Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,152,759 members, 7,817,101 topics. Date: Saturday, 04 May 2024 at 05:32 AM

An Open Letter To The Nigerian Youths-By a Concerned Youth. - Politics - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Politics / An Open Letter To The Nigerian Youths-By a Concerned Youth. (318 Views)

A Message To Reno Omokiri (from A Concerned Igbo) / Re:niger Delta Concerned Youth Gives IPOB 7 Days. Is Already 2 Weeks Now / Audu Ogbeh: Reduce Visa To Nigerian Youths By EU (2) (3) (4)

(1) (Reply) (Go Down)

An Open Letter To The Nigerian Youths-By a Concerned Youth. by Artiiclebeast: 4:54pm On Jun 27, 2020
My fellow Nigerian youths, make una no vex for this pattern wey I decide to take follow una yarn. The reason wey make me decide to follow una yarn with this our other language be say, we gree and know say some of us wey no too go school no dey too understand Eliza language but almost all of us wey get luck take go school, come sabi Eliza language well well still dey understand this our pidgin wellemly.

I don first yarn the tory for this thread but some people Dey think say na joke.
https://www.nairaland.com/5942435/nigerian-youths-lets-get-together


The matter wey make me decide to write all of us this message na matter wey don dey chook me for liver as I know say e dey chook all of una sef because na the same house wey be country we all dey.




The matter wey long come reach this level now be say, I don tire for the way this our country dey go round and round like chicken wey dem cut him neck and the person wey cut chicken head na no come fit to hold chicken again and if we no dey careful chicken fit dance without head sotey e go fall enter big hole with him owner wey dey try catch am and nobody go see dem again.




My fellow youths, since dem arrange this we country, na the same people wey dem hand am over to when dem dey their 20s and 30s to rule wey no fit arrange am make we see the head or tail na dem still dey rule us today and still dey arrange how to continue to dey rule us dey go even though say dem don waste all of our common money and scatter the country anyhow because of their greed.

During their time, the matter wey make dem Dey carry gun pursue governments no reach 10% of Wetin we Dey see today but we no go carry gun, Na social media and the power of our votes go be our guns.

The painful part for this whole matter wey dey pain me pass be say, na so our papa dem fold hand dey say "God dey, e go better, e no concern me, or kukuma run leave the country begin tell am waka" from far dey think say dem no go need the country again because dem don run leave suffer. Na this i don care attitude or shey na me wan repair Nigeria na so monkey hand take turn to human being hand inside pot of soup so wey e be say na people wey no know how to repair or better our country come dey in control of everything because the people wey suppose challenge dem don decide say e no concern dem begin speak big big grammar take dey insult the country but everybody dey forget say power of life and death gather for our tongue, so, anything wey we talk or declare na so e dey be, and ofcourse na pikin wey no know himself dem go ask say "wey your mama"? Wey go answer say "my mama dey mad, she dey useless, na she dey there so".

The reason why i dey talk all these things be say, these same people wey carry our country dey nack for ground, violate, and destroy am anyhow don do their own time chop and waste all their yams, dem rule our papa dem, na so the matter still be, now dem don enter almost chop our own yam and time finish, na look we still dey look like mumu because we dey fear wetin no dey there. Now, dem wan begin chop our children wey we don born plus the ones wey we never born own for our korokoro eyes. My question now be say "na so we go siddon dey look, wetin we go tell our children dem". The worst part now be say, dem don arrange and package their children put for everywhere to take continue to rule and control us and our own children join. Wetin happen now, even if na swear or jazz, our eye suppose don clear for once to take know say person no fit die two times and na only coward dey die two times before him real death come meet am. As we dey now sef, whether you stand up to take your life, children life, and destinies back or not, the bad condition and suffer head go still kill you before any death wey you been dey fear before so, wetin you get to lose when you know say all die na die but e better say you die when you dey try change you and your children lives and future from total dabaru.

My people, no be small people wey get flesh and blood only we dey battle with oh, these people get devilish sense wey be say na him dem take dey cause division, lack of mutual trust, and confidence among us so that we no go fit cooperate or join body together come ask dem say "how far"?

Dem don beat down and yeye most of us to the extent wey be say we come dey see dem as people wey love us or our gods anytime wey dem just pinch small salt or take small oil rub our mouths, but all na cunny no be love na to keep us busy make we dey insult and attack ourselves online and offline with the usual names of "Afonja, Nyamiri, Ipob, Almajiri", etc, while dem dey busy and united from the East, West, North, and South of Nigeria dey waste and lavish our commonwealth without any challenge or discrimination. Na sickness be this kind of condition wey dem put us and e get name. The name na "Stockholm Syndrome". People wey sabi book fit check dictionary for the meaning.

