Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,154,763 members, 7,824,188 topics. Date: Saturday, 11 May 2024 at 03:45 AM

****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** - Food (5) - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Food / ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** (23983 Views)

Oyinbo Woman Pictured Praying Before Eating Eba & Egusi With A Bottle Of Stout / Egusi With Okporoko (stock Fish) Soup / How To Prepare Egusi Soup - - The Ultimate Guide (2) (3) (4)

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (Reply) (Go Down)

Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by soleexx(m): 6:55am On Feb 12, 2015
I riili proud of ya Oyinbo Princess...u rill did great!..I belive it will taste delicious just like my mama's

2 Likes

Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by EMEKA1MILLION(m): 7:12am On Feb 12, 2015
Lol.... This Babe funny

2 Likes

Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by Olaone1: 7:14am On Feb 12, 2015
There are many like her in London. Some even speak Yoruba.

1 Like

Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by Nickymezor(f): 7:23am On Feb 12, 2015
Mehn, her pidgin dey tight.8..whr she take learn am sef

2 Likes

Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by Nobody: 7:26am On Feb 12, 2015
Oyinboprincess where you dey stay for lagos? I wan come chop that egusi wink

2 Likes

Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by Moana(f): 7:35am On Feb 12, 2015
loomer:

I know say u na oyinboprincess, I de ask ur real name.

I don see u on Skype na
runz boy tingz

1 Like

Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by Olaone1: 7:36am On Feb 12, 2015
tellwisdom:
This your food no go land person for hospital so?? sad
Trust Mr Wisdom. U no dey ever disappoint cheesy cheesy

2 Likes

Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by Olaone1: 7:37am On Feb 12, 2015
Something dey tell me say dis one don live for Naija before
Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by kliq(m): 7:45am On Feb 12, 2015
Impressive smiley

2 Likes

Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by Moana(f): 7:46am On Feb 12, 2015
crownprince102:

Wetin be the big deal na, I wan chop that egusi and eba make I use am confirm to nairalander say na superb cook you be. Eba no dey easy to get in london na. Na plastic hand my guardian get, na to dey chop oyinbo food wey go dey scatter una stomach every time. If I chop this egusi and eba and the [size=14pt] thing sweet, [/size] i swear to una, guiness go put this inside their
book of record!!!
*Modifies song and starts singing*

Small girl you don't know the ting
I am teaching you the ting
You must give me that sweet ting

grin grin grin

1 Like

Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by Nobody: 7:51am On Feb 12, 2015
Emyben:

No melon seeds in all Canadian groceries and stores? cheesy

Haha melon (pumpkin) seeds dey for sure, but for my city here you nor fit see garri and some other 9ja stuffs - na Toronto dem full embarassed cry

1 Like

Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by Nobody: 8:01am On Feb 12, 2015
tellwisdom:
This your food no go land person for hospital so?? sad
na your mama's egusi go fit land person for ICU sef

3 Likes

Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by Exjoker(m): 8:07am On Feb 12, 2015
OyinboPrincess:
@Exjoker - nor b by force u go believe na.... but I nor fit lie ontop my own post. Next time I go shoot full video self!!! Make una subscribe to my YouTube channel, u go see am as I don upload na! wink
Lol. Okay where did you learn to cook that? And you're good at speaking Nigeria pidgin English, have you ever stayed in Nigeria?

1 Like

Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by Nobody: 8:09am On Feb 12, 2015
OyinboPrincess:
As I don dey try this Egusi - ehhh - e don sweet me well well ooo... I don kolo to taste am again, so na to learn the formula b the next thing ooo!!

I nor fit relax, I wan chop am, the feelin too much self... so, I don carry my Oyinbo self go one local Afro-Caribbean shop, full my basket with all ingredients wey I wan use cook am.

YouTube don help me sabi am na, so to cook am mysef b the next mata...

If u go follow this Oyinbo wey to cook am eh, e go sweet u wella grin

- Boil meat for one pot, add maggie cubes, thyme, paprika, small mixed seasoning, one chopped small onion for taste (you for use any meat wey u like sha, but me I dey use lamb & beef or chicken)

- As u don dey boil meat, use the time to take one tin plumb tomatoes, one chopped onion & pepper (na the small red pepper oo - two I dey use, u fit put any amount wey sweet u - if na hot u like am add three/four) put all inside ur food processor - blend am well

- The blended mixture u go now put for one small pot, no oil oo! Put am for high heat, make e cook well well... u go leave am for fire till the time e don reduce, don thick

- As the mixture don dey boil, take ur melon seeds wey u wan use (1 cup) and blend am for food processor. U for use small water to blend ooo, so e go make a smooth paste, put am for one bowl, so u go add am to ur soup later

- Check ur meat na, if e don soft (to the way u like am) take am off fire, leave am for the side, with the water... u go use small stock from this water to add to ur soup later. If e neva cook finish, reduce the heat small, keep checking until e don cook finish

- Collect another pot, add small palm oil, make sure e don cover the bottom of the pan, roughly 1cm high. Put am for fire

- The blended mixture wey dey another pot (tomatos, onion, pepper), check am - if e don reduce finish, turn off the heat/burner

