey Alex Xander don even write self?
But i go tell una say if anybody need am make una contact me baba
olowo on facebook,
naso people shout,
baba olowo you too much abeg,
more greese to your elbows,
naso i answer them,
abeg also if you want make i dey call your name as i dey usually do
for this my funny story baba olowo, you fit contact me baba olowo so
we fit negotiate as the thing go be,
as i look for where the whole crowds dem sidon,
naso i sight one bros make carry head like mountain of fire loudspeaker dem,
as i won yab the bros,
oboy we no believe say the bros run comot o,
baba run open gate dey run dey go house,
ahhh you won stay make baba olowo yab your life?
Oboy people just dey laugh dey catch fun,
baba olowo abeg continue we love you!!
Naso i shout,
abeg una help me remember this email marketing guy make dem dey call pat ogidi?
Baba don send me email sotey even when baba go dey for toilet him go
compose message send to all him email subscribers dem,
pat ogidi dey teach about importing stuffs at cheap rates from foreign
country, then you go sell them higher prize when the thing don get to
nigeria here so,
as your name take be pat ogidi so,
now you don make all your subscribers dem don dey eat agidi abi na eko
dem dey call am self,
as you do face like old dstv remote make don spoil so,
na your type isrealite for bible dey put for their warfront, make dem
their enemies see you kill sharp sharp,
as your mouth take sharp like crocodile tale so,
no time you no go always dey talk like antelop make dey see him period,
as you carry neck like all those old houses make full ajengunle,
hahhahahahahha
i don die o,
pat ogidi na you be this?
See as the whole crowd dey laugh baba,
chaiii baba olowo you too much o,
abeg to compose stuffs like this no easy at all,
naso i continue,
see come pat ogidi,
na because of you one of my guy don dey import baked fish dem,
baba go import finish, three days all the fish dem don spoil,
hahhahhahahhahaa
chaiii that my guy na great fool him be,
why you go even listen to this pat ogidi of a guy make do mouth like
trap make dem dey use catch rabbit,
but na later we come dey hear say the trap na only snakes the thing
dey see catch self,
chaiii that one na bad luck trap be that,
wetin we won use snakes dem do na?
Oboy we no believe say pat ogidi even dey for here dey laugh himself,
hahhahahahahhahaa
naso baba shout,
oh my gosh, this guy has killed me,
people burst laugh
hahahhahahahhahha
kikikikikiiiikkikiiiiiki
abeg come o,
na motor engine we dey repair for here?
Why person go dey laugh
kikikkkiikkikikiiiki?
Like rat make go thief red oil dey lick forget him brothers dem,
the rat won lick am only am so him fit forget him worries, and him fit
survive the days of hardship when food go scarce to see,
hahahhahahahhahaha
abeg all my fans dem,
laugh responsibly at your own risk,
naso one bros stand up shout,
abeg na when i don read baba olowo funny episodes dem finish na that
time my eyesight was restored,
praise the lord!!
Ahhh people confuse o,
come o which time baba olowo turn to pastor so?
Naso i answer dem,
abeg if you want get a supernatural healing from above,
try make you read all my epsiodes dem from beginning to the latest one,
after you read am finish then go read psalm 99 for bible join am,
i swear you go receive your healing instantly no joke,
ahhh people shout na true talk you talk baba,
abeg baba olowo why you funny like this?
Naso people stand up shout,
when we celebrate we go pop champaigne!!!
Naso i answer them,
abeg before una go start to dey pop champaigne like cow make dey do
strong head for him owner so,
abeg i won yan una something first,
e get one bros make dey always disturb me,
abeg baba olowo which time you go compose your next funny episode na?
I cant wait o,
una know say na upstairs i been dey stay now,
baba go use ladder climb up for my window side dey shout,
see come baba olowo,
as you do neck like old lizard so,
do fast post this thing online na make i laugh small na,
wetin be your own self?

