Franvincoop's Posts
Nairaland Forum › Franvincoop's Profile › Franvincoop's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 63 64 65 66 67 68 69 70 (of 70 pages)
Wetin I dey reason na wetin I fit tell this man make him sell me the mama of the dogs as e don born 12, make we run the mama pepper soup with Plantain take hold body for ARSLIV on Sunday. Ohhh what a day!!!!! |
Leicester City Chairman Iran President and FM Atleast 3 in the last 6 months in the USA Anything copter or anything wey get rotors, forget am na die you dey even if na brand new na still die you dey. Na why most of the people wey get private jets no get copter cuz deep down they know say na flying coffin santaclaws: |
Bros, dont pretend like u dont know her or have u 4gotten? na the same lady give Eve apple naw.... BABANGBALI: |
Mr. Man, all those American whatever you mentioned are made in China and shipped to the USA. I repeat all of them cars, iphones, whatever. Between China and USA na who di import from each other pass, go and verify as they say... OChimex: |
Na you go surely manufacture am? Where u go see AK47 for 250K buy? Even for 3 million for dis economy u no fit get am. Check am bros, if AK47 na 250K ehh you no for di see any bandits or herdsmen carrying dane guns like those ones Ribadu burnt. AK47 no di rust nor rotten, u fit bury am come back after 20 years dig am back then oil am, e go fire like brand new. Kalashnikov na forever gun finallybusy: |
50k kwa ![]() See 1 single AK 47 bullet na 27k, I mean just one bullet, na black market price I di give u so. When I mean black market, I mean the price wey uniform pple di sell to bandits/thieves. No ask me how I know, just knowsay I know pple wey don sell their own. If u hear shooting, just di count 27k by the number of gunshots. Na scam dey scam dis guy sef or he come buy cheap to go sell. 1 AK 47 na around 4 million naira black market price in Nigeria but the pple wey dem buy am pass na those Cameroon rebels wey dey fight their government. Dem dey buy 1 AK47 around 8 million naira and 1 bullet around 40k based on current cfa exchange rate. If dem put you in charge of armoury for any force for dis country, just know say u done rich be that. Everybody dey sell, soldiers, policemen, immigration, customs, ndlea, efcc, safety corps, I mean everybody. Fuckallmods: |
Just the devaluation alone na how many percent? Oya calculator, calculate tell us. Kobicove: |
U can be seeing 6 and I am seeing 9. Another man's terrorist is another man's freedom fighter. The greatest gift the enemy and occupation can give me is to assassinate me,”. “I prefer to die a martyr than die a meaningless death.” Yahya Sinwar [quote author=Righteousness2 post=132547662][/quote] |
Put those leaves inside 1L bottle and fill up with cheap whisky, crush bitter kola put inside, then add small 4-20 then close and keep in a dark place for 21 days. After 21 days or more open and take 1/4 glass every 10-30 minutes before u wan knack, u go thank me later. The name for this mixture na combine + dogoyaro. But if malaria try dey your body, your name na sweat but if you no get malaria, your name na knacking. |
Israel cannot claim the right of self-defense against a threat that emanates from a territory it occupies, from a territory that is under belligerent occupation. The fierce Hamas 7/10 attack was no more brutal than 75 years of denial of the right of return to Palestinian refugees, or 57 years of Israeli occupation, or the 17-year siege of the Gaza Strip. |
Na dis guy be that aboki wey dem mention for this story, if not how e a whole corps member go take wan derail this thread with "corpse" eventhough we knowsay na NYSC service im wan talk about. I don talk am say illiteracy is better, far better than half education. Regarding the topic, make we first find out if the girl na Christian or Muslim cuz dis wan wey aboki dey inside and the girl say dem pack her and her belongings give aboki, who here knows whether aboki don pay bride price? I don attend wedding/betrothal wey dem hand 8 years old girl to 67 years old man and everybody dey clap dey jolly dey happy. Thunder go fire anybody wey go ask me if I be dey happy for the wedding or not, dats Nigeria for you, take it or japa. No ask me go ask Lugard. SaoPaullo: |
I can design a biogas plant for your project, which will use all the wastewater from the cassava/garri process and the dung of the goats to generate gas on site which you can use for cooking and running a generator for electricity plus the same plant will provide you with quality fertiliser for your farming all year round. This will cost less than a million naira. adonainana: |
Yes, but CNG is a whole lot less risky than that gas cylinder in your kitchen right now and less flammable than it. I have been using it since 2017, no be today we dey use am. See CNG is lighter than air, if it leaks it will just evaporate above as air will disperse it immediately and the whole gas leak will disappear in an instant and secondly sparks cannot cause it to ignite it will need a full flame near it to ignite. LNG is the same gas which had been Liquified well below zero degree that is why your gas cylinder is always dead cold, if it leaks, it is heavier than air and will displace air to rise above it while it will pool on the ground roaming around for its(the gas)temperature to increase and make it lighter than air before it disperses, only God knows how long that will take if you are a chosen or not but you will be having a dangerous situation on your hand cuz if someone as much as flips on a switch, y'all burn in hell. Capiche? No offence meant and not wishing any bad thing to your family. professore: |
