Youngzubi: Episode........32
Sunday GBEDU!!!!
The Game Players -------------------------- big mama's cabal ----------------------------------------
"Hello mama!",i holla big mama,as i pick her call,
"hello spana",she yan
"mama i dey with u nah",i yan "ok,i want u,spata and Stevo to dressup,i will send striker,him go come carry una from festac come my house,make una prepare well,e get some client wey need una service,so make una prepare well for the task big mama yan"
"ehn! ok no le'le mama,we go dey wait striker arrival,i yan
"good,till then to get ready,she yan
"ok ma!,i cut the phone,pocket am as i waka go down stairs,my guys just dey enter house,all of dem come dey sweat like say dem do marathon race,
"spana!!,boss the boss!!,after u nah u oo!!,they begin hail me,
"brotherly how far nah"simple yan,asin guy we dey hear as that chick take dey halla since early mo-mo,guy u sure say u allow am wake up,
"o boy!,she too make sense o i shout"i for give dem more detail but i just code the level;guy the babe just dey burst my brain,the early mo-mo kpekus just good for my health,i yan
"but how u take jam her,how una take meet nahim be my question",spata yan,onto say him never see or hear anything about her before
"em!"i hum scratching my head;see guy nah peson babe be that,but nah kidnap dem kidnap her shaar,so onto normal level i saved her that yesterday,she sef come fall for me,watin my pikin go do nah,as the babe hot,she just carry,come dey rugged nahim me sef waka go buy her market this morning no time to check time'i explain give dem,
"Sharp Gee!!!,erotic shout
"nothing do u boss,i support the notion wey yan say"chop an clean mouth nobi sin!!,spata yan as we begin laff
"tem!!! tem!!,brotherly more kpekus to ur apka-amu,but nah the day u go nack HIV ur papa go begin price ya casket,sentino yan
"eh!! sentino nah maya go carry HIV"i no say i don pass my boundary"so i position my sef well to run,
"watin u talk just now?,sentino yan as him face change
"em! see my guy nah mistake,abeg i no go try am again,i yan but for wia sentino fly land ontop my body as we begin roll for ground,all my guys begin hail us as dem dey clap dey shout
"go!!!!spana! go senty!!!!
after we don waste our strength finish,sentino comot for my body as we stagger stand up dey breath like say we just achieve world heavy weight lifting,i hear as moto horn sound for our gate peeee!! peee!!!!
"ah! i bin don forget o!,spata,Stevo abeg make una run go baff,dress and prepare big mama yan say she get big fish runs for us,nah striker wey come pick us dey horn for gate so i yan
"confirm!!!!!!!!!,spata begin jump up dey shine teeth as him begin twist waste
"at last-at last,we finally get sugar mummy matter to run,Stevo yan
"so we no go follow?,simple yan
"nah only three of us she mention,i yan
"ok nah,we go dey hia dey handle that your skin light,at least party nobi bad idea,sentino yan
"nah gawd go punish ya ancestor! no go try am o,play matter don pass o!,if any"e don do bros sentino cut in
"ah ah!! naso the babe dey she pra pra! ya head reach,nah play i dey follow play boss,i no dey crase to near ur babe so chill man,take a chill pile,sentino yan
"koboko!!!,striker land knock for our door,
"come in nah,abi u still won knock small,i yan as he open door an bounce inside
"heeeyyy!!! see mah niggas mehn!!,pop! pop!! something,striker shout as him waka come inside
"the boss!!,how things nah,i yan as we begin shake
"life good bro,u guys are crook mehnnn!!!,see how everybody chicks is just swelling,no prob enjoy yourselves its Wat u work for,said striker
"abeg make ya sef comfortable make we run go prepare,i yan
"thats no prob man,any chick available?"he wink"
"em! simple!,i yan
"yes boss,he yan
"take him to those househelp room,i yan onto say nah the girls wey big mama carry come give us as domestic help nah dem everybody dey service if konji nor gree us go find runs girls,dem dey 4 girls around 25 27 years old,dem be fire! for bedmatics but non of dem fine for face only over sized br**st and backside wey go make u forget dia face matter
"wow!!!,boss man,nice one thanks mahn,striker yan as him huge muscle vibrate onto say him dey shake hand for up dey hail me
"simple later carry him go meet the girls for dia room while i rush go up,without wasting time,i rush go baff then rush outside again as i begin prepare
20mins later all of us don waka come down dey wait for striker,nah only those girls scream we just dey hear
"that striker guy bad o!,spata yan
"before nko watin u expect,i yan,i bin won stand up go call striker say the one wey him do don ok,but i sight my babe as she waka dey come down from stairs,ajebotically taking the steps one by one jejely
"hi!,she yan to my guys with better smile as spata begin turn head like standing fan dey look her till she waka come sidon for my laps
"u don wake,i yan touching her hair as the smell begin cool my system maybe she bought it from Bigsarah becos that lady eh! she get better-better hair wey she dey sell
"spata close ya mouth nah,i yan
"eh!,he yan
"closeup joor,i yan
"ogbeni nodey drop spit for my shoe joor,sentino tap him as my guy(spata) wake up from slumber nahim he come reply the babe "hi!"
