Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,153,674 members, 7,820,363 topics. Date: Tuesday, 07 May 2024 at 01:41 PM

Pidgin English Proverbs. Add Yours... Don't Spoil The Fun. - Jokes Etc (2) - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Jokes Etc / Pidgin English Proverbs. Add Yours... Don't Spoil The Fun. (32828 Views)

Don't Spoil The Fun(secondary School Throwback) / Just For Fun: English Vs Pidgin / Don't Spoil The Fun, Keep It Moving - Add Yours (2) (3) (4)

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (Reply) (Go Down)

Re: Pidgin English Proverbs. Add Yours... Don't Spoil The Fun. by ohosi4real(m): 5:28pm On Oct 19, 2019
Ashow no dey get shame

2 Likes

Re: Pidgin English Proverbs. Add Yours... Don't Spoil The Fun. by FDURU(m): 5:28pm On Oct 19, 2019
na only time e go take stammerer go call im papa name.

3 Likes

Re: Pidgin English Proverbs. Add Yours... Don't Spoil The Fun. by Nobody: 5:28pm On Oct 19, 2019
Monkey sabi jump, monkey sabi jump.
Na tree way near tree angry

1 Like 1 Share

Re: Pidgin English Proverbs. Add Yours... Don't Spoil The Fun. by yunafa(f): 5:28pm On Oct 19, 2019
Hot water wey make yam soft dey make egg strong.

20 Likes

Re: Pidgin English Proverbs. Add Yours... Don't Spoil The Fun. by ekaette1621: 5:28pm On Oct 19, 2019
Bihari no carry lion face but him wicked grin grin grin grin

22 Likes 1 Share

Re: Pidgin English Proverbs. Add Yours... Don't Spoil The Fun. by Hotzone(m): 5:29pm On Oct 19, 2019
Hunger no Dey wait for tomorrow

1 Like

Re: Pidgin English Proverbs. Add Yours... Don't Spoil The Fun. by OiOi: 5:29pm On Oct 19, 2019
I go like make e happen
Re: Pidgin English Proverbs. Add Yours... Don't Spoil The Fun. by dynicks(m): 5:29pm On Oct 19, 2019
angry
Re: Pidgin English Proverbs. Add Yours... Don't Spoil The Fun. by olerry(m): 5:29pm On Oct 19, 2019
Fly wey stubborn na him dey follow dead body enter grave
Re: Pidgin English Proverbs. Add Yours... Don't Spoil The Fun. by OiOi: 5:30pm On Oct 19, 2019
dynicks:
angry
lol too long to book space bro

1 Like

Re: Pidgin English Proverbs. Add Yours... Don't Spoil The Fun. by denjjy(m): 5:30pm On Oct 19, 2019
>pikin wey say him mama no go sleep no go see sleep too.
>Monkey dey work baboon dey chop.
>Monkey no fine but him mama like am
Re: Pidgin English Proverbs. Add Yours... Don't Spoil The Fun. by luminouz(m): 5:30pm On Oct 19, 2019
Prettychichi21:
money nor like noise na why dem nor de play music for bank
This one no sweet jor

1 Like

Re: Pidgin English Proverbs. Add Yours... Don't Spoil The Fun. by Hotzone(m): 5:30pm On Oct 19, 2019
Monkey sabi jump na because tree near the body
Re: Pidgin English Proverbs. Add Yours... Don't Spoil The Fun. by Nobody: 5:30pm On Oct 19, 2019
Nyamiri Nnamdi Kanu wey collect ipob piglets money, go carry am go spend for UK....

All hail Nnamdi Kanu...may you live forever and enjoy the money you have collected from ipob piglets
Re: Pidgin English Proverbs. Add Yours... Don't Spoil The Fun. by dynicks(m): 5:30pm On Oct 19, 2019
OiOi:
lol too long to book space bro
lol...u sef..

2 Likes

Re: Pidgin English Proverbs. Add Yours... Don't Spoil The Fun. by Nobody: 5:30pm On Oct 19, 2019
xxxtedyxxx:
Pikin wey dey find party rice no suppose to fear dance.

Monkey no fine but em mama like am.


Toto water no dey plenty but e dey reach pri.ck take baff..grin

Coconut know say e dey go far, thats why e carry water join body
.
Re: Pidgin English Proverbs. Add Yours... Don't Spoil The Fun. by EXOUSIAng: 5:31pm On Oct 19, 2019
Space
I dey come
Re: Pidgin English Proverbs. Add Yours... Don't Spoil The Fun. by Uniquequeen20: 5:31pm On Oct 19, 2019
If elder know and e tell him pikin and pikin no gree hear na the tin dey kill the pikin.
But if elder know and he no gree tell him pikin na the tin go kill d elder
Re: Pidgin English Proverbs. Add Yours... Don't Spoil The Fun. by deepwater(f): 5:31pm On Oct 19, 2019
Burger no fit tell eba how e dey be inside banga

