Bullala1's Posts
Nairaland Forum › Bullala1's Profile › Bullala1's Posts
1 (of 1 pages)
Las las most useless men men go still marry marry. Respect for marriage no dey again. Useless people go hide behind phone pad dey type shit. God dey watch and e must catch everybody. |
You know what? make we level this matter. Everyday for NL i dey see boys wey no wan work again dey claim say sugar mummy wahala, Bros, na lazy you dey no be only you fine. No go dey form fine boy still dey find woman wey senior you to prack! On the d-low, na lazy you dey! Na either financial condition or evil spirit cause am nigga. (Girls too, wey dey find sugar daddy, babe na loose you dey, go get help and stop polluting everywhere spiritually. Effort to position yaself where sugar mama/papa go see you could still be used to position business idea where investor go see am.) For the ones wey get work still dey find sugar mummy, Sorry o! Na curse dey your head. If you love am, no more hotel room, carry am dey go area see your boys and girls dem for hood. Carry am go church or mosque hear God word, follow am go her own family house to see her brothers and sisters dem (if dem no reach to born you). Any hesitation from her, bros na tissue you be because she use you dey hol body until her confidence rise again. Sugar mama wey dey find small boy unto gangster loving and milkcub treats, ogun fire you there. Your confidence don go and na issue carry you go that side. Go get help with better therapist. If una love una self well? the test no be to go fine fine location / coded joint / hotel room. Make you follow am go im parents house so una go quick settle down since you need more time to quickly start enjoying the union. Any hesitation mami na use the nigga use you. Give yurself brain go work on your mind and confidence. Follow am go church abi na mosque For una men wey dey find small small girls to pracke dey form love. Una agemate don catch up with all una lies, you don enter small girls wey you fit lie to. Na Ogun to castrate una finish. My lord, na here i rest my rant. Evil dey smell. Nasty smell and people go dey inside am dey smile. |
Bro e no follow. Sugar, pepper or sale mummy, go find work. You no be hero/ na zero you be. All of these boys wey no train brain but only prick una carry, time will tell. |
Una dey really enjoy this straffing without rest of mind? e no dey sweet o! |
Omo! Wetin be this for the first video abeg. The guy no get roof abi wetin? Omo no be by force abeg! Rubbish! |
Nigga/Nigguress no try am. I go just use the country borrow money. stillwerise: |
You don shake table. Until you fall down there. This definition na everybody wey dey my area na. Me sef join. |
Person dey beg to useful peeps dey laugh. Bro you na national treasure.Nigga either you; 1 trade forex- octa fx/ hotforex 2 set up you tube channel and get it monetized by having 1k subscribers and 4k watch hours (invest 3 months) 3. Just follow this article. Helped me too. https://antvt.com/100-investment-ideas-in-2022-you-should-not-miss/ |
Meanwhile their pew still full. Their pale there. Religion the poor man's opium. |
1 (of 1 pages)