Labadi69's Posts
Nairaland Forum › Labadi69's Profile › Labadi69's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 38 39 40 41 42 43 44 45 46 (of 62 pages)
babakb:Immigration consultant wey never see airport before. Owu na bastard. Come on gerrout of here. Mugu ![]() |
Konji without money na bastard! Many years of rejection from women na bigger bastard!! Soapy na the biggest bastard!!! Na konji dey worry all these small boys. Tueh ![]() |
FRANKOSKI:Ludacris ft Mystikal ![]() |
Youonlyliveonce:Guy no be me cause your poverty for Naija na. You wey dey find sugarmummy and gigolo hook up work up and down to survive dey tell me about dealing with problems in life? While you dey suffer and look for how to cut out to Vietnam and Ivory Coast of all places to escape poverty, me dey go there go play and come back. E still no mean say I dey happy to see my fellow Nigerians wey dey go there go suffer. Since una no wan hear word, I’m done passing advice to idiots. Oya carry your load dey go na. Anything wey you see make you carry. Mugu ![]() |
babakb:Oya pack your bag and move to Ivory Coast na. Then come back after three months to tell us if you don’t feel like coming back home after sleeping with 10 other guys and plenty mosquitoes inside Naija man shop for Abobo ![]() |
Jobs no too dey there for Ivorians, na Naija go come enter there find better work with him zero French? Abi you wan make dem go do vulcanizer work there? You say make dem go do business. But you don tell dem say na person wey don enter to research wetin go move wey no dey the country go make am there? You just dey advise them to just cut out and go and figure things out when they move there like say na Yankee. You don tell them how expensive the city is compared to Naija? Hotel, Rent, light, food, beer, everything cost pass for there. You no see person and him guys wey dey sleep for shop. Is that what you want for your family member? Mugu ![]() |
How can I hate Ivory Coast and still be going there to catch fun? You get sense so? I repeat, Ivory Coast is not better than Naija for person wey no get job or money or better business to do there. Anybody that has something doing in Naija should not leave it to go suffer for Ivory Coast of all places. If you want to encourage people, encourage them not to go suffer for place wey no too better pass Naija apart from constant light wey dem dey get. Of what use is constant light if you no get money to even pay for their very costly light? Encourage them to only go after doing thorough homework on their prospects there. Na people like you dey advise people to enter fire just so that you go dey house dey laugh. Just look your stupid Ugandan tales say you enter Abidjan and big bum bum woman carry you go her family house sotey you come dey nack am there under her parents roof. Yamayama fall on you with that stupid lamba. Mugu ![]() |
edwonderz:No you won’t |
TWoods:The US will never give you a visa to go to culinary school. Take that to the bank any day of the week. To learn what? To cook American food? American food wey be burger and fries. Na wetin she no fit learn from YouTube? This na rejection straight ![]() |
OP I saw the posts wey the other person write and everything he said was very true say you dey sell ogede to mugus. Stop lying, he never asked you to forgive him. He just deleted all he said cos you started talking about how this na your thread or something like that. Guy if to say Ivory Coast so easy like that, why you no stay there and make your millions? Why you cut out? Why you never go back there? If you like continue to dey use guys catch cruise say you enter a whole Abidjan homeless and with no money and all the girls with big bum bum rush you and shelter you come dey give you free abuna up and down on top. Na beans? You no see the guys wey dey on ground dey write say e no easy like that? I fit bet everything wey I get say you never comot from Youpougun (or whichever local area you stayed) when you dey there and I can bet say you no see woman pant until suffer make you cut out. Continue to dey deceive yourself and mugus wey no get sense you hear? ![]() |
adubam:Stop talking nonesense. I don’t and never lived in Abidjan. I visit there often and know it as well as I know Naija. For your information, I have a good time when I am in the city. Very good time sef. In Plateau, Cocody and Zone Quatre. But e no mean say make I no talk true and allow person wey dey use una catch cruise to deceive person say Abidjan na easy place for a Nigerian to go hustle. I’m not saying it’s impossible. I said it is not easy. You must go there with a job, have money or go with business wey you no go dey compete with Ivorians. Make I shock una, Ivorians look at Naija as heaven. They want to move to Naija. So why will person be telling una say the place is easy make all man fall in? Why he no stay there? Instead make you hear word, continue to dey form blind loyalty to OP until you carry your two left legs enter fire. Mugu ![]() |
edwonderz:You must sha show covid test. Better take it in Naija like a day or two before you travel. Otherwise them go delay you for airport if you enter without it and have to take it at their airport. Infact most airlines no go even let you board without it. I advise you to check with the airline you are going with. |
adubam:Guy I no wan kill any sweet memoirs. I wan talk true as things be make people no go make mistake with their lives. Instead make you happy say person dey talk am as e be, your little mind dey tell you say I dey try kill person memoir. After now una go enter there then come and start complaining say things don change because of covid. Na lie. No be covid anything. Things were never as sweet as OP made it look. Unless say you hold correct bar there ![]() |
Holywizard:Guy come back home. I don advice you. You have no business being in Abidjan ![]() |
Holywizard:So you comot Naija go dey sleep for shop in Abidjan. Was life that hopeless for you in Naija? Why you dey suffer yourself like that? And upon say na shop you dey sleep you still get mind to dey look for Ivorian woman wey you go nack. Brother, better come back home and suffer that suffer for your fatherland ![]() |
MERCHANDISER:Na dem dey even teach Ivorians bad things and after police arrest them, some idiots will say na set up and false accusations. Ivorians are generally nice to foreigners though they have the hate for Nigerians as most African countries do because of our loud ways and how we use money to collect their women. But a Nigerian wey stay in him lane and show dem courtesy and respect can never ever be set up. Many Nigerians are living good with no wahala over there. |
Holywizard:These are not false accusations. They are true. Many Nigerians there are criminals. They go there thinking it’s heaven after reading all the things wey people like OP dey write. After reaching there, they see the reality say life is not that easy and then turn to crime instead of going back home to be ridiculed by friends and family. They die there! And then turn to crime just to survive ![]() |
Ashirioluwa:People need to listen to this poster. He speaks nothing but the truth about the situation of things. Very accurate!!! |
Ashirioluwa:Gbam!!! No mind that guy. E be like say na small boy or villager ![]() |
adubam:No goody goody dey there before sef unless say you get money or are at least middle class. OP just dey use una catch cruise. Ivory Coast is not a rich country. Most Ivorians are poor. Na just now things dey even change. This na country wey civil war almost destroyed ![]() |
Holywizard:Doesn’t money circulate a lot in Naija? Is there any country in Africa wey money dey circulate like Naija? Yet are people not suffering? I repeat to any new person. If you no get money , job and good long term plans, you better stay in Naija and hustle. No say because life rough for Naija make you jakpa go find better life with nothing for Ivory Coast. Na suffer go dey wait you there if you try am ![]() |
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 38 39 40 41 42 43 44 45 46 (of 62 pages)



