Joyakosa's Posts
Nairaland Forum › Joyakosa's Profile › Joyakosa's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 9 10 (of 10 pages)
Music star Davido dey real embrace fatherhood fully although him be only 25. The father of two share snapchat foto of himself dey feed em second pikin for U.S. The singer wey get eventful week, base on em new single Fall and em fly go Jamaica, through Atlanta for music video shoot with dancehall heavyweight Popcaan. Daddy Davido dey impress the neutrals! source: http://www.joyakosacorner.com/daddy-duty-davido-feed-em-weeks-old-daughter
|
News cum to us from the office of the publicity secretary of late Moji Olaiya burial committee,the matter no only dey shocking but he dey very disturbing base on the good life wey late moji olaiya live. According to Yomi Fabiyi, some top actors try their best to sabotage the burial ceremony of Moji Olaiya as dey call for sudden meeting of all actors and also dem cum make am very mandatory & dem know fully well say the final burial rites dey hold yesterday. the angry Fabiyi go on top him social media pages say em dey shock, say some top actors and executives of the industry fit try to sabotage their efforts as dem call for all actors to report for one impromptu meeting. The actor cum yarn say although dey try, but dem fail woefully because the burial dey successful. source:http://www.joyakosacorner.com/shocking-see-how-top-actor-try-to-scatter-moji-olaiya-burial
|
Award winning Nollywood actress and real estate dealer, Chika Ike na one of a kind diva wey dey always look smashing whenever she dey go occasion or not. The beautiful Nollywood successful actress go on top her Instagram handle to share one breathtaking foto of herself & she cum look like angel.no doubt she get beauty to behold. source:http://www.joyakosacorner.com/chika-ike-slay-for-new-foto
|
One Zimbabwean man loose em wife after she take am pay for football bet. Charles Jambaya, 26, take em 22 years old wife Caroline Shumba take pledge to another man ontop UEFA Champions League final between Real Madrid and Juventus. Jambaya take mouth make agreement with 30 years old Eugene Gumbo say if Juventus lose e go give am em wife, and Gumbo take $500 take bet for Madrid. Real Madrid kon defeat Juventus 4-1 and Eugene kon request for em prize wey be Jambaya’s wife. The wife wey no know wetin dey happen, dey very surprise when Eugene tell am say sho go need follow am because em don win her from bet. She no gree follow Eugene, as she go stay with her aunt, wey kon carry the matter go one traditional court. Jambaya tell the Chiefs wey dey the Traditional Court say em no dey for em sense when em dey make that pledge sey make dem forgive am. Dem kon fine the two men with animal each. source : http://www.joyakosacorner.com/man-take-em-22-years-old-wife-bet-uefa-champions-league
|
Nollywood actress, Kate Henshaw na definitely one of the top actress wey we love and she share this lovely foto of herself as she dey rock her natural hair. The delectable actress also go on as she caption to share this powerful motivational message. See wetin she write: Start your week with 110% positivity!!Purpose to try and smile.. Purpose to look ahead with a heart of gratitude… It is not a mistake you are still here!! Forge ahead… Refuse to take prisoners!! Shut down naysayers before their words take root in the soil of your heart!!! IT IS NOT OVER TILL BABA GOD SAYS IT IS!! HE IS NEVER LATE BUT ALWAYS ON TIME!! Lots of love to all my fans/followers/friends.. Your support and words of encouragement mean a lot… source visit: http://www.joyakosacorner.com/actress-kate-henshaw-show-off-her-stylish-natural-hair-with-motivational-message
|
Finally the remain of our peaceful Nollywood actress wey be Moji Olaiya don finally go rest amidst tears and anguish. The mother of two dey survive by her two parents, two daughters and her loving friends. Moji die for Canada from child birth complications wey lead to heart attack on May 17 in Canada. Her first daughter wey be Adunola na 18 years and her new born na just two months old. May Her soul rest in peace. [b]source visit:[/b]http://www.joyakosacorner.com/see-foto-of-late-actress-moji-olaiya-as-she-finally-rest
|
kot Udobia village wey dey Etinan Local Government Area of Akwa Ibom State don plan to immortalize one 90 years old virgin, Miss Agnes Udofia. Report talk say Udofia through out her live dey care for other people pikin. Na over 50 men, women and children gather round her on Monday to give thanks to God sey he preserve life of the woman wey dem think say na their mama. One businessman, Mr. Fabian Udoh, wey Udofia train, talk say em dey happy to come the village kon honour Udofia. He talk say since em dey small, he never see any man with Udofia. And say she dey always raise other people pikin. He say, “She has touched the lives of over 50 children. I have always known her not to have any relationship with any man. “We are proposing a