Nigeria has finished me!! - Politics (6) - Nairaland
Nairaland Forum › Nairaland General › Politics › Nigeria has finished me!! (220645 Views)
1 2 3 4 5 6 7 8 9 10 ... 118 Reply (Go Down)
| Re: Nigeria has finished me!! by Hisduchess(f): 6:06pm On Jul 07, 2016 |
MaziOmenuko:bros I don laugh pee for my cloth.u ve got talents ooo.maybe u shld try a bit of comedy ooo.its cos of u am following this thread.kudos Nwa nnaa.jisie ike |
| Re: Nigeria has finished me!! by Nobody: 6:09pm On Jul 07, 2016*. Modified: 3:02pm On Jul 08, 2016 |
Me I no understand again my brother. Some of us wey still dey struggle to go school if we dey hear dis kind thing, I no go lie e dey discourage us wella.... I come dey think say - shey I want leave work wey graduate dey find go school den later later come join the graduates dey look for work? I say na lie o, I go just do part time jeje keep my Job (because the job dey in line with wettin i want study sef)..... As for our Government and country, I no see how the fight of corruption take be distraction for them to do the necessary...... I still dey wonder ![]() As for wettin we go do nau nau? Me I done learn something take the hold body (Vocation), me I dey go clean houses wey go allow me and pay shikini money, I get friend wey done go villa go start farm, I get plenty wey done travel go jand (plenty wey still want travel sef) Wettin we go nau na help ourselves o, anyhow - the how somehow dey for our hand...... |
| Re: Nigeria has finished me!! by vickvilles(m): 6:33pm On Jul 07, 2016 |
Me I dey provoke here, some of us go dey follow fayose case, saraki case and nonsense people case, wen we suppose pursue some people grandpapa commot 4 dis country. Den dey use position dey chop our money dey fool us up and down like people wey nor know how den create dem..any person wey con gist me politics en..God go punish am...na d way forward I wan hear...una dey hear so...demonstration of crazy leaders..their fada. |
| Re: Nigeria has finished me!! by MaziOmenuko: 6:45pm On Jul 07, 2016 |
Shey na when dem gree stamp your visa na him u go fit travel? This one hunger dey show for person face like say na tribal mark, oyibo go look u one eye for embassy realise say hunger don reset ur brain, say if him stamp your visa now, u fit go pregnant all the girls wey dey him country so him go stamp rejection for ur application. Na so I just play-play go apply for one abroad university for masters like say I get shishi to fund am. 24hrs later, dem don approve my application sharp-sharp, grant me provissional admission come dey even call me for phone to go pay school fees sharp-sharp. Na him I realise say the huzzling is real and don dey enter international level. The guy come dey call me for phone every 2 hrs like say him Papa dash mE money for abroad school fees. As I dey so, my brain don block. I know no wether I go even fit find 'x' again for any mathematical equation. Na so we look for 'x' everyday for secondary school like say na we throway am. We come enter university come dey find 'Dee x' like say the one wey we find for secondary school no do them. Shey we don find all 'x' and 'Dee x' finish like say tomorrow no dey, now to get better work na wahala. Na him den dey call me to go pay abroad school fees for masters...God punish them! I don ask the guy for scholarship. The guy say dem go give me 10% off if I pay within 1 month. I don calculate the 10% come tell am make him send me the 10% as cash so that I go complete an with my own money go pay the 100%. Ee be like the guy don realise say na scam me self be. Him don respect himself no call me again. Their father! |
| Re: Nigeria has finished me!! by signature2012(m): 6:49pm On Jul 07, 2016 |
MaziOmenuko:Lol ![]() |
| Re: Nigeria has finished me!! by MaziOmenuko: 6:56pm On Jul 07, 2016 |
Hisduchess:Omalicha NWA, kedu ka imere. Ife a'nalu adiri easy at all! |
| Re: Nigeria has finished me!! by Hisduchess(f): 7:00pm On Jul 07, 2016 |
MaziOmenuko:adi m Mma.ama m na a na eme |
| Re: Nigeria has finished me!! by Nobody: 7:01pm On Jul 07, 2016 |
MaziOmenuko:LMAO.. nna , this boy sef |
| Re: Nigeria has finished me!! by csamii: 7:02pm On Jul 07, 2016 |
jamace:Those people wey dey live close to those rich men no dey hungry. If hunga wire dem like e wire one guy for my street wey vex climb enter one rich man compound. Him no send the barb wire and bottle wey dey the man fence, him no send say na day time. Him just enter kill the man dog wey everybody for that street dey fear, lift am still pass that same fence, come carry am go cook chop. Nigeria don reset many people head especially graduates. |
| Re: Nigeria has finished me!! by MaziOmenuko: 7:05pm On Jul 07, 2016 |
