₦airaland Forum

Welcome, Guest: RegisterLoginWith GoogleTrendingRecentNew

Stats: 3,326,719 members, 8,427,752 topics. Date: Tuesday, 16 June 2026 at 12:00 PM

Toggle theme

Pidgin English Proverbs. Add Yours... Don't Spoil The Fun. - Jokes Etc (2) - Nairaland

Nairaland ForumEntertainmentJokes EtcPidgin English Proverbs. Add Yours... Don't Spoil The Fun. (35779 Views)

1 2 3 4 5 6 Reply (Go Down)

Re: Pidgin English Proverbs. Add Yours... Don't Spoil The Fun. by ohosi4real(m): 5:28pm On Oct 19, 2019
Ashow no dey get shame
Re: Pidgin English Proverbs. Add Yours... Don't Spoil The Fun. by FDURU(m): 5:28pm On Oct 19, 2019
na only time e go take stammerer go call im papa name.
Re: Pidgin English Proverbs. Add Yours... Don't Spoil The Fun. by Nobody: 5:28pm On Oct 19, 2019
Monkey sabi jump, monkey sabi jump.
Na tree way near tree angry
Re: Pidgin English Proverbs. Add Yours... Don't Spoil The Fun. by yunafa(f): 5:28pm On Oct 19, 2019
Hot water wey make yam soft dey make egg strong.
Re: Pidgin English Proverbs. Add Yours... Don't Spoil The Fun. by ekaette1621: 5:28pm On Oct 19, 2019
Bihari no carry lion face but him wicked grin grin grin grin
Re: Pidgin English Proverbs. Add Yours... Don't Spoil The Fun. by Hotzone(m): 5:29pm On Oct 19, 2019
Hunger no Dey wait for tomorrow
Re: Pidgin English Proverbs. Add Yours... Don't Spoil The Fun. by OiOi: 5:29pm On Oct 19, 2019
I go like make e happen
Re: Pidgin English Proverbs. Add Yours... Don't Spoil The Fun. by dynicks(m): 5:29pm On Oct 19, 2019
angry
Re: Pidgin English Proverbs. Add Yours... Don't Spoil The Fun. by olerry(m): 5:29pm On Oct 19, 2019
Fly wey stubborn na him dey follow dead body enter grave
Re: Pidgin English Proverbs. Add Yours... Don't Spoil The Fun. by OiOi: 5:30pm On Oct 19, 2019
dynicks:
angry
lol too long to book space bro
Re: Pidgin English Proverbs. Add Yours... Don't Spoil The Fun. by denjjy(m): 5:30pm On Oct 19, 2019
>pikin wey say him mama no go sleep no go see sleep too.
>Monkey dey work baboon dey chop.
>Monkey no fine but him mama like am
Re: Pidgin English Proverbs. Add Yours... Don't Spoil The Fun. by luminouz(m): 5:30pm On Oct 19, 2019
Prettychichi21:
money nor like noise na why dem nor de play music for bank
This one no sweet jor
Re: Pidgin English Proverbs. Add Yours... Don't Spoil The Fun. by Hotzone(m): 5:30pm On Oct 19, 2019
Monkey sabi jump na because tree near the body
Re: Pidgin English Proverbs. Add Yours... Don't Spoil The Fun. by Nobody: 5:30pm On Oct 19, 2019
Nyamiri Nnamdi Kanu wey collect ipob piglets money, go carry am go spend for UK....

All hail Nnamdi Kanu...may you live forever and enjoy the money you have collected from ipob piglets
Re: Pidgin English Proverbs. Add Yours... Don't Spoil The Fun. by dynicks(m): 5:30pm On Oct 19, 2019
OiOi:
lol too long to book space bro
lol...u sef..
Re: Pidgin English Proverbs. Add Yours... Don't Spoil The Fun. by Nobody: 5:30pm On Oct 19, 2019
xxxtedyxxx:
Pikin wey dey find party rice no suppose to fear dance.

Monkey no fine but em mama like am.


