Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / NewStats: 3,153,877 members, 7,821,052 topics. Date: Wednesday, 08 May 2024 at 07:28 AM |
Nairaland Forum / Nairaland / General / Culture / Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest (37532 Views)
Words From The Epie Language Of Yenagoa. / Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up / Pidgin Words, Meaning And Origin You Need To Know (2) (3) (4)
(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) ... (14) (Reply) (Go Down)
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Barfibassey(m): 5:10pm On Oct 01, 2018 |
I salute all dey boys and girls were dey follow shuku mouth for dis mata, who nah too much naija we no dey carri last....Op nah beta oil dey ur head twale 4u baba but you Bleep up sey you no mention Akwa-cross side 1 Like |
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by AreaFada2: 5:10pm On Oct 01, 2018 |
Nobodi fit nack pidgin like Benin boys. Pidgin don kolobi DNA 4 dia sef. 1 Like |
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by maxzzo1(m): 5:10pm On Oct 01, 2018 |
Who goes der? |
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by ibori1(m): 5:11pm On Oct 01, 2018 |
na waffi get pidgin na, any oda pidgins na ogbolor waffi I hail oooo |
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by DeRay98(m): 5:12pm On Oct 01, 2018 |
Pidgin na Edo/Delta(Bendel) get am but na Delta dey more sabi re-invent new word for pidgin pass Edo. I rep Edo but I tro hand for wafi people. 2 Likes |
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Adakintroy: 5:15pm On Oct 01, 2018 |
The only thing we get pass oil, na slang. Like lakpalakpa the thing full our head. Like craw. Craw..the thing full body. Benin go start from children Chappell. No vex. Na we get talk.. no put us for talk. Say make we come drag pidgin with who?..una be funny ancenstors.. We no DE speak correct English for warri, senior men DE dodge am. English na sweet mouth. Real matter. Pidgin English DE free us...na our symbol. Confirm am. 1 Like |
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by noruwasman(m): 5:16pm On Oct 01, 2018 |
kikilove: oshere take am easy na, your bobo fit come from Bini oh, you neva can tell |
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by cardiorap: 5:19pm On Oct 01, 2018 |
On how e be men don lap, two seconds. Make I just position one side dey observe. Even though say me I dey rep Pitakwa wella, abobi, with my full orientation, I dey troway salute for Warri pidgin. Comot Warri for the list, then we go yarn and cap you the koko say for the Pidgin matters, na PH top am. |
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by anath(m): 5:19pm On Oct 01, 2018 |
The mara tire me, lik dis lik dis old mama for Sapele go use even beni boys tk shine for d lvl so tay na waf town con join dat list. OP I nor blame u sha, we dy observe u.... |
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Lothbrok(m): 5:19pm On Oct 01, 2018 |
Sinistami: There is a huge difference between pidgin and capping. . All the Germans on this thread should capless for the days are evil. . . Apply 99.1 |
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by infinito1990(m): 5:21pm On Oct 01, 2018 |
Sinistami: Waffi I dey hail ooo I greet d house specially Na our papa dem talk say 'Ear way nor hear word go follow the head go ground' Nobody 5 Kobo state fit drag pidgin with waff town especially Uvwie Udu and WARRI E don tail wen we dey tear pidgin Small pikin way think say he fit use he touch count he teeth nor go old pass he papa |
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Nobody: 5:23pm On Oct 01, 2018 |
Sinistami: I rep Ph city nd waffi no wori urself. 2 secs make i decode dat ur chaise cappings Yesterday me n my guy go lap in house, sit down 4 in frontage, we bin plan to go ashawo house cari okpo so our preek no go too wori us 4 nite. B4 we knw Area boys burst out na we run enta house, wen tins com cool smal na my bros say make e check outside, na police burst out we area, dive am give am charge say e follow d area men buga nana, no b small mata o, bros dey jail nw but me still reach my house dat nite, My girl com around, omo d way i Bleep her, she fear life.. |
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Ssalk: 5:25pm On Oct 01, 2018 |
I just dey see all Dese jemperepete pipo wan dey follow Benin dey do chest 4 pigin mata. Na only igbudu and efurun 4 waffi go fit dey Rob shoulder wit beni. una dey learn. |
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by mildflame: 5:25pm On Oct 01, 2018 |
safarigirl: na wa o! na wa o! see how u just murder pidgin, shey pidgin no be language like d GRAMMAR wey u de speak, like any language other wey GOD create. Those days RAP and HIP HOP na 4 ghetto pple but see wey rap/hip hop de now, abi you no see how 2face and other guys don carry pidgin pass where FELA stop. Abeg OYINGBO MADAM join and take pidgin to d next level nu de condemn am like this na, pidigin de for BBC de for DSTV small time we go de everywhere 4d WORLD join d train fot pidgin in nursery and seconary school in NAIJA |
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by killuminati(m): 5:27pm On Oct 01, 2018 |
Sinistami:Omo dis ya yarns strong wela. But man code base on Lag Barracks tinns. How e come go with ya Padiman? |
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Kezee360(m): 5:30pm On Oct 01, 2018 |
Warri ,who dey the caban make we go blast |
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by killuminati(m): 5:32pm On Oct 01, 2018 |
tonzo:Baba, I salute you. I ball for Warri 2016, shey u sabi ogbolopkoso area? I dey flex one hotel for dat corner. I wan even ball in next week so |
