Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,152,739 members, 7,817,038 topics. Date: Saturday, 04 May 2024 at 12:17 AM

****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** - Food (4) - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Food / ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** (23959 Views)

Oyinbo Woman Pictured Praying Before Eating Eba & Egusi With A Bottle Of Stout / Egusi With Okporoko (stock Fish) Soup / How To Prepare Egusi Soup - - The Ultimate Guide (2) (3) (4)

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (Reply) (Go Down)

Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by OyinboPrincess(f): 1:32am On Feb 12, 2015
@Mordyb - abeg give me Mom's feedback o - make I come correct myself wey I don messup small grin I don laugh scata with ur comment re: ur female friends, wasere ooooo - u funi die cheesy
Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by sharpboyus(m): 1:42am On Feb 12, 2015
OyinboPrincess:
@crownprince102 - chop knuckles ooo grin I don chop burger from time to time (sebi u nor dey see my cheeks abi!?!?!) lol but nor b everytime b that, occasionally. Ehen, for Peckham, I nor sabi the name jare but e dey for Peckham Rye, as una walk down pass Argos for ur right, keep heading down, under the train track wey get bridge above d road, e dey there for the right... na small shop oo but they sell am for there... the stick meat wey they sell sweet die self!!! Lewisham kee - omo many places dey there too, but wey they dey I nor fit explain ooo.... pele. U fit get Iyan na, even for all those small shops self - na Pounded Yam b that ooo.... only water u go take mix for house, e don ready b that grin cool



@Oyinbooribcess, you mean lolak?
Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by OyinboPrincess(f): 1:47am On Feb 12, 2015
@sharpboysus - na my name b OyinboPrincess ooo nor b Oyinbooribcess - ur eye don nack abi LOOOL u don shayo abi grin wetin b lolak self??

2 Likes

Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by Nobody: 1:51am On Feb 12, 2015
Nollywood should contact this girl fast

8 Likes

Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by quickly: 1:57am On Feb 12, 2015
OyinboPrincess:
@crownprince102 - chop knuckles ooo grin I don chop burger from time to time (sebi u nor dey see my cheeks abi!?!?!) lol but nor b everytime b that, occasionally. Ehen, for Peckham, I nor sabi the name jare but e dey for Peckham Rye, as una walk down pass Argos for ur right, keep heading down, under the train track wey get bridge above d road, e dey there for the right... na small shop oo but they sell am for there... the stick meat wey they sell sweet die self!!! Lewisham kee - omo many places dey there too, but wey they dey I nor fit explain ooo.... pele. U fit get Iyan na, even for all those small shops self - na Pounded Yam b that ooo.... only water u go take mix for house, e don ready b that grin cool

Just be careful with naija ppl u met online. Most are good but 1% are pure evil. even as some never see oyinbo like u b4.

Dont send money 2 any 1 also dont befriend or date any 1 from this site.

7 Likes 1 Share

Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by crownprince102: 2:00am On Feb 12, 2015
OyinboPrincess:
@crownprince102 - chop knuckles ooo grin I don chop burger from time to time (sebi u nor dey see my cheeks abi!?!?!) lol but nor b everytime b that, occasionally. Ehen, for Peckham, I nor sabi the name jare but e dey for Peckham Rye, as una walk down pass Argos for ur right, keep heading down, under the train track wey get bridge above d road, e dey there for the right... na small shop oo but they sell am for there... the stick meat wey they sell sweet die self!!! Lewisham kee - omo many places dey there too, but wey they dey I nor fit explain ooo.... pele. U fit get Iyan na, even for all those small shops self - na Pounded Yam b that ooo.... only water u go take mix for house, e don ready b that grin cool
Chai! U don turn Nigerian ooo, infact you be correct lagosian, see as you describe road and the thing dey clear. The first time Oyinbo describe road for me.... Chai, na God find me that day cos I don lost far far. The man just talk say "you walk down the road and move diagonal through erith and get your way through". As I try am, na dartford I dey go, na crayford I find my self. Thank God say he no to far from each other, na God go bless Graham Bell wey invent telephone ooo, if not for that mama charley for don deport me say I dey idle and have to no to go for the street of london

6 Likes

Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by OyinboPrincess(f): 2:04am On Feb 12, 2015
@babyosisi - my sista, na Nollywood nor go gree carry person from UK come act for 9ja na... I knw say e nor go happen ooo.. lol - but I HAIL U OOO for ur acknowledgement and support *chop knuckle* grin One love from London Sista 2 Lagos Sista (even tho I knw say u dey US) cheesy

@quickly - ose for this ur comment ooo - my eye don clear well well na, no-one fit try mumu me na.... I don dey ontop jare smiley wasere!!

