Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,155,884 members, 7,828,140 topics. Date: Wednesday, 15 May 2024 at 02:42 AM

Funny Warri Proverbs(just For Laugh) - Jokes Etc - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Jokes Etc / Funny Warri Proverbs(just For Laugh) (1920 Views)

Just For Fun: English Vs Pidgin / Pidgin English Proverbs. Add Yours... Don't Spoil The Fun. / Happy Women's Day# Just For Laugh# (2) (3) (4)

(1) (Reply) (Go Down)

Funny Warri Proverbs(just For Laugh) by Henryjr(m): 5:12pm On Aug 03, 2019
1. Na person wey never see problem dey use English dey pray.�

2. Book wey no gree enter head go enta exam hall ���



3. Goat wen get mind follow lion go catch fish, make e know say weda dem catch fish or not, Lion food don set oh.

4.who naked no dey chuck hand for pocket…!



5. wetin concern dog wit family planning?..

6.Na determination dey make Okada overtake trailer for road.

7. This one good, this one good na em mad man take dey gather plenty load.

8.Pikin wey go strong go strong…. No be say until dem name am Samson.

9.Na over confidence make February no complete.

10. Do you know who I am? Do you know who I am?..Naso hold up take dey start.

11.Head wey no wan think go carry load..

12. Hand wey stay long for pocket, know say nothing de that pocket.

13. Forget Trust ��� If trust dey, Water nor for boil Fish.

16.No matter how lizard do press-up reach, e no fit get muscle pass crocodile �. ✌

17. E de clear pimple, e de clear pimple na so bleaching de start.

18. Feel at home, feel at home na eim dae make visitor spoil remote ��

19. Escort me, escort me naso slave trade take start.

20. It’s a small world!! No mean say you fit trek from Naija go London.

21. Christianity is free, but you must buy Bible

22. Person nor dey use shame chop winch o

23.Make I chop this guy money, Make I Chop this guy money. Na so ashawo take start oh.

24. You no need spoon and cutlery to chop slap.

25. Jollof Rice wey dey for bottom of pot 2day go dey for top of cooler 2moro.

26. The patient dog �… Nah hungry go kill am.

27. Na I go do am later na e make fowl no fly like other birds.

28. No food for lazy man no be for pesin wey em mama get restaurants.

29. Who dey hold landlord rentage no dey fry stew way curry dey.

30. I am covered by the blood of JESUS E no mean say make u no lock door sleep oooh ��

3 Likes 2 Shares

Re: Funny Warri Proverbs(just For Laugh) by dangoteinlaw: 5:15pm On Aug 03, 2019
Lmao food dey for lazy man. Na matter of where him dey grin
Re: Funny Warri Proverbs(just For Laugh) by hisgrace090: 5:20pm On Aug 03, 2019
Warri no de carry last.
Re: Funny Warri Proverbs(just For Laugh) by kernniejay(m): 5:28pm On Aug 03, 2019
I no even sure whether Warri get local dialect except pidgin.
Re: Funny Warri Proverbs(just For Laugh) by Henryjr(m): 5:50pm On Aug 03, 2019
kernniejay:
I no even sure whether Warri get local dialect except pidgin.
. If you see where real warri boys dey talk, to comot no go ever enta your mind. Their pidgin too get swag. I had one warri street boy as a friend back then in Edjeba, u need to hear him speak.

1 Like

Re: Funny Warri Proverbs(just For Laugh) by Oche211(m): 6:02pm On Aug 03, 2019
Good

(1) (Reply)

Throwback Thursday:what Was The First Phone You Used? / A Dark Confession / Help

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 9
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.