Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,152,741 members, 7,817,047 topics. Date: Saturday, 04 May 2024 at 12:46 AM

Wenger No Go Eva Change - Sports - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Sports / Wenger No Go Eva Change (589 Views)

Wenger No Where To Be Found As English Clubs Spend £897m / Chelsea Doctor, Eva Caneiro, Accused Of Having An Affair With A Chelsea Player / Wenger: No Regrets Over Snubbing Fabregas (2) (3) (4)

(1) (Reply)

Wenger No Go Eva Change by Livermeka: 9:05am On Dec 14, 2012
Arsenal Coachee Arsene Wenger talk say im go continu to dey do ,as im dey do as per d way im dey take train players for inside the klub insted of to dey scatta big big kulele dey sign playas.

Efen as Brdford take comot Arsenal for d Lig Cup for Tuesday , e be like say Theo Walcott sef wan waka, afta dem bin don lose Cesc Fabregas, Robin Van Persie plus Samir Nasri , all wey jabo make dem go collect better kulele for anoda side.

For interview wey im gif FourFourTwo magazine, Wenger gree say e pain am as all im big big player dem bin waka dat time wey dem bin dey play better ball, but im no go change d way im dey take do transfer.

We fit stop wetin dey happen ( d way wey players dey waka) becos of d kain young young britis players wey we get, we go try build d team with dem.

"I get confido say all of dem go stay, no be say we no wan spend moni, we fit, but no be our style be dat, me go dey continue to dey train d small small boys dem come buy beta players wey sabi ball make dem take glue bodi, but d koko be say we wan produce players wey undastan how we wan play ball.

Pressure dey wella, d seven years wey we neva win anytin dey disturb no be small, but wetin man fit do, d game sef don change, look Chelsea and Man City dem wit all dem big big moni, we no get choice, na to add anoda engine for our motor be dat.

As i don tey for here, all dis 16 years so, i dey fil like say na me dey responsible for d ogbonge levels wey we dey show efriday, juss imagine say dem dey change coachee efri two two year, player come dey for like 10 years, na d player go get levels pass, but if na coachee wey stay like 15 years, im don enta pipo mind be dat. E go gif u correct respect, na to salute pipul go dey salute u cos dem go respect d way u dey take do ya tins.
© supersport.com

http://ng.supersport.mobi/football/nigeria-naija/news/121214/Wenger_no_go_eva_change

(1) (Reply)

New Dad Osaze Odemwingie's Late Equaliser Earned A Late Point For West Brom / Caf Dismisses Egyptian Ref That Gave Controversial Penalty Against Nigeria / Chelsea's Mikel Receives Goal.comnigeria Player Of The Year Award

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 12
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.