Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,151,329 members, 7,811,967 topics. Date: Monday, 29 April 2024 at 02:59 AM

Highlights From President Muhammadu Buhari's Interview - Politics - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Politics / Highlights From President Muhammadu Buhari's Interview (385 Views)

Lagos Mention In Buhari's Interview Not Reference To Tinubu, Says Presidency / President Buhari's Interview On Arise TV (Updates) / Photos From President Buhari Interview With Arise TV That Got Nigerians Talking (2) (3) (4)

(1) (Reply) (Go Down)

Highlights From President Muhammadu Buhari's Interview by Akell(m): 11:45am On Jun 10, 2021
Nigeria President Muhammadu Buhari say im biggest worry na from di northwest wia di pipo from same culture dey kill each oda.

Di president tok dis one during one interview e do with Arise news TV say den go treat dem 'in di language wey dem understand.'

"Di ones for di south east we know dem, di ones for di north east we know dem, na di ones for di north west be di problem.

"Di same pipo from di same culture dey kill-kill each oda and dey steal each oda cattle burn dia villages. We go treat dem di language dem go understand. We don give di police and di military power to be ruthless and in few weeks time, difference go dey"

"If you keep pipo away from dia farm, pipo go hungry and if di society go hungry, di goment go enta trouble and we no wan enta trouble becos we already dey face enough problem, we don warn dem and sooner or later you go see result." Buhari tok.

Wetin else Buhari tok for di interview?
On di accusation of appointment lopsidedness, e say pipo no suppose get job sake of di region wey dem come from. E say pipo competence na im dem suppose look into and dat many of dem don pay dia dues and don serve for different location and many of dem don work for fifteen to eighteen years and many of dem don learn from the system.

Talking about di recent appointment of di Chief of Army Staff e say,

"Positions need to be earned, you no go just take somebody from seniority to balance up.

"Do you know wia im bin dey serve before e become COAS? You no go just pick somebody becos e be senior, you go pick somebody wey di sojas know, e don suffer with dem, to tell you di truth I no know dis pipo, most of dem I don forget dem.

Banditry in the northeast

"Di problem of di northeast dey difficult. Di present govnor dey work very hard and dey take risk, I ask am di Boko Haram pipo dem be Nigerians, he say dem join

We get problem of unemployment, we get problem of youths wey dey find wetin to eat.

Di level of poverty dey unimaginable, dis na our problem but those wey dey keep eye for wetin we dey do know di difference between di time we come in and now and dem fit judge di mata.

Banditry in northwest

"We change di security heads, service chiefs and all and we hold serious meetings with dem at least three, each one last three hours

I first allow dem to go round and see di tins wey dey ground, dem make changes in di officers and command, we tell dem say we want confidence to dey rebuild and we tell dem say we want make pipo go back to dia land so food problem no go dey. I tink say dem dey do am, we no dey too make noise becos we no one alert dem say we dey take dem headone

For instance we stop mining for Zamfara, we stop di foreigners we dey tok to di govnor although e no dey our party but we wan secure di region.

Di important tin na di question of local security apparatus, we get police for every camp, dem no dey wear uniform and carry riflr just to intimidate pipo but to make sure say dem protect pipo

I too almost dey overwhelmed by wetin dey happun dia now but we dey treat bandits for di northwest as criminals now. dem dey suffer a lot of casualties dem know am.

Dem no go wan tok am so as not to discourage dia recruits.

State policing

Those of us wey we dey old enough to know di old era, dat time di traditional rulesr dey more effective.

"For instance some govnors come meet me say herders enta farm kill farmers dia cattle destroy farms, I ask dem say dem elect dem abi, so make dem to go back and handle am.

I tell di govnors to go back to di old system so dem go get intelligence locally, dem go know wetin dey happun for dia constituencies, dem no go fit just win election and tink say pesin go do dia work for dem, I send dem go back.

Open grazing

Wetin I do na to ask dem to go and dig out di gazette of first republic wey show cattle routes and grazing areas.

Cattle route wen dem dey move up kontri, north south east west, if you allow your cattle enta pesin farm dat time dem go arrest you and pipo bin dey behave demsef.