Toto water no dey plenty but e dey reach pri.ck take baff..grin

Coconut know say e dey go far, thats why e carry water join body
.
Re: Pidgin English Proverbs. Add Yours... Don't Spoil The Fun. by EXOUSIAng: 5:31pm On Oct 19, 2019
Space
I dey come
Re: Pidgin English Proverbs. Add Yours... Don't Spoil The Fun. by Uniquequeen20: 5:31pm On Oct 19, 2019
If elder know and e tell him pikin and pikin no gree hear na the tin dey kill the pikin.
But if elder know and he no gree tell him pikin na the tin go kill d elder
Re: Pidgin English Proverbs. Add Yours... Don't Spoil The Fun. by deepwater(f): 5:31pm On Oct 19, 2019
Burger no fit tell eba how e dey be inside banga
Re: Pidgin English Proverbs. Add Yours... Don't Spoil The Fun. by Nobody: 5:31pm On Oct 19, 2019
Buhari wey go deal with u neva come back fro london grin grin grin
Re: Pidgin English Proverbs. Add Yours... Don't Spoil The Fun. by HowDareU(m):
Pikin wey sey im papa na old fool go reap de same reward wen im grow old. Age na number. Strong sh*t sey I strong, I strong until purge humble am. Rat think sey im smart but trap dey always fool am. Gorimakpa dey scratch head but na lice dey benefit pass
Re: Pidgin English Proverbs. Add Yours... Don't Spoil The Fun. by maxilly(m): 5:33pm On Oct 19, 2019
Na woman wen never see wahala before dey hold her breast if she dey run
Re: Pidgin English Proverbs. Add Yours... Don't Spoil The Fun. by Goldwine1(f):
1. Eye when dey cry, dey see road.
2. Dem marry wife give you, you still dey ask for mat.
3. Today News paper na tomorrow suya wrap
4. Na where food dey, belle dey face.
5. If Tse-tse fly land for blokkus, na sense dem take dey pursue am.
6. I get am before, no be property.
7. Who nor go, no go know
9. Soup wen dey sweet na better money kill am.
10. Dog play, na fall for me, I fall for you.
11. If to say Trust dey, water nor for dey boil fish.
12. Kola nut nor dey hear english
13. Cow wey no get tail na God dey help am drive fly from im bodi.
14. Nothing consine agbero with overload.
15. Pesin wey say make my yam no done, im water nor go boil
Re: Pidgin English Proverbs. Add Yours... Don't Spoil The Fun. by munanonye16: 5:34pm On Oct 19, 2019
xxxtedyxxx:
No basket for rotten mango....grin

E don tey wey yansh dey back...

Eye no dey see ear, no matter how e take sharp..;

Anywhere belle face na front.

Woman wey dey find pikin no dey wear pant.

No be person wey call police dey win case.

Where dem dey sell weed no dey get signboard.

Madness no hard to form, na the trekking be wahala.



Add yours.
.....u try
Re: Pidgin English Proverbs. Add Yours... Don't Spoil The Fun. by Nicklaus619(m): 5:34pm On Oct 19, 2019
No matta how you temper hot reach e no go fit boil yam

Escort me escort me nah so slave trade take start grin

Person way take elephant use set trap wan catch Wetin pass elephant

Hand shake way don pass elbow nah fight grin
Re: Pidgin English Proverbs. Add Yours... Don't Spoil The Fun. by Rolex66: 5:34pm On Oct 19, 2019
Na from clap dem dey take enter dance.

Carry me I carry you, nahim dey make rice full pot.

Okpolo eye no be open eye
Re: Pidgin English Proverbs. Add Yours... Don't Spoil The Fun. by Jonah507(m):
No mata how lizard do press up reach e no go fit get muscle pass crocodile


Some kponkponf beta pass half bread
Re: Pidgin English Proverbs. Add Yours... Don't Spoil The Fun. by Judolisco(m): 5:35pm On Oct 19, 2019
E dey comut pimples e dey comut pimples na so bleaching dey take start
Re: Pidgin English Proverbs. Add Yours... Don't Spoil The Fun. by sunnyEfe: 5:36pm On Oct 19, 2019
Bleep the world even thou say na me prick go pain�..Proudly Area..
Luckysbab:
No be until person dey shout Warri upandan; na correct area be this. shocked
Re: Pidgin English Proverbs. Add Yours... Don't Spoil The Fun. by wahles(m): 5:36pm On Oct 19, 2019
This one good! this one good ! Naim make mad man gather load
Re: Pidgin English Proverbs. Add Yours... Don't Spoil The Fun. by Votewisely2019: 5:37pm On Oct 19, 2019
Na mumu pikin dey measure blokos with him father outside
Na only man wey marry K-leg wife know how him dey take sleep with am.
Re: Pidgin English Proverbs. Add Yours... Don't Spoil The Fun. by onome442(m): 5:37pm On Oct 19, 2019
anything wen rat shop na possy belle he go still enter. na condition make crayfish bend. na egunje spoil lagos.
1 2 3 4 5 6 Reply

Don't Spoil The Fun(secondary School Throwback)--definition Of Women!!! Add Yours.Just For Fun: English Vs Pidgin234

Read N Laff:- A Collection Of Hilarious JokesCopy and Paste Yahoo! Offlines IM in Here. <all The Funnies And Rumours>Dumbest Questions You've Ever Been Asked?