- Check ur palm oil na, if e don hot well well, start to dey smoke - ehen, e don ready b that. Add the blended mixture of tomatoes, onion & pepper - careful ooo - e go spit die

- By this time I know say ur meat don cook, if u neva remove am from fire already, do so now

- Take this time as u don fry ur mixture to wash the pots wey u don use finish ooo - u not wan finish cook with plenty washing to do na

- Stir this ur frying mixture small ooo, make sure e nor go burn

- As u don leave am to fry, cut Spinach into strips (the fresh one na the best one ooo) u for use scissors - e easy sha

- Check ur mixture again ooo - if e don begin to dry small, add tiny stock from ur meat water, na dash u go dash am

- Use ur nose to smell the frying mixture na.... if e don smell like e pepper don cook small, e don ready for the melon seeds b that.... Use one small spoon drop the grounded melon seeds into the pot, ontop the tomatoes, onion and pepper... keep dropping spoonfuls around ontop, spread am well covering everywhere

- Let am fry small ontop the mixture for a few mins on high heat... after a few mins don pass, turn am well. These melon seeds dey stick, burn, well well, so now u wan turn am from the bottom regularly

- As ur soup don thick small, add more stock water from ur meat - people like their Egusi with different thickness's, so find the one wey u like

- Add two maggie cubes again to this ur soup

- After roughly ten mins, e don cook b that smiley add the meat to the Egusi and keep turning for another ten mins, this one go allow the flavours to enter ur meat small

- Wen the ten mins don go, add the cut Spinach leaves and stir... after five more mins e don finish finally grin

To serve, u for use Gari or Pounded Yam to eat am, some people even take Semo chop - na ur choice b that

OMO THE THING SWEET DIE OOO - NOR B SAY ANYTHING... any help required, hunt me down smiley

https://www.youtube.com/watch?v=Pd7BpYpz7t4

You fit contact me here:

Facebook - Oyinbo Princess
Twitter - @OyinboPrincess

If pesin chop that your eba na choke pesin go choke. You try small sha but na until I see you pound yam before I cut cap for you

1 Like

Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by Nobody: 8:28am On Feb 12, 2015
Though she didn't add all the condiments,like dried fish,stock fish,pomo etc,but she try abeg.

2 Likes

Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by Nobody: 8:33am On Feb 12, 2015
Thanks ma london sister for making me feel great. Its a great feeling to love and be loved back. Today I know I'm not the only one doing the loving the people I love love me too. ONE LOVE!

1 Like

Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by Mayor21(m): 8:49am On Feb 12, 2015
I no gree, this babe pidgin too good, no b sa she even grow up 4 naija sef. Na naija person b diz gan!

2 Likes

Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by ifoundmyperfect: 8:53am On Feb 12, 2015
your egusi don dey make my mouth water.... grin grin grin grin

1 Like

Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by kaylobs(m): 9:09am On Feb 12, 2015
This @OyinboPrincess Na for real o. Me don download all her YouTube video to confirm whether she dey lie. Also you can read her interview @ Net.ng to confirm.
Also follow am for Twitter @OyinboPrincess and Facebook at Oyinbo Princess. She is for real

We just need to support her and the sky is just her starting point. You can never know it may be her destiny to make it thru Naija way..

Also I can testify that she is very friendly..

2 Likes

Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by mabeni(m): 9:36am On Feb 12, 2015
FriedPlantain:
Where this babe take learn pidgin like this
may be na one 9ja igbo Guy wey dey bleep her teach her.
Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by esosuo: 9:38am On Feb 12, 2015
dis babe try wella , looks like dem don get study pigin for dos foreign schools now oh because the way she dey finish the tin no be learner matas oh

2 Likes

Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by tellwisdom: 9:46am On Feb 12, 2015
Viogu:
na your mama's egusi go fit land person for ICU sef

Who be this omo ale?? sad

1 Like

Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by loomer: 9:55am On Feb 12, 2015
Moana:
runz boy tingz

Me no get time for runz o,

1 Like

Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by crownprince102: 10:08am On Feb 12, 2015
quickly:

Just be careful with naija ppl u met online. Most are good but 1% are pure evil. even as some never see oyinbo like u b4.

Dont send money 2 any 1 also dont befriend or date any 1 from this site.

looolz...... Do you mean the igbo boys? grin
Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by EgusiSoup: 10:09am On Feb 12, 2015
OyinboPrincess:
As I don dey try this Egusi - ehhh - e don sweet me well well ooo... I don kolo to taste am again, so na to learn the formula b the next thing ooo!!

I nor fit relax, I wan chop am, the feelin too much self... so, I don carry my Oyinbo self go one local Afro-Caribbean shop, full my basket with all ingredients wey I wan use cook am.

YouTube don help me sabi am na, so to cook am mysef b the next mata...

