Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,148,903 members, 7,802,929 topics. Date: Saturday, 20 April 2024 at 03:50 AM

Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest - Culture - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Culture / Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest (37309 Views)

Words From The Epie Language Of Yenagoa. / Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up / Pidgin Words, Meaning And Origin You Need To Know (2) (3) (4)

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) ... (14) (Reply) (Go Down)

Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Sinistami(m): 8:15pm On Sep 29, 2018
Ehehn! Why I open this thread be say everybody don de too Binu for Pidgin leadership for this Naija as e stand. So now ehn I wan make we for do proper Pidgin Battle. Una de hia me so! I de rep Yenagoa. I lap this thread ruggedly. so make una kpompi small, make I for be Judge. Oyaaa! Show una Self!

The Rules be say. wen pesin throwey Slang come another person go try decode am if e no fit then im fail I go de give points according to person weh trowey slang pass and pesin weh decode slang pass!

34 Likes 3 Shares

Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by cooldipo(m): 8:16pm On Sep 29, 2018
I wan learn grin

20 Likes 2 Shares

Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Sinistami(m): 8:18pm On Sep 29, 2018
OK sure say your mendolla fit chest am

19 Likes 3 Shares

Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Sinistami(m): 8:58pm On Sep 29, 2018
Okay na me de start am

Abobi Na so e go o! Yesterday me and Padimina bin lap im Wari , tanda for I'm Veranda. we bin de plan to go Lap Ozed junction carry small pololo make man no Kon go de rub mej for night. nai before we knw Area Men for the Area Kon start Para nai we GATS sub enter im hass (House) o. Nai wen tins don jant small nai my Bross Kon go say im wan go sight how the outside be o. Nai Ojo begin bust out. Dive am say I'm mus join for the Boys wen just raks na na. No be small tin o now my Padiman de Sanko as e stand so. But Sha as I reach my way DAT Night, My Banni lap me. Omo she fear kpanshin

149 Likes 7 Shares

Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Nobody: 9:14pm On Sep 29, 2018
First of all I rep Benin
As for the pigin matter nah we Benin invent am ..Benin is the home of pigin infact e everything for benin nah with pigin,baba the matter serious ooh..I swear bayelsa they learn, davido admit for Benin radio station say skelewo nah slag for Benin

45 Likes 6 Shares

Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Sinistami(m): 9:25pm On Sep 29, 2018
Jesse25:
First of all I rep Benin
As for the pigin matter nah we Benin invent am ..Benin is the home of pigin infact e everything for benin nah with pigin,baba the matter serious ooh..I swear bayelsa they learn, davido admit for Benin radio station say skelewo nah slag for Benin

We Yeniz Men no de buga plenti. but Bross I sure say Waffi men go follo you Nak teeth for that yan. and Padi man try decode my pidgin weh I nak dia nor vex.

91 Likes 4 Shares

Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Sinistami(m): 9:38pm On Sep 29, 2018
cooldipo:
I wan learn grin
Sure say your Mendolla fit chest am!

14 Likes

Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Anduku: 5:39am On Sep 30, 2018
Nonsense

8 Likes 3 Shares

Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Sinistami(m): 12:47pm On Sep 30, 2018
Anduku:
Nonsense
Wetin be ur own wahala

51 Likes 1 Share

Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Sinistami(m): 12:57pm On Sep 30, 2018
Anduku:
Nonsense

OK its rubbish but you still wasted your time commenting on it just to follow it. Ofurukpe Nigga

113 Likes 3 Shares

Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Nobody: 1:23pm On Sep 30, 2018
Sinistami:


We Yeniz Men no de buga plenti. but Bross I sure say Waffi men go follo you Nak teeth for that yan. and Padi man try decode my pidgin weh I nak dia nor vex.
When you don knack para finish let me know, I go complete am for you, well sha happy Sunday

4 Likes 1 Share

Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Sinistami(m): 1:25pm On Sep 30, 2018
Jesse25:

When you don knack para finish let me know, I go complete am for you, well sha happy Sunday

No shakin na Happy Sunday give u back

1 Like

Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Nobody: 1:28pm On Sep 30, 2018
Sinistami:


No shakin na Happy Sunday give u back
No take it back in full.... cheesy

6 Likes

Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by tonzo(m): 7:47am On Oct 01, 2018
Pele(sapele)naim be d ogbonge home of pidgin langua
How Una Marra be for here sef
No be say dem say ,I rep waff city.happy miliki to our obodo naija today.
As we dey shayo today make we use we ankaras take do evri sofri sofri.ekelebe no get say to dey if dem do anyhow dem go do go collect anyhow.