foundation to immortalise her. We all came home today to celebrate her now that she is alive. It will make no meaning celebrating her after death. She gave most of us life and we must celebrate her when she is alive,” Apart from thanksgiving service and reception wey people wey grow up for Udofia hand organize, St. Pius Catholic Church, Ikot Udobia, also organise another thanksgiving programme for her. As Udofia take talk, she say she never marry before and she never follow any man sleep. She say, “I was born partially blind and so, no man saw anything good in me. So, I grew up without a man. I have never slept with any man as far as my memory can carry me, not even in my dream.” Udofia talk say she belief say God no create am make she get husband, pikin and anything wey she fit call her own. She say she see things around her as normal. She say, “I live my life the way you see me. No feeling for a man. I don’t see it as abnormal.” Udofia, talk say she enjoy to dey take care of children and she no get her own business at all. She say the children wey she train, their mama dey always drop them with her if dem dey go farm, market or stream. “I would take care of them until they returned to take their children. I feed them and keep them happy as long as they stay with me,” source: http://www.joyakosacorner.com/akwa-ibom-community-plan-to-immortalise-90-years-old-virgin
|
Officers from Ariaria Police Division for Aba, Abia state, don arrest one Christopher Tochukwu, ontop sey he get baby factory for No. 252 Faulks Road, Aba. Tochukwu wey claim wey talk say em be pastor for one new generation Pentecostal church, turn one-storey building wey em dey use as Church and medical centre for pregnant girls wey em kidnap. As report take yarn, one police source yarn say detectives rescue three pregnant girls with one girl wey dem don sell her pikin to unknown person. Dem also arrest Tochukwu, wey be the pastor, and the person wey dey operate the clinic, dem also rescue one two weeks old baby wey dem carry go motherless babies’ home for care and custody. One of the girls wey narrate wetin she don go through, Imeabo Udo talk say na one young man wey promise to help am take care of her pikin, na em carry her go the clinic, she say but when se reach there dem coleect her two years old boy from am as dem sell am to one woman. Jane Ikechukwu, Blessing and Gift, their tory also na the samething, na person carry dem go the clinic for antenatal care but dem kon force dem make dem stay the clinic back for extra one month. As Blessing take talk, she say Tochukwu rape them one after another, as dem lock dem for different room for inside the clinic. She say, “The pastor was coming to rape us one after the other. It was while he was raping one of us, that the girl fought him and wounded him with a broken glass. It was the girl that escaped through the window and alerted the Police.” Tochukwu wey talk say em train as nurse, deny say em rape the girls. He talk say em no get any arrangement to sell their pikin, sey em just dey keep them so dem go fit pay their bill after em don treat them. The State Commissioner of Police, Mr. Adeleye Oyebade, confirm the matter say investigation dey go on. source visit: http://www.joyakosacorner.com/police-arrest-pastor-wey-dey-run-baby-factory |
Nigerian transvestite and bleaching expert wey be Bobrisky sometime last month go on top him social media to slam celebrity stylist and serial entrepreneur wey be Toyin Lawani after she use style Attack am. Toyin Lawani and Bobrisky attend burial party together and after the event, Toyin go on top Instagram to laugh about how filters dey cover up for some people, she see one person for real life. Bobrisky clapped back but Toyin no gree respond. Earlier today dem arrest Toyin Lawani’s baby-daddy wey be Lord Trigg, base on unpaid hotel bills for Lagos. Bobrisky no waste time to throw shade on top the matter and laugh about am via him Snapchat app. source visit: http://www.joyakosacorner.com/bobrisky-attack-toyin-lawani-after-dem-arrest-her-baby-daddy-over-unpaid-hotel-bills-alleged-fraud
|
Nigerian singer, Dammy Krane wey dem arrest 3 days ago for grand theft allegations, credit card fraud, identity theft and the owl issue lead to him detention for police station, after then we see plenty tweets emerging from him official Twitter account. See Wetin one of the tweet Yarn: ‘This one, that one, rumor…One time for my fans, new material coming, I go talk everything. God got, help me say amin o!’new material coming’ Today, rapper CDQ go on top him social media to react over the arrest and tweet. Him cum later delete the posts, but him don forget say people share as screen short don take over. source visit: http://www.joyakosacorner.com/cdq-use-dammy-krane-do-yeyejest-base-on-him-arrest-for-credit-card-fraud-for-miami
|
