₦airaland Forum

Welcome, Guest: RegisterLoginWith GoogleTrendingRecentNew

Stats: 3,328,605 members, 8,436,512 topics. Date: Tuesday, 30 June 2026 at 12:09 PM

Toggle theme

****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** - Food - Nairaland

Nairaland ForumNairaland GeneralFood****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** (25829 Views)

1 2 3 4 5 6 7 Reply (Go Down)

****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by OyinboPrincess(op): 1:55pm On Feb 11, 2015
As I don dey try this Egusi - ehhh - e don sweet me well well ooo... I don kolo to taste am again, so na to learn the formula b the next thing ooo!!

I nor fit relax, I wan chop am, the feelin too much self... so, I don carry my Oyinbo self go one local Afro-Caribbean shop, full my basket with all ingredients wey I wan use cook am.

YouTube don help me sabi am na, so to cook am mysef b the next mata...

If u go follow this Oyinbo wey to cook am eh, e go sweet u wella grin

- Boil meat for one pot, add maggie cubes, thyme, paprika, small mixed seasoning, one chopped small onion for taste (you for use any meat wey u like sha, but me I dey use lamb & beef or chicken)

- As u don dey boil meat, use the time to take one tin plumb tomatoes, one chopped onion & pepper (na the small red pepper oo - two I dey use, u fit put any amount wey sweet u - if na hot u like am add three/four) put all inside ur food processor - blend am well

- The blended mixture u go now put for one small pot, no oil oo! Put am for high heat, make e cook well well... u go leave am for fire till the time e don reduce, don thick

- As the mixture don dey boil, take ur melon seeds wey u wan use (1 cup) and blend am for food processor. U for use small water to blend ooo, so e go make a smooth paste, put am for one bowl, so u go add am to ur soup later

- Check ur meat na, if e don soft (to the way u like am) take am off fire, leave am for the side, with the water... u go use small stock from this water to add to ur soup later. If e neva cook finish, reduce the heat small, keep checking until e don cook finish

- Collect another pot, add small palm oil, make sure e don cover the bottom of the pan, roughly 1cm high. Put am for fire

- The blended mixture wey dey another pot (tomatos, onion, pepper), check am - if e don reduce finish, turn off the heat/burner

- Check ur palm oil na, if e don hot well well, start to dey smoke - ehen, e don ready b that. Add the blended mixture of tomatoes, onion & pepper - careful ooo - e go spit die

- By this time I know say ur meat don cook, if u neva remove am from fire already, do so now

- Take this time as u don fry ur mixture to wash the pots wey u don use finish ooo - u not wan finish cook with plenty washing to do na

- Stir this ur frying mixture small ooo, make sure e nor go burn

- As u don leave am to fry, cut Spinach into strips (the fresh one na the best one ooo) u for use scissors - e easy sha

- Check ur mixture again ooo - if e don begin to dry small, add tiny stock from ur meat water, na dash u go dash am

- Use ur nose to smell the frying mixture na.... if e don smell like e pepper don cook small, e don ready for the melon seeds b that.... Use one small spoon drop the grounded melon seeds into the pot, ontop the tomatoes, onion and pepper... keep dropping spoonfuls around ontop, spread am well covering everywhere

- Let am fry small ontop the mixture for a few mins on high heat... after a few mins don pass, turn am well. These melon seeds dey stick, burn, well well, so now u wan turn am from the bottom regularly

- As ur soup don thick small, add more stock water from ur meat - people like their Egusi with different thickness's, so find the one wey u like

- Add two maggie cubes again to this ur soup

- After roughly ten mins, e don cook b that smiley add the meat to the Egusi and keep turning for another ten mins, this one go allow the flavours to enter ur meat small

- Wen the ten mins don go, add the cut Spinach leaves and stir... after five more mins e don finish finally grin

To serve, u for use Gari or Pounded Yam to eat am, some people even take Semo chop - na ur choice b that

OMO THE THING SWEET DIE OOO - NOR B SAY ANYTHING... any help required, hunt me down smiley


https://www.youtube.com/watch?v=Pd7BpYpz7t4

You fit contact me here:

Facebook - Oyinbo Princess
Twitter - @OyinboPrincess

Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by Nobody: 3:36pm On Feb 11, 2015
Nice. Looks good and I believe it tastes good too.
Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by Mustack: 3:53pm On Feb 11, 2015
that's nice
Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by OyinboPrincess(op): 4:23pm On Feb 11, 2015
@3cycle - ose ooo - e sweet die, nor b small grin

@Mustack - ose baba smiley
Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by loomer: 8:22pm On Feb 11, 2015
Omo, wetn be ur name self
Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by OyinboPrincess(op): 8:35pm On Feb 11, 2015
@loomer - na Oyinbo Princess I be ooo, check am for Google self wink

u for follow me ontop twitter at facebook na
Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by loomer: 8:44pm On Feb 11, 2015
OyinboPrincess:
@loomer - na Oyinbo Princess I be ooo, check am for Google self wink

u for follow me ontop twitter at facebook na
I know say u na oyinboprincess, I de ask ur real name.