Do read more in my blog https://emeka10..com
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 7:25pm On Jan 05, 2019
Please i really need your comments here if you want this my story to grow,

or will it be nice i end it like this?
Abeg i just need contributions so i can compose more funny episodes upto 100 or so,
na me be baba olowo to compose things like this no dey hard me o,
but i need una encouragements thanks

baba olowo
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by ceecane2(m): 5:09pm On Jan 06, 2019
Jst stumbled in dus story. Guy u tryin. Like a lot of pple said dnt wori bout d comments for nw
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 8:42pm On Jan 06, 2019
ceecane2:
Jst stumbled in dus story. Guy u tryin. Like a lot of pple said dnt wori bout d comments for nw

you are really welcome bro,
i have heard what you said anyways i will still continue,but the comments you know are for encouragements,
i would have composed more than this by now had it been i see comments,
anyways will be droping more funny episodes again here,

baba olowo d long prick stories can never die,
all for the fun baba

baba olowo
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 12:11pm On Jan 07, 2019
Episode 48
(baba olowo my number one nigga)

hahhahahahhaaaa
see as everybody dey laugh

so baba olowo u dey fear make any of your guys no snap you picture as you dey area dey play obi is a boy with area girls dem?

Chaiii baba olowo your mouth no good,

naso i shout,
abeg anybody here get any group for facebook make i fit join dey post my story dem everyday for there?

Chaiii people shout,
oga the group make you create by yourself baba olowo d long prick never do for you?

Naso i tell them,
abeg the group make i been dey now make dem dey call laugh till you forget your password,

i tell una say some people don laugh sotey dem don forget their facebook password for there,

hahahhahahhahaha
see as people dey laugh chaiii i don die,

currently now the problem make we dey face now na the admins of the group, i tell una say as we dey speak now dem no remember their password again o,

this na the second time the admins dem dey forget their facebook password,
abeg tell me how them won take dey approve people post for the group now abeg?

Na later dem con dey blame me say na since when i join the group as a member con dey post this my funny story baba olowo d long prick,

na since that time dem start to dey get problem to dey remember their password,

the group now na facebook moderators na dem dey help dem approve people post after 5 days the person go don post am self forget am,

if to say me baba olowo no dey wise i for don also follow dem forget my password self,

hahhahahahhaahhaha
see as people dey laugh dey catch fun as me baba olowo dey entertain dem on top stage so,

naso i continue,
abeg wetin dey vex me now be say, na one other group make dem dey call laugh till you die,

hahahhahahahhahha
chaiii which kind useless group be that one na?

The thing pain me say i don already join dem,
now wetin i dey try do now na to just leave the group,
but anytime make i click on leave the group,

instead make dem go delete me comot na one notification go con tell me say thank you for adding 6 more of your friends here in our group,

chaiiii i don do this thing tire sotey almost all my friends dem don join the group finish without them knowing say na by mistake i dey use add dem there,

hahahhahahahhaha

the thing be say you fit join the group but noting for this life go fit make you comot,

hahhahahahhahaha
abeg that group na dead man get the group?

See the name self,
laugh till you die,
abeg i no won laugh die o,

hahhahahhahahahahaha
one bros stand up shout,
baba olowo na you be my number one nigga,

you too funny abeg,
anytime i won baff go work i go make sure say i read one of your funny episode,
if i still come back from work i go still go read another one,

ahhhh baba olowo you don make me laugh one day sotey i no know wen person make dey drive bicycle jam me scatter person market for roadside,

hahahhahahahhahahahah
baba olowo you be the boss abeg,

as the bros hail me finish naso i remember one guy make dem dey call devilmaycry,

i been don dey tell people if you won read baba olowo funny story, make sure say na for night if you don come back you go read am,

naso devilmaycry no gree listen,
sotey baba hold him phone still dey read my funny story baba olowo d long prick dey waka for road,

we no believe as we see matured man fall inside gutter gbosa,

hahhahahahhahahhaha
chaiii see laugh

baba no know when he fall inside gutter,the worst thing be say as guys them rush carry am come outside baba still dey shine teeth dey laugh o,

the thing confuse people,
una sure say this guy never mad?

As people dey pure devilmaycry water so him fit clean small,

chaiii we no believe as one guy thief devilmaycry phone run,

people no believe wetin happen,
the thing be like film for devilmaycry,

but na when we don dey like 5 more minutes,
we con see the same guy make thief devilmaycry phone,
baba carry the phone come back o,

ahhh wetin happen?
The guy talk say as him carry the phone run,as him say make him look the phone well naso him see baba olowo funny story for there,

baba no know when him read am start to dey laugh for road like mad man sotey him waka by himself come back con return the phone by mistake,

even now make him dey here so him no just know where him dey now,

ahhhh the guy shout i no just know how i take reach here again o?

