Ebos's Posts
Nairaland Forum › Ebos's Profile › Ebos's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 9 10 11 12 (of 34 pages)
@Chiol You made some good points. The fight era is gone - the people that despised Catholic are no longer here. Those in the thread now are all Catholics. Anyway, I can see one guy (debosky) I fought him during the war and he's here again. Don't just mind him ![]() You are welcome to this thread. ![]() |
But Oby, when are u going to have my time now? But I have una Clock now ![]() |
Don't worry I will post it to Carlosein. I know when I will do dat ![]() |
Oby I no even see ur body na only eyes. At least u know how I look like but I can't tell how u look like |
But Oby, abi u no see my body? Answer me now ![]() |
Come Viee, u mean u no see my body? I no fit believe wetin una dey talk, mbanu now. I dey PH but I may come to Lagos tomorrow because e get wetin I wan come do and fit stay only 4 days and I go come back to PH. |
Oby una no better pass me anything, at least una be see my body but I no see u and Carlosein body. How una come better pass me? If u see me any place, u go fit recognise me but una own nobdy fit recognise una. ![]() Viee, my vacation don even start as I dey here now. Maybe, I wan start am fully with a new week begining from Monday next week. Me dey here now just to play with una before I go begin the journey. ![]() |
viee: U dis girl, thank and understand wetin, Abeg post ur full pic and u dey there they thank dey understand. I no understand anything. No be dat kind thanks I want. E be like say u no fit control ur hand for keyboard again. ![]() |
These people and their wayo tire ebos no be small. Lawyer be attached his full pic. At least me show my body, but wetin come be these guys own? Oby and Carlosein come carry nose and eyes as if say dem behead them. But Viee still dey work for her teeth. Her own be say nothing at all. In fact, e better nothing than the kind thing wey Oby and Carlosein post here. |
See una tomorrow. I need the pic before I go , Let tomorrow be another day. ![]() Oh, dis girl wey be Oby don bury sense man (ebos) Abi? ![]() |
Oby, wetin dey your profile no satisfy at all. Post your full pic here. Haba! Viee, if na part of us we post - then, make u go first and post your full pic. Na me first post something. Why not go first. You and Oby and Carlosein - wetin come happen now. ![]() |
Oby, u have to pay for waiting fee. How long e go take u post the pic? Carlosein, see wetin Viee and Oby dey do even as you join dem dey provoke me. |
Na child abuse be dat. Parmperme carry beer give those kids. Dem drink begin sleep like say tomorrow no dey. E bad o. ![]() |
Still waiting for the pics but nothing I have seen. Wetin happen now? How many times I go ask wetin come happen. In fact, if una see me right now, the misery on my face will tell the amount of pains in my heart - because of the pics you guys have refused to post. Where are the pics?Again, on no account should any person copy another person's picture. Don't betray the trust. Oby, no let me miss my profit where I dey wait for ur pic as if say I dey wait for Christ second coming ![]() |
Carlosein, wetin dey ur profile? Abi na lipstick u paint part of ur face. Haba, my own show more dan ur own now. Ask these babes now, dem go tell you better. Abi, u dey good for costume? Abeg post a pic wey go show your face fine. I no come understand una again o. ![]() |
Viee I dey here wan confirm with my eyes - so, how I go come ask u about Oby pics. Wetin be dis now? I get eyes and e no dey difficult to post am for us. |
Oby stop dat! wetin dey for ur profile? No be ordinary flower you carry put there. Post ur pic here make we see u. I no wan here story. Viee, I don dey ask u since say which kind teeth u wan post here? Make una stop dis thing o. Abi na 168 hrs X 2 your pic go come dey ready. If say una dey around me now - I for snap una quick quick with my local Digital Camara. Wetin be dis now? Make una post am now. Ebos wan concentrate for biz because dem don do sharp credit my money today. And thank God I be don make little profit as per my first trading now. Oby and Viee I wan see una pic. Carlosein fit forward him own for my box for now or him fit post am here too. |
Haba, Jessy-girl, no katakata here. I hope na peace you carry come I have been trying to comprehend your post but it has not been possible. Not getting your point at all. ![]() |
