Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / NewStats: 3,150,902 members, 7,810,467 topics. Date: Saturday, 27 April 2024 at 09:34 AM |
Nairaland Forum / Nairaland / General / Culture / Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest (37399 Views)
Words From The Epie Language Of Yenagoa. / Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up / Pidgin Words, Meaning And Origin You Need To Know (2) (3) (4)
(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) ... (14) (Reply) (Go Down)
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by infinito1990(m): 4:38pm On Oct 01, 2018 |
Sinistami: Wetin you dey try yan be say You and your guy won go run lash ashi for ozed junction nai kporkpor go show for area Nai men discharge but base on say your guy won go observe the area weda dem don march Nai dem gbab am join The guy crash station till dawn You self con go comb your banni with pepper eye 2 Likes |
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Captain0147: 4:39pm On Oct 01, 2018 |
Area Area.. na we dey run am I Rep Safi and wafi..make all men pep for 1side.. Bros and sist like this eh. boys dey.. Paranod we dey Benu..we vex.no joy .. waiting dey sup.. 9ja @58 don cast..after akada no job.. . No � light. No wale..koti and Congo.. just dey wan area boys barack..i enter cartel go buy poo..as I dey fall out Congo and koti alain with me say I don Bleep up to dey..blow weed 4 street ..& monkey tia bros b4 dem code as a warri boy I don discharge enter zanga.. B4 I zab he be like film..for them eye.. Bros make I pack well body dry hurt letter things we go alian 0147 for life only real men. |
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by kvngjesse(m): 4:39pm On Oct 01, 2018 |
#Warri |
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by mildflame: 4:41pm On Oct 01, 2018 |
safarigirl: madam dis no be sports yarn abeg, use pidgin teach small pikin and use dis grammar wey u de scatter here see which one go simple pass |
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Taeewo(m): 4:42pm On Oct 01, 2018 |
he be like say una wan make i use galagala comot una head? abi una want make i sell una to galan galan paper n gala. |
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Onugbu(m): 4:42pm On Oct 01, 2018 |
Sinistami:Original cairo entity, baba i feel u |
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by tinktanker: 4:43pm On Oct 01, 2018 |
Dronedude:u sharp |
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Bryan88(m): 4:43pm On Oct 01, 2018 |
Jesse25:'Benin is the home of pigin?' Bros that thing na pure english u speak so ooo...Shuuu!!! You fall hand die! |
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by nelronaldo(m): 4:43pm On Oct 01, 2018 |
nosagold:LWKM |
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Onugbu(m): 4:43pm On Oct 01, 2018 |
Captain0147:For those wey no decode, na port Harcourt de nigga de rep 1 Like |
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Bigvirus: 4:44pm On Oct 01, 2018 |
mtchewwww !!!!! men dey here dey form okorlormor say dem Sabi speak pidgin English. nah d accent be pidgin ooooo if una nor know. slangs join sha. listen to warri pidgin accent & be d judge ursef. |
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Bizibi(m): 4:44pm On Oct 01, 2018 |
I greet una oooo!!! |
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by WarriAproko: 4:44pm On Oct 01, 2018 |
I dey downtown dey reason dey take sk. Naso ekelebe burstenter were bra dem dey. Omo see as everybody gbes. Koti hold me cus bodi dun down with sk and mokite. Dem carry me go lodge dat night for calarbar man hotel wen dey eboh. Daybreak koti say make i hala my people make dem come pay for d night wen i pass. Dem charge me 20grand. I say i dun die. Who send make i leave my zanga go downtown. Koti threaten me say nah high college dem go move me enter soon. Naso i vess load Calarbar man slap.. Nah ones sombody pour me holywater say why i dey gbege for dream... 2 Likes |
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by eduminati(m): 4:44pm On Oct 01, 2018 |
Jesse25:Tah shurrrrrup your mouth there. I be correct Warri boy. Okumagba area for that matter. Na area be pidgin for Nigeria. You get mind ooo. I graduate from Uniben and Benin no get level at all for pidgin. I come here with full attack and I mean am well. Warri people go say "na pikin wey no know the value of toto dey pack sand put." Na Warri be number one so you better put the respeck for our name. If you be area Abeg like am. I use this medium to hail our ogbe Ijaw, ekurede urhobo, ekurede Itsekiri, Okumagba, agbassa, iyara, edjeba, ugborikoko people etc. You no dey match line at all. Benin, ph, Bayelsa dey trek for where we dey. 2 Likes |
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Evangkatsoulis: 4:44pm On Oct 01, 2018 |
Sinistami: "No b say dem say, I rep warri" actually means he reps warri. |
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by mildflame: 4:44pm On Oct 01, 2018 |
Barfibassey: na nija babe OYINGBO things too de her head especially sports |