If u go follow this Oyinbo wey to cook am eh, e go sweet u wella grin

- Boil meat for one pot, add maggie cubes, thyme, paprika, small mixed seasoning, one chopped small onion for taste (you for use any meat wey u like sha, but me I dey use lamb & beef or chicken)

- As u don dey boil meat, use the time to take one tin plumb tomatoes, one chopped onion & pepper (na the small red pepper oo - two I dey use, u fit put any amount wey sweet u - if na hot u like am add three/four) put all inside ur food processor - blend am well

- The blended mixture u go now put for one small pot, no oil oo! Put am for high heat, make e cook well well... u go leave am for fire till the time e don reduce, don thick

- As the mixture don dey boil, take ur melon seeds wey u wan use (1 cup) and blend am for food processor. U for use small water to blend ooo, so e go make a smooth paste, put am for one bowl, so u go add am to ur soup later

- Check ur meat na, if e don soft (to the way u like am) take am off fire, leave am for the side, with the water... u go use small stock from this water to add to ur soup later. If e neva cook finish, reduce the heat small, keep checking until e don cook finish

- Collect another pot, add small palm oil, make sure e don cover the bottom of the pan, roughly 1cm high. Put am for fire

- The blended mixture wey dey another pot (tomatos, onion, pepper), check am - if e don reduce finish, turn off the heat/burner

- Check ur palm oil na, if e don hot well well, start to dey smoke - ehen, e don ready b that. Add the blended mixture of tomatoes, onion & pepper - careful ooo - e go spit die

- By this time I know say ur meat don cook, if u neva remove am from fire already, do so now

- Take this time as u don fry ur mixture to wash the pots wey u don use finish ooo - u not wan finish cook with plenty washing to do na

- Stir this ur frying mixture small ooo, make sure e nor go burn

- As u don leave am to fry, cut Spinach into strips (the fresh one na the best one ooo) u for use scissors - e easy sha

- Check ur mixture again ooo - if e don begin to dry small, add tiny stock from ur meat water, na dash u go dash am

- Use ur nose to smell the frying mixture na.... if e don smell like e pepper don cook small, e don ready for the melon seeds b that.... Use one small spoon drop the grounded melon seeds into the pot, ontop the tomatoes, onion and pepper... keep dropping spoonfuls around ontop, spread am well covering everywhere

- Let am fry small ontop the mixture for a few mins on high heat... after a few mins don pass, turn am well. These melon seeds dey stick, burn, well well, so now u wan turn am from the bottom regularly

- As ur soup don thick small, add more stock water from ur meat - people like their Egusi with different thickness's, so find the one wey u like

- Add two maggie cubes again to this ur soup

- After roughly ten mins, e don cook b that smiley add the meat to the Egusi and keep turning for another ten mins, this one go allow the flavours to enter ur meat small

- Wen the ten mins don go, add the cut Spinach leaves and stir... after five more mins e don finish finally grin

To serve, u for use Gari or Pounded Yam to eat am, some people even take Semo chop - na ur choice b that

OMO THE THING SWEET DIE OOO - NOR B SAY ANYTHING... any help required, hunt me down smiley

https://www.youtube.com/watch?v=Pd7BpYpz7t4

You fit contact me here:

Facebook - Oyinbo Princess
Twitter - @OyinboPrincess

How does this affect the price if Egusi in the market?

EgusiSoup

1 Like

Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by Bants(m): 11:14am On Feb 12, 2015

If you british you go dey peckham, woolwich, plumstead side or even moston for manchester
Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by Nobody: 11:41am On Feb 12, 2015
Moana:

*Modifies song and starts singing*

Small girl you don't know the ting
I am teaching you the ting
You must give me that sweet ting

grin grin grin
Haha

How come I don't know this song?

Will you sing it for me please?

cool
Moana:

*Modifies song and starts singing*

Small girl you don't know the ting
I am teaching you the ting
You must give me that sweet ting

grin grin grin
Haha

How come I don't know this song?

Will you sing it for me please?

1 Like

Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by vicchi12(f): 12:13pm On Feb 12, 2015
Lilboots:

That ya tongue go soon cut. Mark my words
Yours will be eaten by a dog. Excuse me, move along, now!
Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by Expsbterror(m): 12:31pm On Feb 12, 2015
Viogu:
na your mama's egusi go fit land person for ICU sef

Hmmmm... This is gonna b cool cool

1 Like 1 Share

Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by babsjnr(m): 12:42pm On Feb 12, 2015
Oyinboprincess u fit come cook dis kind egusi for me for Birmingham

1 Like

Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by Lilboots(m): 12:51pm On Feb 12, 2015
vicchi12:

Yours will be eaten by a dog. Excuse me, move along, now!

Excuse you for what? Do you own this thread? angry angry. See me see this early morning wahala. Waka!! Anumanu!!! lipsrsealed lipsrsealed embarassed
Re: ****Oyinbo Wey Share Love For EGUSI**** by ThoniaSlim(f): 12:52pm On Feb 12, 2015
If you like call me a HATER but I could care less!

You came to a Nigerian forum to show us how to cook egusi soup? Seriously rolling my eyes!

2 Likes

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (Reply)

What Food Taste Better The Next Day -. Photo / 1200 Christmas Chickens Lost To Auto Accident / Concern Over Low Quality Of Local Rice

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 67
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.