Some suspected robbers don stab one bank agent, Ayodele Awodiran, to death for Lambe Junction, Alausa village, wey dey Ifo Local Government Area of Ogun State. Na eight men attack the 38 years old graduate of Economics from University of Ado-Ekiti, Ekiti State, when he dey come back from work around 10pm on Sunday. Dem collect two POS terminals, one accounting record book, recharge cards wey worth N40,000, and cash of N200,000, with ATM card for em hand. When he identify one of the robbers as em neighbour dem kon stab am with screw driver and knife as dem leave am make he die. Dem rush the father of three to one private hospital but dem reject am for there before dem kon admit am for General hospital, Ifako where he kon die. One family friend, talk say dem still dey mourn em dead when alert of N2.1m enter as dem dey comot the money for em account. He say, “AY had POS terminals in his shop. Whenever people needed cash, they went to him with their ATM cards. He gave them the cash after charging a token like N100 or N200. He also sold recharge cards and he had some people working for him. “He was going home on Sunday, May 14, when the okada (motorcycle) he was taking home was waylaid by armed robbers. The assailants, numbering eight, collected money from him. He also released his ATM card PIN code to them as well; but they still killed him. “Two days after he died, the family received alerts of N2m on his phone.” DEm inform em bank management and dem also report the matter to policemen for Ajuwon division. Police operatives investigate the withdraw wey kon lead dem to arrest nine people wey dey include the chairman of okada riders association for the area. The suspects confess to the crime and dem talk say dem no wan kill am but na because em identify one of them. Dem also talk say dem don dey monitor am for sometime. The okada ma wey carry am that day also na part of the plan so e go fit dey easy for them to carry out their operation. As tori take talk, na Ayodele neighbour wey be part of the gang suggest make he take the okada man wey Ayodele too kon agree as he no know sey na set up. The okada man kon carry am pass where the men dey wait for am. Bosede wey be Ayodele wife just born their third pikin as she talk say their marriage sef never reach five years when dem kill her husband. She say, “I was with him on that day. He asked me to leave with the kids around 9pm so I could prepare food for him. When I got home, I called his line, but he did not pick the call. I guess it was around that time that those people held him hostage before killing him. I want justice to be done. My husband must not die in vain.” The Ogun State Police Public Relations Officer, Abimbola Oyeyemi, confirm the matter say investigation stil dey go on ontop the matter. source: http://www.joyakosacorner.com/robbers-kill-bank-agents-collect-two-pos-withdraw-n2m-for-em-account#
|
Seriously to Buy fuel from Black Market traders No dey legal but currently the governor of Ekiti state, Ayodele Fayose dey spotted when him dey buy from Okada riders wey dey hawk gas for the state capital. The foto cum out through the special adviserPublic Communications and New Media to Ekiti State Government, Lere Olayinka on social media. Do you think the governor made the right call? source: http://www.joyakosacorner.com/ekiti-governor-buy-fuel-from-black-market
|
Top blogger wey be Linda Ikeji share new selfie post wey dey shock every body online,she be 37 years old blogger. Linda wey recently becum lover of selfie foto share new foto of herself for ontop her Instagram page and she end up to shock over 1.2million followers with her outstanding beauty. even Laura Ikeji wey be Linda sister dey shock when she see the foto, she no waste time at all as she sharperly repost the foto. Linda dey always yarn say“success is sexy” and she look sexy for these foto abi no be so? she be one successful lady. source: http://www.joyakosacorner.com/linda-ikeji-shock-the-internet-with-her-new-look-foto
|
Because of the high rate of violence against women for Argentina, more than 100 women don waka go street naked to protest vehemently against the mata wey dey happen. The women carry out one unusual screaming protest for the front of the president palace for President Mauricio Macri’s residence. Dem no even mind anybody wey dey look dem for Buenos Aires, the women remove their clothes, dem cum form pile of bodies and dem cum scream angrily en masse. The protest dey organise by Artistic Force of Communicative Shock (FACC) as part of a ‘Femicide is Genocide’ protest against gender-based violence. This one na just the begging of wetin go happen for the next march of the feminist collective NiUnaMenos (Not One Fewer) wey go take placr on Saturday. visit for more: http://www.joyakosacorner.com/see-more-than-100-women-go-naked-to-protest-against-women-violation
|