2 Likes

Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by OyinboPrincess(f): 2:08am On Feb 12, 2015
@crownprince102 - chaiiii baba, see walka na... omo d man don cris b that ooo, e won put u for one v looooong thing jare - ehen, thank God for telephone creations ooo, wey e come give person mind create na. Ehen, follow the road wey I come give u for Peckham na, u go see the shop sha.... e small tho, but u go see many stick meat and Iyan don dey for mould already, packaged in transparent wraps for window self, u nor go miss am na. U knw say na, u nor b JJC, so abeg, no loose urself again for road oooo grin

2 Likes

Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by Nobody: 2:16am On Feb 12, 2015
OyinboPrincess:
@babyosisi - my sista, na Nollywood nor go gree carry person from UK come act for 9ja na... I knw say e nor go happen ooo.. lol - but I HAIL U OOO for ur acknowledgement and support *chop knuckle* grin One love from London Sista 2 Lagos Sista (even tho I knw say u dey US) cheesy

@quickly - ose for this ur comment ooo - my eye don clear well well na, no-one fit try mumu me na.... I don dey ontop jare smiley wasere!!

Ah!
Na you get this hand o!

See as you just dey drop pidgin like no man's business
Nollywood dey come London too
Haba
Just dey do ya thing
As ya story dey out dia,na so one person go see you one day come connect you,small time now queen Eliza currency aka ego igwe aka iron money go full ya 'Ghana must go"
E fit happen
You sabi mercy Johnson abi,mercy Johnson,the Fine one wey just born pikin the other day
Na pure water e dey sell for mazzamazza na dia one person come see am take am go Upper Iweka road for Onitsha ,see her now doing iyanga
Well no be like dat e take happen but you understand wetin I wan talk

Goodluck girl
Love your bubbly spirit

5 Likes

Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by Emmysteve(m): 2:18am On Feb 12, 2015
Aswear this babe go sabi cook pass some of these yeye naija babes wey dey form. Abeg nothing do u. *Chop knuckle*

2 Likes

Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by sharpboyus(m): 2:28am On Feb 12, 2015
OyinboPrincess:
@sharpboysus - na my name b OyinboPrincess ooo nor b Oyinbooribcess - ur eye don nack abi LOOOL u don shayo abi grin wetin b lolak self??


Its autotype na.... No vex.... You still dey live for that your ends And how far your sister self?
Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by JayJustus(m): 2:30am On Feb 12, 2015
is this not one of the ladies I saw on Instagram doing that Falz the badt guy Ello bae challenge

1 Like

Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by OyinboPrincess(f): 2:32am On Feb 12, 2015
@babyosisi - omo u don dey try for me this night ooo - see as u reply steady and na bere encouragement u wan fill my hand wiv oo - ose ooo ehen na - I know say God dey my back for everything na. Sure say anything fit happen na and I hope say one day sha, I fit give something to the 9ja entertainment business, wey I fit entertain people wey I treasure most - Nigerians. I knw say na so they don find Johnson na.... e b lyk say na the right place, right time b that ooo - but I nor dey chase dreams, I don catch am! So the time wey e come my side, double handed I go hold am so. Na so I understand wetin u talk na, ose ooo - na positivity u preach - wasere!! I hope say u too go carry go wey u wan go.. IJN. Ur spirit don high me this night kiss we for follow one another on twitter na, if una get am search me - @OyinboPrincess

@Emmysteve - looooooooool at yeye babes..... I knw say na mind I com apply learn am na, so even if na yeye babe, she still fit learn sha grin 'chop knuckle' back ooo

1 Like

Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by OyinboPrincess(f): 2:34am On Feb 12, 2015
@JayJustus - looool nor b me ooo baba tongue
Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by Lilboots(m): 2:40am On Feb 12, 2015
I no dey go Peckham Rye again o. Na so I go buy foodstuffs for there. Na im the Oga wey sell me the stuff say I fit bring my moto come carry the goods. The bros no even tell me so no packing for there as I no live for London. Na so I go carry my motor come park for the street , I come begin pack my foodstuffs wey I buy inside my car boot. I just notice say every person wey dey pass jus dey look me pity. Me sef no see other cars wey stop dey pack goods. Na only delivery lorries and this red London buses dey stop.