"no u for leave am tomorrow ewu!,nah naw the girl greet u,Stevo yan
"watin happen sef abi nah bad thing to look fine girl eh!,as spana yan say make we no near her,at least make i use eyes tear her nah,spata yan
"hahaha!! oh my gawd you guys are just too hilarious",she yan
striker bounce outside as him continue dey struggle with him belt,nahim all of turn begin look am,he finally succeed in tying the belt well,hmmm! he sigh then carry head up as him eye jam our stare
"what!!,he yan confused onto say everybody just quiet come dey look him,he begin look us one by one till his wor-wor eye jam my babe
"whaaat dah Bleep!,this babe make mehn!!,hey sweetheart how u doing,he yan as him come meet the babe hold her hand
"hi!"she yan smiling
"what's your name,striker as
"vicky,she yan as she turn look me"i will still deal with u later,she yan to me before facing striker again
"oh! vicky you'er an angel,what a damsel yo mama gave birth to,striker yan,as vicky begin giggle ontopmy leg
"awww!,thanks,she yan
"oya make we begin go,spata snatch vicky hand comot from striker hand as him push him dey go outside
"hey babe we l'll see some other time huh!! ....striker shout
"ok byee!!!,vicky yan
"i try stand up but vicky push me go back,
"so u let another guy ask for my name in this house before u could,she yan frowning
"nah dat time i come understand watin she mean by"i will still deal with u" oh no vex,i bin still dey plan to ask u once u wake,i yan
"and am still sleeping right,she yan
"see we go yan better later,i get business for hand wey i won go handle,"see u later i yan as i waka go outside
"not even a kiss,she yan
"when i come back i shout"
"oga spana!! make i help u collect am??,sentino shout
"and i go-go visit maya this night,i yan back
we enter moto as striker start the moto begin drive,we begin discuss dey argue from one rubbish to another,we talk-talk till we reach banana island for lagos,omo we begin another argument say nobi Nigeria we still dey , onto say lagos banana island too fine as oyinbo full everywhere
"hey! guys its ok,lets be serious now,here is big mama's home,striker yan as him stop for one big gate begin horn
one giant security guy waka come open the gate as we drive enter the compound jesuu!! come see people wey dey chop our money,inside the compound nah three storey building,dem paint am pure white all through come use wall ties disgn the frontage like paradise,another long building dey by the side,ontop am nah chairs and something wey be like microscope for the side,nah red and white step lead go up the there
we waka come down from the moto,nahim i begin survey the whole compound as i sight security guard everywhere
striker lead us enter their guest house,omo come see choping things as GBEDU full the whole table,wine,full chicken and many-many more,we settle down as their maids begin serve us,trust guys we nor send the food as everybody settle for wine, beer and cigarette
16mins later big mama surface,everyday young,she waka majestically as her fair skin and coloured Brazilian her rhyme,tall with thick body,her makeup just compliment her already gawd given beauty as her endowment perfect her womanliness,she load well asin well loaded
"you guys are having fun already,big man yan as she come join us
"wow your husband sabi better thing o! mama,i yan
"you can say that again,she yan
"i bin won ask her wia we go-go meet those client,when she step inside the guest house,immediately our eye jam the smile wey dey her face disappear instanta as i focus my gaze on her
"she no expect to see him in her Home,but now wey she do,all the anger she bin dey get for him vanished as her breath hang,such a cute guy,no she can't watch him perish like that,for she no go fit forgive herself if watin dey future happen to him,she no fit let her ma'le succeed "No!,she murmured as she return her gaze on him again
"spana nobi u i dey follow talk big mama yan,but spana just open mouth dey look one particular direction,so big mama followed his gaze till she sight her daughter standing at her back"oh! no! she sigh" "Cynthia what's meaning of this,why the long stare between u two!!,big mama barked at her daughter
"em!,ma! mum am sorry",she yan as she turn and dash outside instantly
"i thought i could convince her,i thought i could change her mind set towards him,but no! i was wrong,with what i saw in her eyes now,she is really in love with him,which is the last thing i would live to witness,i think its high time she join her siblings in U S A,good that would definitely solve it all"big mama conclude her thought
"striker!,big mama yan
"ma!,striker yan
"take dem to where Mrs chidinma and co log at eko and suit hotel,she yan "spana,she halla me
"ma!,i yan
"do ya job well,i go come see una for festac,i get meeting to attend now bye she yan as she stand up and begin waka
watin concern me,i hiss as i grab the chicken begin chop,later-later striker carry us as we begin go eko hotel wia our client dem dey
to be continued
vote youngzubi for literature award
https://www.nairaland.com/4652535/nomination-thread-august-5k-award
Happy Sunday God bless!!!! Lol na only me you see add for the Tori, anyhow carry go |