Driver dropping dey,make I enta Hausa quarters go change 100dolomi to naija kpogiri
I hail all the Sabi people for this Kuban

133 Likes 7 Shares

Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Sinistami(m): 2:09pm On Oct 01, 2018
tonzo:
Pele(sapele)naim be d ogbonge home of pidgin langua
How Una Marra be for here sef
No be say dem say ,I rep waff city.happy miliki to our obodo naija today.
As we dey shayo today make we use we ankaras take do evri sofri sofri.ekelebe no get say to dey if dem do anyhow dem go do go collect anyhow.

Driver dropping dey,make I enta Hausa quarters go change 100dolomi to naija kpogiri
I hail all the Sabi people for this Kuban

I Sight you! Your face de Show Boloko I de feel Your yans scatter for this Obodo Bayelsa weh I tanda so. but make I try decode that Yan wen you yan for there sha.

Sapele is the real home of Pidgin. How are you people here? Its not that I rep Warri city. Happy indepence day to Nigeria. As we are partying let's use Ankaras and do everything Softly. The police don't have a say because if they do it's to they own detriment.
Driver I need to come down let me go into Hausa quarters and change a 100 Dollars to Naira. I salute every knowing person in this Thread.

71 Likes 5 Shares

Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Ishilove: 3:02pm On Oct 01, 2018
Sinistami:
Okay na me de start am

Abobi Na so e go o! Yesterday me and Padimina bin lap im Wari , tanda for I'm Veranda. we bin de plan to go Lap Ozed junction carry small pololo make man no Kon go de rub mej for night. nai before we knw Area Men for the Area Kon start Para nai we GATS sub enter im hass (House) o. Nai wen tins don jant small nai my Bross Kon go say im wan go sight how the outside be o. Nai Ojo begin bust out. Dive am say I'm mus join for the Boys wen just raks na na. No be small tin o now my Padiman de Sanko as e stand so. But Sha as I reach my way DAT Night, My Banni lap me. Omo she fear kpanshin
You speak in esoteric tongues... undecided

13 Likes

Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Ishilove: 3:05pm On Oct 01, 2018
Sinistami:


I Sight you! Your face de Show Boloko I de feel Your yans scatter for this Obodo Bayelsa weh I tanda so. but make I try decode that Yan wen you yan for there sha.

Sapele is the real home of Pidgin. How are you people here? Its not that I rep Warriors city. Happy indepence day to Nigeria. As we are partying let's use Ankaras and do everything Softly. The police don't have a say because if they do it's to they own detriment.
Driver I need to come down let me go into Hausa quarters and change a 100 Dollars to Naira. I salute every knowing person in this Thread.
How on Earth did you decode that?! My eyes glazed over halfway through

11 Likes

Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Anijay1212(m): 3:24pm On Oct 01, 2018
Chisos !!!
See as boys dey lap pidgin like say notin dey happen.
Dis one wey i see so e mean say nah o level i still dey o...
Wait o... Na who dey misyarn under me so abi Bubu purshu am for dream,but i suspect say im village people dom pay am visit or my weight dey press am too much on top im head.
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Samsimple(m): 3:25pm On Oct 01, 2018
This tread is as lifeless as our president..

*spits*
person wey quote me make e remember say "yansh no get teeth but e dey cut sh!t"

25 Likes 1 Share

Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Livebygrace: 3:25pm On Oct 01, 2018
Pigin galore
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by OBTMOS(m): 3:26pm On Oct 01, 2018
We.die here

1 Like

Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Jerrick(m): 3:26pm On Oct 01, 2018
This is promising grin

1 Like

Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by SocialJustice: 3:27pm On Oct 01, 2018
Jesse25:
First of all I rep Benin
As for the pigin matter nah we Benin invent am ..Benin is the home of pigin infact e everything for benin nah with pigin,baba the matter serious ooh..I swear bayelsa they learn, davido admit for Benin radio station say skelewo nah slag for Benin
Go sit down one place. Bini boys speak Bini, them no sabi pidgin. When them dey parliament, you no go ever hear pidgin only bini

