₦airaland Forum

Welcome, Guest: RegisterLoginWith GoogleTrendingRecentNew

Stats: 3,330,564 members, 8,446,060 topics. Date: Thursday, 16 July 2026 at 02:25 AM

Toggle theme

Demelza's Posts

Nairaland ForumDemelza's ProfileDemelza's Posts

1 2 3 4 5 6 7 8 ... 55 56 57 58 59 60 61 62 63 (of 151 pages)

RomanceRe: Celebrating My Birthday Live On Nairaland by demelza: 2:09pm On Nov 15, 2013
Dannylux: (((Shots fired))) undecided
grin E-jolosi
RomanceRe: Celebrating My Birthday Live On Nairaland by demelza: 2:06pm On Nov 15, 2013
chycoroxie: *whispers to her* we can share him n chop his money
After we go waka
Correct babe!
You definitely know wassup.
RomanceRe: Celebrating My Birthday Live On Nairaland by demelza: 2:04pm On Nov 15, 2013
lirusehn: u see. And bad belle dey lie say na me runs am. I go deal wit una 4 outside. I if i knw kill persn here mey ma forefathers no wake up again. Mtchew
Na only mouth u sabi make. Come try am na!
RomanceRe: Celebrating My Birthday Live On Nairaland by demelza: 1:59pm On Nov 15, 2013
vizboy: who goes to a party and sit at the corner my Rove?
Vizboy!
Which kin rubbish be this?
How many rove you get for this party? angry
RomanceRe: Celebrating My Birthday Live On Nairaland by demelza: 1:57pm On Nov 15, 2013
INeedAnEngrJob: Op, wen u wan cut ur cake nah
You just enter now now dey find cake? You no even wish the celebrant happie birthday.
Habatically!
RomanceRe: Celebrating My Birthday Live On Nairaland by demelza: 1:53pm On Nov 15, 2013
lirusehn: wetin u dey tok?? Ehn no tell me na, wetin u dey toki? me wey dey outside dey watch fight naim u see thief phone. Dis mata go hot *runs out 4 a bottle* abeg mey una no tok put o
Make una hold am o! The guy wan take style run. Na him carry the fone, I see am wit my korokoro eyes.
*ties headtie around waist*
RomanceRe: Celebrating My Birthday Live On Nairaland by demelza: 1:47pm On Nov 15, 2013
lirusehn: shuo!! D numb no dey gree go oshocked
How the number go go?
You think say I no see the time you off am put for pocket?
RomanceRe: Celebrating My Birthday Live On Nairaland by demelza: 1:43pm On Nov 15, 2013
[quote author=deejay_harry1]grin[/quote]mtcheeeew!
Enemy of progress. grin
RomanceRe: Celebrating My Birthday Live On Nairaland by demelza: 1:39pm On Nov 15, 2013
Dannylux: you work at yabaleft? cry
No come koba me for here.
What the hell is yabaleft? I work in a hospital that deals with patients who are deficient in the neurosurgical part of the brain.
RomanceRe: Celebrating My Birthday Live On Nairaland by demelza: 1:31pm On Nov 15, 2013
[quote author=deejay_harry1]see no dating co worker policy na.. angry we go jam for office sha... [/quote]If you try harrassment, I go report you straight to oga Presher.
RomanceRe: Celebrating My Birthday Live On Nairaland by demelza: 1:28pm On Nov 15, 2013
Dannylux: Demelza, wanna dance? wink
You look like person wey no fit dance.
I'll pass on that offer
RomanceRe: Celebrating My Birthday Live On Nairaland by demelza: 1:14pm On Nov 15, 2013
[quote author=deejay_harry1]oya make we twerk am dey go.. whine am for me..grin[/quote]Oya go look for your mate. This place no be office.
RomanceRe: Celebrating My Birthday Live On Nairaland by demelza: 1:13pm On Nov 15, 2013
rosebetty: No vex. As . See say nobody order for the tin since. I say make I pity vizboi make e no waste.
Ok I understand you.
Drink the thing codedly o! I no want make you attract some touts wey dey here.
RomanceRe: Celebrating My Birthday Live On Nairaland by demelza: 1:07pm On Nov 15, 2013
[quote author=deejay_harry1]of cos na . i lock with 5 padlocks sef. the patients wont be smelling air for a while grin[/quote]Good!
Nobody send dem make them run mad. Enjoy the partay!
RomanceRe: Celebrating My Birthday Live On Nairaland by demelza: 1:02pm On Nov 15, 2013
rosebetty: Hapi birthday vizboi. Abeg na dat garri and groundnut me wan chop. jux put one pure water.
Kai!
See as this babe just fall my hand!
Maka why? undecided
RomanceRe: Celebrating My Birthday Live On Nairaland by demelza: 12:55pm On Nov 15, 2013
[quote author=deejay_harry1]and im late sad[/quote]Oga! I hope say you lock up the psychiatric hospital before you reach here o!
RomanceRe: Celebrating My Birthday Live On Nairaland by demelza: 12:43pm On Nov 15, 2013
[quote author=born_to_be_gr8t]grin grin grin

