Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,149,809 members, 7,806,264 topics. Date: Tuesday, 23 April 2024 at 01:45 PM

Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest - Culture (7) - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Culture / Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest (37340 Views)

Words From The Epie Language Of Yenagoa. / Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up / Pidgin Words, Meaning And Origin You Need To Know (2) (3) (4)

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) ... (14) (Reply) (Go Down)

Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Barfibassey(m): 5:10pm On Oct 01, 2018
I salute all dey boys and girls were dey follow shuku mouth for dis mata, who nah too much naija we no dey carri last....Op nah beta oil dey ur head twale 4u baba but you Bleep up sey you no mention Akwa-cross side

1 Like

Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by AreaFada2: 5:10pm On Oct 01, 2018
Nobodi fit nack pidgin like Benin boys. Pidgin don kolobi DNA 4 dia sef.

1 Like

Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by maxzzo1(m): 5:10pm On Oct 01, 2018
Who goes der?
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by ibori1(m): 5:11pm On Oct 01, 2018
na waffi get pidgin na, any oda pidgins na ogbolor



waffi I hail oooo
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by DeRay98(m): 5:12pm On Oct 01, 2018
Pidgin na Edo/Delta(Bendel) get am but na Delta dey more sabi re-invent new word for pidgin pass Edo. I rep Edo but I tro hand for wafi people.

2 Likes

Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Adakintroy: 5:15pm On Oct 01, 2018
The only thing we get pass oil, na slang. Like lakpalakpa the thing full our head. Like craw. Craw..the thing full body.

Benin go start from children Chappell. No vex. Na we get talk.. no put us for talk.

Say make we come drag pidgin with who?..una be funny ancenstors..

We no DE speak correct English for warri, senior men DE dodge am. English na sweet mouth. Real matter.

Pidgin English DE free us...na our symbol. Confirm am.

1 Like

Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by noruwasman(m): 5:16pm On Oct 01, 2018
kikilove:
thank u my brother. Benin when be legbere for pigin dem come out come voke dey wan follow warri drag. Benin done baff?. Na okporkpise matter nie Benin take dey win. If na for pidgin ehnn make dem bench

oshere take am easy na, your bobo fit come from Bini oh, you neva can tell
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by cardiorap: 5:19pm On Oct 01, 2018
On how e be men don lap, two seconds. Make I just position one side dey observe. Even though say me I dey rep Pitakwa wella, abobi, with my full orientation, I dey troway salute for Warri pidgin.

Comot Warri for the list, then we go yarn and cap you the koko say for the Pidgin matters, na PH top am.
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by anath(m): 5:19pm On Oct 01, 2018
The mara tire me, lik dis lik dis old mama for Sapele go use even beni boys tk shine for d lvl so tay na waf town con join dat list. OP I nor blame u sha, we dy observe u....
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Lothbrok(m): 5:19pm On Oct 01, 2018
Sinistami:
Okay na me de start am

Abobi Na so e go o! Yesterday me and Padimina bin lap im Wari , tanda for I'm Veranda. we bin de plan to go Lap Ozed junction carry small pololo make man no Kon go de rub mej for night. nai before we knw Area Men for the Area Kon start Para nai we GATS sub enter im hass (House) o. Nai wen tins don jant small nai my Bross Kon go say im wan go sight how the outside be o. Nai Ojo begin bust out. Dive am say I'm mus join for the Boys wen just raks na na. No be small tin o now my Padiman de Sanko as e stand so. But Sha as I reach my way DAT Night, My Banni lap me. Omo she fear kpanshin


There is a huge difference between pidgin and capping. .

All the Germans on this thread should capless for the days are evil. . . Apply 99.1
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by infinito1990(m): 5:21pm On Oct 01, 2018
Sinistami:

Ehehn! Why I open this thread be say everybody don de too Binu for Pidgin leadership for this Naija as e stand. So now ehn I wan make we for do proper Pidgin Battle. Una de hia me so! I de rep Yenagoa. I lap this thread ruggedly. so make una kpompi small, make I for be Judge. Oyaaa! Show una Self!