I don see u on Skype na
Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by Mustack: 9:20pm On Feb 11, 2015
OyinboPrincess:
@3cycle - ose ooo - e sweet die, nor b small grin

@Mustack - ose baba smiley
opekete, you too gbaski. big thumbs up.
Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by Nobody: 10:51pm On Feb 11, 2015
Where this babe take learn pidgin like thishuh
Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by meshacha1: 10:51pm On Feb 11, 2015
African delicacies is the best in the whole world.
We do cooking here in Nigeria
A average Nigerian cannot do without eba. ..take it or leave it.

Please if you are proud of African delicacies HIT like. Thanks
Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by WIZGUY69(m): 10:51pm On Feb 11, 2015
@ oyinbo princess, wet in u de feel likehuh?.
say u sabi cook egusi?
*in airforce1's voice*
cooking my own egusi soup.
join you soon. grin
______________________________
Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by Blackchampion(m): 10:52pm On Feb 11, 2015
Nairaland abino shares her egusi recipe
Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by countsparrow: 10:52pm On Feb 11, 2015
Hahahahaha dat ur EBA go get koko...

@oyinboprinces ur head dey dey... Ur pidgin sef beta pass my own... chao knuckle...
Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by teamlee: 10:53pm On Feb 11, 2015
can you cook for me ?
Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by Optional2(f): 10:53pm On Feb 11, 2015
Hmm
Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by CaptainAmerica1: 10:53pm On Feb 11, 2015
Op, How come you sabi pidgin English wella?

Btw, that Egusi go make sense with pounded yam and washed with chilled zobo.
Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by Sanchez01: 10:53pm On Feb 11, 2015
Is this for real?? shocked shocked shocked
Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by bwgist: 10:53pm On Feb 11, 2015
good one
Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by Nobody: 10:54pm On Feb 11, 2015
Great job haha! Some Naija girls can't even do this lipsrsealed But this your eba and egusi dey make me miss Nigeria oo embarassed Can I have some, please?
Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by Akalia(m): 10:54pm On Feb 11, 2015
Oooh! (feeling nausea) I can't eat that, anyway nice giving it a try.
Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by Jarus(m): 10:54pm On Feb 11, 2015
u sure say u be oyinbo or afin?
Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by gbaskiboy: 10:54pm On Feb 11, 2015
Ok
Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by bebe2(f):
loomer:
I know say u na oyinboprincess, I de ask ur real name.


I don see u on Skype na
just leave her alone.

wetin u dey use her real name?

anyways na she do her sef,

she go recieve PM tire.

i trust our boys here grin
Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by kingarizona1(m): 10:54pm On Feb 11, 2015
White folks been eating Nigerian food since 1914
Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by shadelek(m): 10:55pm On Feb 11, 2015
Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by Ghadafy(m): 10:56pm On Feb 11, 2015
lol, well done o!!
Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by Dewze(m): 10:56pm On Feb 11, 2015
loomer:
I know say u na oyinboprincess, I de ask ur real name.


I don see u on Skype na
Na wa for you. You for kuku ask for her home address and social security number. Nigerians sha.
Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by UrennaNkoli(f): 10:57pm On Feb 11, 2015
Oyinboprincess you sure sey you be oyinbo so ? This one wey you sabi speak pidgin like this....
Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by lion042(m): 10:57pm On Feb 11, 2015
God what is this?
Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by DancingSkeleton(m):
Kk smiley








wait first undecided who she don help huh
1 2 3 4 5 6 7 Reply

Oyinbo Woman Pictured Praying Before Eating Eba & Egusi With A Bottle Of StoutEgusi With Okporoko (stock Fish) SoupHow To Prepare Egusi Soup - - The Ultimate Guide234

1 Cup Of Garri Is N300 In My Area, What About U?What Is KALE Leaf Called In Nigeria Local Market And Dialect?How To Make KFC Crispy Chicken For Your Enjoyment This Holiday (Photos, Video)