For di grazing areas dem build tins like even veterinary centre, Na di rush to di centre dey cause di problem.

Dem need to go through dat. If you alLow your cattle to go through farms, dem go arrest your cattle and you go pay, Pipo dey behave demsefs den, so dat di herders dey limited, dia routes dey known if problem dey, e dey easy to know.

Benue govnor say I no dey discipline dem becos I be one of dem, I no fit say I no be one of dem, but I tell am say di Nigerian cattle rearer no dey carry more dan stick sometimes matchet to cut tree, but dis ones dey carry AK47 , Fulanis from Mauritania and elsewhere for Africa look like Nigerians so pipo dey confuse dem. I assure you we dey try to resuscitate di cattle routes and grazing areas so pipo go dey accountable.

Buhari on Ipob

President Buhari on di security palava for di south east Buhari say di region pipo "spread across everywhere, with business everywhere and everything," E add say, Ipob no know wetin dem dey tok about and "we say we go treat dem in a way dem understand. We go organise the military and police to pursue dem.

On Twitter ban and wen dem go lift di ban, Buhari say, "Dat one I go keep to myself"

On Niger relationship

How many neighbours we get? If we no get good relationship with dem we go be in trouble.

We need to contribute to our neighbours, if we no get a good relationship with Niger, Chad and Cameroon for

instance, Boko Haram for don deal with us worst.

As you know, Niger don discover oil, we no want dem to go trhough Benin Republic, we want dem to come through Nigeria. If di rails, roads dey work, Nigerians go dey very busy and leave you alone.

Wetin next after presidency?

Buhari say : "I never ever abandon my farm, I still get some cattle, wen I leave, I go dey go my farm daily and try to keep and myself busy.

Before dem, I go try to convince Nigerians say I mean very well for dem. I go make sure say dem see say I dey work on di problems we get.

Visibly, we need progress in, southwest, southeast. Right now, northwest dey worry and dem go hear am hot-hot.

"I hope Nigerians go dey fair to me. Make dem try spend time on security, economy, wia we dey before I come and wen I comot make dem look am, I hope Nigerians go dey fair to me". Buhari tok.

Re: Highlights From President Muhammadu Buhari's Interview by Nobody: 11:47am On Jun 10, 2021
Carefully selected excerpts by his British handlers.


Britain this is 2021, we are not fools.
Re: Highlights From President Muhammadu Buhari's Interview by Ekez(m): 11:47am On Jun 10, 2021
For the past three years you no grant interview, the wan Wey you manage grant today you talk rubbish,
Incoherent BS
Re: Highlights From President Muhammadu Buhari's Interview by WiszyFraud: 11:49am On Jun 10, 2021
undecided
Re: Highlights From President Muhammadu Buhari's Interview by money121(m): 11:51am On Jun 10, 2021
Ok
Re: Highlights From President Muhammadu Buhari's Interview by DDDEnterprises: 11:52am On Jun 10, 2021
Alright.

Learnt he gave unrelated answers to some questions. undecided
Re: Highlights From President Muhammadu Buhari's Interview by Guyman02: 11:54am On Jun 10, 2021
The OP giving us assignment to read highlights of Buhari interview reminds me of the picture below

Re: Highlights From President Muhammadu Buhari's Interview by Nobody: 11:58am On Jun 10, 2021
.check siggyundecided
.
Re: Highlights From President Muhammadu Buhari's Interview by Oracleforce: 12:06pm On Jun 10, 2021
I'm very sure that this is already a prepared acting interview....the script has been written and Buhari came as the main actor...

May God help us.
Re: Highlights From President Muhammadu Buhari's Interview by RussianKGB: 12:08pm On Jun 10, 2021
Answering questions like a local government chairman. Very outdated, uninspiring, confused president.
Re: Highlights From President Muhammadu Buhari's Interview by Aboks(m): 12:28pm On Jun 10, 2021
News in pigin English

(1) (Reply)

June 12: Fg Declares Monday Public Holiday / Solution To The Igbos. On The "Southsouth" Problem / Afenifere, Ohanaeze, PANDEF Insist On Restructuring Ahead Talks With ACF

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 27
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.