Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,154,850 members, 7,824,537 topics. Date: Saturday, 11 May 2024 at 12:01 PM

Make Una Help Racko This Serious Matter - Romance - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Romance / Make Una Help Racko This Serious Matter (752 Views)

Make Una Help Me Locate This Access Babe / Nairalanders Make Una Help Us Settle This Matter.....(pictures) / Help! This Has Become A Serious Matter(pictures) (2) (3) (4)

(1) (Reply) (Go Down)

Make Una Help Racko This Serious Matter by Offpoint1: 10:37pm On Sep 14, 2021
I do some motion graphics job for one client like that... Base on nature of dey job and its urgency, we "kiss heart"(agreed} on 150k.
Baba ring my aza with 50k as initial ho-body money.

Long story short, I finish job in just 3days {cuz na urgency, him get presentation for ABJ} Baba sey him go send am to him team members for approval. Hawa later baba ring me sey him team members don approve job.

Okey, balance up ma send your final work. Baba begin yarn stories sey if him return from ABJ on Wednesday him go ring my aza.

As a gentle and business minded guy man I be, i reason with am give am everything... Wednesday come baba no call or message me to update me. Me sef no boda message am until Friday... Baba begin yarn story sey him still dey Abuja (Na Abuja I dey hear conductor dey shout Orile! Orile!! Orile!!!?) I just bone him lie like Bonny cant.

Ma I no too drag dey tory like my neighbour generstor... Today make 2 months since den, baba no gree balance me.

As my sapa level don dey enter express, I ring baba, I para tire for am this morning. Baba still dey beg sey him no get money but e go try reason me 40k today before fowl sleep... Still as a gentleman I just calm end call.

Why this tory waka like ashawo reach here be sey, I see 40k alert twice this evening... Na him baba call me begin dey beg sey na mistake him make, na 40k him bin wan send, sey network set am up... Ma please send 40k back, sey no be him money.
Baba you dey ho me 100k for 2 months and believe sey I go send this money back!!!? I just end him call, turn off my sim and switch to mifi.

My people how una see this matter? Ma reason am dey 40k back?

My heart too soft, I don dey reason to send am back... But I wan frustrate am small till tomorrow evening.... My 2nd mind dey tell me ma kuku send dey 80k back, ma no ask dey money again till kingdom comes.
Re: Make Una Help Racko This Serious Matter by topoftheworld(m): 10:43pm On Sep 14, 2021
Baba God don pay U ur money..
Hold it tight and never transfer any shishi to him..
Re: Make Una Help Racko This Serious Matter by anthonyuncle(m): 10:50pm On Sep 14, 2021
tell him that he is still owing you 20k

3 Likes

Re: Make Una Help Racko This Serious Matter by Eminimore: 10:56pm On Sep 14, 2021
Normally send am 5k back tell am say you won use 75k do surgery for spoon way you swallow two months ago

2 Likes

Re: Make Una Help Racko This Serious Matter by Nobody: 11:07pm On Sep 14, 2021
The pidgin is very smooth. I wish I can speak that way. Very cool
Re: Make Una Help Racko This Serious Matter by Bilabong(m): 11:10pm On Sep 14, 2021
He owes u a #100k and sents #80k and u want to send back #40k...


Our mumu good heart no too much for this country?

2 Likes

Re: Make Una Help Racko This Serious Matter by Nobody: 11:11pm On Sep 14, 2021
Eminimore:
Normally send am 5k back tell am say you won use 75k do surgery for spoon way you swallow two months ago
Badman grin
Re: Make Una Help Racko This Serious Matter by Eminimore: 11:45pm On Sep 14, 2021
SmellySperm:

Badman grin
@smellysperm you know this thing's normally na shocked shocked shocked
Re: Make Una Help Racko This Serious Matter by Nobody: 11:47pm On Sep 14, 2021
Eminimore:

@smellysperm you know this thing's normally na shocked shocked shocked
Whyyyyyyyyyyyyy! Na OG u be abeg
Re: Make Una Help Racko This Serious Matter by Nobody: 12:12am On Sep 15, 2021
Follow your heart.
Re: Make Una Help Racko This Serious Matter by Sonnobax15(m): 4:07am On Sep 15, 2021
undecided op,na only an award winning mumu go send that money go back undecided

No try am.........E dey very clear to me say the guy team members don give am the money but he don chop am throway since undecided

Na so God dey do him things....... Codedly but dem dey always dey end up as blessings in disguise for our good grin
Re: Make Una Help Racko This Serious Matter by Michelle55: 7:02am On Sep 15, 2021
If you resend that money, I wee personally consult Ifa on your behalf to know the kinda jazz ya village pipu used on you after which, I wee locate you wherever you are to beat it out of you undecided
Just no let ya good heart finally kee you, shioor!
Re: Make Una Help Racko This Serious Matter by Duchessree(f): 7:28am On Sep 15, 2021
Don't send the money back grin
Re: Make Una Help Racko This Serious Matter by Skullano(m): 7:29am On Sep 15, 2021
His owing you 20k now, case closed.
Re: Make Una Help Racko This Serious Matter by yuping(m): 7:55am On Sep 15, 2021
Offpoint1:
I do some motion graphics job for one client like that... Base on nature of dey job and its urgency, we "kiss heart"(agreed} on 150k.
Baba ring my aza with 50k as initial ho-body money.

Long story short, I finish job in just 3days {cuz na urgency, him get presentation for ABJ} Baba sey him go send am to him team members for approval. Hawa later baba ring me sey him team members don approve job.

Okey, balance up ma send your final work. Baba begin yarn stories sey if him return from ABJ on Wednesday him go ring my aza.


Baba you dey ho me 100k for 2 months and believe sey I go send this money back!!!? I just end him call, turn off my sim and switch to mifi.

My people how una see this matter? Ma reason am dey 40k back?

My heart too soft, I don dey reason to send am back... But I wan frustrate am small till tomorrow evening.... My 2nd mind dey tell me ma kuku send dey 80k back, ma no ask dey money again till kingdom comes.
Man this Nigeria everyone is like a fraud put your sim back and call him to balance you the remaining if not you are coming to his office, it will surprise you that he already collect even more from the office.

(1) (Reply)

They Are Still Dating You Because They Have Not Seen Your Replacement Yet. / Recommend Movies For Me Pls / Should I Relocate

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 19
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.