I will be making a thread here on nairaland about biogas and biogas plants very soon. I will let you know when I do. Emco1: |
We are not buying the gas but we are producing it ourselves and including the household biogas plant for sale. U can use poultry, pig, goat or even human excreta in your toilet and it will still produce biogas. We have a system that purifies and upgrades it to NG - Natural gas which is 90%+ Methane but because we don't compress it, we can't call it CNG. Love800: |
Methane burns cleaner than butane/propane mix with full beautiful blue flame. I am a specialist in gases - biogas, CBG, LNG, CNG, purification, upgrading, compression. The gas cookers you see here can run on both methane and butane/propane mix. uuzba:
|
It's natural gas, just note that it's not from petroleum refining. Can be from cracks in the ground or natural decaying waste. Have u ever heard about biogas which is obtainable from decaying waste or dung? If you purify and compress biogas, you get CNG. I am presently using purified biogas collected in gas bags for cooking and running my generator from cow dung and kitchen waste. With a quality compressor, I can compress it and put into gas cylinders for use in vehicles or cooking. This is CNG. FireUpNow: |
Ogbuefi Ozo Nnamani |
Na PACT act dem di chop? For dis economy, just go anywhere near where dem dey cook dog, go yarn abt dat your PACT act stuffs, if dem no nack you 2by2 change my name. Omoawoke: |
Fake story... Ogun go kill ur popsy and mumcy join if u quote me. I no see the blender nor the blended remains but una wan make I believe wetin I no see? No b juju be that? OP, the blender na which brand, moulinex, beko or aba made? |
Freeboys dey cry "ebi mpa wa oh" unto tinubulation and skyrocketing cost of all foodstuffs for outside meanwhile for backyard dem dey jejely increase budget/rations for prisoners. Do u gerrit? Do u get where dem want u to be? Are you where they want u to be? I don know abt u but we di buy fuel 97 naira per litre, no be mistake, I mean 97 naira not 970 naira. I hope say u read am well "N750 was allocated per day for each prisoner, while N800 was spent daily on feeding each of the 900 dogs". |
Walking of course, but dem never yet chop phorget: |
"Oh my dealer, oh my dealer, oh my dealer I wan enter Canada, oh my dealer, oh my dealer give me visa I wan enter Canasa" |
God bless you sir. Is it possible for me to buy the seeds of this Cameroon pepper for planting? okoroemeka: |
Can you also prove in court that he does not smoke, sniff or inject? bro4u: |
Na who dey count? |
Yahoo+ don cashout Carry odds of over 2.5 lives, flexing...ballin...Highness.. boom auto crash....miraculously survived..... This format b don cast, but e dey gradually come back. |
Abeg somebody fit help remind me again how many B dem spend for renovate dis guy VP residence ? |
No capping, me only get 117 names wey I dey use collect salary every month and we 30 dey share am unto percentage. I know colleagues wey dey run thousand salary monthly. Wetin concern me with anti corruption when ma turn don reach. Na now u know say Nigeria na company? I no send ur papa. We dey b4 tinubu and go exist after tinubu, any oda thing na smelly sperm dey hungry u. |
Nigerians sabi celebrate mediocrity. Just like dem hail Tinubu enter power and Nigerians deserve their leaders. B4 u quote me, abeg answer these questions with ur phallus..... if not na amadioha+ogun go kill ur papa and ur children join. Who the hell is Jay Jay Okocha? Na statistics or dribbling we go chop? How many trophy him get? How many epl? FA cup or Carling cup? How many champions league medal + matches? Uefa cup? 4get afcon cuz na for Lagos Cameroon carry cup, how many afcon final him play? If u use these statistics wey we no go chop, u go see say the following persons pass J.j okocha Victor Boniface Victor Osimhen Taribo West Victor Ikpeba Finidi Papilo Kan u believe it Nwankwo J.O Mikel D Drogba Yaya toure Mahrez S. Mane M. Salah Mboma Patrick Rigobert Song Ahmed Hassan Hassan Hassan Albouterika Bwalya Hadji T. Nkono Milla S. Etoo G. Weah |
3 Nigerians, abeg OP no spoil Cameroonians their name. Na 3 Nigerians with Cameroonian identity, na em be say dem don first buy Cameroon passport travel go Uganda wan buy Ugandan passport but yawa come gas, so dem claim Cameroonian to get better treatment than the damn Nigerians wey full their jail. Na seasoned traveller dey inform you so, most Cameroonians abroad are Nigerians low key, person wey e minimum wage fit buy 2 bags of rice + change + 24 hours light + no generator + State owned refinery + cheap fuel, wetin dem dey take Kampala do? Uganda a landlocked country meanwhile Cameroon Douala port dey work 5B dolls per day cuz even CAR + Chad no get seaport na Douala port dem dey use. If u doubt me, call NCAN, dem go confirm say those names no be Cameroon names. Na SS guys dem be at worst na SE guys. |

