DeltaBachelor's Posts
Nairaland Forum › DeltaBachelor's Profile › DeltaBachelor's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 175 176 177 178 179 180 181 182 183 (of 189 pages)
ekeday:Welcome bro. Na man you be ![]() |
UjuJoan2:lol. No wahala. Me just Dey ask simple question, but as 9ja babe wey you be, you must let me know say you be grandmama. So people wey don marry nor dey send PM’s or chat privately abi ? Wahala nor dey jare since you don even rush go check my profile . I am not the guy from way back then . HML !!!! Take care ma . |
UjuJoan2:hmmmm. It’s not hate now. It’s an advice . I prefer it when someone is being blunt. The truth is that that guy can still work in the entertainment industry, but definitely not as a comedian. He can tilt towards other people like AY Makun that are not necessarily funny, but still make money off entertainment. It was just an unbiased criticism to make him better, No cap. That said, make I focus on the one wey consine me jare. My email : deltabachelor@gmail.com . Everything you need to know about me is on that email . That’s my identity. Oga come parlour make we discuss. I dey wait you inside ![]() |
UjuJoan2:Uju darling . Nne let’s call a spade a spade jare. You sef check the video na. For the Buhari regime, the video go even Dey make us vex sef instead of the opposite. Meanwhile can we talk in private ? ![]() |
Andypamii:I am having a start up company oooooo. If you would be kind to help me grow it by partnering with me on marketing, I would be grateful. I stay around Igando axis. Are you male or female ? Let me know if you are interested. Thanks |
Guy comedy nor be your thing. Nor vex. Just use the time wey you waste take do another thing. These ones dem dry pass panla wey them bring from maiduguri ![]() |
BKsoul:Hmmmm . That’s cool. Are you based in Lag ? |
BKsoul:Ok dear. From which state ? |
BKsoul:Hmmmm. Are you Igbo ? |
BKsoul:So sorry dear. May God Almighty grant you and your family the fortitude to bear this great loss. Amen |
BKsoul:Hello. So sorry for your loss dear. Please take heart. Was he sick ? |
Yomi4reel:Which Language be that ? Them be like Warri people wey dey another country oooooo ![]() |
BirtherOfKings:Hi. Where in Lag do you stay ? |
magnificientzaz:Same here too. Wow !!!! |
Divoc19:hahahaha. Bad pikin. See as you come hijack another person thread. You better find babe give that chap ooooo. I nor wan hear stories that touches the heart later |
Lilsameey:lol. The hustle na still part of the training. E go pure one day. Keep the hope alive mate. Cheers !!!! |
Divoc19:That’s so true ma’am. I have replied . I also believe we have good things around us. Hopefully, you are one of them, ‘cause heaven knows I need good good tidings at this point in time. Cheers !!!! |
Lilsameey:If you want rugged face and you Dey Lagos, we fit drill you small for barracks. When you stand with your head for like 3 hours, na two things fit happen. It’s either all the blood go straight to your head and give you a bicycle-seat head or all the veins for your face go come out making you a ruggedy Baba ![]() |
Divoc19:hahahaha. It wasn’t part of the deal jor. The challenge na who go first mail. Although you still never do am sha but my number of followers and PM’ers just Dey increase like Messi Instagram page ![]() The thing be like juju ooooo. So fine babes dey this Nairaland like this. I think say Misogynists and Feminist full am ooooo ![]() Sometimes e dey be like say na battle for supremacy between Redpillers ( self acclaimed correct guys ) and Bluepillers ( self -acclaimed independent feminists ). The sharp ones inside them just Dey “ cash-out” on a low ![]() |
Divoc19:lol. All-in-all sha, na me still win. Although this very patient dog fit nor even see biscuit bone chop sef as another man don buy everything ![]() |
Lilsameey:lol. You sure say nor be you be that ? Mr fine face like woman own. If woman face fine, na the front dey suffer am oooooo. If man own too fine, na the back go suffer am. But if man face rugged come fine small with masculine features like chiseled jaw line, fluffy beards and thick eye brows with a V- shaped waistline, 6 packs and athletic legs, chai the front must enjoy tire ![]() |
Divoc19:lol. Na now wey I don know say you be person mama you wan mail me ba ? |
Lilsameey:Na person wife and mama you want make I enter ba ? O wrong naw ! |
Lilsameey:Chai !!!! R.I.P to your yansh brother . Please if you nor wan dey wear pampers for the rest of your life and you are in Lagos, avoid places like Festac, VGC, Ikeja and Yaba . If you must go there, try wear Iron pant wey get very strong padlock ooooo ![]() |
Divoc19:lol. Thanks. I wish you the very best as well. This little conversation don even make like 3 people send me PM now now sef. Abi you follow dey among ? ![]() If you nor dey, that’s too bad ooooo, but you open road for me sha, so no lele ![]() Cheers !!!! |