3 Likes

Re: Pidgin English Proverbs. Add Yours... Don't Spoil The Fun. by Nobody: 5:31pm On Oct 19, 2019
Buhari wey go deal with u neva come back fro london grin grin grin
Re: Pidgin English Proverbs. Add Yours... Don't Spoil The Fun. by HowDareU: 5:33pm On Oct 19, 2019
Pikin wey sey im papa na old fool go reap de same reward wen im grow old. Age na number. Strong sh*t sey I strong, I strong until purge humble am. Rat think sey im smart but trap dey always fool am. Gorimakpa dey scratch head but na lice dey benefit pass

1 Like

Re: Pidgin English Proverbs. Add Yours... Don't Spoil The Fun. by maxilly(m): 5:33pm On Oct 19, 2019
Na woman wen never see wahala before dey hold her breast if she dey run

14 Likes 1 Share

Re: Pidgin English Proverbs. Add Yours... Don't Spoil The Fun. by Goldwine1(f): 5:33pm On Oct 19, 2019
1. Eye when dey cry, dey see road.
2. Dem marry wife give you, you still dey ask for mat.
3. Today News paper na tomorrow suya wrap
4. Na where food dey, belle dey face.
5. If Tse-tse fly land for blokkus, na sense dem take dey pursue am.
6. I get am before, no be property.
7. Who nor go, no go know
9. Soup wen dey sweet na better money kill am.
10. Dog play, na fall for me, I fall for you.
11. If to say Trust dey, water nor for dey boil fish.
12. Kola nut nor dey hear english
13. Cow wey no get tail na God dey help am drive fly from im bodi.
14. Nothing consine agbero with overload.
15. Pesin wey say make my yam no done, im water nor go boil

31 Likes 6 Shares

Re: Pidgin English Proverbs. Add Yours... Don't Spoil The Fun. by munanonye16: 5:34pm On Oct 19, 2019
xxxtedyxxx:
No basket for rotten mango....grin

E don tey wey yansh dey back...

Eye no dey see ear, no matter how e take sharp..;

Anywhere belle face na front.

Woman wey dey find pikin no dey wear pant.

No be person wey call police dey win case.

Where dem dey sell weed no dey get signboard.

Madness no hard to form, na the trekking be wahala.



Add yours.
.....u try

4 Likes 2 Shares

Re: Pidgin English Proverbs. Add Yours... Don't Spoil The Fun. by Nicklaus619(m): 5:34pm On Oct 19, 2019
No matta how you temper hot reach e no go fit boil yam

Escort me escort me nah so slave trade take start grin

Person way take elephant use set trap wan catch Wetin pass elephant

Hand shake way don pass elbow nah fight grin

9 Likes 1 Share

Re: Pidgin English Proverbs. Add Yours... Don't Spoil The Fun. by Rolex66: 5:34pm On Oct 19, 2019
Na from clap dem dey take enter dance.

Carry me I carry you, nahim dey make rice full pot.

Okpolo eye no be open eye

8 Likes 2 Shares

Re: Pidgin English Proverbs. Add Yours... Don't Spoil The Fun. by Jonah507(m): 5:35pm On Oct 19, 2019
No mata how lizard do press up reach e no go fit get muscle pass crocodile


Some kponkponf beta pass half bread

6 Likes 2 Shares

Re: Pidgin English Proverbs. Add Yours... Don't Spoil The Fun. by Judolisco(m): 5:35pm On Oct 19, 2019
E dey comut pimples e dey comut pimples na so bleaching dey take start

5 Likes

Re: Pidgin English Proverbs. Add Yours... Don't Spoil The Fun. by sunnyEfe: 5:36pm On Oct 19, 2019
Bleep the world even thou say na me prick go pain�..Proudly Area..
Luckysbab:


No be until person dey shout Warri upandan; na correct area be this. shocked

3 Likes 2 Shares

Re: Pidgin English Proverbs. Add Yours... Don't Spoil The Fun. by wahles(m): 5:36pm On Oct 19, 2019
This one good! this one good ! Naim make mad man gather load

11 Likes

Re: Pidgin English Proverbs. Add Yours... Don't Spoil The Fun. by Votewisely2019: 5:37pm On Oct 19, 2019
Na mumu pikin dey measure blokos with him father outside
Na only man wey marry K-leg wife know how him dey take sleep with am.

4 Likes 2 Shares

Re: Pidgin English Proverbs. Add Yours... Don't Spoil The Fun. by onome442(m): 5:37pm On Oct 19, 2019
anything wen rat shop na possy belle he go still enter. na condition make crayfish bend. na egunje spoil lagos.

3 Likes 3 Shares

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (Reply)

Hilarious Story Caused By Malpractice / Dumb Funny Labels/warnings / Saka Rejects Ministerial Position

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 19
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.