Nollywood actress Moji Olaiya wey die last month,her burial go take place for Ikoyi cemetery immidately her body arrive to Nigeria. Yomi Fabiyi wey dey in charge of the burial arrangement for the late actress make the announcement for Instagram. Him write, It is CONFIRMED that the remain of the Late thespian Moji Olaiya upon arrival from Canada will be buried at EBONY VAULT at Ikoyi Cemetery, Lagos. The immigration procedure for the return of the body and child to Nigeria is at an advance stage, all documents secured and we shall loose no time to give exact details as soon as we have a green light from Canada. We appreciate your understanding and patience so far. T-SHIRT to wear on the day of the burial is now available for N1,500( get yours asap as limited copies are available)To get yours, pls call Taiwo Banky on 0803 474 0982) or Shade Oliwo on 0802 319 8754) or attend her house for purchase yours. (You can also get yours on the day of the Memorial and Artiste Night when announced). The family appreciate the media, friends, colleagues and fans for their continued love and patience so far. Kind regards. Yomi Fabiyi Publicity Secretary For: Burial Committee for LMO visit here:http://www.joyakosacorner.com/moji-olaiya-burial-go-take-place-for-ikoyi
|
Police don arrest three suspected members of the gang wey organise the kidnap of 6 pupils from Lagos State Model College, Igbonla wey dey for Epe. Operatives of the Inspector-General of Police Intelligence Response Team for Benin, Edo State, arrest the suspects as dem dey act on intelligence report. Suspects names na Endurance Egelu, aka Jubby, 25; Stanley Irabomini, aka Powei, 25; and 24-year-old Endurance Bentel. Egelu dey hail from Abere town for Ovia South Local Government Area, Edo State, Irabomini and Bentel na natives of Ovia South LGA of the state. On how dem take catch dem on Tuesday, operatives of IRT wey ACP Abba Kyari lead, trail the three suspected militants to where dem dey relax for Benin, Edo State, around 4pm. Source yarn sey the gang so, go visit one of their members wey dey for hospital wey get gunshot injury after security agents attack dem on Friday for Lagos. The source say, “Some arrests have been made. Specifically, three of the gang members have been arrested. Some of them got injured in the Friday gun battle. One of the injured was taken to Benin for treatment. The three suspects came out from the creek to visit him in Benin. The IRT team struck immediately and arrested them. “They have already confessed to the kidnapping of the six pupils and they are cooperating with us. There is serious effort to rescue the children and arrest other members of the gang.” Another officer yarn say, “They (the suspects) also confessed to have participated in the kidnappings of prominent personalities in Lagos and Ogun states, including the Oniba of Iba and pupils and staff members of the Nigerian Turkish International Colleges, Isheri. They said they came to Benin to see their injured colleague and relax for a while before going back to the creek,” Meanwhile, House of Representatives on Wednesday don tell Inspector-General of Police, Mr. Ibrahim Idris, make he try rescue the pupils wey dem kidnap. Member of the House wey dey represent Epe Constituency, Mr. Tasir Olawale-Raji, don call for urgent action from the police as he dey yarn about kidnapping for riverine communities for Lagos State don dey too much and dem need stop am. Read part of the motion wey dem pass to the House here, “The House also notes that the school was earlier attacked by kidnappers on Thursday, October 6, 2016, resulting in the kidnapping of four pupils who were later released after spending some days in captivity. “It further notes that the riverine communities of Ishawo in Ikorodu, Igbodu in Epe, Ebute Lekki in Ibeju Lekki and Ise in Epe have come under siege lately following the incidents of April 1, 2017, where Mr. Ademola Salami was kidnapped in Ise town and was not released until May 5, 2017, after negotiation between the kidnappers and the family. “Also, on May 19, 2017, the Baale of Ebute Lekki, Alhaji Salina Kareem, was abducted from his village and has yet to be released. “Cognisance that if this spate of kidnapping is not arrested, it may pose a threat to the ongoing investments worth billions of dollars in the Lekki Free Trade Zone, which include the first indigenous private refinery in Nigeria and the Lekki Deep Sea Port, among others.” House acknowledge efforts of the joint security team wey federal and Lagos State governments put to take tackle insecurity for the state, but dem also call sey make dem review security strategies to take avert any future occurrence. for more visit: www.joyakosacorner.com
|