The Rules be say. wen pesin throwey Slang come another person go try decode am if e no fit then im fail I go de give points according to person weh trowey slang pass and pesin weh decode slang pass!

Waffi I dey hail ooo
I greet d house specially
Na our papa dem talk say 'Ear way nor hear word go follow the head go ground'
Nobody 5 Kobo state fit drag pidgin with waff town especially Uvwie Udu and WARRI
E don tail wen we dey tear pidgin
Small pikin way think say he fit use he touch count he teeth nor go old pass he papa
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Nobody: 5:23pm On Oct 01, 2018
Sinistami:
Okay na me de start am

Abobi Na so e go o! Yesterday me and Padimina bin lap im Wari , tanda for I'm Veranda. we bin de plan to go Lap Ozed junction carry small pololo make man no Kon go de rub mej for night. nai before we knw Area Men for the Area Kon start Para nai we GATS sub enter im hass (House) o. Nai wen tins don jant small nai my Bross Kon go say im wan go sight how the outside be o. Nai Ojo begin bust out. Dive am say I'm mus join for the Boys wen just raks na na. No be small tin o now my Padiman de Sanko as e stand so. But Sha as I reach my way DAT Night, My Banni lap me. Omo she fear kpanshin


I rep Ph city nd waffi no wori urself.
2 secs make i decodeĀ  dat ur chaise cappings


Yesterday me n my guy go lap in house, sit down 4 in frontage, we bin plan to go ashawo house cari okpo so our preek no go too wori us 4 nite. B4 we knw Area boys burst out na we run enta house, wen tins com cool smal na my bros say make e check outside, na police burst out we area, dive am give am charge say e follow d area men buga nana, no b small mata o, bros dey jail nw but me still reach my house dat nite, My girl com around, omo d way i Bleep her, she fear life..
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Ssalk: 5:25pm On Oct 01, 2018
I just dey see all Dese jemperepete pipo wan dey follow Benin dey do chest 4 pigin mata. Na only igbudu and efurun 4 waffi go fit dey Rob shoulder wit beni. una dey learn.
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by mildflame: 5:25pm On Oct 01, 2018
safarigirl:
if they have teachers, can't they teach them in pidgin? Can't they interprete these things?

As it stands, pidgin is associated with thuggery, semi-illiteracy and comedy. Hardly any positives, it is also a limiting factor because as sweet as it sounds, it has its limit. You can not really do big things with pidgin.

na wa o! na wa o! see how u just murder pidgin, shey pidgin no be language like d GRAMMAR wey u de speak, like any language other wey GOD create. Those days RAP and HIP HOP na 4 ghetto pple but see wey rap/hip hop de now, abi you no see how 2face and other guys don carry pidgin pass where FELA stop.
Abeg OYINGBO MADAM join and take pidgin to d next level nu de condemn am like this na, pidigin de for BBC de for DSTV small time we go de everywhere 4d WORLD join d train fot pidgin in nursery and seconary school in NAIJA
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by killuminati(m): 5:27pm On Oct 01, 2018
Sinistami:
Okay na me de start am

Abobi Na so e go o! Yesterday me and Padimina bin lap im Wari , tanda for I'm Veranda. we bin de plan to go Lap Ozed junction carry small pololo make man no Kon go de rub mej for night. nai before we knw Area Men for the Area Kon start Para nai we GATS sub enter im hass (House) o. Nai wen tins don jant small nai my Bross Kon go say im wan go sight how the outside be o. Nai Ojo begin bust out. Dive am say I'm mus join for the Boys wen just raks na na. No be small tin o now my Padiman de Sanko as e stand so. But Sha as I reach my way DAT Night, My Banni lap me. Omo she fear kpanshin
Omo dis ya yarns strong wela. But man code base on Lag Barracks tinns. How e come go with ya Padiman?
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Kezee360(m): 5:30pm On Oct 01, 2018
Warri ,who dey the caban make we go blast
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by killuminati(m): 5:32pm On Oct 01, 2018
tonzo:
Pele(sapele)naim be d ogbonge home of pidgin langua
How Una Marra be for here sef
No be say dem say ,I rep waff city.happy miliki to our obodo naija today.
As we dey shayo today make we use we ankaras take do evri sofri sofri.ekelebe no get say to dey if dem do anyhow dem go do go collect anyhow.