Anyways, I come land house na. The thing no even reach 3 days, Omo, dem hammer me ticket. £80. Shuo!!! shocked shocked shocked. Food wey even carry me go there no reach 80 pounds. Omo , since that day, I run from Peckham rye. I jus dey manage d naija african shop wey dey my side

2 Likes

Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by Lilboots(m): 2:43am On Feb 12, 2015
@OyinboPrincess, u dey try wella. Make God bless ur hustle. E no easy grin grin grin

1 Like

Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by Gboliwe: 2:48am On Feb 12, 2015
Chai!

I really need to upgrade my pidgin English. See as OyiboPrincess dey drop it. I am challenged!

Well done girl!

4 Likes

Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by Lilboots(m): 2:57am On Feb 12, 2015
[
Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by vicchi12(f): 3:08am On Feb 12, 2015
Yawns!
Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by Lilboots(m): 3:14am On Feb 12, 2015
vicchi12:
Yawns!

Go sleep. Wondering what u r doing awake. This ur yawning don too much cool

1 Like

Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by vicchi12(f): 3:19am On Feb 12, 2015
Lilboots:


Go sleep. Wondering what u r doing awake. This ur yawning don too much cool
Yawns!! tongue
Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by BlackLeopard(m): 3:46am On Feb 12, 2015
@OyinboPrincess, thank for share.

2 Likes

Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by Lilboots(m): 3:48am On Feb 12, 2015
vicchi12:

Yawns!! tongue

That ya tongue go soon cut. Mark my words

1 Like

Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by sidecheek(f): 3:56am On Feb 12, 2015
You try no be Small¿ your pidgin na Die¿ but egusi no dey sweet Jo¿ I no like Am¿ which country are you Anyway¿ I fit teach you how to make Ofe nsala¿ grin and you teach me your grandmother recipe for lamb chops¿

1 Like

Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by sidecheek(f): 3:58am On Feb 12, 2015
Truth
quickly:


Just be careful with naija ppl u met online. Most are good but 1% are pure evil. even as some never see oyinbo like u b4.

Dont send money 2 any 1 also dont befriend or date any 1 from this site.

1 Like

Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by tellwisdom: 5:52am On Feb 12, 2015
This your food no go land person for hospital so?? sad

3 Likes

Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by armyofone(m): 5:54am On Feb 12, 2015
Hot eba and egusi soup yummy. You use goat meat so grin I know say goat na ya pet but the meat sweet for egusi soup no be small thing.

1 Like

Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by Emyben(m): 6:04am On Feb 12, 2015
Amefrica:


Try to swap 'fit' for the 'for' wey you dey type. That's the only fault in your pidgin I fit pinpoint at the moment.

You may wanna cook and send some give me for Canada here, eba and egusi dey hungry me die.. embarassed cry

No melon seeds in all Canadian groceries and stores? cheesy

1 Like

Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by 1miccza: 6:20am On Feb 12, 2015
Nice job op but i think more of the vegetables would have made more sense though

1 Like

Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by anthoniaz(f): 6:31am On Feb 12, 2015
shocked Oyinboprincess, na u dey yarn pidgin like dis! I gbadu ur style. grin

2 Likes

Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by donodion(m): 6:43am On Feb 12, 2015
I dey follow now now now

1 Like

Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by Nobody: 6:48am On Feb 12, 2015
I watch your youtube videos, i don believe you oooo. Hmmmm u try no be small. shocked shocked

2 Likes

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (Reply)

What Food Taste Better The Next Day -. Photo / 1200 Christmas Chickens Lost To Auto Accident / Concern Over Low Quality Of Local Rice

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 42
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.