Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / NewStats: 3,194,763 members, 7,955,911 topics. Date: Sunday, 22 September 2024 at 06:27 PM |
Nairaland Forum / Entertainment / Jokes Etc / Finally Psalm 23 In Nigerian Pidgin (12639 Views)
Funny Nigerian Pidgin Proverbs And Their Loose Translations ... / Nigerian Pidgin Proverbs That Will Surely Make You Laugh: Add Yours Too / Collection Of Nigerian Pidgin Quotes (not Funny) (2) (3) (4)
Finally Psalm 23 In Nigerian Pidgin by Koolking(m): 5:22pm On Dec 20, 2011 |
Finally the new NIGERIA PIDGIN ENGLISH BIBLE is out. One of the popular chapters na psalm 23 reads:- 1.[/b]Baba God na my shephard, i dey kampe. [b]2. E make me sidon for where betta dey flow, come put me near stream make mai bodi thermacool. 3. E panel beat mai soul come spray am white, come dey carry me dey go through express road go meet righteousness, sake of Im name. 4. Walahi!, if I waka pass where arm robber, 419 and juju people boku, come even join boko haram reach valley of the shadow of death sef, mai bodi dey inside cloth. Your rod and staff nko? Na so dem dey like back bone dey comfort me. 5. You don prepare beta food on top table make I chop. All mai enemies dey look waa waa, ** mtcheeew long throat**. You rub me for head wit vaseline intensive lotion. Mai cup na River Niger wey overflow im bank. 6. True true, betta life and mercy go gum mai back till I quench. And man pikin go tanda for God house from lai lai to lai lai. GOD ALMIGTHY NA YOU BIKO AMEN. |
Re: Finally Psalm 23 In Nigerian Pidgin by Nobody: 5:50pm On Dec 20, 2011 |
very funny |
Re: Finally Psalm 23 In Nigerian Pidgin by dani1luv: 7:24pm On Dec 20, 2011 |
hahahahahahahahahahahaah |
Re: Finally Psalm 23 In Nigerian Pidgin by nnamanis(m): 9:01pm On Dec 20, 2011 |
guy u dey photocopy like mad, Y u go dub another person work, try to invent urs nd be a good boy.@koolking |
Re: Finally Psalm 23 In Nigerian Pidgin by Nobody: 9:08pm On Dec 20, 2011 |
^^^ hw e take concine u na, na ya money en take photocopy |
Re: Finally Psalm 23 In Nigerian Pidgin by mikuz(m): 9:29pm On Dec 20, 2011 |
@donkollione, haba, wetin happen to that photocopying machine wey dey ya house na? The compressor don spoil?? E get one joke i wan come photocopy sef . . ! My own dey get network problem! . . Maybe na the sim . . Which sim you dey use sef? |
Re: Finally Psalm 23 In Nigerian Pidgin by Nobody: 12:08am On Dec 21, 2011 |
^^^ NA NOKIA SIM DEM DEY CALL AM , E DEY WORK LIKE CRAZY HMMM MK DANI1LUV NOR CATCH U OOO, NA SO EN CATCH ME DE ODA TYM OO I RUN |
Re: Finally Psalm 23 In Nigerian Pidgin by Koolking(m): 1:03pm On Dec 21, 2011 |
nnamanis: Guy, I get copyright license na. My motivation was to ease tension. A good laugh is good for us as Nigerians. So much hate, distrust and despair in the system. You can as well paste yours, let laugh it out joor |
Re: Finally Psalm 23 In Nigerian Pidgin by ARareGem(f): 6:01pm On Dec 21, 2011 |
^ You try jor. |
Re: Finally Psalm 23 In Nigerian Pidgin by dani1luv: 10:58am On Dec 22, 2011 |
DONkollione: who wan photocopy?? |
Re: Finally Psalm 23 In Nigerian Pidgin by udoh2k: 11:12am On Feb 28, 2012 |
The Nigerian Pidgin Bible project is now online live! The Book of John is now available for translation. Visit www.NigerianPidginBible.org And be part of the project in just 3 simple steps: 1. Register/Login 2. Search for the chapter/verse you want to translate or vote 3. Click Edit to add your translation of the verse, or, click Vote to vote (recommend, score) the translation already made. Make we join head translate de Bible for Naija Pidgin. Visit www.NigerianPidginBible.org |
Re: Finally Psalm 23 In Nigerian Pidgin by sutoboy(m): 12:45am On Mar 01, 2012 |
Na ur hand i dey oh baba God! Na Dani bi d moderator for here! |
Re: Finally Psalm 23 In Nigerian Pidgin by udoh2k: 6:19pm On Nov 27, 2012 |
Is it possible to produce a "real" pidgin bible for Nigerians? Yes, it is possible if you volunteer to translate a verse or two of the Holy Bible into Nigerian Pidgin. The project site to achieve this feat is now ready at http://www.nigerianpidginbible.org. Register, Login and translate a verse or two into pidgin. Up to three translations can be given for each verse. If you like or prefer a translation somebody else have done, you can simply click on the 'vote' button: that will increase the rating of that translation. You can provide support to the project thru (1)constructive criticism to the contact on the web website (2) Finance , to enable the maintenance of the site and continuity of the project (3) Telling people about the project or liking it on facebook http://www.facebook.com/nigerianpidginbible , and (4) Translating or voting a verse or two. |
(1) (Reply)
17 Funny But True "QUOTES" / Funny Pics And Write Us / Funny Naija Pix:
(Go Up)
Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 21 |