Wey the pictures them now? No long story, in fact I be dey rush for Nairaland site now say una don fullam with pics. Dis wan wey Oby say make we ask Viee no story. Ebos wan see am as she say she be fresh girl Hum fresh girl post am again. Viee wey your own pic. Me no dey happy now. Post am now and Carlosein wey your own. IMake una do quick quick ![]() |
I get people wey dey wait for me here. See una tomorrow, I dey go out now. ![]() |
Dem no wan post anything. Oby say him wan post her own and Viee say him dey work on it. I talk am say another 168 hrs go expire. Me I don tire for una self. Me come post my full pic for una ok o. Carlosein, I still dey wait for una pic. Oby post your own too. ![]() Viee which celebration u wan do now? Abi u wan marry? Answer. Again, abi lion dey ur profile? E be like say think we be Samson wey fit kill lion. Na him u dey talk say na best friend. What of if hunger come catch am. Wetin go happen? |
i don laugh die for this place!!Viee why u wan laugh die now? Abi u wan make tears full ground. No try dat joke again o. By the time I begin cry, Carlosein follow, Oby increase the gear and Lawyer begin roll - Haba, the angel dem go send you back to us immediately. Again, shey u and oby say my mouth fine. Ok, I be hear the same thing for CNN today. ![]() Oby and Viee wey una own pics? Ebos be post only him mouth but una own, even nose or eyes I no see. Carlosein wetin be ur own now? Which kind pic u wan post for us here? I dey wait the pics dem right now. Make e begin pour in for dis thread. ![]() |
OK, agreed - post one of your parts but let it be like mine. As for Carlosein, na only him remain now. I go post am to him. Then, I will know you all have seen ebos and I will be out from Nairaland for a while. That's the reason of making you guys know the person you have been discussing with for a long time and nothing more. It's proper doing what I have just done. ![]() I will post it to Carlosein when I'm alone with him in this thread - just the way I did when I was with Viee and Oby. ![]() Ok, till tomorrow ![]() |
I think I have shown my full self? You can post the mouth too. Abi, wetin go come happen? |
Ok, make una post una own because I'm showing my back for dis thread for a while. Post am now, just now. |
No b only fruit u b, but udalaUdala, another fruit? Oby, I go charge for u now. Na only mouth u see for that pic? You say Viee talk true. Na who come lie? ![]() |
what do you mean by chocolate? Abi fair well well o - don't mind d pic. It just show 70% of my colour. So, me dey tell lie and vie dey talk true? Na only mouth u be see?Again, make una no dey compare me with pawpaw. Wetin come happen? Abi fruit? ![]() |
so, na mouth I be post? You now know say Viee dey joke |
ok, see wetin I post - ![]() |
Oby, nothing to chop. Me just dey play around since dey wipe my capital. I wan just relax a bit. But, na today I just deposit another money. So, I dey wait from now to 7 working days for dem to credit it for me. However, dem come tell us say because of severe economic conditions experienced in USA, dem no go accept any new orders from now until the situation improves. Dem say the market dey too dangerous. So, we still dey wait when the market go improve couple my money wey dem go credit. Read ur news, dem say USA close Market today in honour of Martin Luther Jr Holiday. So, traders dey wait for now. Ok, I go post am now. ![]() |
Oby, wetin u mean by "until u came up by posting your mouth on the net?" I no post only my mouth now. Ask viee make she tell una the truth. Haba, so una still dey take viee joke so serious? Ok, me be save wetin I post before and I fit repeat am. Haba.I go see whether I fit print am out too - na 18 pages. Dat's na big money o. ![]() |
Viee still going thru the link u posted - it's quite interesting and will read it all thru. I love dat. ![]() Oby, wetin Igbo man do now? Shebi, una follow dey give them the impression say Igbos na wayo Haba, dat's not a good impression my sister. You check am now. Even, Viee don support say don mind am - dat's means Igbos na wayo. Me exclude myself for the wayo ![]() |
You made some good points. The fight era is gone - the people that despised Catholic are no longer here. Those in the thread now are all Catholics. Anyway, I can see one guy (debosky) I fought him during the war and he's here again. Don't just mind him


Where are the pics?