Segunk1's Posts
Nairaland Forum › Segunk1's Profile › Segunk1's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 9 10 (of 64 pages)
Gentlelord:Greetings to you my supremost comradium, u know my river will never forget its source, I'm always here both in spirit and ghost mode, but d network is extremely bad in this my PPA jungle, I only browse efficiently whenever I come out to Abj. Bwatey to all aforementioned, I cut three hartty cheers for you guys and also for people behind the solidity of this thread, may u all walk and never stumble....... But me I still sail ooh, anchor on me, treasure island is where I chill....... #1love@all. |
vimma:Lagos is still paying till tomorrow. FCT doesn't u can ask ufondunenye She's also one of d 16B corp member serving in Abj. |
alabi484:Lol bro, me gan sef com taya for d mats, atleast Make FG n NYSC carry una come out of that stream now, una don swim reach nah. |
Hello guys, hope you guys are keeping it strong, seems FG and NYSC are now totally confused oooh. |
from right to left, Segunk1, lindabell, Teaser4 on cultural day while in Magaji Dan Yanusa camp, Keffi Nasarawa. See as ayaf dudu finish choi.
|
alabi484:Lolzz. Hello guys aw una dey. |
vimma:1. Lagos 15-10k 2. Lagos 15-10k 3. Lagos 15-10k excluding medical corp members, theirs is higher. 4. Lagos Again..... Lol.
|
I hereby welcome y'all on board..... |
Continuation of epistle of SegunK1 back in Keffi Nasarawa camp........ Na soso gehs dem property naim Teaser4 dey survey upandan everytime wey I see am under that his rayban abacha..... Lol.... Badt niggie. Teaser4 n jibs4lv has said many about nasarawa camp, its truly one of the best in nigeria, constant electricity, borehole water, no morning jogging sef, soldiers too dey friendly compared to other camps, dem still dey jam us music everyday gan sef from obs studio, really pain me say e dey late 4me to join d OBS cos na dere I go even function pass as a Djay, dat my registration really stress me so I no get time den. My hostel (Hostel C) naim stubborn pass for camp, na we dey disturb camp I swear, even camp commandant come dey beg us one day to behave, jibs4lv can gist u small cos we dey same hostel. Na only my hostel get upper chamber n lower chamber... Lol, I dey part of upper chamber, awa own na big boys territory, flexing arena, if party finish for hall we dey go continue for hostel with mp4 beat speaker n some shayos till everybody go bed. As for lower chamber...... O boy na noise makers n thugs full there, na noise everytime, but wetin I like about them naim b their elemu gyration session dey make sense, I dey join dem sometimes. Me no sabi chase gehs upandan oooh, I'm always with my lindabell na she make that camp sweet me walahi if not, ehn I no go mix with pple ooh as per say na my nature b that..... Naso Missmossy com catsh me for mami one day like that, really enjoyed her company too, atleast I see lindabell, dogofara, teaser4,jibs4lv, Isaac young, Missmossy, we all balled together and it was fun. #My Keffi breeds abeg make una epp me complete this beagle sound....... For nasarawa, for nasarawa......... Naskofas make una complete abeg make I see my nas fellows in the house. More updates coming soon. |
thorrvik55:Oh brother so itis u dat has been saying that wan tin wan tin concerning strea 2 not camping sooner in liar mohammed's voice bah Kos u u have done urs n u Don't want stream 2 to do theirs shey Oya take it diah...Lemme load another one cos I know someone else would be needing it soon ![]() ![]()
|
madejobi:bae just relax and watch me u hear. |
ashewoboy:Brother pls manage yourself and comport your immorality Don't forget you are in the public, must you do this all the time Must you pollute all threads Yeah I know you did same thing with posimii in 2016B2 and here you come again, even if u re wayward atleast keep it to urself, must you display your stinky attitude out side all the time Please Go Get Brain and Don't Bring That Bullshit To 17A pls, we love, care and respect one another here, if you can't do that, its better not bringing that your poo here....... Be warned this is the last time I want to believe you are a gentle guy, you aint gon like what would happen next if you continue. God bless you sir.Cc: Chriswazo. |
madejobi:I mean d Kogi kofa that was ranting in liar mohamned's voice about suspension of. Stream 2 wan tin wan tin nii. |
Preciousify:see this geh, u for add alqaeda n konto dance join.... Mtcheeew yeh-yeh n u want to be collecting awa 19,800 just like that without working for it bah Issokay 3Hatty cheers for u with 7 slaps.