After the fight wey happen On Tuesday between navy and police for Calabar, another tori on Wednesday dey indicate sey some naval operatives use one General Purpose Machine Gun (GPMG) to take bring down one part of Akim Police Barracks wey dey for Cross River wey be the State capital. The whole katakata start on Tuesday when one policeman go shoot one unidentified naval rating ontop traffic offence. The matter still kon rise again after navy personnel go burn Akim Police Station, wey dey along IBB Way, as dem set to police motor on fire. Dem shoot two policemen, Sergeant Odudu and Corporal Emmanuel Mbang, at close range, as dem shoot third policeman, Ibiam, for em left eye. Person wey dey near there when the naval go attack the police station yarn how e take happen. He say, “The navy operatives came out from the gutter and started shooting at a very close range, while a GPMP mounted far Away started firing at the station. Those that shot the policemen came out from the gutter. “They accessed the police station through the underground water drainage channels. The policemen that died were shot at close range by naval personnel that emerged from the gutter. They were running out for safety thinking that the naval men were far away.” Meanwhile, Governor Ben Ayade talk say the whole katakata don end and peace don dey. He say, “I just met with all the service commanders on the incident that happened on Tuesday. The whole area is calm after the unfortunate incident that arouse from the misunderstanding between a policeman and a naval rating.” The governor talk say senior officers for both police and navy dey very fast to intervene to the matter. He say the state don dey calm now and peaceful and dem don dey ready to receive Acting President, Prof. Yemi Osinbajo, wey suppose visit the state today. for more visit: www.joyakosacorner.com
|
popular Hollywood Actor Wey We Know As Jimmy Fox Real name na Eric Marlon Bishop (born December 13, 1967), we all know am professionally by him stage name Jamie Foxx, na American actor, singer, songwriter, record producer and comedian. He win Academy Award for Best Actor, BAFTA Award for Best Actor for Leading Role, and Golden Globe Award for Best Actor for Musical or Comedy, for him portrayal of Ray Charles for 2004 biographical film Ray. That same year, dem nominate am for Academy Award for Best Supporting Actor for him role for crime film Collateral. Image result for jamie foxx real name I many people know am as Jimmy foxx but na him stage name be that. for more visit:www.joyakosacorner.com
|
Ever since Olajumoke Orisaguna don become super star , she dey always stay on top of her game The former breadseller wey turn model don dey her new project wey she title Olajumoke’s sauce wey dem go unveil by Cruise n chillz for no distant time. he go be one of their biggest boat party ever with plenty chop chop and drink. The model wey take some foto shoot dey rock the same very hairstyle of popular and award winning singer , wey be Yemi Akade and we also know as Mama Africa. If you look the model from far you go think say she be Yemi Alade because of the unique hairstyle give her similar look with yemi alade. Some days back she share some foto of her self wey be behind the scene we know get am for mind say she dey plan to shock us with her new similar look to yemi alade hairstyle. Check Out the Foto Here: check out more pikin news: www.joyakosacorner.com
|
Agbero on Tuesday night invade Imo State automobile market wey dey for Aba – Owerri road for Owerri, as dem steal kon spoil some goods wey dey enter price of N10m. This one happen when the motor dealers dey get issue with officers of 211 regiment group of Nigeria Airforce base, Owerri, as dem take block the road to take protest. When dem dey yarn newsmen before dem start te whole gbege, the Chairman, Board of Trustees, Imo State automobile market, Mr. Rufus Osueke, talk say dem just enter market for morning only for dem to kon see sey dem don vandalize all their goods. Osueke talk say em no wan talk say Agents of the state Government get hand for the matter. for more visit: www.joyakosacorner.com
|
Serious tension dey for Owode Street and the environs for Oshodi ontop sey attack fit happen anytime after after dem kill one prominent member of National Union of Road Transport Workers (NURTW) Rasaq Bello, wey dem dey call Hamburger, for Shogunle Lagos when dem dey do local council primaries of All Progressives Congress (APC). Hamburger na Lagos State Treasurer of Tricycle Operators, wey be branch of NURTW. As the tori take be, na some gang members wey their leader na Samson Agbetoye, wey dem dey call Golden, na dem shoot Bello on Monday wey em kon die. As witness take talk, the trouble start after the dem cancel the primary for Shogunle ward, wey dem do for the town hall wey dey the area ontop how dem dey conduct the exercise. After the cancellation, Hamburger with em group kon enter Golden base for Ago Owu street. Both of the gangs kon start to dey shoot demselves, na when bullet hit Hamburger na em dem carry am comot for there. Report even gather say most of the people for the area don leave the place ontop say dem dey fear sey Hamburger people go come back kon attack.. FOR MORE VISIT: www.joyakosacorner.com
|
