Warfibabe's Posts
Nairaland Forum › Warfibabe's Profile › Warfibabe's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 11 12 13 14 15 (of 15 pages)
Jomo-gbomo:My brother na there you pass fail. I am a very happy person if you know me physically. therefore it will take more than some immature comments from a junkie like you to let bile flow into me system. . If you dont find this thread funny abeg try fade comot from here!!. . You dey block breeze!. |
Jomo-gbomo:No offence but your type aint worth sh*t 2 me. This is just a fun thread meant for happy people, but obviously you are just one sad motherf**ker (excuse my foul language). If u consider this thread a junk, simply move to another thread. Comments are very well appreciated and welcomed here, but also not compulsory. Thanks. |
Gaygurl:That place na highest o!. Even if rain fall self you go still see Big Boyz dey drag seat for under rain. . No time o!. ![]() |
3RNEST:Bros you jus dey feel me. . . Na true you talk!. . . Lol!. |
tomi_ade:Na true? pls stop drawing my leg o!. |
Idowuogbo:lol!!!. . . ![]() |
Gaygurl:My sister i dey hail u too, dat una area too make brain for flexing sha. . . Lol!. ![]() |
![]() hbabe:Grammar ke?. . . No time for grammar 4 here o!. Even the babes no wan hear ur grammar self! After all no be food e be!. . |
Agluvs9ja:HE HE HE. My sister u dey feel me so, na true u talk o!. . . Still on the toasting level-- Warri guy go first call you as you just dey wake up (And they get real good timing!) then he go ask you say wetin you wan do for that day, maybe you go say " Em, i go dey bendel Estate " he go say " Where for bendel Estate?" you go say " Na near the police station i go dey" He go say " I know that area, one of my guy dey stay there" ( anywhere you call for them, they must know somebody for that area). Then he go come ask you "when you go comot for the area?" you go tell am say "maybe towards afternoon or evening" E go come say "ok, call me when you dey leave the area make we just see". . . My dear before one hour wey you reach where you dey go, warri guy don call you again to know whether you don reach your destination. If you tell am yes!, 30 minutes no go reach before the guy go call you say " How far? You go fit meet me for front of the police station in 20 minutes time? I come discuss some issues with my guy for the area, so make i just use the opportunity take see you. Abeg no waste time o! You know say i go need to rush back to work". . . The guy no go ever gree say he dey trail you follow the whole town. . Lolllllzzz!!. ![]() |
MOBO444:I only attended army day primary school briefly, and i attended ogbe secondary school and Delsu. Momoh close sounds really familiar, but i still dey try remember where e dey. |
I dey thank all of una once again for the warm welcome wey una give me. . However i just wan inform una say my post don enter Romance section. Happy reading. Feel free to contribute and ask questions abt warfi, i go answer to d best of my ability. . . Una well done. ![]() |
MOBO444:I am not close to the royal family, i only lived near them. Where did u live at ovie palace Rd? And which primary and secondary schools did u attend?. . . Nice to know u sha. |
;d ;d ;d ;d ;d |
(imma need an interpreter 4 d sake of those who do not understand pidgin english nd slangs, volunteers pls!.). Warri i hail!. Na warri i know say them no dey toast babes but them dey get them big time!. (original warfi guy? For where!). If na because of warri guys na im make them bring FAST FOOD JOINTS come the town, all of them go rotten finish. Because warri guy can never carry im babe go there, (unless the fast food joint dey sell BEER!). . . Now let us review their toasting pattern, for example we have a lagosian toaster (na jus for example o!) and a correct Warfi toaster. i'll start with the LAGOSIAN- He sees this beautiful girl, walks up 2 her, quietly asks 4 her number, they fix a date, he takes her to fanciful places, beautiful dinners, countless shows, cinemas, etc. Then after all the trippings before he go come ask the babe to be im girlfriend, in which case the babe either accept or reject his proposal. . WARFI GUY- He meets this girl, e no go approach her for the first two weeks because e dey take im time to study the girl to make sure say another guy no dey chop am, after then he go come look for person wey know the babe, na from that person he go collect the girl number. Then for night he go come send her recharge card, the next night he go come send am another recharge card with an instruction for the girl to save im number, by then the confused girl go wan know who he be, which of course he no go tell her. The next evening he go call am again, na then he go come introduce himself properly, he go come tell am say "abeg i no know if you go get chance on saturday make i take you out around 6 o.clock". Na only warri guys dey fix date and time wey dem go take meet babe. Once the girl don gree, them no go call again, even the babe go dey feel say the guy don forget, until that saturday reach dem go come call the babe for afternoon jus to remind her say "Na 6 oclock we talk o!" incase the girl forget. . . 