This Oyinbo don marry naija guy and na Peckham, Brixton or Camberwell she dey live for London, kpele oo, enjoy your egusi wella and next time add ewuro leaves to it
OyinboPrincess: As I don dey try this Egusi - ehhh - e don sweet me well well ooo... I don kolo to taste am again, so na to learn the formula b the next thing ooo!!
I nor fit relax, I wan chop am, the feelin too much self... so, I don carry my Oyinbo self go one local Afro-Caribbean shop, full my basket with all ingredients wey I wan use cook am.
YouTube don help me sabi am na, so to cook am mysef b the next mata...
If u go follow this Oyinbo wey to cook am eh, e go sweet u wella
- Boil meat for one pot, add maggie cubes, thyme, paprika, small mixed seasoning, one chopped small onion for taste (you for use any meat wey u like sha, but me I dey use lamb & beef or chicken)
- As u don dey boil meat, use the time to take one tin plumb tomatoes, one chopped onion & pepper (na the small red pepper oo - two I dey use, u fit put any amount wey sweet u - if na hot u like am add three/four) put all inside ur food processor - blend am well
- The blended mixture u go now put for one small pot, no oil oo! Put am for high heat, make e cook well well... u go leave am for fire till the time e don reduce, don thick
- As the mixture don dey boil, take ur melon seeds wey u wan use (1 cup) and blend am for food processor. U for use small water to blend ooo, so e go make a smooth paste, put am for one bowl, so u go add am to ur soup later
- Check ur meat na, if e don soft (to the way u like am) take am off fire, leave am for the side, with the water... u go use small stock from this water to add to ur soup later. If e neva cook finish, reduce the heat small, keep checking until e don cook finish
- Collect another pot, add small palm oil, make sure e don cover the bottom of the pan, roughly 1cm high. Put am for fire
- The blended mixture wey dey another pot (tomatos, onion, pepper), check am - if e don reduce finish, turn off the heat/burner
- Check ur palm oil na, if e don hot well well, start to dey smoke - ehen, e don ready b that. Add the blended mixture of tomatoes, onion & pepper - careful ooo - e go spit die
- By this time I know say ur meat don cook, if u neva remove am from fire already, do so now
- Take this time as u don fry ur mixture to wash the pots wey u don use finish ooo - u not wan finish cook with plenty washing to do na
- Stir this ur frying mixture small ooo, make sure e nor go burn
- As u don leave am to fry, cut Spinach into strips (the fresh one na the best one ooo) u for use scissors - e easy sha
- Check ur mixture again ooo - if e don begin to dry small, add tiny stock from ur meat water, na dash u go dash am
- Use ur nose to smell the frying mixture na.... if e don smell like e pepper don cook small, e don ready for the melon seeds b that.... Use one small spoon drop the grounded melon seeds into the pot, ontop the tomatoes, onion and pepper... keep dropping spoonfuls around ontop, spread am well covering everywhere
- Let am fry small ontop the mixture for a few mins on high heat... after a few mins don pass, turn am well. These melon seeds dey stick, burn, well well, so now u wan turn am from the bottom regularly
- As ur soup don thick small, add more stock water from ur meat - people like their Egusi with different thickness's, so find the one wey u like
- Add two maggie cubes again to this ur soup
- After roughly ten mins, e don cook b that add the meat to the Egusi and keep turning for another ten mins, this one go allow the flavours to enter ur meat small
- Wen the ten mins don go, add the cut Spinach leaves and stir... after five more mins e don finish finally
To serve, u for use Gari or Pounded Yam to eat am, some people even take Semo chop - na ur choice b that
OMO THE THING SWEET DIE OOO - NOR B SAY ANYTHING... any help required, hunt me down
Omo - I think say I go thank individually for comments ooo, but na too many jare!!
I salute u for these ur comments and time visiting my post... for those non-believers, na OYINBO I b ooo, u for go check my videos ontop YouTube, just search Oyinbo Princess.... for those wey wan follow me small, u know say my twitter and facebook page dey for my original post - oya na, make una follow sharp!!
London 2 Lagos, ONELOVE - ose ose ose
PS - nor b only Egusi I fit cook na.... anyone wey u like I go do am if I nor sabi already, I go learn quick sha - uploaded: fried rice
Abi dey think say she don marry one naija guy for there. she try, she even try pass some of our babes here. she dey for this forum make i congratulate her?
let me show her some love by following her on twitter
OyinboPrincess: Omo - I think say I go thank individually for comments ooo, but na too many jare!!
I salute u for these ur comments and time visiting my post... for those non-believers, na OYINBO I b ooo, u for go check my videos ontop YouTube, just search Oyinbo Princess.... for those wey wan follow me small, u know say my twitter and facebook page dey for my original post - oya na, make una follow sharp!!
London 2 Lagos, ONELOVE - ose ose ose
PS - nor b only Egusi I fit cook na.... anyone wey u like I go do am if I nor sabi already, I go learn quick sha - uploaded: fried rice
I never believe my eyes....CHHHHIIIIISSSSSSSSSOOOOOOOOOSSSSSSSS!!!!!

Omo, I just watch the video now..this lady dey blow pidgin as if na naija dem born am...@oyinboprincess, be ready for enough pm and disturbances from Nairaland guys..
meshacha1: African delicacies is the best in the whole world. We do cooking here in Nigeria A average Nigerian cannot do without eba. ..take it or leave it.
Please if you are proud of African delicacies HIT like. Thanks
Here in US i nor dey eat out o, na correct eba or ola ola i dey nack with different type of soup on top. My wife na good cook, trust owerri women they can cook. But, nothing i miss than real pounded yam and akpu from naija . The way i go rush pandy and fufu with egusi soup when i land Naija this year hmmmm...
this girl pidgin flows won make me cum...like seriously.. oyinboprincess....ur head dey there...u oga wen dey house really teach u well...n u sabi learn...nairalanders... we can now boast of a white Nigerian... this na correct warri pako babe
OyinboPrincess: Omo - I think say I go thank individually for comments ooo, but na too many jare!!
I salute u for these ur comments and time visiting my post... for those non-believers, na OYINBO I b ooo, u for go check my videos ontop YouTube, just search Oyinbo Princess.... for those wey wan follow me small, u know say my twitter and facebook page dey for my original post - oya na, make una follow sharp!!
London 2 Lagos, ONELOVE - ose ose ose
PS - nor b only Egusi I fit cook na.... anyone wey u like I go do am if I nor sabi already, I go learn quick sha - uploaded: fried rice
I see say you dey support Chelsea, nah dia u fall my hand, why not Arsenal(king of london)?