₦airaland Forum

Welcome, Guest: RegisterLoginWith GoogleTrendingRecentNew

Stats: 3,329,923 members, 8,443,002 topics. Date: Saturday, 11 July 2026 at 12:30 AM

Toggle theme

Here Are Some silly Questions People Ask - Nairaland General - Nairaland

Nairaland ForumNairaland GeneralHere Are Some silly Questions People Ask (30862 Views)

1 2 3 4 Reply (Go Down)

Here Are Some silly Questions People Ask by omanifrank(op): 10:12pm On Jun 06, 2015
1. You see identical twins, you still dey ask 'na twins be dis'? No bros, na picmix...lol .


2. Nepa brings light and everyone in the neighborhood shouts 'up Nepaaa'! My guy ask me, O boy na light be that? No oh, Na Holy Ghost fire! Lol! .




3. You see person dey vomit, you still dey ask am 'you no well'? Em well, e juz dey practice how to vomit. .


4. You just wake up from sleep person come ask you "you don wake?" No oh, I come buy bread wey I go chop for dream. .


5. You see woman wey born new pikin u ask her "madam u don born? " No ohhhh, she buy am for OLX... .



6. You greet person "good morning ma" ! She ask, my pikin you don wakehuh? no ohhhh, I dey sleep walk... .



7. My guy ask me "O boy where u dey?" I tell am say i dey bank, nd him ask me "Wat is happening there?" Nah new yam festival.. *LMAO* .



8. My neighbour sees me opening the gates to drive out and asks me, U dey comot? Not at all... I be the new gateman... .




9. I dey watch film… my guy enta come ask me "Guy na film u dey watch? No naa... I dey discuss with Osuofia... .


10.U see me dey chop indomie come dey ask me, O boy, na indomie u dey chop so? No ohhhh... Na fried rubber band mixed with thread.
.


Dont Forget To Share
Re: Here Are Some silly Questions People Ask by holicalpha(m):
You see Neymar put "o see" score goal, you still dey ask "na Goal be that".huh

You see Barcelona with Trophy, You still dey ask "na them win the match".??

You see Real Madrid on top their bed,they sleep..you still dey ask "they Play Final".huh

You see "- Valar Morghulis" under comment you still dey ask "na Holicalpha post that thing"


I Dedicate this FTC to the UEFA CHAMPIONS; FC BARCELONA.


- Valar Morghulis
Re: Here Are Some silly Questions People Ask by lovaleenny(f): 10:35pm On Jun 06, 2015
And this made fp undecided
Re: Here Are Some silly Questions People Ask by Smartlux(m): 10:35pm On Jun 06, 2015
hmmmm,, fp o!!!
Re: Here Are Some silly Questions People Ask by CountDracula(m): 10:35pm On Jun 06, 2015
Dis? Frontpage? Really?
Re: Here Are Some silly Questions People Ask by Nobody: 10:35pm On Jun 06, 2015
What are those?
Re: Here Are Some silly Questions People Ask by tociano009(m): 10:35pm On Jun 06, 2015
A
Re: Here Are Some silly Questions People Ask by KingEbukasBlog(m): 10:35pm On Jun 06, 2015
grin
Re: Here Are Some silly Questions People Ask by spicytayomic(m): 10:35pm On Jun 06, 2015
grin grin
Re: Here Are Some silly Questions People Ask by Gombs(m): 10:36pm On Jun 06, 2015

Re: Here Are Some silly Questions People Ask by sammieguze(m):
Aunty philo; Sam Sam... Is this you?

Sam: cheesy No o aunty philo... Its my shadow.

Aunty philo; What re you doing in the toilet?

Sam: cooking #straightfaced
Re: Here Are Some silly Questions People Ask by elohorayodele: 10:36pm On Jun 06, 2015
Na wA
Re: Here Are Some silly Questions People Ask by tollytexy(m): 10:36pm On Jun 06, 2015
The 8 & 10 killed it
Re: Here Are Some silly Questions People Ask by legaxi(m): 10:36pm On Jun 06, 2015
My guy be like "you don wake " no i dey learn how to open eye for dream
Re: Here Are Some silly Questions People Ask by ekochris(m): 10:36pm On Jun 06, 2015
Person go see with towel inside bathroom, dem go come dey ask 'You dey bath'?..... No na baptism i dey do.
Re: Here Are Some silly Questions People Ask by teemsa: 10:36pm On Jun 06, 2015
Hahahahah!
Re: Here Are Some silly Questions People Ask by Aitee1: 10:36pm On Jun 06, 2015
Re: Here Are Some silly Questions People Ask by McEwen(m): 10:36pm On Jun 06, 2015
And Juve lost undecided
Re: Here Are Some silly Questions People Ask by holluwai(m): 10:36pm On Jun 06, 2015
Hahaha

Person come your house, you dey ask na your face be that? No, no be my face, na mask.
Re: Here Are Some silly Questions People Ask by tollytexy(m): 10:36pm On Jun 06, 2015
Gombs:
How many times will this kind thread on same topic make front page? undecided
make yours too make u gain front page na..
Re: Here Are Some silly Questions People Ask by johnwizey: 10:36pm On Jun 06, 2015
dry
Re: Here Are Some silly Questions People Ask by netmoneywizard: 10:37pm On Jun 06, 2015
Clears throat

I dedicate this space to Cristiano Ronaldo grin grin cuz I'm happy messi didn't scoscore
Re: Here Are Some silly Questions People Ask by maberry(m): 10:37pm On Jun 06, 2015
Cool
Re: Here Are Some silly Questions People Ask by opeiiwo: 10:37pm On Jun 06, 2015
4. You just wake up from sleep person come ask you "you don wake?" No oh, I come buy bread wey I go chop for dream. .
#
this one got me
Re: Here Are Some silly Questions People Ask by Tee999: 10:37pm On Jun 06, 2015
Really
Re: Here Are Some silly Questions People Ask by Aitee1: 10:37pm On Jun 06, 2015
McEwen:
And Juve lost undecided
Don't tell me in your dream land you expected them to beat almighty barca? angry
Re: Here Are Some silly Questions People Ask by Adeoba10(m): 10:37pm On Jun 06, 2015
You saw a thread on frontpage, and u still dey ask, N DIS MAKE FP? Nooo na backyard yard.

.
You saw a thread on frontpage u still dey ask, how many times will dis make frontpage? Na, 1 million UNGANTABLE time.
Re: Here Are Some silly Questions People Ask by elohorayodele: 10:37pm On Jun 06, 2015
Na wa, Nigerians sabi ask funny questions sha
1 2 3 4 Reply

Silly Questions Nigerians Ask And Their Deserving Answers10 Funny Answers To Common Nigerian silly Questions7 Annoying Questions Naija People Ask And Their Answers234

TB Joshua Reacts To New Gay LawLASG CCTV Van Stuck On Electricity Cables At Abule Egba (photos)Jos: Keke Driver With No Phone Returns Laptop And Wallet Of A Passenger