Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,154,182 members, 7,822,004 topics. Date: Thursday, 09 May 2024 at 12:40 AM

Okada Ban (Pidgin Poem) - Literature - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Literature / Okada Ban (Pidgin Poem) (625 Views)

AS E DEY Happen(a Pidgin Story) / Naruto Chapter 593 (pidgin English) / I Wanna Learn Pidgin English! (2) (3) (4)

(1) (Reply) (Go Down)

Okada Ban (Pidgin Poem) by afroxyz: 10:56am On Oct 25, 2012
Dem don ban okada,
Now bus conductors go dey smile
Dem go carry passengers dey shine,
Even gala sellers don hammer

As dem don ban okada
Make sure say your phone get earphone,
And your shoe no be high heel,
E better make you sabi apian way

Carry small umbrella,
Carry small rag,
No forget to buy brown hanky,
And those palasa yaba glasses.

Now wey dem don ban okada,
If you be agbero, go find work.
Becos dem go soon ban bus,
To make chance for BRT.

If your bobo be car owner,
Make you go beg Fashola,
Becos chicks go plenty pass water
Any shout? Na red card

As dem ban okada,
Na Igbobi doctors happy pass
But if ​​U̶̲̥̅̊ dey sell crutches,
Soory o, na bad market.

Since wey dem don ban okada,
We go do am PH style,
5 people for one cab,
Nobody get money for chater.

Aboki go turn shoemaker,
Rider go go back to villa,
Then we go leave lagos for the lawyer
As him don ban okada.

But as dem don ban okada,
I hope say dem don settle police,
Cos na poor man go still suffer,
When boys come for night.

1 Like

Re: Okada Ban (Pidgin Poem) by masterpiecer(m): 11:02am On Oct 25, 2012
^i find dis very interesting and very creative, especially the 'dem don ban okada', 'as dem don ban...'
Re: Okada Ban (Pidgin Poem) by shewanna: 11:10am On Oct 25, 2012
Nice one!
Re: Okada Ban (Pidgin Poem) by oladayo042: 1:03pm On Oct 25, 2012
Beautiful.

If you dey sell crutches, you better find a new trade. You can start with selling shoes with thick soles, cos people go start to dey trek.

(1) (Reply)

Echoes Of The Heart! / Be Humble / Beyond The Rainbow

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 9
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.