Driver dropping dey,make I enta Hausa quarters go change 100dolomi to naija kpogiri
I hail all the Sabi people for this Kuban
Baba, I salute you. I ball for Warri 2016, shey u sabi ogbolopkoso area? I dey flex one hotel for dat corner. I wan even ball in next week so
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by BillgatesMaigad(m): 5:33pm On Oct 01, 2018
As I dey here so ehn, me dey vex like this and I fit burst person head. E get this geh wey I try package this morning for my area, the banny set nor be small. Correct back with soft face like today bread. I on the babi then she yarn me sey she don already reach my area. Na so I sharpaly enter the nearest pharmacy to arrange Tboy to wage my conscience, I kuku from dia collect 4litres of fuels for my gen onto sey obabi go full ground remain. 2minutes larra I con on the babi oh......she nor pick call, I on am again, and again. Obobs as I dey yarn una so ehn the babi don off phone.
Thunder which level

Dat geh ehn E nor go beta for her. All dis yeye gehs for this portharcourt wey use correct guys like us dey play ehn, one day una cup go full.
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Sinistami(m): 5:34pm On Oct 01, 2018
Edoziesmart:



Abobi me I dey feel your parol wella like woman couti.
Which unit wey you dey rep for yen town?
Me nah swali I lap like ozed.


You no the matter be say flood just dey tear person nyash for nkoro here.
As things be now we gat to shele, carry head put for one corner dey watch the careless flood. I dey tells you.

Abobi your Face de Shoe Boloki. Mi na Amarata Ebis street. Flood Neva reach My way Sha. make our two gather rep yentown for this Kabal na. be like Waffi men don full the place kperere.

2 Likes

Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Sinistami(m): 5:36pm On Oct 01, 2018
HMZi:
Me ma lap this thread jagadly....Na to pin dey kpor wetin dey sup...#Makurdi no follow for competition but we mount..Op tis thread make, I dey with you.

I sight you which Unit you de rep?
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by oshe11: 5:37pm On Oct 01, 2018
Sinistami:


Sure say your Mendolla fit chest am!

Honestly I feel its an Insult to compare Waffi pidgin with any other.....


Las las if im burst people go realise say na Mumu their head stand ontop

As for your yarnings up there.....

If I no decode wetin I gain.....


Sha no give ur ella belle and hope u cari food go give u guy for jail....

Me I deg down for my AP dey clean my lashes....
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by reciprokal: 5:40pm On Oct 01, 2018
Jesse25:
First of all I rep Benin
As for the pigin matter nah we Benin invent am ..Benin is the home of pigin infact e everything for benin nah with pigin,baba the matter serious ooh..I swear bayelsa they learn, davido admit for Benin radio station say skelewo nah slag for Benin
As a Uniben graduate, the first language in Benin is Bini. No two Bini people speak pidgin to each other as their default language.

1 Like

Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Mizwisdom(f): 5:40pm On Oct 01, 2018
Pipu wey de speak pidgin as language no de for here, wey ma Ikom, Ogoja, Obudu, Bekwarra pipu? Make una no mind these local champions wey full for here de speak slangs wey no get head dem no no how far.
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Glory147: 5:40pm On Oct 01, 2018
Everybody sharap dia!!!
Una forget say they no dey pursue black goat for night Una wan come dey follow delta boys hold ground for pidgin English when our mama take born us, train us, until today.. E BE LIKE SAY UNA KISS CRASE.

Any where for this world when I go, I dey rep SAFFI.. And for this matter when una dey yan, I want drop one small gist.

Base on one or two matters when play for my end yesterday, unto say they Kane one smally lappy for hostel, all men gat discharge because we know say last last koti go show as anybody they meet na suspect.. Na so I just discharge enter one side where I know say I fit sleep close eye.

I nor know say na carry waka I dey carry Waka.

