Pillar12's Posts
Nairaland Forum › Pillar12's Profile › Pillar12's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 34 35 36 37 38 39 (of 39 pages)
In the space of 10 minutes laycon has won more than some people's fave in their entire stay in big brother house See bragging right left right center Congratulations to team sport Laycon and Ozo Congratulations to team black Laycon and Dora and some people say e no deserve to win...Na dog go chop una mouth Laycon would be the most deserving bbn winner in history I swear this boy dey underrated ICONS are proud of you boy Bragging right too much
|
I dey read one mumu post say miracle dey intelligent pass laycon, that person really deserve to be slap better resounding slap. So you be pilot mean say you sabi book pass every other person wey dey work in any other field abi which kind mumu dey nairaland like this Laycon shitt all over miracle in terms of intelligence it's not even close. Lay lay that's verse, we dey see as laycon dey aced all intellectual tasks for this show how many miracle ace for en set? aside aviation stuffs guy man no sabi anything even tobi and bambam sabi book pass miracle forget pilot or no pilot. Put Laycon and Miracle make them compete for intellectual stuffs i go bank all my life savings ontop laycon and lay lay go win hands down and it won't even be close. For entertaining stuffs again that same shim still say miracle dey entertaining abeg for where oh? miracle wey everybody tagged boring guy abeg which miracle again? aside arena games dude is another big delawood. Laycon wey carry show for head since day 1 singlehandedly, Party, Vibe, Erica entanglement, Cruise master etc Abeg let's be guided oh Laycon and miracle no suppose dey the same sentence laycon na the most deserving bbn winner ever more deserving than Efe Miracle and Mercy combined Before i go lay lay intelligence too dey underrated Man is an all rounder |
Last day of voting Apply more pressure if possible All votes for Laycon Victory is ours
|
thatigboman:Diswan and sense dey do social distancing
|
Munzy14:I dey tell you For neo mind him be efe of this season For dora mind her bubby don already win the 85m for her and she seeing she actually survived 2 toughest evictions back to back she don win be that I like nengi oh but for nengi mind she be mercy of this season lol but am sure she won't be that surprise if laycon win because she dey always tell biggie say she feel say laycon strong for outside For vee na she go happy pass if laycon win But Neo and Dora those two go don pinch their names as the winner of bbn 5
|
Lay lay dey plan as him go take rent 2 bedroom flat Should will tell him? |
tonididdy:Nengi was at 5M as at yesterday Laycon was at 4.9M during that same time but later won 333k last night courtesy of WAW task. that took him ahead of nengi (5.2m) Remember nengi hasn't won anything for about 2weeks now aside from the ones shared amongst the hms...lay won flutterwave alongside ozo 1m 500k each, and more money than nengi in indomie task, 333k last night again. Laycon don overtake her |
Laycon 6.2m + 85m = 91.2million Omo ologo |
tonididdy:Laycon na the richest (6.2M,) Nengi (6M) Where you do your own calculation? Nengi 8M ke |
Las las biggie always keep the best task for the last 5 This is easily the best task on this show We are fully entertained I pity all the evicted Hms right now...imagine watching your fellow hms grooving and having fun whilst they are watching them on TV. O wrong nau Lipton Laycon Nengi Neo Dorathy Vee Thanks for entertaining us tonight, this is the content we signed for We are fully entertained Modified - Special appreciation goes to the band, that was an Amazing performance. i comot cap for them |
Lipton try abeg See me dancing along with the finalist Omo to be finalist good oh...Enjoyment everyday |
If you are not watching now you are missing mehn See party grove |
See as laycon dey make me proud Best speech so far Make i go punish my boy with more votes That speech was deep mehn |
Threebear:So all your favourites would make it after the show and Laycon wouldn't If i swear for you now even God no go vex But i won't...because i know Laycon will make it big outside the house and become one of the biggest artist in africa not just Nigeria alone and you will eventually become one of his fans. take that to the bank Don't be a salty shim Get a life Love & Light |
Street ti take over Laycon for 85million
|
WAW first round scores are in Laycon Dora and Vee - 45pts (Winner) Neo and Nengi - 30pts Second part of the task is about quiz |
