₦airaland Forum

Welcome, Guest: RegisterLoginWith GoogleTrendingRecentNew

Stats: 3,326,888 members, 8,428,503 topics. Date: Wednesday, 17 June 2026 at 01:59 PM

Toggle theme

Wetin Una Dey Chop For UK???? - Romance - Nairaland

Nairaland ForumNairaland GeneralRomanceWetin Una Dey Chop For UK???? (2603 Views)

1 Reply (Go Down)

Wetin Una Dey Chop For UK???? by RollinTNDA(op): 10:50pm On Mar 09
One ugly babe for my church enter UK last year October.

I just calm down find her Facebook now

Omo shocked shocked shocked She come fresh like tear rubber
I just dey wonder how?? How?? How??

Babe wey worwor for Africa that year
She never spent 1 yr for UK now her skin don glow up massively.

Wetin una dey chop for that UK abeg
Abi na Oyinbo cream or what??
Re: Wetin Una Dey Chop For UK???? by RollinTNDA(op): 10:56pm On Mar 09
Asin this got me really thinking if some Ugly Nigerian babes are really not ugly.

Maybe they just need to travel abroad
Re: Wetin Una Dey Chop For UK???? by Adexvivacity(m): 12:25am On Mar 10
When you see her one on one, you will understand the mighty work of Snapchat.
Re: Wetin Una Dey Chop For UK???? by Maj196(m): 4:25am On Mar 10
It's mostly the weather sha
Re: Wetin Una Dey Chop For UK???? by Ay04z(m): 5:07am On Mar 10
Na d cool weather
Re: Wetin Una Dey Chop For UK???? by Jhagz(m): 5:19am On Mar 10
Omo no believe everything you Dey see online. Na weather and filter
Re: Wetin Una Dey Chop For UK???? by MONEY247: 7:06am On Mar 10
It's the weather.. Majorly..
If I stay where the weather is cool you go think say I be black American....

But suffer too much for naija sha
Re: Wetin Una Dey Chop For UK???? by adamkkk: 7:27am On Mar 10
Truth... My friend Klinton travelled after our Waec, klinton started looking like a rapper with his new Benz in less than a year... He was sending us pictures back then.


My uncle turned USA to his second house, he still looked like "tinubu". Me av been there on few occasions, everything there makes u relax... Just peace Bt I still look like Naija man.
Re: Wetin Una Dey Chop For UK???? by Baronthecelebri(m): 7:39am On Mar 10
Peaceful environment,no stress for anything
Re: Wetin Una Dey Chop For UK???? by RollinTNDA(op): 11:08am On Mar 10
Na Facebook she dey bro
She no be those type to use filter.
Adexvivacity:
When you see her one on one, you will understand the mighty work of Snapchat.
Re: Wetin Una Dey Chop For UK???? by RollinTNDA(op): 11:10am On Mar 10
But there is no snow in her pictures
Which other weather fit make her skin glow
Maj196:
It's mostly the weather sha
Re: Wetin Una Dey Chop For UK???? by RollinTNDA(op): 11:12am On Mar 10
It can't be filter.
Filter dey bleach your whole skin??

Babe is getting fairer in complexion
Filter na only for face e dey affect
I'm talking about her full body dey glow
Jhagz:
Omo no believe everything you Dey see online. Na weather and filter
Re: Wetin Una Dey Chop For UK???? by Precious201010(m): 12:30pm On Mar 10
RollinTNDA:
Na Facebook she dey bro
She no be those type to use filter.
My brother wether Facebook or Instagram, all na still Snapchat na.... If e dey easy to change like that, Why Ngolo Kante never fine pass as him be before.
Re: Wetin Una Dey Chop For UK???? by SisterAnn(f): 3:55pm On Mar 10
RollinTNDA:
Asin this got me really thinking if some Ugly Nigerian babes are really not ugly.

Maybe they just need to travel abroad
They are eating the pets.
Re: Wetin Una Dey Chop For UK???? by 247man: 4:03pm On Mar 10
RollinTNDA:
One ugly babe for my church enter UK last year October.

I just calm down find her Facebook now

Omo shocked shocked shocked She come fresh like tear rubber
I just dey wonder how?? How?? How??

Babe wey worwor for Africa that year
She never spent 1 yr for UK now her skin don glow up massively.

Wetin una dey chop for that UK abeg
Abi na Oyinbo cream or what??
Dont be deceived. Its weather plus snapchat
Re: Wetin Una Dey Chop For UK???? by ogaprime(m): 4:52pm On Mar 10
The joy soap she dey use for naija different from the joy soap she dey use for UK. Even coca cola, chicken and water sef dey different. Come to talk of body creams and lotions. So wetin you come dey expect?
Re: Wetin Una Dey Chop For UK???? by kiddaz: 7:18pm On Mar 10
Adexvivacity:
When you see her one on one, you will understand the mighty work of Snapchat.
No mind the novice grin
Re: Wetin Una Dey Chop For UK???? by BigYash: 9:18pm On Mar 10
Na Fliter and AI enhancement them dey chop to take deceive you
Re: Wetin Una Dey Chop For UK???? by VaginaAcademic: 11:09pm On Mar 10
RollinTNDA:
One ugly babe for my church enter UK last year October.

I just calm down find her Facebook now

Omo shocked shocked shocked She come fresh like tear rubber
I just dey wonder how?? How?? How??

Babe wey worwor for Africa that year
She never spent 1 yr for UK now her skin don glow up massively.

Wetin una dey chop for that UK abeg
Abi na Oyinbo cream or what??
not chop but the weather na air conditioner for most time of the year grin
Re: Wetin Una Dey Chop For UK???? by AllBlack: 2:57am On Mar 11
SisterAnn:
They are eating the pets.
somebody please shoot me 😂
Re: Wetin Una Dey Chop For UK???? by SisterAnn(f): 9:25am On Mar 11
AllBlack:
somebody please shoot me 😂
Hahaha 😃

Go to Iran.
Re: Wetin Una Dey Chop For UK???? by AllBlack: 1:06pm On Mar 11
SisterAnn:
Hahaha 😃

Go to Iran.
So who I wan leave Nancy and Cynthia and all my babes for? Leave my wife go where? Iran abi Iranu?
Re: Wetin Una Dey Chop For UK???? by jmoore(m): 9:06pm On Mar 11
RollinTNDA:
It can't be filter. Filter dey bleach your whole skin??
Babe is getting fairer in complexion Filter na only for face e dey affect I'm talking about her full body dey glow
Saka never fair?
Re: Wetin Una Dey Chop For UK???? by BrickandLace(f): 9:13pm On Mar 11
Trifle and cider
1 Reply

Where Una Dey See Money From??"No Be Una Dey Knack Us?" - Lady Berates Men Who Get Mad At "Body Counts"Wetin una want to dey do now? (Pictures)234

One Simp Story That Hunts Me Til This DayHow To Dump A Man?How You Know Whom To Marry?