|
Preciousify:oh cool but u no drop ur camp experience n updates ooo, u sef copy me But good to see u back here, na una dey flex lagos na issoryt. |
Mustack:Lol hope u never break ur ankle sharr. |
Rinsola32:Lol, my mouth fa Issoryt I ll deal with u, PM me ur contact first b4 I blow whistle for u![]() Chat lindabell up about the pouch thing na she ll surely get for u. |
[quote author=madejobi post=57753196][/quote]Woos that perzon sef lemme send thunder wey just comot for gym give am, what rubbinch ![]() |
offiong123:Probably July 4th or 7th but not yet confirmed dou but keep checking nysc.gov.ng for updates. |
kitogram:na just to check if ur school dey accredited, it depends shar some schools dey do general one for students while some give individual pls confirm from ur school. |
Pls who has seen phunkyposh, Preciousify, morinsola32, christly99 and others u guys should come ooo daddy is here. Cutestcuty84, missmossy awayu. Now I don finally learn how to dodge bomb courtesy of dogofara now missing her sef. My one and only lindabell pls do quick and come back oooh cos I'm missing u gidigaan nii. @rinsola32 u Kan goan report me to lindabell now if u want u hear She's now in lagos ![]() ![]() #Hail baba for the gehz ![]() |
Gentlelord:bro I hail thee oooh, don miss everyone walahi, camp wahala fit tear pesin pant if pesin no take time, thank God we re out. |
jibs4lv:yaf tok it finish bro nasarawa state has one of the best camp in nigeria, but outside camp na something else oooh, if dem no post u go keffi, lafia, mararaba, karo, mehn just forget am u don turn fulani be that, upon all activities wey I do, dem still carry me go bush inshort dis one even worst sef 1HR 40mins on bike with full speed to my local govt with 1k. Rukubi, doma lg no be am ayalll. Inshort no place like EKO ile in nigeria walahi. |
kitogram:exactly all what u uploaded during online registratun. Pls go with your originals.
|
nobsalis:Just normal docs u uploaded online, I think for nigerian grads na SOR, School I.D, CUL, Green card. Nothing really much for Nigerian grads compared to pple who schooled outside nigeria (Foreign grads) dat one wahala plenty small, all photocopies shouldn't be more than 5 copies each, if more Dan that, u fit end up dashing iya elepa (groundnut seller) at last, P. Photograph shouldn't be more than 8/12 if u don do 20 copies already.... Keep am u go use am till year 2023 lol. Foreign grads can mention me for any info. Mind u pls go with all originals of ur docs for physical verification, very important to avoid stories that touches the kidney. #safe. |
Good morning my awesome nairalanders, I sincerely appologize for not keeping to promises and I'm also sorry I ve not been functioning well wen it comes to dropping of updates, been going off n on due to all activities I engaged myself with while on camp. I know I ve offended the entire house so please forgive n accept my appology. Now I'm fully home, I promise to help tackle any related nysc question to d best of my knowledge, just mention me. Thanks guys. |
So yesterday was my platoon's (1) turn to cook for the camp, so we all showed our cooking skills, we made bread and tea for breakfast, beans and garri for lunch, rice and stew with fish or beef for dinner, but those kitchen women come pour water for the stew after we don prepare am... Lol. But feefool no geh shoice ooh na to shop am like dat like dat.... When u re in Rome, U behave like a roman. #Naskofa nonilizing. Aw una dey my feefoool.
|
cutestcuty84:Nyammmii (in Calabar language) babe Don't allow bad belles to koman use deir reggae to spoil our blues ooh.
|
lindabell:Chimooohhh! But honey u know I would never do such nah, pls turn to the right side of the bed n u ll find me. |
BeautyBaebee:Errrmmmm! Yes Ma, I'm sorry ma, I wee nor do dat again ma. Hope u re doing good. |
cutestcuty84:U re still not trusting me kwa Issokay. But I ve really missed u gidigaan. |
Kos u u have done urs n u Don't want stream 2 to do theirs shey