Baba fall for ground hold belle dey laugh
hahahhahahhahaaah
chaiii baba olowo you too funny die,

na when guys dem use better plank wipe baba gbosa,

baba eye clear,
sharp sharp baba stand up pick race run,
oboy crowd pursue baba dey go the next street,

una see wetin baba olowo story dey cause abi?
Chaiii i no believe say a whole thief go return person phone all because of baba olowo funny story,

hahahhahahahhahaha
everybody burst laugh

baba olowo you too much abeg,
naso people rush come outside dey spray me money,

hahahaahhahahahaa
baba olowo don make us laugh today tire,

hahhahahahhahhaa
abeg una sure say we go go house today self?

I don suffer,

Watch out for episode 49
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 7:43am On Jan 08, 2019
Episode 49
(see come, baba olowo na thunder go fire you there idiot)

see as everybody burst laugh
hahahhhahaaha

baba olowo you too funny abeg,,
naso people shout abeg baba continue,
oboy we no believe john arigu laugh stone one bros chair gbosa!!,

oboy people confuse o,
see come john arigu as you do neck like old bendel road so,
mind yourself o,

naso i shout,
i been remember when last i make call to one stupid radio station make dem dey call wetin consine us?
una imagine say the radio station name na, wetin consine us radio station,

na later we con dey hear say na seun make get nairaland nahim dey sponsor the radio station,

oboy like so i call the station because i been dey listen to their football program make dem dey call, see come jaj jay okocha no good football show,

naso sharp sharp dem pick like fools,
as dem pick like so i just rush introduce my self to them,

hello sir my name is stanley okafor am calling you from lagos,

oboy the next thing make i hear na wetin consine us?

Why you come dey tell us your name like say e consine us self?
abeg talk wetin carry you come here make we do sharp sharp cut this your useless call abeg,

chaiii the thing pain me die,
see dem all this useless radio station people dey use me dey play so,
upon say na my own credit i dey use call dem,

naso i continue
am sorry sir,but i will like to contribute to you guys discussions about who is the best footballer in the world,

before i go finish,
one of them shout, guy wetin be your problem self?

I said go to the point and stop waisting out time here idiot,

ahhh the thing surprise me,
chaiii wetin be this?

Naso i continue,
abeg to me morata for chelsea no just good at all,
that guy suppose dey for roadside dey clean people shoe like aboki dem,
thats his calling for life and not been a footballer,

before i go talk finish,
naso one of the radio presenter dem shout,
see come you this mad man of a guy called stanley okorokoko abi wetin be ur surname self?

Is like you are mad and really stupid?
Are we talking about morata here or is it about the rivalry between ronaldo and messi?

Who can be considered the best in football history,

and you are here talking off key,
something that does not literally consine our topic of the day,

looks like you need a maternity test for your brains fool,

ahhhhh the thing confuse me o,
oboy this radio people dem really dey rude die,

chaiii i don die today,
wetin even make me call them this idiots at the first place self?

Ahhhh the thing vex me baba olowo,

naso i tell dem,
see come as all of una carry neck like mtn face cap make dem dey share give people so,

una dey very stupid for insulting me like this,

na una type dem dey use exchange for olden days collect one round of sex from ashawo, do finish troway the condom,

as una do face like mountain of fire church back to sender prayer point dem so,

bitch ass fools nahim una be,
cowards of this our century,
broke ass radio presenters with no degree of knowledge,

see come as una carry eye like 2019 voters card so,
just remember say na strange hunger from foreign land nahim go catch una there,

before una neck go long like ostrich make just come back from him traditional marriage from village so,

hahaahahahahahhaa
oboy i no believe say dem the radio presenters dem dey laugh theirselfs,

hahahhahahahhahahaha
abeg who is this mugu bikonu?
This guy is so really funny,

haahhahahahhahahahhaa

oboy i no believe the next thing make i hear,

see come baba olowo na thunder go fire you there idiot,

ahhhh the thing surprise me o,
chaiii the voice resemble seun make get nairaland voice so,

oboy i no believe say dem don go even call seun come self,

naso i answer seun,
see come seun as you do face like mad man forgotten pant so,
you better close that your long mouth for there idiot,

as you carry chest like small pikin pampers so,

na your type village people dey contribute money so dem fit do marriage at least make you marry wife,

na me baba olowo you dey talk to abi?