Still on this same matter, if we count from 1999 come reach now na 21 years don waka, and pikin like me wey just begin dey get bia bia that time don almost turn to grandpapa now and no better thing change for we country and our people lives except say person don born children wey still dey the same yawa condition.

Now, the current ones time go finish by 2023, and by that time another one of dem go still continue the yawa as dem don already dey ginger now. We all know say if dem succeed like that na another 8 years go waka. God know say by that time i no go fit open my mouth call myself youth again just like so many of us. The question now come be say, shey na like dis we go dey dey, and you wey think say you be smallie at 20 years for 2015, when these people do their 8 years two times my brother, you don dey near menopause at 38 be dat oh, so make una shine una eyes.

For how long we go fold our hands dey look like say e no concern us while some wey no know their left from their right go dey hail, campaign for, and abuse each other because of these our common enemies?

As all of us dey witness am and to the shame of a nation and generation, our youths don lose hope sotey most of dem don embrace the idea of get-rich-quick at all cost by copying the rogue politicians wey dem dey aspire to be like in any way criminally possible because our society don rotten reach where e be say we all dey worship materialism and nobody dey ask how anybody take make am. Most of the youths now dey see am as a normal lifestyle to dey proud of say dem be thieves wey dey enter farm wey dem no plant anything put to begin harvest another man fruits without any shame or remorse. We must change all these mentality and orientation.

Some people go dey wonder why this matter dey pepper me for body like this, na because of say i be direct victim of these maladministration, ogbonge corruption, and the life desire of some very few old rogues to continue to dey cause the whole country pain until the country go delete. Just to give una small idea, na me be the small boy wey frustration and how to see road for small better life make him and him mates jump enter desert begin use leg dey go Europe over 20 years ago. I see my mates dey collapse out of exhaustion dey die for desert and river swallow so many including the many wey we meet their skeletons for road wey been don try before us. Abeg i no wan remember things, so, make we leave this gist for another day.

As i dey do this my rally for we the youths to get sense, wake up from their sleep, rise up to rescue our future and own children future, anybody wey say him wan kill me or arrest me suppose understand say na my ghost and spirit him wan fight with because i don die tey tey for flesh and the worst prison wey dem wan put me no reach the prisons and suffer wey my eye don see from my small life experiences.

Dem say we be online warriors or say we never ready for leadership, my brothers and sisters make we all come together to take advantage of the thing wey dem take dey laff us for once to take free ourselves from our oppressors in a very quiet, bloodless, and social-media driven way.

My people, how long we wan dey manage and pretend like say we no get head to think. All these things na how dem purposely position us overtime by destroying everything wey suppose fit help us get sense.

For example, make una see wetin our educational system don become. Dem kill am sotey dem come abandon am for we the poor people and our kids because e no fit their own children. The people wey be teachers for most of we schools now na people wey be say na frustration and olodo make dem no fit go better school wey dem come take settle to do NCE come begin dey teach our children wetin dem no sabi. Na so our children go still carry the olodoism and frustration enter the same teaching level continue the cycle like that. At the end of the day wetin wey dey see, na graduates wey be say if you write "A" wey big reach like Aso Rock ask am wetin e be e no go know. All these na deliberate level to make sure say their own children wey dem send go the best schools oversea go still come rule all of us.

My dear Nigerian youths, with all the confusion wey dey happen for the midst of the old people wey don use our lives and future play okoso tire, e no get better time than now for us to come together to free ourselves, country, and futures from the shackles of our collective oppressors.

Na this matter come make us start one movement for telegram for now wey we dey call "Our Future Is Now" wey some wonderful youths wey say dem no go fit die like cowards and say enough don reach enough don dey volunteer, share, and exchange ideas to set up structure wey go dey solid, wey no dey about one single individual or group of individuals, hard to hijack, useless to moles and saboteurs.

I dey use this opportunity to beg every Nigerian youth wey know say him or her don tire for the status quo and like to take charge of our country and future to come join us with all their skills and know-hows to arrange this movement well and solid so that wetin happen and destroy other movements like these before no go fit happen again this time. We suppose dey learn from the past so that we no go make the same mistakes.

If you go like join this movement make we build and make am solid, go telegram, search for the name "@nigerianyouthsaretired" make we begin rub mind to determine the kind country and future wey wan continue to live because if at 75, my papa don retire since and i don move out from him house since begin live my own life with my family wey be say him no dey come help me plan my life and future for my house, why e be say people wey even senior am go dey decide how me and my children future wan be?

Na another election dem don dey prepare for this 2023 and dem don dey plan how to use us with the small small money and contracts wey dem go give some of us to print campaign stuffs for dem, handle their campaign on all social media, help dem with fund raising, and to come their rallies to come dey sing, shout, and kill ourselves for dem to continue the oppression. Why we no go fit do all these things for ourselves and retire these our grandfathers dem this time for good and take control of our lives?

