Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,153,798 members, 7,820,803 topics. Date: Tuesday, 07 May 2024 at 10:00 PM

My Friend No Wan Marry Im Babe Again because Of The Babe Papa - Romance - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Romance / My Friend No Wan Marry Im Babe Again because Of The Babe Papa (1019 Views)

Who Wan Marry These Girls ? / All Relationship Will Go Complicated Dis September because Of This (photo). / 5 Secrets You Must Not Tell Your Best Friend -no Matter Wht (2) (3) (4)

(1) (Reply) (Go Down)

My Friend No Wan Marry Im Babe Again because Of The Babe Papa by Nobody: 5:23pm On Oct 25, 2011
one of my very close pally just break up with im babe and call off the wedding plans.i ask the bobo wetin be the reason and im tell me say the babe confess to am say her papa na native doctor.now the bobo say im babe na very good girl and strong christian like him but na the native doctor business wey her papa dey engage in na im dey fear am.i tell my friend say if the girl na good girl dem im no need to fear about marrying her but my friend no wan hear ooo.the main the main thing wey dey worry my friend be say what of if im come provoke the babe wen dem don dey married and the babe go meet her papa for strong medicine juju wey she go come use on am no be that one go come worse pass?.i come assure my pally say since the babe na strong christian she no go wan involve in any diabolical wahala and besides no weapon fashioned against god"s annionted shall ever prosper.but the bobo no wan listen to me.im say im just wan protect himself against any juju wahala.my fellow nairalanders if na una dey dis my pally shoe wetin una for do?
Re: My Friend No Wan Marry Im Babe Again because Of The Babe Papa by zealot4me(f): 5:34pm On Oct 25, 2011
undecided undecided undecided undecided undecided
Re: My Friend No Wan Marry Im Babe Again because Of The Babe Papa by bekay911(f): 6:50pm On Oct 25, 2011
So d guy didnt knw hu d babe fada all d while dey wer dating. Schmuck
Re: My Friend No Wan Marry Im Babe Again because Of The Babe Papa by emofine(f): 9:31pm On Oct 25, 2011
tell ur friend to borrow that bullet proof charm from the late Yisa Anifowose, if he no believe wetin hin bible don tok concerning any weapons fashioned against him . . . touch not my annoited etc den mek he use back up nau if one power fail another still dey

or better yet mek im follow u go Christ embassy sample new babe dia abi
Re: My Friend No Wan Marry Im Babe Again because Of The Babe Papa by seedord247(m): 9:38pm On Oct 25, 2011
GuY we nor be mumu Like you . . . Most of you story na papa and pikin dey fight for baby.

If you nor get any good thread to put on, Just wait for people wey get sense make talk better thing.

Msheww.
Re: My Friend No Wan Marry Im Babe Again because Of The Babe Papa by coogar: 9:45pm On Oct 25, 2011
lefulefu:

one of my very close pally just break up with im babe and call off the wedding plans.i ask the bobo wetin be the reason and im tell me say the babe confess to am say her papa na native doctor.now the bobo say im babe na very good girl and strong christian like him but na the native doctor business wey her papa dey engage in na im dey fear am.i tell my friend say if the girl na good girl dem im no need to fear about marrying her but my friend no wan hear ooo.the main the main thing wey dey worry my friend be say what of if im come provoke the babe wen dem don dey married and the babe go meet her papa for strong medicine juju wey she go come use on am no be that one go come worse pass?.i come assure my pally say since the babe na strong christian she no go wan involve in any diabolical wahala and besides no weapon fashioned against god"s annionted shall ever prosper.but the bobo no wan listen to me.im say im just wan protect himself against any juju wahala.my fellow nairalanders if na una dey dis my pally shoe wetin una for do?

lefulefu and his cretinous topics. . . .

you'd be better off driving brt buses than hurting our eyes with your pathetic tales.
#sheeeeeeeeesh# get a life, man!
Re: My Friend No Wan Marry Im Babe Again because Of The Babe Papa by freecocoa(f): 9:54pm On Oct 25, 2011
Even though say we know say this your tori na lie,I go still contribute.
That your friend no be better christian and him no know wetin him want,make the girl leave am sef,instead of am to find way convert the girl papa,him dey fear.
Re: My Friend No Wan Marry Im Babe Again because Of The Babe Papa by seedord247(m): 9:56pm On Oct 25, 2011
Mshewww . . . . . what do you expect from a flock of the same cannibals.
Re: My Friend No Wan Marry Im Babe Again because Of The Babe Papa by freecocoa(f): 9:58pm On Oct 25, 2011
Even though say we know say this your tori na lie,I go still contribute.
That your friend no be better christian and him no know wetin him want,make the girl leave am sef,instead of am to find way convert the girl papa,him dey fear.
Re: My Friend No Wan Marry Im Babe Again because Of The Babe Papa by seedord247(m): 10:04pm On Oct 25, 2011
Is there no Vaccine for stupidity since they said Ignorance is not an excuse.
Re: My Friend No Wan Marry Im Babe Again because Of The Babe Papa by Nobody: 10:24pm On Oct 25, 2011
seedord247:

