Ebos's Posts
Nairaland Forum › Ebos's Profile › Ebos's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 9 10 (of 34 pages)
haba! Oby, which kind surgery u wan do? May God be with you. Hp u are not afraid? Kingdud, I hope u dey Babcock and still carry Unilag joinam. You go fit cope? ![]() |
I thank God for my mum, though, me never see am for a week now but she is improving. Haba! my own greediness no be say na super glue now ![]() |
I greedy o, no bi say u talkam, I greedy no biu small. Me, no dey gree put my PC on because once I putam na forex straight. If i putam off, i no dey toucham at all. |
Carlosein, no bi say Oby mention your name. Forex be hit me one heavy blow yesterday. ![]() However, greediness no dey gree me at times to call it a day. I for go rest yesterday, but me know fit understand wetin carry me enter market wey I don conclude say no more again. Na him dey make me shut down my PC completely to avoid over trading. ![]() |
Oby1:Make i carry go? But the only loss be shake me for head no be small - 420 dollars loss. convert it to Naira. ![]() |
Oby1:I no get anything to worry. In fact, e bi na say na me the harmer forex these days. Since Monday last week, na yesterday I record one but heavy loss. But all the same, na me dey hit forex now. ![]() |
Oby1:You nkwanu wey show small face come dey yab, how soon? ![]() |
these guys cannot show face |
Hey guys! Oby and Carlosein, my server no gree connect again yesterday. Na him make me go offline. Lawyer, Carlosein na moon but u be him twin (onwa) ![]() |
O, it's like the moon is just passing by but decides to hang for a while ![]() |
Oby1:It's only twice now only that I will soon be going out. But it's just twice |
Viee, I don't even catch you online too. It's difficult and it was only once I caught Oby online. Carlosein na moon. |
Oby, My server dey worry me for forex no be small o. It's affecting my trade - struggling to close my positions but difficult to connect to my account with my broker. So, I can't close my profits. |
@Lady, Good 2 know u scored the highest mark. Congratulations! All the time wey Viee dey write her exams, she no tell us wetin she be dey score - hp say she still perform well. I trust ![]() |
Haba! Lawyer wetin u dey yab catholic pikin dem now? ;DCorrect children plenty for Catholic my brother. Na there dem finish self. Other churches no match dem. Oby, dis one wey you dey ask Lawyer whether na Viee disappear pass him. Disappear na the same. All we know be say Viee and Lawyer be no show face 4 here. Carlosein, maybe u fit be my best man. You go just stay for my back dey watch others as dem dey eat the small food wey I go present - and the wedding go be on Good Friday so dat meat no go dey and food itself go small because of fasting . But, we go promise u say no worry for food when we reach house. Dat one be say, as we reach house we go tell u say "abeg no vex dem don finish the food wey we keep 4 u. ![]() |
Hum, Pamperme, u are doing good job here no be small. wow!Lindiwe, thanks but where u disappear come go? Come show face here 4 this thread now. Ok, if Viee n Lawyer no appear here, maybe my action no go dey difference from those suicide bombers. ![]() Oby, hope say no too much work for 2day? Carlosein, I don foget say me never marry self. if no be say u remind me of the wedding - I for don forget finish ![]() |
O e be like say load of work dey hold you for office? Pls, let it be tomorrow. Someone dey here dey worry me since. 2morrow or later this night. |
I’m even trading right now - all the while I have been chatting with you. |
I’m still very much on it now – though, I was not regular on it because I could not just sit tight on PC while my mum was sick. I tried to trade often but I paid for it because I was not relaxed. As from next week I will devote more time and August ending will determine whether me go come Lagos in September and stay 4 two weeks. My plan fit bring me to Lagos. |
Oby1:And it's a pleasure we feel your glowing face - though your mouth no start 2day. So, no talk say you be use your mouth just 2day. ![]() |
Oby, the good news is that you are pretty good at jokes - may Ebos be good enough like you - thinking about your thinking just only to get mouth like yours. ![]() |
Lady, only joking, ok? I know that jokes can be a creative way to see Peace and happiness in our own lives that we can share together. It allows us to see and to listen to each other. It also creates a dialogue between individuals – seeing Peace was born out of an understanding reached through jokes. May God be with u my sister.Oby, na you get mouth pass everybody here - your own no get twin. ![]() |
Oby1:So, u never know say all the Angels and Saints dey revealam 4 here Abi, we need any other Prophet?~Lady~:Abi, u wan make we scare? As u dey shout huh! ![]() |
Hey, Oby, e be like say na trouble Lady run enter here. Don't worry, dem no fit pursue u enter this place. ![]() My mum is getting better - thanks all for ur prayers. |
oh, Lady again online - E be like say 2day go better o. Lady I be greet o. Viee don disappear. Wetin dat one be now.Oby, I worshiped there 3 times. Yes, I join u 4 de song, sweet mother ![]() |
make I see someone - 15 mins. |
Oby1:Oby, me thank God 4 the kind mother HE give me. In fact all of us no dey play with my mum because she no carry us joke at all even as we don grow finish. Oby1:See Oby dey feel say I know sabi St Charles. The parish wey I come whether na 3 times when I be dey do IT in late 90s |
Oby, me go surely visit St Charles dis year. No be 4 Idowu backyard d church dey? I sabi the church well. |
Haba, who come be this now? Viee, haba now! 2day me get luck well well. we come jam online. Viee, explain - where u come go since now Explain now before I go hire Lawyer 4 ur case. ![]() |
I no yab Lawyer now . Na him talk say to find trouble na him work. No be Gani brother. ![]() Me must visit St Charles, Olodi one day. At least I be know 2 guys' house but I never know whether dem don comot where them dey live then. |
My business has not taken me far to Lebanon as I planned due to my mother. Her sickness started March ending, but I have not been steady in my state and Port Harcourt. |
Lawyer dey search 4 case. Him say his work na to find trouble. Na him make he never show face now. Him dey find plenty trouble wey go takem go court begin blow grammar. ![]() How Lagos and St Charles Olodi, Apapa? |



