Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,151,606 members, 7,812,988 topics. Date: Tuesday, 30 April 2024 at 01:50 AM

Nigeria has finished me!! - Politics (2) - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Politics / Nigeria has finished me!! (190200 Views)

[Classified Video, MUST WATCH]: NNAMDI KANU HAS FINISHED NIGERIA!!! / Nigeria Has Finished Me: Lessons Learnt / Nigeia Has Finished Me Rejoinder (2) (3) (4)

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) ... (117) (Reply) (Go Down)

Re: Nigeria has finished me!! by Nobody: 12:11am On Jul 07, 2016
hahaha..chaii.
these guys too funny o
Re: Nigeria has finished me!! by coolestdude01(m): 12:14am On Jul 07, 2016
MaziOmenuko:
Hilarious! The truth in simple and plain language. Me self lock myself for house dey sleep since today, that na why I no fit sleep again.

My paddy say na club him want make we go this night, I don tell am say I get running stomach.
For where, stomach wey never see better food chop, wetin wan run inside am again?
lwkmd. My brother, wetin u think say we fit do na? Me tire oh.

5 Likes

Re: Nigeria has finished me!! by coolestdude01(m): 12:16am On Jul 07, 2016

11 Likes

Re: Nigeria has finished me!! by Nobody: 12:19am On Jul 07, 2016
coolestdude01:
lwkmd. My brother, wetin u think say we fit do na? Me tire oh.

Na d question be that....what's the way forward??

Abi make we gather go aso.rock tell buhari say we no dey comot there until we get better job? if dem wan shoot us make dem shoot?

abi na to use leg run comot from this country?

46 Likes 2 Shares

Re: Nigeria has finished me!! by coolestdude01(m): 12:24am On Jul 07, 2016
DDeliverer:

Na d question be that....what's the way forward??

Abi make we gather go aso.rock tell buhari say we no dey comot there until we get better job? if dem wan shoot us make dem shoot?

abi na to use leg run comot from this country?
Not a bad idea oh..but make them no go shoot person oh. This country wey killing anyhow no be new tin

26 Likes 1 Share

Re: Nigeria has finished me!! by Nobody: 12:29am On Jul 07, 2016
coolestdude01:
what's your point?

Oju zobo ni baba gbe wa ooo

Boys no dey smile at all...Nothing do you. We sabi that life

2 Likes

Re: Nigeria has finished me!! by coolestdude01(m): 12:33am On Jul 07, 2016
OmoAjowa7:

Oju zobo ni baba gbe wa ooo

Boys no dey smile at all...Nothing do you. We sabi that life
e jamisi... Bawo lo le ranmilowo? Fi ona Han mi... Je ka mo way. E jor... E Dakun sad

2 Likes

Re: Nigeria has finished me!! by Nobody: 12:33am On Jul 07, 2016
The funny thing be say boys don dey old....I know my age!

Na around this my age na my dad dey when he marry my momsi....I never even fit take of myself if woman join me...no be die?

Our people go just dey suffer dey lock up...

wetin this one mean??

147 Likes 12 Shares

Re: Nigeria has finished me!! by signature2012(m): 2:00am On Jul 07, 2016
DDeliverer:
The funny thing be say boys don dey old....I know my age!

Na around this my age na my dad dey when he marry my momsi....I never even fit take of myself if woman join me...no be die?

Our people go just dey suffer dey lock up...

wetin this one mean??

Guy,what I will just say is,never give up!

I remember one time I had only a single Jean,na dis Jean I dey wear daily,this tori don tey small o.
One particular day,na so I wear this same Jean,I dey road dey go,something fell for my hand,as I say make I pick am,na so my Jean just dey tear,I just turn am to crazy Jean,but today,things don better,life don change for good,don't rely on any govt but God,so as far life dey,their is hope.

103 Likes 6 Shares

Re: Nigeria has finished me!! by zeberebe: 4:51am On Jul 07, 2016
Izonpikin:
grin grin.....

Guy take am easy...Nigeria tire all of us
tell him

2 Likes

Re: Nigeria has finished me!! by zeberebe: 4:53am On Jul 07, 2016
DDeliverer:

this na laffing matter?

na who don chop dey laff sha....carry on!
lol

1 Like 1 Share

Re: Nigeria has finished me!! by Amberon: 4:59am On Jul 07, 2016
I like your anger. Every Nigerian should be furious. Then and only then can there be a revolution.

108 Likes 6 Shares

Re: Nigeria has finished me!! by Teespice(f): 6:13am On Jul 07, 2016
as much as the op is hilarious, sadly this is the reality most Nigerians are facing today.

since the beginning of this month, I have been thinking about life after NYSC, as per job hunting.

I believe what will be will be.