See come as you resemble new anglican church make dem never bless so,

na your type dey plan with john arigu go rob rex v eddie last hope for this life,

brand new hat make rex v eddie go buy last week nahim una go thief so,

and una know say na baba last hope be that,

hahahhahahahahahhaa
hahahahahahahhahahaha

people laugh sotey i hear bottle sound gbosa!! for inside the radio station,

ahhhh the thing fear me o,
so people full inside that radio self?

Oboy na later we come dey hear say people make dey work only for inside the radio station dem reach 50,000 people,

come o,wetin happen na?

Why people plenty there like say na national stadium dem dey?

Na work dem dey work for there abi dem just dey act like audience?

Abeg after episode 50,
me baba olowo go rest or else this facebook babe angel okey comment for my post here so,

so if una like this my story make una better go beg angel okey o,
if not i go stop again,

Watch out for episode 50
baba olowo i am not the best
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 8:16am On Jan 08, 2019
Abeg make una no mind me baba olowo o,
abeg na one award i need to win dey really push me like this,

naso one bros shout,
see come baba olowo we never even brush teeth self, before u even post this your episode 49 here,
are you mentally ok

abeg i really need this guys,
me baba olowo i dey on my kneels o,
if you guys truelly love me na to just go comment for the thread stanley okafor baba olowo story,

i really need this guys,
una know say if i win am surely me baba olowo go yab the award and also dem the organisers dem,
una know say my yabbing no good so we all go laugh tire if dem announce me the winner,

please guys i need your helps thanks

baba olowo
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 2:55pm On Jan 08, 2019
Episode 50 coming soon live on Hd

baba olowo
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 7:36am On Jan 09, 2019
Episode 50
(baba olowo, i am not the best)

this na my final episode to dey post here, except una go help me beg this my facebook babe angel okey,
why she no dey ever comment for any of them my story dem here?

Anytime i go check her pictures i no just know why my thing dey stand anyhow so?
Is this love abi na lust?

Naso youngzubi shout,
see come baba olowo as you take do face like blind lover so,

abeg continue to dey entertain us abeg,
before you carry neck like jss 2 student,

hahhahaahhaha
everybody burst laugh
chaiii i don die

naso i answer am,
see come youngzubi as you do yansh like transformer make dem just put for T-junction so,

na your type dey go train goat dey sell, forget to dey collect money from people,

as you carry face like cream crackers biscuit so,

na your type people dey use take exchange collect small pikin stick sweet lick finish troway the stick,

hahahahhahahahahaha
chaiii youngzubi na you be this?

Naso i continue from where i stop,

Hahhahahahahhhaha all my niggas dem una welcome back o,

i tell una say e been get one group i been dey,
naso i post one of my funny episode for there,

sotey one guy laugh like mad man comment rubish join am,
oboy wetin we see for comment box na,

lolololololollllllllllllllllllllooooooollllllllllllllllllllllllooooooooooollllllllllllllllllllllllllllllooooooolo
lol
lol

come o, na comment be that?
the thing surprise people o,

we no know wether na the guy keypad no just good abi na facebook service error cause am,

naso we speechless dey look the guy,
see come as you do face like old policeman make no won gree retire so,
abeg no go try comment like that for here o,

i still dey wonder this rex v eddie of a guy make change name to eddie ola so,

see come make e no be say you this imposter don go kidnap our real guy make dem dey call rex v eddie?

una sure say no be another person be that make dey claim rex v eddie?

I know how i go take know wether na truelly him be that,
na to just send better thunder to him butthole for maternity testing,

hahhahahahhahahhaa
see as people dey laugh
baba olowo you too much abeg,

see as youngzubi baba dey shine teeth,
i know say you go like where baba olowo dey yab people well well,

abeg i no mean am o, all for the fun of this group o,
i dey even wonder wetin make me no even travel go village this christmas self?

hahahhahhahhaa
naso i take funny reach?