6 on the dot the guy don dey the girl area to come pick her up, then he go carry her go either PTI CONFERENCE CENTRE or NNPC Junior staff club or all those plenty JOINTS wey dey inside BENDEL ESTATE. Then he go drop her for house after he make sure she carry takeaway for her People wey dey house( if not nobody go reason him face if he come look for their sister next time). That same night he go come call the babe to ask her if she dey ok with everything wey he do for am, if her family enjoy the takeaway wey she give them?. Then he go come tell the babe say he go like see her the next day, in which she either agree or tell am say she no get chance. . And trust warri guy! Dem dey always get chance to see babe for first date, no matter the time wey the girl go call for am. After them don see the next day, them go come agree to meet the next saturday. And this time na the joint wey where all him guys dey hang out he go carry the babe go. And trust warri guys wey no dey carry last! Nobody go question the guy abt the babe, because everybody dey assume say as far as she follow you come there, na ur racket already. . After date no 2, the next time them go meet na when the guy go invite her to follow him to either wedding, or burial, or birthday self (whether the babe know celebrant or not). But take note that before e go reach this stage that means the guy really don like the girl. . . After this stage don pass, the next time them go meet na for him house, and then picking and dropping her off wit his car level don pass. The guy go siddon house dey control babe on how she go fit locate him crib. . . By the time she reach there food and drink dey wait for her, and mind you na there matter go take close because the next time she go come, na only she go cook food wey dem go eat, for the next visit, the guy go come remember say he never wash clothes for three months since him former babe waka leave am. . After then the guy don duplicate key for the babe because no time again o!. Na so relationship don start! No "can u be my girlfriend" or even "i think i am in love with you" . . . Before you know the babe don pack come follow the guy dey stay house. . . Even if them wan marry self, nothin like "will you marry me" when the girl don already know say na marriage she dey since she meet am!. . Warri!!!. . . Them too much o!. ![]() |
Thank you all for welcoming me to your fold, i just dey feel the love mennn!!!. Even though some "LOVE" wan come overtake other people own 4 here (cork u dey hear me so?), Im starting a new topic later on, and its about "Warri Guys and their toasting pattern" feel free to contribute or ask questions. Other topics still dey ground, so make una stay tuned o!. Cheers. |
Beautifullest ke? Bros abeg plenty gals beautifullest pass me 4 dis nigeria, even for nairaland o!, Unless u dey try me say na worwor girls dey reign 4 your area!. Hehehehe!. |
@omolola1, thank you, One Cabin biscuit for you!, You be AREA too?. Omolola1: |
@No1madman, my dear no worry na you go belleful. Lol!. @MOBO444, Where in ovie palace road? I once lived behind K.W ESTATE, close to INGOTS GUEST HOUSE and i also lived near KEYSTONE SCHOOLS, @ Cork, dis your love too quick o!, Lol!. ![]() |
My apologies to all. I was never informed dat pidgin English is highly prohibited in Nairaland. Wait let me check my handbook, (flippin thru the handbook handed to me by oluwaseun). But seriously all i want to do is have plenty of fun here, and warri story no get queen's English. Cant i just do both?. |
U wan employ me? Lol!, ![]() Cork-Mr: |
U wan employ me? Lol!, ![]() |
I dey new for here, and Na one of my friends na im introduce me to this site. I wan know wetin dey happen for this place, make i no come turn mugu 4 here. And also if una like i fit dey give una updates on wetin dey happen 4 warri, slangs, gbege, all join!. Nothin spoil!. I full d ground remain, If u be AREA! Or assistant AREA! Feel free to Rub mind 4 dis thead, ask questions, or contribute your own yarnings, i dey assure u say your hand no go fall for here. Na WE WE!. ![]() |
Good post!. Me think im gonna copy dis and show my friends!. I see so many fake relationships around me, i've been a victim myself, so i KNOW!. The point is try to be yourself and stop showing fake qualities dat u dont have!. You see girls wey be AREA!!! 4 house pretending to be gentle for the sake of their guy. Girls dat can NEVA cook, clean, or even wash their own clothes at home, doing so in their bf's house. Girls dat can not give their brothers and sisters 10 naira to buy groundnuts take drink garri, na dem dey pay house rents for their bfs. Girls wey no even remember say their grandmama dey stay d next street, na dem dey visit the guy mama 4times a week, Infact e too plenty to mention!. Jus try to be yourself in your relationship! Who go love you for you go definitely stay!. My boyfriend is so crazy about me and vice versa because we entered d relationship as ourselves and neva try to outdo the other in any way (4 bed maybe). And it is definitely the best relationship of my life!. Thanks. ![]() |
and you let that much bile flow through your blood?