For you wey think say the country dey irredeemable and the only solution na to carry your bag run comot go another man country, i wan tell you say no matter what and the kind passport wey you go collect from another man land, your home must be your home. I don live that life and i know how far.

If you think say na lie i dey talk, make you go ask an average African-American say whether him go like relocate go one fresh country for Africa to go set up and live their lives jeje make you hear wetin dem go tell you. For the number of years wey dem don live for country wey dem help build, we all dey see how dem still dey treat dem not to talk of us wey be say our name alone na exhibit.

I use una and una children future beg una, abeg make una join us for this movement of our lives and futures.

I hail una oh, make una share this link for una status, facebook walls,twitter, instagram, and everywhere make everybody hear the word.

We don Dey progress small small and below Na some of the objectives wey I still Dey work on to submit to the group along with other people own wey we go make corrections to and continue to Dey modify as we progress and get more experienced hands on deck:

Objective:




- To first begin to desensitize the Nigerian youth against the normalization of all crimes, vices, ethnocentric, tribalism, bigotry, religious intolerance, and the ignorant use of our rogue politicians as an excuse to perpetuate these ignoble and despicable lifestyles which are not worthy of emulation. To this end, we shall strive to change our orientation from a ”materialism-centered/worshipping) culture to one that respects, rewards, and places legal hard/smart work and frowns at questionable characters and their acquisitions.




- 2. To be a rallying point for all Nigerian youths who have become constantly disillusioned and losing hope in how the country had been set up and ran by the old guards hence, seeking to get involved practically by democratic means in leadership at all levels.




- 3. To be a movement that would help the Nigerian youth to see beyond the hate, divide, and mistrust for one another as had been deliberately stoked by the old and current system for an easy means to continually impoverish, loot our common patrimony, and rule over us without recourse to ours and our children’s future.




- 4. To leverage on our numbers and unity to effect a democratic change of guard to our generation, take charge of our future, and begin to build a country of our dreams by our terms and selves.




- 5. To unanimously study, review, expunge, and replace parts or the whole of our present constitution (in a mock constitutional review amongst us online), replace it with a generally agreed one that would be in tune with present time and help us in building a new country of our dreams that would be devoid of tribalism, ethnoreligious bias, cronyism, but one unified and egalitarian Nigeria we shall all be proud of.




- 6. To have a youth representing each state of the federation where we would be able discuss our present set-up as a country if to restructure or not and how to restructure by practicing same in a mock system amongst us to give us a better understanding and an idea of what set-up would be best fit for a truly unified and prosperous Nigeria that we seek to build.




- To discuss and suggest ways to drastically cut down on the huge cost of governance at all level as it presently stands including salaries/allowances of elected officials, and serves as a huge waste on our fast-dwindling mono-economy to make it less attractive for mediocres who would see public service as a get-rich-quick avenue from ascending to leadership positions.




- To seek ways to diversify our economy by identifying, securing, and harnessing other vast deposits of natural resources our country has been blessed with.




- We shall seek ways to examine every single MDA's to look into how we can bring them all up to date deploying and taking advantage of technology to block avenues of corruption, waste, unnecessary duplication of MDA's, etc.




- We shall seek to take a record of, and keep a database of every youth in our fold to give us an idea on how to implement the subsequent creation of a national database to capture every single Nigerian with a register to update births and deaths as they occur.
You talk, you die. You keep quiet, you die. Make your choice.

Join our movement for telegram if the situation too don tire you and you want make things happen.

Telegraph: @nigerianyouthsaretired. Search and join us.

My name na Peterson Ehimare Ojieson, i be Nigerian youths wey say enough is enough.
Twitter: @petersonojieson
Instagram: theirregularmigrant

#freelancecorporalmartins
Re: An Open Letter To The Nigerian Youths-By a Concerned Youth. by Artiiclebeast: 9:05am On Jun 28, 2020
Join our movement for telegram if the situation too don tire you and you want make things happen.

Telegraph: @nigerianyouthsaretired. Search and join us.
Re: An Open Letter To The Nigerian Youths-By a Concerned Youth. by Artiiclebeast: 5:22am On Jun 30, 2020
Well done Nigerian Youths.
Re: An Open Letter To The Nigerian Youths-By a Concerned Youth. by Artiiclebeast: 2:06pm On Jul 01, 2020
Are you fed up with the status quo Nigeria is today? Join us here https://www.nairaland.com/5942435/nigerian-youths-lets-get-together Search and join our telegram group (nigerianyouthsaretired) pls retweet and follow

(1) (Reply)

Tinubu No Get Level / “enough Is Enough, Buhari’s Northern Appointments Should Stop,” / You Can't Demonize Buhari And Called Osibanjo A Saint.

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 52
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.