19 Likes 1 Share

Re: Nigeria has finished me!! by freeage7(m): 6:31am On Jul 07, 2016
Op u say u dey vex? Na play u dey, I vex pass u oo, no just go there...Nigeria don finish oo, we just dey deceive ourselves dey carry on. Imagine inside June, I no see light up to 2hrs put together, PHCN dey give me bill of 12k shuoooo! Bubu say make we get patience, but I ask, does it need to get so bad before it get better...the most daunting task now, na how I won take secure the future of my kids inside this harsh economy...country wey 3 course meal no sure...God punish our leaders both past and present.

58 Likes 9 Shares

Re: Nigeria has finished me!! by MaziOmenuko: 7:08am On Jul 07, 2016
Ee come be like say everything for this country dey harsh, mosquitoes come harsh pass. No insecticide dey kill them again, abi dem don mutate come develope resistance for insecticide. I don spray tire, pour snipper sotey na me the snipper wan come kill. To breathe na wahala, still mosquitoes dey bite, sulk and even chew.

The other day I no sabi as rat take run enter my kitchen. I no even border myself to look for am. I just secure my certificate them because I know say if hunger finish with am for that my kitchen, the next thing him go do na to dey find my certificate. This morning, na so I see the rat lie down for my kitchen. I been think say him don die until I notice say him dey breath small small and dey blink him eyes. I just use broom sweep the thing comot.

The huzzling is real!

434 Likes 75 Shares

Re: Nigeria has finished me!! by Nobody: 7:15am On Jul 07, 2016
MaziOmenuko:
Ee come be like say everything for this country dey harsh, mosquitoes come harsh pass. No insecticide dey kill them again, abi dem don mutate come develope resistance for insecticide. I don spray tire, pour snipper sotey na me the snipper wan come kill. To breathe na wahala, still mosquitoes dey bite, sulk and even chew.

The other day I no sabi as rat take run enter my kitchen. I no even border myself to look for am. I just secure my certificate them because I know say if hunger finish with am for that my kitchen, the next thing him go do na to dey find my certificate. This morning, na so I see the rat lie down for my kitchen. I been think say him don die until I notice say him dey breath small small and dey blink him eyes. I just use broom sweep the thing comot.

The huzzling is real!

oboy, you go try hands on comedy oh..

bovi gat nothing on you oh...

112 Likes 11 Shares

Re: Nigeria has finished me!! by Nobody: 7:16am On Jul 07, 2016
DDeliverer:
As you see me so..I weak..

Boys don dey enter street, some don dey turn to tout, others dey run Yahoo. yahoo, internet fraud , e get a dozen other appellation.. But I no go blame them..I no fit. No be their fault say this country be like this...no be their fault say Some people chose to suck us dry, no be their fault say them wan make ends meet..

Some don turn tout...Few days ago, for one state for this country, one tout celebrate his 1billion naira..tout wey no finish primary six get 1billion and the money still dey increase..you no even get reach 100k ( I just talk 100k to give us level)...some graduates no even get reach 10k for account..

yet, those senators way una dey worship, most of them no go school o....I con dey ask myself how manage? why this country be like this? why this country like force and threat? why dem no dey respect gentle man?

prince akpabio?

1 Like

Re: Nigeria has finished me!! by Nobody: 7:20am On Jul 07, 2016
Teespice:
as much as the op is hilarious, sadly this is the reality most Nigerians are facing today.

since the beginning of this month, I have been thinking about life after NYSC, as per job hunting.

I believe what will be will be.

what will be will be....some people even change am to "what gonna be gonna be"..
all that na still part of the e go better wey we dey talk... but nobody dey talk HOW e go better or WHEN e go better....

You no suppose to stress yourself na....last last, just package yourself, do shakara, one rich bobo go come marry you...you don change to big woman be that na....abi?

52 Likes 2 Shares

Re: Nigeria has finished me!! by Nobody: 7:22am On Jul 07, 2016
Anticorruption:

prince akpabio?
Nah...
Re: Nigeria has finished me!! by Nobody: 7:23am On Jul 07, 2016
signature2012:

Guy,what I will just say is,never give up!

I remember one time I had only a single Jean,na dis Jean I dey wear daily,this tori don tey small o.
One particular day,na so I wear this same Jean,I dey road dey go,something fell for my hand,as I say make I pick am,na so my Jean just dey tear,I just turn am to crazy Jean,but today,things don better,life don change for good,don't rely on any govt but God,so as far life dey,their is hope.

e go better abi??

20 Likes

Re: Nigeria has finished me!! by Almajiri1: 7:24am On Jul 07, 2016
This holy anger needs to be felt on the streets of Nigeria revolution wise.

34 Likes 1 Share

Re: Nigeria has finished me!! by MaziOmenuko: 7:25am On Jul 07, 2016
DDeliverer:

oboy, you go try hands on comedy oh..

bovi gat nothing on you oh...

Na for harsh times na him talent dey come out oo. The most amazing talents are born out of hunger and survival instincts.