Divoc19:Hahahaha. Bad girl. Now I can confidently say I have met my match. Kudos dear, nor be every babe dey fit yarn like this. It must have taken years of street smartness, experience and all. I did a little digging and saw that you’re married even with a daughter sef. In that case, no need to dey waste my lingo, pick up lines and toasting vibes for here jare. You are taken already, so make I find another person wey go replace you ![]() BTW, Expresswriter nor mind that babe jare. The perfect person for you go locate you. Nor be every man go sabi toast woman na ![]() I nor get 2nd moniker oooooo. Na when I don marry I wan get. I go change this one to “ Deltahusband” so that babes here go know say I don dey taken . As per the 2nd option, why you talk say e nor go lead to regrets ? You want to cheat on your Oga with me abi ? I go report you to Oga ![]() Because you talk for one of your thread say you convert to Muslim, you wan claim to be the Moh here abi ? You better change yourself into a mountain and load yourself inside Uber to my place right now ![]() |
Lilsameey:lol. I understand boss. Na whining me sef Dey so. Although, I nor understand this plaiting of your hair thing ooooo. Na Gorimapa ( Kodos) I dey barb because I dey bald, and according to science, we bald men pack testosterone full body wey dey magnet women like chewing gum . If the skodos come go with goatee or better beard gang, you go just notice say them go dey drool with ecstasy ;, particularly when you come go be TDH guy with a perfect and sarcastic sense of humor. You know say woman dey like wetin dem hear pass wetin dem see. I go win you for that one be that. Before them go see your effeminate baby face sef, I go don off pata tey tey . |
Kingsean:Na so Baba. Nothing sweet pass after you and your woman ( Wife of Gf ) don quarrel finish, una come do make-up sex. Choi ! E go just be like say una just Dey meet for the first time , especially after una Dey cuddle come Dey reason how una go take better una lives.That kind plan, even juju nor fit stop am ![]() |
Lilsameey:hahaha. First off lad, if you read my comments, you go know say I nor too send physical appearance. I see myself more as a Sapio- sexual. That being said, I also believe that being attractive is subjective. Wetin Mr A fit find attractive , Mr B go call am ugly. Still on the matter sha, e sure me say you nor fine reach me. I nor mean to brag but na you cause am. Me and her Dey play one game…. The waiting game. We wan see who go first ‘fo’ . I just Dey laugh her face cause she Dey claim Queen. Instead of her to make her move now and claim her King, she wan Dey follow me rub shoulder. Na Joker she go end up with las las for this card game ![]() |
Divoc19:You nor fit hit any spot. I nor get any mumu button ooooo and yes no one can wait “impatiently” forever. I guess that was what brought about the saying that if a certain Moh doesn’t go the mountain, the mountain will go to him. Whichever one happens first, it’s still a win-win situation. This your stubbornness don make us derail the thread of somebody wey dey find love. You better send a PM to Expresswriter ooooo. Na him need am pass me ![]() Nor be only wait impatiently forever…. Na 2 things fit happen. It’s either you discard any notion or belief you have had before of the guy chatting you up first and do the needful, or you take the 2nd option of letting go but regretting your actions everyday. Nor be every babe wey dey relationship now dey with their first choice oooooo. Some Dey vex inside relationships and marriages like this. Na wetin you want make this your small ego cause for you be that ![]() |
Divoc19:Make I follow your trail ? I laugh in Swahili . I be like cock wey dey follow bread crumbs until him enter pot of soup abi ? . Madam, you go get white bia bia if na that one you want oooo. I don express my interest the first time and you show yourself as normal 9ja babe wey you be na. You went on the defensive. Make me too defend now. Go buy all the strikers wey dey this world like Messi, Neymar , Mbappe and Lukaku and maybe I fit allow you score one goal to my heart ![]() |
Kingsean:lol. Bro I nor be Arsenal Wenger oooooo. Na manager I be not coach. How I go build someone to my taste ? Na me born am ? I nor be Academy coach abeg. Before you go build someone to your taste, them go show you potential at least. All those Yamaha and tiger wey I dey talk about na just Big fuel tank and Big Capacitor them get ( hope you understand ? ) Them nor get better engine ( brain ) . I like big tank and capacitor with high voltage ooooo, but na engine sure pass, na the brain go stand the test of time, so if she carry front and back without opolo, na to park and go ooooo. I nor wan spend the rest of my life with somebody wey be say na only to bleep and raise kids we go dey do. No intellectual conversation, educative arguments and bantering. |
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 175 176 177 178 179 180 181 182 183 (of 189 pages)

. I am not the guy from way back then
. HML !!!! Take care ma .