This broomdumbdumb don start him wack trolling today again Wetin concern Icons and media tour when our fave still dey house. if you like litter kidd erica and ozo pictures and news all over the thread E no concern us our main aim na to crown laycon big brother naija season 5 winner because na the biggest bragging right be that anything aside that E no concern us Kiddrica fans suppose dey shame sef, Laycon still dey house get 1.1M followers imagine how him followers go skyrocket when him leave the house with 85M on sunday and Erica after 3weeks for outside babe still dey struggle to reach 900k followers. E be things oh ICONS and Elites no be mate, the gap btw them huge gan ICONS shitt all over them. na privilege for Elites to be compared with ICONS Abeg iCONs keep voting jare...We are aiming for the biggest bragging right of the season come sunday Love and Light |
The last time Laycon get 41.41% them say him dey up with weak housemates This week them say the line up na El classico say Laycon no fit reach 41% again Today Laycon surpass him previous vote con enter 50.11% for the strongest line up ever Shebi we tell una say Laycon no get competition for that house Anyways unto the biggest one now ICONS make we finally crown all our effort this week Tell a friend to tell a friend that lay lay is the password for this week ICONS We have to go extra hard this week I don start for my end here oh Have you too? Love and Light |
Laycon - 50% Dorathy - 26% Ozo - 19% Trikytee - 4% Dia papa ICONS no be una mate |
Feelgood is the real legit source here Threebeer na scam Simp Ozo has been evicted |
Lay lay energy no be here A whole vibe |
History was made tonight Laycon first Hm to ever get to a million followers while still in the house. ICONS we made it possible Greatest fanbase of all time Respect Respect
|
Brownsun:Before party start E fit reach 1m oh Twice as tall Omo Ologo
|
Broobembem:Now i know why them dey call you broomdumbdumb Omo you dumb nobi small...So you expect laycon wey no partake for this puzzle game make him win? I dey shame on you behalf. Ozo vee and trikytee wey follow partake you no troll them na laycon wey no follow for the game you dey troll I must troll i must troll na embarrassment e dey later cause. |
Brownsun:Before 12pm tomorrow my boy would become the first ever HM in the history of bba/bbn to reach 1M followers on instagram while still in the house. A great feat that can only be achieve by legends (Sheer Brilliance) ICONS lead |
No arena game last night ooo Be as if them wan give prince the 2M for overall best time oh Laycon and Neo suppose don overtake am assuming they play arena game yesterday This agenda wey biggie dey do no be am oh |
davodyguy:Love & Light We move |
davodyguy:Forget ooo na everybody crucify laycon on that very day including you and i but i tell myself say this boy no fit just dey on this show without any particular reason...I say make i no judge am at first say make i give am benefit of doubt so i start to dey follow am closely that very day but boy was so lost and out of place maybe him dey feel less important when him see people wey pass am but after some few hours before them sleep that night baba just drop some few bars omo the hms shock even me sef shock, i dey except make him dey rap like efe or any low budget rapper but damn dude was spitting bars. i think say na only rap him go sabi until baba start to dey speak wisdom again the next morning. Erica and fellow hms no believe wetin dem see. From that day i stan am ooo Make we no dey judge book by it cover. From shame to fame. God change laycon story People wey mock am at first come later became fans including me. E dey like fairytale story |
Laycon to trickytee:my task this week was to try to bond with OZo and it happened Automatically with me and him pairing in the same task groups ,has made me to know him so well,I missed judge him at first he is full of humour and he is really a brilliant person as well ,I think he is really a nice person to be around him. Trickytee:ya Ozo have always been intelligent but you and him have the same qualities Laycon: sure I don't believe that Trickytee :you are intelligent that is why we call u Oracle Laycon: smile Trickytee : you really seems to know everything I wish my brain was like that. Laycon: all brain are the same you just need to focus on everything you want to know.. Trickytee : laughing my IQ na 000 oh Laycon and Trikytee last night convo |
davodyguy:Them later join the movement baa? |
Lay Lay everywhere See grace na
|
Dannyxy:No mind them their own definition of content na cuddling smooching and acting lovey dovey As Laycon no fit into the above mentioned them say e no get content Lay lay wey be content master...person carry show for him head since day 1 up till now e no easy na, haters sef no believe am say that kind boy fit dey give content back to back. Na why them dey monitor every move wey him make for that house positive or negative them sha go wan drag am. Laycon na their nightmare without laycon this thread go still dey page 2500, everybody wan associate with starboy Laycon this Laycon that Abeg who be the show again? layCONtent |