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by BillgatesMaigad(m): 5:33pm On Oct 01, 2018 |
As I dey here so ehn, me dey vex like this and I fit burst person head. E get this geh wey I try package this morning for my area, the banny set nor be small. Correct back with soft face like today bread. I on the babi then she yarn me sey she don already reach my area. Na so I sharpaly enter the nearest pharmacy to arrange Tboy to wage my conscience, I kuku from dia collect 4litres of fuels for my gen onto sey obabi go full ground remain. 2minutes larra I con on the babi oh......she nor pick call, I on am again, and again. Obobs as I dey yarn una so ehn the babi don off phone. Thunder which level Dat geh ehn E nor go beta for her. All dis yeye gehs for this portharcourt wey use correct guys like us dey play ehn, one day una cup go full. |
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Sinistami(m): 5:34pm On Oct 01, 2018 |
Edoziesmart: Abobi your Face de Shoe Boloki. Mi na Amarata Ebis street. Flood Neva reach My way Sha. make our two gather rep yentown for this Kabal na. be like Waffi men don full the place kperere. 2 Likes |
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Sinistami(m): 5:36pm On Oct 01, 2018 |
HMZi: I sight you which Unit you de rep? |
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by oshe11: 5:37pm On Oct 01, 2018 |
Sinistami:Honestly I feel its an Insult to compare Waffi pidgin with any other..... Las las if im burst people go realise say na Mumu their head stand ontop As for your yarnings up there..... If I no decode wetin I gain..... Sha no give ur ella belle and hope u cari food go give u guy for jail.... Me I deg down for my AP dey clean my lashes.... |
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by reciprokal: 5:40pm On Oct 01, 2018 |
Jesse25:As a Uniben graduate, the first language in Benin is Bini. No two Bini people speak pidgin to each other as their default language. 1 Like |
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Mizwisdom(f): 5:40pm On Oct 01, 2018 |
Pipu wey de speak pidgin as language no de for here, wey ma Ikom, Ogoja, Obudu, Bekwarra pipu? Make una no mind these local champions wey full for here de speak slangs wey no get head dem no no how far. |
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Glory147: 5:40pm On Oct 01, 2018 |
Everybody sharap dia!!! Una forget say they no dey pursue black goat for night Una wan come dey follow delta boys hold ground for pidgin English when our mama take born us, train us, until today.. E BE LIKE SAY UNA KISS CRASE. Any where for this world when I go, I dey rep SAFFI.. And for this matter when una dey yan, I want drop one small gist. Base on one or two matters when play for my end yesterday, unto say they Kane one smally lappy for hostel, all men gat discharge because we know say last last koti go show as anybody they meet na suspect.. Na so I just discharge enter one side where I know say I fit sleep close eye. I nor know say na carry waka I dey carry Waka. As I reach my guy end for where I cut out go, we just flex every where just good base on say body done kpra na once I Lego... The next thing when I hear na one hot sandin nai I hear for my ear na so I jump wake, my body done soak.. E no tey nai my eye clear say be like na dream oooooo. But before I know I just hear one babe dey shout say ""my lappy, my lappy, they done move my lappy. "" Nai I say shwoooo be like this dream wan turn to krokro matter oooooo.. Like this I done dey arrange to discharge cos last last koti fill still fall out. MAKE I TELL UNA SOMETHING. Pidgin English no mean say you go dey yan apata.. Na langua when e be say when you yan am, e dey sweet and e dey Jones for belle... You and who you dey yan with dey code every but any other ofrukpe nigga when wan put ear for the matter no go fit follow up. |
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Sinistami(m): 5:41pm On Oct 01, 2018 |
TroubleMaker47: You don code am for normal pidgin weh even Lagos peeps fit understand. you try Sha |
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by surveyProf(m): 5:41pm On Oct 01, 2018 |
safarigirl: Correct madam, ur head dey der.... |
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Odunharry(m): 5:42pm On Oct 01, 2018 |
All die na die.. Una face show well |
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by yublings(m): 5:42pm On Oct 01, 2018 |
wen my padi sight my leg e hail, im mouth no fit close naim e cut for me. On a normal day na so we dey role base on say everything soft. But like dis like dis man gas kpro becos wizo too many for street. Any how e be sha I dey always soji becos at anytime man fit gbeys. I rep pele (sapele). Make una decode. |
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by ibkayee(f): 5:43pm On Oct 01, 2018 |
Wetin dey 1 Like |
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by reciprokal: 5:44pm On Oct 01, 2018 |
Sinistami: This is area slang! Not necessary mastery of pidgin English. In many pidgin English areas, slangs are demographic and never general. Only few slangs becomes acceptable as general slangs. Mastery of pidgin English is more pronounced in fluency in speaking without having an underlying tribal accent at the background. It is never by slangs per say as every street and area get their own slangs and only one or two become acceptable and generalised by the pidgin community . 2 Likes 1 Share |
(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) ... (14) (Reply)
Oba Of Benin Detains Nelson Oghogho, Palace Aide (Photos) / "I Haven’t Adopted The Title Of An Emir" - Oluwo Of Iwo Oba Abdul-Rasheed Akanbi / Masquerade Seriously Beats An Okada Rider (video)
(Go Up)
Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 57 |