Popular Nigerian transvestite and bleaching expert, Idris Okuneye wey we know as Bobrisky dey definitely have swell time out there for United States since when him land . The controversial Bobrisky waka cummont with se’xy mesh top for pool party with him friends and he be like say him dey very excited about the mata. for more visit: www.joyakosacorner.com
|
Na one kain gbege happen on Monday after one foreman and one five-year-old girl die for the three-storeyed building wey collapse for one Daddy Alaja Street, Oke Arin, Idumota, Lagos Island when dem dey renovate am. The gbege happen around 7 o’clock for morning and na like fourteen people get serious injury from the incident. As report take yarn, the landlord don tell people sey make dem comot for the building when dem wan renovate am. He carry the job give contractor, but the contractor tell am make he collapse the building because e don worst pass renovation, but the landlord no gree sey na renovation em want. Some of the tenants no gree comot for the house and some of the people wey dey work for the house sef kon start to dey live for there. Officials of Lagos State Emergency Management Agency, Lagos State Building Control Agency, Lagos State Fire Service, Lagos State Ambulance Service, National Emergency Management Agency, Nigeria Security and Civil Defence Corps, and the police don respond for the incident so. One man wey dey stay around there wey help rescue some of the victims yarn as e take happen. He say, “Around past 7am, we heard a loud noise and we all ran to safety. We later discovered that it was a building that collapsed. “We brought out 10 people from the rubble, but two died. Those that died were the man in charge of the bricklayers (foreman), who we call Baba Ibeji. “The second was a five-year-old girl, Farida. She had gone to the toilet when the pillars fell on her and she could not wriggle her way out. Her father, mother, elder brother and the family’s housemaid, were rescued with some injuries.” One Deejay, talk say em lost em equipment wey dey worth N3million for the collapse so. He talk say the owner of the house no dey collect house rent from dem for about six years now, sey the landlord no even know if anybody dey stay for the house or not. The Acting General Manager of LASBCA, Oyewale Joseph, talk say dem go prosecute the landlord and the contractor with the site engineer ontop the incident so. He talk say the agency don seal off the building like two times before but na everytime the contractor dey comot the seal to take work for the building. He say, “Preliminary investigation shows that the site is in a swampy place. It was a former refuse dump and the building had been sealed twice. First was last year and sometime this year. We also chased the occupants out last week when we got information that people were staying there. “But unfortunately, we learnt that the developer made use of the weekend and the Democracy Day to renovate the structure. There is no document to show they had any permission before this ugly incident happened. We were able to remove 14 people from the rubble.” The LASEMA General Manager, Mr. Adesina Tiamiyu, talk say na like 14 people get serious injury and dem don treat dem and the two people wey die, dem don carry their dead body give their family make dem go bury them. for more visit: www.joyakosacorner.com
|
Nigerian Transvestite wey be Bobrisky dey United State of American presently and he be like say him dey get amazing time for there. Him go him Snapchat to share him adventurous life out there as him go clubbing and some guys spray am with lots of dollars. Bobrisky also show off the person wey spray am the dollars and him also share another with some wey him dey move with for U.,him yarn say dem be currect guys. see foto: for more visit: www.joyakosacorner.com
|
Olabisi Onabanjo University, National Association of Science Students, NASS president, Comrade Adefuwa Christopher don die inside accident wey happen for Ile-Ife road, Osun State on Sunday. He die inside the accident wey happen when em with 21 others dey go school back from the excursion to Idanre Hills wey dey Akure, Ondo State. As how the accident take happen, na one trailer go hit their bus. Na only Adefuwa die as others get serious injury. for more visit: www.joyakosacorner.com
|
Debbie Rise fit no be the person wey win the 25million Naira prize money of the Big Brother Naija show, but the artiste dey definitely enjoy the fame of the after-show. No be new thing, Debbie Rise fight the battle with thirteen other contestants for South Africa and walk out as one of the top five. Surprisingly,people get to dey enjoy her style after the very popular show. Believe it or not, Debbie don dey sharperly become celebrity. Even popular rapper Ice Prince confess say Debbie Rise na him type of girl. One other thing wey we don notice for her modesty na, she cover up all the yori yori parts of her body as she once yarn say no amount of money go make her expose her body. source/for more pigin news visit: www.joyakosacorner.com see foto:
|