16 Likes

Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Righteousness89(m): 3:27pm On Oct 01, 2018
Ty
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Amberon1: 3:27pm On Oct 01, 2018
lipsrsealed
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Nobody: 3:27pm On Oct 01, 2018
Oh na na na na, omo, its Paper boi, you know the voltage nah
It’s your boi Erigga Paper boi & Graham D baba
Omo E get wetin play when ah go Accra recently mehn!
Ah nor fit yarn am, so ah gats put, ah gats express am through music you understand
About my guy Okiemute



Okiemute say like this he wan go join HK
For Accra nothing dey him hand only 10k
Eribaba believe me ah nor be JK
Before ah waka we fit gather smoke your SK
As we dey smoke ah tell am say na Akanuche
E work for me nor mean say e go work for Uche
He say Erigga lock up, who I wan follow pench
Na my real guy beside, ah dey expect one cash
On he way to Lagos he receive alert
Family land na he sell the boi too get heart
Enter Accra, he guys dey hail am Bossu
He nor dey hustle every night steady bottle
If dem wan cook for house nai him dey go withdraw
Small small big Man for Accra don poor
Nobody tell am around 10 o’clock for night
Dem send am message lock gate, fling him things outside



Habeg!!!
According to brother Shaggy
Oyibo talk say, patience na virtue is okay thank you
The same kpo wey we smoke write better music
Some other artiste smoke am wetin dem sing stupid
Are you feeling me? Or should I repeat
No be everybody be your man inside this street
Boiz don fall person because of yeye pick up
For my present police throw am for pick up
Okiemute come area we ask am wetin sup
For like 2 days ah swear my guy no gree talk
Only to hear say he say where dem carry am go
Dem give am knife shook mirror but nah him mama show
He say he nor fit use him mama na him make am discharge
Say around 10 o’clock for night he enter road come Lag
Forgetting say everything wey dey happen for Accra, area don hear the real gist ah wan laugh belle scatter



Because E work for Mr A like that
No mean say E go work ki for Mr B like that
Because your friend travel go Ghana en make him money
You think say if you travel you go make am too
Use your sense waka no be leg
The hustle wey we dey so na God abeg
If not for the Streets, boiz for dey beg
Na only God fit to change leggedis to Benz





Note: this song is dedicated to all the Great men out there and also through all this inspiration some of us are living gracefully now


Work and pray.

31 Likes 2 Shares

Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by gaby(m): 3:27pm On Oct 01, 2018
Lol...

No keys to take kpokish di original pigin slang for all d keyboards wey dey d world...

3 Likes

Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by eendy(f): 3:27pm On Oct 01, 2018
Na warri nai pidgin English take hand teh touch ground... e get how go even tidy the pidgin pass enh you go weak for yoursef ... I wonder why kpomo men go dey bring this kind argument.

if warri use pidgin take tidy matters for you... you go feel am

13 Likes 1 Share

Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by ehis05(m): 3:28pm On Oct 01, 2018
Sinistami:
Okay na me de start am

Abobi Na so e go o! Yesterday me and Padimina bin lap im Wari , tanda for I'm Veranda. we bin de plan to go Lap Ozed junction carry small pololo make man no Kon go de rub mej for night. nai before we knw Area Men for the Area Kon start Para nai we GATS sub enter im hass (House) o. Nai wen tins don jant small nai my Bross Kon go say im wan go sight how the outside be o. Nai Ojo begin bust out. Dive am say I'm mus join for the Boys wen just raks na na. No be small tin o now my Padiman de Sanko as e stand so. But Sha as I reach my way DAT Night, My Banni lap me. Omo she fear kpanshin
chai dis one is strong

4 Likes

Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by SoftP(m): 3:28pm On Oct 01, 2018
See all dis ofurukpe wey never taste street dey drag oil with Warri...
For warri to dey dat list naa under rating
Ishii

24 Likes 1 Share

Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by BruncleZuma: 3:28pm On Oct 01, 2018
grin grin grin grin

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) ... (14) (Reply)

Oba Adewale Akanbi Drives His G-wagon In Canada. Photos / Olu Of Warri, Wife Holiday In Ghana, Meet President Akufo-Addo (Photos) / Oba Of Benin Detains Nelson Oghogho, Palace Aide (Photos)

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 40
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.