MY FRIENDS ARE HERE[/quote]Abeg where the nearest exit dey? I too like my face.
RomanceRe: Celebrating My Birthday Live On Nairaland by demelza: 12:42pm On Nov 15, 2013
vizboy: that my rove
Dat rove no be for free.
I hope you don package my food and drinks keep. I go soon checkout!
RomanceRe: Celebrating My Birthday Live On Nairaland by demelza: 12:35pm On Nov 15, 2013
[quote author=born_to_be_gr8t]embarassed embarassed embarassed embarassed
Birthday boy too stingy,so nobody fit rock ur babe...I DEY VEX[/quote]Vex enter lagoon.
RomanceRe: Celebrating My Birthday Live On Nairaland by demelza: 12:30pm On Nov 15, 2013
lirusehn: *breakz bottle* wey 'em d bouncer?:/
Agbero don climb fence enter.
RomanceRe: Celebrating My Birthday Live On Nairaland by demelza: 12:24pm On Nov 15, 2013
[quote author=born_to_be_gr8t]i think u dey see am...if i don high,na small thing dey vex me[/quote]I no know say ex militant dey dis party. Vizboy abeg invite soldiers for am. Him no fit do anything.
RomanceRe: Celebrating My Birthday Live On Nairaland by demelza: 12:11pm On Nov 15, 2013
[quote author=imsu.boi] you neva leave me na. You still dey here ni.

Oya come siddon for my lap. grin
[/quote]I no blame you, na the 10 bottles wey you don drink dey talk.
RomanceRe: Celebrating My Birthday Live On Nairaland by demelza: 12:08pm On Nov 15, 2013
[quote author=born_to_be_gr8t]embarassed embarassed embarassed embarassed embarassed
E be like say time don reach,wey we go scatter this party,so u bday boy,u no fit let person rock ur babe abi?
you too stingy, and u demelza!!!...i dey wait u for junction embarassed embarassed embarassed embarassed embarassed[/quote]Patapata You no fit do anything. Na me talk am!
Christianity EtcRe: This Pictures Will Show You Some Of The Best Way To Identify A Witch Around You by demelza: 12:05pm On Nov 15, 2013
No wonder Nigeria is not progressing, majority of our women look like witches. grin
In other news, Mac still remains the best cosmetics.
Nairaland GeneralRe: Afam God Is Watching You by demelza: 12:01pm On Nov 15, 2013
A repentant tribalist?
Crikey! We dont see that everyday. grin
RomanceRe: Celebrating My Birthday Live On Nairaland by demelza: 11:56am On Nov 15, 2013
[quote author=born_to_be_gr8t]grin

free dat jonzing man...BTW o!!!,this babe u come alone?...come here make i rock u small..oya shake am for me!!gringringrin[/quote]E be like say you too don manya. Abi na craze dey worry u.
Vizboy hold me o! Make I no scatter bottle for person head o! angry
RomanceRe: Celebrating My Birthday Live On Nairaland by demelza: 11:48am On Nov 15, 2013
[quote author=born_to_be_gr8t]GUY take am easy o,na ur 5th bottle be that,i no fit carry person o!!!! gringringrin[/quote]Just leave am make e dey behave like person wey neva see drink before. Him babe don leave am tey tey. grin
RomanceRe: Celebrating My Birthday Live On Nairaland by demelza: 11:46am On Nov 15, 2013
vizboy: them fine oh tell them make dem crash enter the party say better dey
Ok sir!
Eyin girls oya!

RomanceRe: Celebrating My Birthday Live On Nairaland by demelza: 11:44am On Nov 15, 2013
[quote author=imsu.boi] those bouncers wey dey for door go handle them!


Abeg gimme anoda bottle of star dia!

With one plate of catfish pepper soup grin grin
[/quote]Mr. Man you come here to chop abi you wan come celebrate with the celebrant?
You no see as girls dey look you? Get small shame na. grin
RomanceRe: Celebrating My Birthday Live On Nairaland by demelza: 11:40am On Nov 15, 2013
vizboy: call that guy make dey door make he handle them
See as them line up o! Who be the bouncer sef?

RomanceRe: Celebrating My Birthday Live On Nairaland by demelza: 11:34am On Nov 15, 2013
Vizboy some girls wan crash the party, make I allow them?

1 2 3 4 5 6 7 8 ... 55 56 57 58 59 60 61 62 63 (of 151 pages)