Khassy's Posts
Nairaland Forum › Khassy's Profile › Khassy's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 93 94 95 96 97 98 99 100 101 (of 280 pages)
tobihence alert ti wole ![]() ![]() ![]() |
Boombay reply your WhatsApp ![]() ![]() |
tens4real:dm dash me one yeye course like that jare... dem d call am history edu abi wetin serf you nko...any show yet ![]() |
Titidi:a female friend needs a roomie got all the requirements you stated.. 80K send a pm if interested |
MzLarem:there's a reason you're still stuck on your 2500 chinko phone ![]() ![]() |
MzLarem:is it your beans or your tomato paste ![]() ![]() |
Na was for this mumu network ooo ![]() ![]() Anyways na there today matter end sha.... So for now this na the ranking of churches 1)DIGC 2)MICC 3)LFC 4)RCF Unchecked churches yet 1)Rhema 2)COZA Oya make I go find new chick against next weekend ![]() ![]() ![]() Anybody wey d one odo make he jam me for bekandims ... I wear green trouser and white polo with blue easy wear and fadeout glasses ![]() ![]() |
Na was for this mumu network ooo ![]() ![]() Anyways na there today matter end sha.... So for now this na the ranking of churches 1)DIGC 2)MICC 3)LFC 4)RCF Unchecked churches yet 1)Rhema 2)COZA |
[b] As e d go I jus decide begin do survey of the church Omo that church get fine girls gaan ooo ![]() ![]() I jus sight one smallie wey d look me , as ah catch her she jus pretend like say no be me she bin d look but as per sharp guy I dn already code wassup... After gbogbotigbo.. Offering time reach ![]() ![]() Thank God say their offering envelope no be those white transparent ones... I jus dip hand for my suit comot my 20# stylishly put am for offering basket as if na 1000# I port put ![]() ![]() As church close naim dm say make first timers wait behind.. I jus siddon d wait naim I turn see the smallie ooo .... I jus look her smile come use my most fav pickup line before you know she dn gimme number (I count am for my mind 1down 2more to go ![]() )After all them talk talk..I see nylon back with package inside...I dn reason say na fried rice ni oooo... I jus smile look inside come see say an coke and sticker My mood change...if say dem d change gift I for demand for rice aswear ![]() I jus d use d vex move outside naim I jam that chick wey wan come collect ma suit for door... I jus drop small punchlines for her head na there I come discover say an even fellow Arewa girl serf from JTown (JOS) .. I just collect her number,name ,dept(HIS) and level (400) tell her say I go call her later... Before I know she dn d invite me say den get evening program and make I try attend am.... I jus reason for my mind say how I go go church twice in a day abi na me be church founder ni![]() ![]() I jus flash her my white teeth tell her say I go show (For dream abi... Na me be una pastor abi una no d get visitor for una church ![]() )I jus pack my things begin go down... I jus jam one better chick... If you see the girl Cowbell ehnnn.... You for use am do breakfast for your whole compound and lunch go still half of una.. Omo if you see as ma English Behind ehn... I begin d drop all my flows and rhymes make d girl gimme number but she jus d smile like second hand lab-rat ![]() ![]() As I jus give up tel her say "see you some other time" she jus smile say make I give her my phone ... I jus say make I see wetin she wan do.. Na there the bae type number gimme oooo.. Come see as I happy like person wey jus win express ticket from Borno ![]() ... She even tell me her address serf ![]() I jus count am (3 babes today ) Anyways I come house drink the coke finish come sleep wake up see 5misswd calls from the "suit-girl" I come d feel maserf as I call her back she begin tell me say dm been d expect me for church ni... I jus hiss pretend say network bad off the call ( who una wan turn full member for una church abi una no want make I chop new comer gift for RHEMA next Sunday ![]() ). [/b] |
[b] As I reash church I first notice say like 70% of us wear suit and like 90% wear black suit so bad me come d unique in my blue suit ![]() ![]() ![]() I just waka majestically and synthetically go siddon for my seat, first thing wey I notice be say my left and right na guys siddon there but girls d my back and front sha ( I just tell maserf say this church go boring die today As dancing time ready... I just d my own d do big boy dance naim peeps jus d meet me say em like my suit ooo I jus d smile d catch Cruz as usual ![]() ... One chick wey fine like maltina bottle come tell me for ear say I LOVE YOUR SUIT AND WOULDN'T MIND COMING OVER TO COLLECT IT .... My mind firs ring like Nokia torchlight ringtone .... I jus decide compose smile tell her thanks (for my mind... Your number go enter my phone today ![]() ![]() )As e d hot.. Pastor jus begin talk say TURN TO YOUR NEIGHBOR AND TELL HIM/HER I LOVE YOU AND THERE'S NOTHING YOU CAN DO ABOUT IT.... na so I turn see say my neighbor na guy (that na 14yrs niyen ooo) I jus burst laf turn face my forward... D guy serf burst laff before I know people jus d laf anyhow cus boys no gree talk am to fellow guys ![]() ![]() ![]() I jus d reason the babe wey d my front as she fine reash and the pickup line to use for her [/b] Make I add tomato paste for this beans I d come ![]() ![]() |
Oya as e d hot make I d drop am I dn d plan go church today since last two weeks na because I wan go with bae oooo ![]() . Na so I dress up early morning before 8:30, kit up wella with ma suit and tie because today church ehnnnn.... Na baes I plan go get ooo that suit get one kind jazz wey d make girls trip once I wear am ![]() ![]() As e d be na... Bae no free follow me go church ooo na there I reason am say kasala ti shele oooo Who wan lost... Na so I dress finish..take like 29 pishures ![]() ![]() pick ma bible begin skwalay go church... Come see as neighbours d look me I jus d denge pose d feel maserf as per handsome dude {haters gonn hate sha ![]() }Make I check my beans for fire Abeg... I ho soon show back like action film ![]() ![]() |
Gather around niggas and negroes Its ya real nigga aboutta drop his Sunday experience again Let's go there ![]() ![]() In d meantime Wheesin bring that beans down make person chop jare ![]() ![]() |
Reekado:I no later go jare...police delay us |
MzLarem:as per fresh boys things... too much crushes ![]() ![]() ![]() |
Reekado:all this people asking about khassy sha... make dem better hold body ooo ![]() ![]() |
olatunji21:thanks |
MzLarem:who smiling help ![]() ![]() |
Reekado:only thing I noticed is the fact that bekandims bar has gone out of stock on Amphora plus there's excess of Magic moments ![]() ![]() |
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 93 94 95 96 97 98 99 100 101 (of 280 pages)