Naso people dey shine teeth dey laugh as i dey on top stage dey yab people,

naso one guy shout,
abeg baba olowo you sure say we go fit go house again today?
Because like this i ready die, to stay here even for two weeks self,

as far na you baba olowo dey entertain us here so,

naso i answer the guy,
see come as you do neck like wheel barrow so,

na your type mothers dey advise their children to beware of,

as you do eye like small pikin kidnapper dem so,

hahhahahahhahahahhahah
hahhahahahhahahahhahaha

person laugh shout,
ahhh mogbe!
I don die o,

baba olowo you just too funny,
oboy before we know one babe fall for ground dey vomit,

oboy she still dey laugh dey vomit join am o,

ahhhh baba olowo you don see wetin you cause abi?
Now people don dey laugh dey get stomach upset all because of this your funny yabbing dem,

oboy na later we come dey hear say na the babe go even eat day before yesterday food make don spoil come here dey laugh,

naso people rush the babe comot,

ahhh me baba olowo shout,
see come abeg all this mad men dem make dey happilly rush carry this babe comot here so,

we go think say na hospital una won carry am go,
not knowing say na rape una won go rape this babe so,

expecially you this guy make do face like rex v eddie so

na your type fit even rape mad woman,
as you take dey hold your trouser so like say na rope you use take tire am instead of to go buy belt hold the trouser,

hahhahahahahaaahahhahaa
hahahahhahahahahhahaha

everybody burst laugh
chaiii baba olowo go kill us here o,

naso one bros stand up shout,
abeg i don dey go house before i go faint here with laugh o,

oboy as the bros waka reach the hotel gate,
as him won waka comot,

naso me baba olowo yab am,
see come you this good for nothing bros make do face like atiku presidential election banner so,

na your type dey go thief garri for market no body go know,

as you do yansh like angel okey their kingsmen dem, make me baba olowo dey plan to marry

hahahhahahahhahahhaa
people laugh tire

oboy we no believe wetin we see next,

chaiii the bros laugh himself sotey baba fall for the gate side faint from there,

ahhhh baba olowo don kill person o,

you too funny abeg why people no go dey faint self?

Naso people rush the bros dey go hospital,

ahhhh no body gree stand up again o,
say dem won dey go house

hhahahahhahahahhahahah
hahhahahahahhahahhhaa

one other guy laugh sotey the guy start to dey sing this olamide new music this our love e no go die ooo,
e no go die o
i swear to God e no go die oo
e no go die o

abeg wetin consine music here abeg?

watch out for episode 51
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 9:18pm On Jan 10, 2019
Episode 51 of baba olowo
(nairaland january 5k award)

see come all my fans dem,
na me baba olowo dey talk so,

abeg if you know say una truelly love me and una just won pity my life abeg try help go vote for me baba olowo for this nairaland january 5k award make dey on contest now,

una know say if me baba olowo win,
the kind joke i go crack as i take win the award una go laugh tire troway spit,

i tell una say person fit laugh troway him phone join am,

baba olowo too funny so please spread the word and run go vote for me,

na that time una go know say i really too funny pass like this self,

abeg all my haters dem,
una self can still do mistake go vote for me baba olowo,

naso one bros stand up shout,
abeg baba olowo wetin you won use nairaland january 5k award do na?

Abi wetin 5k won add for your life self?

Naso i answer the bros,
see come as you do face like ethiopia airlines so,

na your type dey go do news caster for radio stations dem, make their salary na #5,000 naira a whole month

hahahhahahahahhahahaa
hahhhahahahhahahaa

everybody burst laugh
hahahhhaahhahahahaahaa

baba olowo you too funny and you really deserve this award abeg,

naso i shout tell people,
e get one time i been organise one small get together party with my fellow nairaland members dem,

oboy we no believe say na only ghost readers na dem full the party o,

nairaland get 2.5 million members
na later we come dey here say ghost readers make come dem reach 2.2 million people

the place don full sotey we reserve special seats for VIP dem for express road,

abeg make dem go sidon there make catapillar help us jam their life troway

hahaahahahahahahhah
everybody burst laugh
chaiii baba olowo you are too funny,

i tell una say as the show start,
i no know who come later go tell them say na trap baba olowo won set for them here,

oboy we no believe wetin we see,

see as dem the whole ghost readers dem fly window run dey go house,

ahhh the thing pain me die,
abeg who let dem know na?

Me baba olowo don plan to gather all of them,
close the front gate beat craze comot from all of them head,

ahhh so dem don finnally excape?

Hahhahahhahhahahah
everybody burst laugh

naso one babe stand up shout,
abeg baba olowo if you finnally win this award now so?

Wetin you go use the 5000 naira as award prize do na?