Me self don dey try nuture other talents, I don dey discover say I get small ability to control my dream, like say na script me dey write and act am at the same time.
Anytime hunger too wire me, I wash my plate and spoon, keep am under my pillow and sleep off. When I land for dream, food go show!

I come extend this my talent to robbing banks in the dream. I don rob almost all Nigerian banks even cbn for dream; the problem be say the money no dey gree follow me wake up.
I still dey work on perfecting this my skill. Who knows, one day I can be able to drag my stolen wealth from dream to my bed side.

240 Likes 45 Shares

Re: Nigeria has finished me!! by ArodeTsolaye: 7:30am On Jul 07, 2016
Almajiri1:
This holy anger needs to be felt on the streets of Nigeria revolution wise.

nigerian wey get coward blood? According to fela Den go say-
'I no wan die, I no wan quench, I get one child"

People wey God don curse with cowardice.

47 Likes 4 Shares

Re: Nigeria has finished me!! by Nobody: 7:33am On Jul 07, 2016
ArodeTsolaye:

nigerian wey get coward blood? According to fela Den go say- 'I no wan die, I no wan quench, I get one child"
People wey God don curse with cowardice.
nawa oo

8 Likes

Re: Nigeria has finished me!! by megawax8: 7:41am On Jul 07, 2016
Lalasticlala, come and see interesting FP topic.

' A frustrated Nairalander vents' .

But op, its really annoying, that is, the state of the nation presently.

7 Likes

Re: Nigeria has finished me!! by Almajiri1: 7:44am On Jul 07, 2016
ArodeTsolaye:

nigerian wey get coward blood? According to fela Den go say-
'I no wan die, I no wan quench, I get one child"

People wey God don curse with cowardice.
If they fail to fight for their collective good,the law of natural selection expressly comes into play like tis happening. Strictly survival of the strongest.

12 Likes 2 Shares

Re: Nigeria has finished me!! by Teespice(f): 7:55am On Jul 07, 2016
DDeliverer:

what will be will be....some people even change am to "what gonna be gonna be"..
all that na still part of the e go better wey we dey talk... but nobody dey talk HOW e go better or WHEN e go better....

You no suppose to stress yourself na....last last, just package yourself, do shakara, one rich bobo go come marry you...you don change to big woman be that na....abi?

and if that happens, your kind will call me a liability and a gold digger.

last time I checked, nobody wants to be attached to a liability.

your line of reasoning sef leaves so much to be desired.

19 Likes

Re: Nigeria has finished me!! by otokx(m): 7:56am On Jul 07, 2016
Some guys go to building sites and get labour work to keep body and soul together, others join cleaning companies and get paid 20k a month just to survive. Driving work is also available for those of sound mind, high personal hygiene and dedication.
Security jobs nko

These are just to mention a few.

6 Likes

Re: Nigeria has finished me!! by MaziOmenuko: 8:01am On Jul 07, 2016
Enhen! Dem don dey shout make dem carry thread go front-page. Person no fit do small complain, next thing dem don carry am put make the whole world see say u dey complain.

We too like aproko and amebo for this country.

38 Likes

Re: Nigeria has finished me!! by Nobody: 8:04am On Jul 07, 2016
Teespice:

and if that happens, your kind will call me a liability and a gold digger.
last time I checked, nobody wants to be attached to a liability.
your line of reasoning sef leaves so much to be desired.

No vex..I just dey talk am say e dey do me...
Nobody get monopoly to the streets oh..you are very much welcome...

e get one small girl for my area...she jes get belly for area..small girl of about 20...nobody know who give am belly, as she just born, she carry the pikin she her Mumçy...as I dey type so, the girl dey Spain..
she just use leg follow some guys move..

the reason I dey tell u this e say, girls even dey hustle pass guys dese days...

45 Likes 1 Share

Re: Nigeria has finished me!! by HIGHESTPOPORI(m): 8:07am On Jul 07, 2016
DDeliverer:
as I dey here now...my temper dey hot..I dey vex!!

Source of income no dey anywhere..some fools go save 'become an entrepreneur' shey na my kidney go give me capital to take set something up? Abi dem go gree give person loan?

Those foools dey deceive themselves say them dey empower youths...which youths? why we like to dey deceive ourselves? shebi na because Nigerians too quiet na him make dem think say we be mumu?

Boys vex enter street begin play bet9ja, baba ijebu and all whatnot....yet, no level...Games dey cut back to back.. if arsenal no draw, Chelsea go lose...which kind betting boys no try...under 1.5, under 11.5, over? goal.goal..name it..

sowtee we enter virtual betting...losing back to back...Every game was a lost..
see graduates dey play virtual at least to get 1k take recharge phone...

na d kind life human being suppose dey llive?
You funny pass Bovi,try Comedy

4 Likes

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) ... (117) (Reply)

The Remaining States That Will Decide The Winner Of The Presidential Election / Nigerian Defence Academy (NDA) military training (pics) / Abba Kyari Is Dead!

Viewing this topic: 1 guest(s)

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 47
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.