Like one year ago, when singer Davido get small clash with the uncle of him baby mama Chief Dele Momodu, him openly disrespect am and even drag the man for him lyrics, but, Banky W wey dey oldder dan davido don show say no be all entertainers dey born with the same age with Davido. Banky W just let himself to beloved by many more fans and music lovers after the Foto of him prostrating to greet Chief Dele Momodu show up online. He no end their oh because many fans dey call on the attention of davido base on him lyrics ans adesua no lie when she yarn say she find good man inside banky w,he be like say banky suppose add humble for him name now. for more pigin news visit : www.joyakosacorner.com
|
Parents of the six pupils of Lagos State Model College, Igbonla, wey dem kidnap don yarn about the way state government dey handle the case. The parents go do meeting with the school after dem kidnappers tell dem make dem pay N1bn as ransom. After the meeting the representatives of the school school say dem go help the parent follow government talk about the matter. Security operatives also don extend their rescue operation to watersides for Ogun and Ondo states, wey dey share border with the school and other places around there. As we take report last week, Gunmen enter the school around 6am on Thursday kon kidnap 10 pupils. After dem ask the pupils questions about their parent dem release 4 out of them kon kidnap six wey their names na Peter Jonah, Isiaq Rahmon, Adebayo George, Judah Agbausi, Pelumi Philips and Farouq Yusuf. The kidnappers call some parents of the victims on Saturday, dey demand for N400m each from two parents, as dem tell two others make dem pay N100m each. Dem tell the parents make dem meet with the school authorities and the state government to take pay the ransom money. But parent don yarn sey Government never yarn anything about the matter so. One parent wey talk yarn say, “The government is not talking to us and it is frustrating. Six children were abducted and it is now four days, but nobody is saying anything. They are busy celebrating Lagos at 50. “To our annoyance, the school authorities sent two vice principals to the meeting. There was no government representative. In fact, we were at the venue of the meeting for more than one hour before they arrived. We had to call them on the telephones. “Two parents called the permanent secretary in the Ministry of Education, asking if there was any development today (Sunday), he said they should go and ask the police. If it were to be in a civilised country, is he not supposed to be in a situation room getting minute-by-minute feedback from the police? “The school representatives called an official on the telephone to come for the meeting, she said she was in another meeting and couldn’t come. We are to meet again on Monday (today).” Meanwhile, security source wey yarn ontop the search wey dem dey search for the pupils yarn sey the kidnappers fit don relocate them because of the gbege on Friday. The security source say, “There were confrontations with the militants on Friday and some of them were killed. We are working on where they keep the children. We are closing in on them. Operatives are combing waterways along the Ikorodu-Epe and other riverine communities in Ogun.” Another officer wey yarn about the matter talk say dem don extend the search to Ibeju-Lekki. “Ibeju-Lekki also shares boundaries with Ogun and Ondo states. We are searching creeks in those borders too in collaboration with Ogun and Ondo states commands,” The spokesperson for Ogun State Police Command, ASP Abimbola Oyeyemi, said, “The police are one. When something happens in one command, every other command has to make sure that the hoodlums are fished out and the victims rescued.” The state Commissioner for Information and Strategy, Steve Ayorinde, talk say government dey work towards the release of the pupils. He say, “The governor is working with security operatives to rescue the pupils. It’s a security matter that may not be open as the parents may want. The governor and the state feel their pain. All hands are deck to secure their release and bring the perpetrators of evil to justice.” for more Pigin News visit: www.joyakosacorner.com
|
The ongoing ruged concert dey filled with exciting moment wey person no fit forget as many guest artists take over the stage to wow the crowd. The concert wey dem do for Afrikan Shrine get the performance of many musical artists and performers like African China, Skibii, Xbusta,Yesmyro, Ninola, kinminjin, Kelyhandsome,Lordofa,Jasa, and others. The crowd dey enjoy their self as dem dey get good time and dey feel entertain,na rapper Rugged man na him organize the show. Visit:www.joyakosacorner.com
|