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by eduminati(m): 4:45pm On Oct 01, 2018 |
Jesse25: Tah shurrrrrup your mouth there. I be correct Warri boy. Okumagba area for that matter. Na area be pidgin for Nigeria. You get mind ooo. I graduate from Uniben and Benin no get level at all for pidgin. I come here with full attack and I mean am well. Warri people go say "na pikin wey no know the value of toto dey pack sand put." Na Warri be number one so you better put the respeck for our name. If you be area Abeg like am. I use this medium to hail our ogbe Ijaw, ekurede urhobo, ekurede Itsekiri, Okumagba, agbassa, iyara, edjeba, ugborikoko people etc. You no dey match line at all. Benin, ph, Bayelsa dey trek for where we dey. |
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by BlindAngel: 4:46pm On Oct 01, 2018 |
SocialJustice: I tire for the guy mata ooo, just dey yarn dust... bini that they speak only bini only, that guy funny sha |
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by HardMirror(m): 4:47pm On Oct 01, 2018 |
Sinistami:make we use our sense not ankara. You miss that part bro. Na you be the reall gee for this pidgin. |
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by WarriAproko: 4:52pm On Oct 01, 2018 |
People wen dey stay agbarho go still claim say dem dey stay warri. To me the people wen their pidgin langua tight nah efurun and warri south...expecially the agbassa, igbudu, okere, edjeba, ogborikoko, ekpan, okumagba,iyara, ukuredeurhobo, odumusobo, Dumurie for effurun, alegbor.. All this area pidgin touch ground finish. Dem fit sell u with pidgin if ur eyes nor strong |
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by safarigirl(f): 4:52pm On Oct 01, 2018 |
mildflame:and what has become of all the kids wey dem use pidgin teach? How many of them don dey run things for ICT or anything sef in the world? E simple finish, na him na people wey dem no use pidgin teach dey make better progress for this life. The only thing pidgin is good for is comedy, na where pidgin children dey reach, that is for the ones wey no turn militant. Once again, not everyone in Nigeria is versed in pidgin. In the North, even pidgin dey hard most of them. Pesin wey go sabi go sabi, irrespective of language used and pesin wey no sabi, no sabi. 2 Likes 1 Share |
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by WarriAproko: 4:55pm On Oct 01, 2018 |
They recognize wafi because of their pidgin langua. And dem dey rep for any were dem dey.he nor dey hide. Wen i serve for kwara state. With my langua and character dem know once say i be from wafi... |
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by WarriAproko: 4:56pm On Oct 01, 2018 |
safarigirl:sharap.if u nor know. |
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by safarigirl(f): 4:57pm On Oct 01, 2018 |
WarriAproko:shift abeg. You wey know, where e carry you reach? |
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by khalazi: 4:58pm On Oct 01, 2018 |
Jon3nity:Lol omo I no too sabi like that o. But how man go do |
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by WarriAproko: 4:58pm On Oct 01, 2018 |
safarigirl:ofurukpe, oyenda. See dis skeleton ayangba wan still yarn.. |
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by ceeceeco: 4:58pm On Oct 01, 2018 |
I rep PH. See as all of una just dey drink caprisonne anyhow, abeg make una chew gala small kwanu. Abobi shun mata for Mattias, dis your mata don dey tie wrapper. cum wey u, u no dey kpor face? wipe ur goggle well o make I no change am for u. #OGBUNABALIBOIZNODEYCARILAST# |
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by mildflame: 4:58pm On Oct 01, 2018 |
safarigirl: but who de teace dem things for ICT with pidgin, u don see any pidgin textbook b4....oyingbo things too plenty for ur HEAD no be small |
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by WarriAproko: 5:00pm On Oct 01, 2018 |
safarigirl:Make i change to english because of ur pic wen i see. Babe how is you. |
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by CheapDataGuy: 5:00pm On Oct 01, 2018 |
Chaii all ths pidgin big pass mee. Na e be say i never sabi pidgin sef b dat |
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by safarigirl(f): 5:04pm On Oct 01, 2018 |
mildflame:if they have teachers, can't they teach them in pidgin? Can't they interprete these things? As it stands, pidgin is associated with thuggery, semi-illiteracy and comedy. Hardly any positives, it is also a limiting factor because as sweet as it sounds, it has its limit. You can not really do big things with pidgin. |
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by SocialJustice: 5:05pm On Oct 01, 2018 |
BlindAngel:You know say some niggiz dey like want buga. |
(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) ... (14) (Reply)
Olu Of Warri, Wife Holiday In Ghana, Meet President Akufo-Addo (Photos) / Oba Of Benin Detains Nelson Oghogho, Palace Aide (Photos) / I Removed 800-year-old Palace Deity As I’m Above Idols –oluwo Of Iwo
Viewing this topic: 1 guest(s)
(Go Up)
Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 51 |