Is there no Vaccine for stupidity since they said Ignorance is not an excuse.
abegi go sh1t for bucket u kobo kobo oshodi motor park tout lipsrsealed
Re: My Friend No Wan Marry Im Babe Again because Of The Babe Papa by Nobody: 10:26pm On Oct 25, 2011
freecocoa:

Even though say we know say this your tori na lie,I go still contribute.
That your friend no be better christian and him no know wetin him want,make the girl leave am sef,instead of am to find way convert the girl papa,him dey fear.
na true tory i dey nack u and by the way i fit understand im condition becoz u know say life no get dublicate shocked.Me sef fear go catch me small to mess with a native doctor dauther grin and frm wetin the bobo tell me the girl papa hate anything christianity.
Re: My Friend No Wan Marry Im Babe Again because Of The Babe Papa by Nobody: 10:28pm On Oct 25, 2011
coogar:

lefulefu and his cretinous topics. . . .

you'd be better off driving brt buses than hurting our eyes with your pathetic tales.
#sheeeeeeeeesh# get a life, man!
Even though i dey drive BRT buses i still hammar money pass u wey dey siddon for desk dey do clerk job grin
Re: My Friend No Wan Marry Im Babe Again because Of The Babe Papa by Nobody: 10:30pm On Oct 25, 2011
emofine:

tell your friend to borrow that bullet proof charm from the late Yisa Anifowose, if he no believe wetin hin bible don tok concerning any weapons fashioned against him . . . touch not my annoited etc den mek he use back up nau if one power fail another still dey

or better yet mek im follow u go Christ embassy sample new babe dia abi
no be the same charm wey some OPC guy wear and im friend shoot am and the bobo come yamutu? grin
Re: My Friend No Wan Marry Im Babe Again because Of The Babe Papa by seedord247(m): 10:31pm On Oct 25, 2011
lefulefu:

na true tory i dey nack u and by the way i fit understand im condition becoz u know say life no get dublicate shocked.Me sef fear go catch me small to mess with a native doctor dauther grin and frm wetin the bobo tell me the girl papa hate anything christianity.

Jumentous Monkey . . . why you dey rant of the thing wey nor happen . . . don't you know all this kind thing they cause Agenesis of Corpus Callosum
Re: My Friend No Wan Marry Im Babe Again because Of The Babe Papa by Nobody: 10:43pm On Oct 25, 2011
seedord247:

Jumentous Monkey . . . why you dey rant of the thing wey nor happen . . . don't you know all this kind thing they cause Agenesis of Corpus Callosum

U wey look like one of those slaves for Armistad na im dey call somebody monkey? grin grin grin grin grin
Re: My Friend No Wan Marry Im Babe Again because Of The Babe Papa by seedord247(m): 10:45pm On Oct 25, 2011
lefulefu:

U wey look like one of those slaves for Armistad na im dey call somebody monkey? grin grin grin grin grin

I nor blaim you . . . You dey Ukraine dey wash dead body for them and you dey show for Facebook say you dey enjoy life for there

when dem nor say you dey suffer.
Re: My Friend No Wan Marry Im Babe Again because Of The Babe Papa by Nobody: 10:53pm On Oct 25, 2011
seedord247:

I nor blaim you . . . You dey Ukraine dey wash dead body for them and you dey show for Facebook say you dey enjoy life for there

when dem nor say you dey suffer.
N wich one come be ur own wahala for inside?.See as u jus dey boil over with envy grin.Na me say make u no travel? grin.Abeg go hug one hot transformer jor grin grin grin grin grin grin grin grin grin grin grin
Re: My Friend No Wan Marry Im Babe Again because Of The Babe Papa by seedord247(m): 10:57pm On Oct 25, 2011
lefulefu:

N wich one come be your own wahala for inside?.See as u jus dey boil over with envy grin.Na me say make u no travel? grin.Abeg go hug one hot transformer jor grin grin grin grin grin grin grin grin grin grin grin

Me no need to dey blabb of where i don go . . . . . I nor fit go country wey my mama nor fit see me physically for one year.

The time wey i go europe i nor think i spend reach one month. He pay me make i go Togo than to go too Ukraine.

Btw How many dead body you wash a day?
Re: My Friend No Wan Marry Im Babe Again because Of The Babe Papa by coogar: 11:45pm On Oct 25, 2011
lefulefu:

Even though i dey drive BRT buses i still hammar money pass u wey dey siddon for desk dey do clerk job grin

it shows you hammer money with your eroded brain cells and your general muppetry.
if there's an award for the biggest douchebag on the planet, you deserve it hands down - no rival.

you possess the mental power of a millipede.
Re: My Friend No Wan Marry Im Babe Again because Of The Babe Papa by Nobody: 11:53pm On Oct 25, 2011
coogar:

it shows you hammer money with your eroded brain cells and your general muppetry.
if there's an award for the biggest douchebag on the planet, you deserve it hands down - no rival.

you possess the mental power of a millipede.
and u have the IQ of a wall gecko
confirmed grin grin grin grin

(1) (Reply)

The Way To A Woman's Heart Is Through Your Bank Account / I Need Your Help With This Fellow Nairalanders. / Nigeria (Dating & Marriage): Does The Complexion Really Matters?

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 41
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.