Abi you go give the money to orphanage dem abi you go spend am?

Naso i anwser the babe,
see come you this babe make do face like wetin devil reject so,

na your type go dey sell piracy movies for alaba market dem,

as you do neck like big factory generator make don spoil,

wetin consine you with how i go spend the prize money if i win the award so?

U know wetin i go do?
I go carry the money go sahara desert go bery the money for there,
since the money no go dey usefull for me,

as you carry long hair like back of cloth so,
na your type dey die early because of amebo and gossips,

as you carry teeth like youngzubi junior sister make do face like onions so,

hahahhhhahahahhahaha
hahahahahhahahahahahha

baba olowo abeg you too funny o,
abeg just tell us simply wetin you go use the award money do?

Naso i answer dem the crowd,
now you are talking like a gentleman,

to me baba olowo,
the money is not important,but what is important to me is the award itself,

to be crowned the really best in the whole month,

not because i am truelly the best but because i have impacted something special daily to people's lifes,

to make people laugh everyday is not a days job,

if its easy then go and startup your own funny stories like me baba olowo

as i still dey talk
naso one bros shout,
baba olowo na lie you dey lie o,

i know say if dem give you the money na for ashawo house you go spend am idiot,

as you do yansh like new yam festival celebrations for village so,

hahahhahhahahahahaha
everybody burst laugh
chaiii

as i won yab the bros,
oboy the bros stand up run with full speed dey go house,

hahhahahahahaaaa
na bouncers dem pursue baba enter street o,

if them fit manage help me catch that bros,
i swear him yabbing no go get part 2,

a whole me baba olowo nahim you dey yab like this pick race run,

okay no problem,

oboy dem no see baba catch,
the bros don excape o,

ahhh naso i tell the crowd dem,
please vote for me and i promise to always make you guys to be happy every single day,

na me dem dey call baba olowo,
to compose things like this daily no dey hard me,

to cut this short,
me baba olowo will donate the money to all of you my fans dem,

all you need na just inbox me baba olowo how far na?

Sharp sharp i go send you 200 or 400 naira airtime,

even though una plenty pass twenty people self,

na me dem dey call baba olowo
i need the award more than the cash prize,

so people no go fit ask me,
abeg baba olowo since you don dey post this your story abeg wetin you don even win self as an award?

Then i fit shine teeth tell them,
am a proud winner of nairaland january 5k award,

abeg vote for me to laugh more thanks

watch out for episode 52
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 7:18pm On Jan 11, 2019
A dedication to GILBERT A O OKONKWO my manager am working for,

chaiii i don die wetin be this?,
life tire me,

the man am working for,
my manager gilbert A O okonkwo is dead,

got the news and i was shoked and surprised to cry tire me,
he died 7th of january 2019 in the evening heading towards the night or so,
i was told his heart stoped beating and he fell down instantly,

at once he was rushed to the nearest hospital but was referred to another hospital in navy town,
see nigeria hospitals all bulshits,

when they got there it was too late,
that was how my manager the man that employed me and currently paying my salary died this month january 2019,
as for now the business is been shut down,
burial arangements will be held next month or so,
as for now i dey house not working till further notice,

na like this person go use take dey jobless for months till i go see another work?

Ahhhhh life tire me,
typing all this with tears on my eyes,

is this the end of baba olowo?
Now make i don make up my mind to dey try drop funny episodes for una at least once a day,

why why why!!!
I never type like this before but to type don even tire me,

chaiii is this the end?
Which fun i won get again to compose stuffs for una again?

Consolations to all his family members expecially his sons and daughters that are mourning now

chaiii is this the end of baba olowo?
today is really a sorrowful day for me baba olowo

baba olowo
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 9:26pm On Jan 11, 2019
Its been a long road but we are here now,

a dedication to my manager who died this month,
its painfull to bear for me baba olowo,
tears on my eyes now.
I dey with my guys now and everywhere here is silent,

no shout and play as we normally do every night here,

baba olowo is down and sad,
which way dey again for me now?

Ahhhhhhhhh
abeg i need una comments not likes because there is nothing to like about here,

anyways this is life

baba olowo

(1) (2) (3) ... (5) (6) (7) (8) (9) (10) (11) ... (22) (Reply)

African Nerd / Out Of The Blue / House Of Secrets : A Story By Angelsss

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 217
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.