Media personality and fashionista, Toke Makinwa dey give us inspirational tip today. She stroll go her IG and share tori on how she lost sponsorships due to bad press. She yarn how dem take remove plug of N20 million deal when the news of her marital woes kasala burst through media. Secondly, she yarn how one sponsor backed out from her book tour due to the news of her ex husband intentions to sue her. She cum yarn about the above examples to encourage her fans to look past every rejections them fit dey face now and to continue dey pressing on. Read wettin she penned down here: When God is involved, it can never be for less. In my life I have seen him come thru so many times I’ll be selfish if I keep it to myself. I remember when we started the OnBecoming tour, we approached a number of companies for sponsorship and one particular incident left me sooo broken. We had been talking back and forth and all was looking exciting till the news of the legal suit hit the press. I remember I was in Ghana and the night before OnBecominginGhana was amazing. I woke up in such high spirit till the news filtered the air and then I got that call, our “potential” had pulled out. I read that text over and over again in tears, they pulled out because they didn’t want to be thrown in the middle of it all (who can blame them) boy was I hurt, I was broken. I had put so much into this project and prayed so hard yet here I was disappointed, I felt I wasn’t good enough, I couldn’t pray and then it hit me, this has happened before, I remember when the news of my marriage hit the press I was in the middle of signing a 20million Naira deal, all was good to go till news broke and it seemed like what everyone was talking about. They pulled out. It was bad timing.I remember how I held the toilet bowl all night, I have never felt that kind of pain in my life. I have worked hard, prayed hard and God knows I needed that money. My life had changed overnight, I was trying to hold on to everything and it seemed like everything was working against me but God came thru, he provided much more than that deal and I have never had to look back to think “if only” I had that money, he kept blessing me. In both cases God over compensated me. SA is looking really good , I can’t wait to share who our sponsor for the OnBecominginSA is, they are not just flying me to SA, my entire team is coming to and everything is paid for in full. Why do I share this you may ask? Perhaps you woke up this morning feeling defeated, you are about to stop trying, you’re so sure your idea sucks and no one will support you, hold on. You are closer than you know,. God has bigger and better plans for you, he knows you’ve cried all night, he knows what this means to you, he will come thru even better. for more visit: www.joyakosacorner.com
|
we know expect late moji olaiya death to cause big waala and kwatan like these. But from the look of things actors don already dey turn against actors following the death of the 42 year old actress. The news of say the late actress moji olaiya burial go take place for abroad just to cut cost don really touch a lot of people,But as her first daughter aduni take beg say make dem bring the body of her mama cum back naija don give the actress and actors no choice than to task each other. omo as all these celeb dey take showcase their flamboyant face of been wealthy for there events,none of dem fit keep up to the tax wey be’ sum of 100K tax. While actress/politician Funke Adesiyan cum out ontop Instagram to call out some suppose actress wey dey flaunt there wealth wey dem no get, another actor wey be the executive of the burial committee tweet say na only five out of the 102 listed pay the money. for more visit: www.joyakosacorner.com
|
Katsina State Police Command don dey search for three-man gang, wey abduct one year old baby from her mama, Suwaiba Ahmadu, kon gang rape her for Danja Local Government Area of the state. As report take talk, Suwaiba dey come back from Angwan Bawa area for Danja LGA, when the suspects attack her. This matter so happen on Sunday, when two members of the gang meet the mother of the pikin for one lonely road kon deceive am make dem carry am ontop okada go where she dey go. When the suspect reach one junction, one of them kon grab the pikin for the mama back kon run enter one bush wey dey there before the third suspect sef kon join them. The three of rape the pikin turn by turn. The Katsina State Police Public Relations Officer, DSP Isha Gambo, confirm the matter, say the police don arrrest one of the gang members as the remaining two don run. He say, “At a point along the bush path, the baby, who was strapped to the back of the mother, was forcefully taken from the mother by two members of the gang. They ran inside the bush with the baby, where another member was waiting for them. The trio thereafter gang-raped the baby. “One of the gang members, Saleh Suleiman, is already in the police net while the other two, whose names we cannot disclose yet, are still on the run.” The police spokesman talk say the pikin papa, Jibril Ahmadu, na em report the matter to Central Police Station, Funtua, and dem don carry the pikin go General Hospital, Funtua, where dem dey treat am.
|