Thoniameek:No try am oo! No be we wey pack our load go live for school like say school na career. We been dey mock people wey dey do part time those days like say our own better. Most of them dey work like u come dey manage part time. As we don laugh them finish, how body be us? Madam, nothing dey campus so no try am! Na only small-small children wey their Papa dey send small money go come dey chase u upandan like say dem fit afford all their fake effizy. If to say I learn mechanic with the 11yrs+ I spend for secondary school and university, I for don be specialist for car maintenance like oga Gazzuzz, mayor and siena them. We carry paper certificate, laminate am like say na precious paper come store am inside folder go hide for inside bag make rat no chop am. Mtchewwww!!!! Abeg, those specialist we I mention, make una no vex when my mention drag una come here wey I dey whine. |
| Re: Nigeria has finished me!! by csamii: 7:22pm On Jul 07, 2016 |
MaziOmenuko:Bros, I laff sotey tears begin roll comot for my eyes. You too funny sha! |
| Re: Nigeria has finished me!! by jamace(m): 7:36pm On Jul 07, 2016 |
csamii: Hunger bad o. |
| Re: Nigeria has finished me!! by MaziOmenuko: 8:04pm On Jul 07, 2016 |
Hisduchess:Obere-obere. Holla me when that ministry finally gets to the permannet site |
| Re: Nigeria has finished me!! by Nobody: 8:23pm On Jul 07, 2016 |
DDeliverer:Don't give up bro. The fact that youre struggling and enduring now means brighter days are ahead if you keep going. Set out a plan and follow it to the bone. |
| Re: Nigeria has finished me!! by ochobaba(m): 8:24pm On Jul 07, 2016 |
DDeliverer:I dunno what you are talking about bro |
| Re: Nigeria has finished me!! by harrysjones(m): 8:26pm On Jul 07, 2016 |
no do am am u fit regret ooo dollyjuke: |
| Re: Nigeria has finished me!! by ToyotaTufiakwa: 8:27pm On Jul 07, 2016 |
DDeliverer:No be your mates dy use Solar ![]() #NdimmaduSef |
| Re: Nigeria has finished me!! by adonshow(m): 8:28pm On Jul 07, 2016 |
DDeliverer:two days small na...my own like months |
| Re: Nigeria has finished me!! by ALAYORMII: 8:28pm On Jul 07, 2016 |
DDeliverer:On the issue of light, we've been enjoying that abundantly in my area Since on Monday till late night Wednesday our light didn't even blink As am writing this, am watching the engager comedy on TVC. Light full here ooo |
| Re: Nigeria has finished me!! by MaziOmenuko: 8:28pm On Jul 07, 2016 |
I talk am! Shey dem don carry the thread go put for front page. Person no kukuma get privacy again! No where is safe to even lament again. Abeg, make I go my diary go lament, make I see who go carry am put front page again. Aproko and amebo people. Ddeliverer, abeg we go yarn later, make we write this our epistle for book see if that one go pay. |
| Re: Nigeria has finished me!! by ToyotaTufiakwa: 8:29pm On Jul 07, 2016 |
DDeliverer:No be your mates day use Solar ?? |
| Re: Nigeria has finished me!! by ALAYORMII: 8:30pm On Jul 07, 2016 |
DDeliverer:On the issue of job, if you see any vacancy, I no mind ooo Am tired of Nigeria in that regard |
| Re: Nigeria has finished me!! by Oyimeoyimemua(f): 8:33pm On Jul 07, 2016 |
its rather unfortunate that d youth of this country are at d receiving end .the gap between the rich and d poor is getting wider,i just pray it won't get to a point where some people will be stoned |
| Re: Nigeria has finished me!! by johnstar(m): 8:34pm On Jul 07, 2016 |
DDeliverer:hw fa dat guy, shey him don reason una funds ![]() |
| Re: Nigeria has finished me!! by annnikky(f): 8:36pm On Jul 07, 2016 |
MaziOmenuko: ![]() |
| Re: Nigeria has finished me!! by ALAYORMII: 8:36pm On Jul 07, 2016 |
DDeliverer:On the issue of becoming an entrepreneur I just look at some people and shake my head The money to establish no dey, if that one dey Nigerian economy go kill you |
| Re: Nigeria has finished me!! by johnstar(m): 8:37pm On Jul 07, 2016 |
MaziOmenuko:lolz weytn u expect na, dm wnt make nairalanders help us, only if we no go see some greedy and stingy ppl wey no go gree help us .. Dat guy don snd una moni so? |
| Re: Nigeria has finished me!! by Nobody: 8:37pm On Jul 07, 2016 |
DDeliverer:. Na 2 days make U dey shout? For my area we don nearly do 2 months no light NEPA carry our transformer go. we don talk tire |
| Re: Nigeria has finished me!! by Nobody: 8:37pm On Jul 07, 2016 |
MaziOmenuko:odogwu..na man you be..I go hala you later.. make I go hustle kerosene warm indomie.. |
| Re: Nigeria has finished me!! by teamobanabo(m): 8:39pm On Jul 07, 2016 |
| Re: Nigeria has finished me!! by Nobody: 8:39pm On Jul 07, 2016 |
johnstar:lol , I no know o...na foxyflows suppose know.. |
| Re: Nigeria has finished me!! by Revolva(m): 8:40pm On Jul 07, 2016 |
Hahhha. Truth naija don taya person oo naija na 7 steps to hellfire Oga no masturbate too much oo olosho ashewo full everywhere now just save some small tin o all girls now na ashewo runs codedly dem de do I don catch our neigbour de do runs twice even my guys sef don catch theirs. |
[Classified Video, MUST WATCH]: NNAMDI KANU HAS FINISHED NIGERIA!!! • Nigeria Has Finished Me: Lessons Learnt • Nigeia Has Finished Me Rejoinder • 2 • 3 • 4
List Of Buhari's 36 Ministers And Their Portfolios • Jega To Announce Presidential Election Results: Part 2 • List Of Private Jet Owners In Nigeria (pictures)