As I reach my guy end for where I cut out go, we just flex every where just good base on say body done kpra na once I Lego... The next thing when I hear na one hot sandin nai I hear for my ear na so I jump wake, my body done soak.. E no tey nai my eye clear say be like na dream oooooo.

But before I know I just hear one babe dey shout say ""my lappy, my lappy, they done move my lappy. ""

Nai I say shwoooo be like this dream wan turn to krokro matter oooooo..

Like this I done dey arrange to discharge cos last last koti fill still fall out.

MAKE I TELL UNA SOMETHING.

Pidgin English no mean say you go dey yan apata.. Na langua when e be say when you yan am, e dey sweet and e dey Jones for belle... You and who you dey yan with dey code every but any other ofrukpe nigga when wan put ear for the matter no go fit follow up.
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Sinistami(m): 5:41pm On Oct 01, 2018
TroubleMaker47:


Mild translation.

My brother na so e go o, Yesterday, me n my friend go house, chill for him varandah, we been dey plan go brothel go carry ashi make konji no come hold man for night, so wen evenin don reach, my bros say him wan go look as tins be outside, na so police begin arrest oo, police dive am say him follow for bad boys wey dey obtain ppl, as e be now, d guy dey police cell now sef, but as i reach my side dat night, i fvck my babe well, chai! She fear better fvcking!


grin shey i try?

You don code am for normal pidgin weh even Lagos peeps fit understand. you try Sha
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by surveyProf(m): 5:41pm On Oct 01, 2018
safarigirl:
and what has become of all the kids wey dem use pidgin teach? How many of them don dey run things for ICT or anything sef in the world?

E simple finish, na him na people wey dem no use pidgin teach dey make better progress for this life. The only thing pidgin is good for is comedy, na where pidgin children dey reach, that is for the ones wey no turn militant.

Once again, not everyone in Nigeria is versed in pidgin. In the North, even pidgin dey hard most of them.

Pesin wey go sabi go sabi, irrespective of language used and pesin wey no sabi, no sabi.


Correct madam, ur head dey der.... grin
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by Odunharry(m): 5:42pm On Oct 01, 2018
All die na die.. Una face show well
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by yublings(m): 5:42pm On Oct 01, 2018
wen my padi sight my leg e hail, im mouth no fit close naim e cut for me. On a normal day na so we dey role base on say everything soft. But like dis like dis man gas kpro becos wizo too many for street. Any how e be sha I dey always soji becos at anytime man fit gbeys. I rep pele (sapele). Make una decode.
Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by ibkayee(f): 5:43pm On Oct 01, 2018
Wetin dey

1 Like

Re: Oyaaa! Waffi Men, Benin Men, Port Harcourt Niggies, Yenagoa Men. Pidgin Contest by reciprokal: 5:44pm On Oct 01, 2018
Sinistami:
Okay na me de start am

Abobi Na so e go o! Yesterday me and Padimina bin lap im Wari , tanda for I'm Veranda. we bin de plan to go Lap Ozed junction carry small pololo make man no Kon go de rub mej for night. nai before we knw Area Men for the Area Kon start Para nai we GATS sub enter im hass (House) o. Nai wen tins don jant small nai my Bross Kon go say im wan go sight how the outside be o. Nai Ojo begin bust out. Dive am say I'm mus join for the Boys wen just raks na na. No be small tin o now my Padiman de Sanko as e stand so. But Sha as I reach my way DAT Night, My Banni lap me. Omo she fear kpanshin

This is area slang! Not necessary mastery of pidgin English.

In many pidgin English areas, slangs are demographic and never general. Only few slangs becomes acceptable as general slangs.

Mastery of pidgin English is more pronounced in fluency in speaking without having an underlying tribal accent at the background.

It is never by slangs per say as every street and area get their own slangs and only one or two become acceptable and generalised by the pidgin community .

2 Likes 1 Share

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) ... (14) (Reply)

Oba Adewale Akanbi Drives His G-wagon In Canada. Photos / Olu Of Warri, Wife Holiday In Ghana, Meet President Akufo-Addo (Photos) / Oba Of Benin Detains Nelson Oghogho, Palace Aide (Photos)

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 62
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.