Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,153,490 members, 7,819,782 topics. Date: Monday, 06 May 2024 at 11:11 PM

The Consequences Of Drinking Alcohol, Using Sapele, Delta State As A Case Study. - Health - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Health / The Consequences Of Drinking Alcohol, Using Sapele, Delta State As A Case Study. (883 Views)

See The Consequences Of Female self-service / The Decay In Edo Health Sector, A Case Study Of Central Hospital Benin. / Kpomo Sellers Arrested In Sapele For Using Embalming Fluid To Fatten Kpomo (2) (3) (4)

(1) (Reply)

The Consequences Of Drinking Alcohol, Using Sapele, Delta State As A Case Study. by akugbemike(m): 1:38am On Aug 10, 2013
WHY MEN DEY DRINK LIKE FISH?

I say make I go buy one trailer of granite
wey I wan take build where my Urhobo
dog go dey stay becos e dey piss anyhow
for my house. Where I dey wait make dem
dey load am, nai I see trailers wey dey
enter the town through toll gate. I start to count the trailers dem... 1, 2, 3, 4, 5, 6, and
7.
Tears nearly fall commot for my eyes.
Unu know wetin d trailers dem carry,
All the trailers load beer tetete dey go off
load for Efemini and Eruche depot wey dey
control beer for d town. Many things come dey run for my mind.
-Who dey drink all dis beer?

-Why sapele men dey drink like this?
Ha!
Na so, I waka leave my tortoise car,
take bike take dey go Efemini depot dey
go ask some questions. As at dat morning
wey sun norva come out, some men don tanda for some beer parlour dey shayo. Sapele men, I use my Nokia 3310 take
google why man dey drink alcohol.
1. Out of frustration.

2. Friends wey some dey mitate.

3. When dem get wahala for house with
deir wives, or wen dem get problem for
work, or babe get belle, or dem get one
trouble or the other.
4. During celebration like house
warming, child naming, person finish
work, get contract or gain admission.

5. For the stomach sake.

6. Some say dem nor wan sweet things
like mineral. Na beer nai bitter? Mumu. If u want wetin bitter, go wash bitter leaf
drink.

7. Make dem for high so that dem fit do
wetin deir clear eye nor go fit do.

Now, make we look the bad side of
drinking beer.
1. E dey affect our health mostly our liver.

2. E dey make many men belle dey big any
how like who swallow karbard.

3. E dey make man dey irresponsible
mostly when e don dey drunk.

4. E dey burn or waste man money.
5. E dey among wetin dey cause diabetis,
high blood pressure, liver wahala, kidney
problem, weak erection As dey even dey
make man gbogi nor dey stand well as e
suppose.

No wonder many young young
boys dey buy so so man power. (Go ask doctor to know whether na lie I dey lie or
inbox Dr Innocent Ohemu na my fan).

6. Beer dey also dey cause peptic ulcer. Some pipo nor go wan believe. Some go
say, I small when my papa dey drink, till
now, nothing don do am. Yes, nor forget
say everybody body nor be dsame. Wetin
fit kill you, fit be blood tonic for me. So,
make we get sense o.

Why men dey drink like fish?
Dem go run leave deir wives or babes for
house, dem go carry another woman go
dey buy beer give for drinking parlour.
Many men nor go fit give you N100 but
dem ready to buy you 3 bottles of star. Drinking of beer dey scatter person money.
And many pipo wey dey drink any how,
winch dey pass dere dey cut eye put like one Mr Stephen wey dey work for Secretariat na so so Gutter e dey sleep wen eva he taste small Drink or smell d Achohol.
Before u know, dem don dey maya any
how.
Na for drinking parlour dem for dey poison many men if you nor know.
Once some get problem with their wives
or get wahala for life, dem go dey drink.

See, when you drink anyhow. And you
come high becos u feel say e go help u
solve your problem. Sorry. When you don drink oil, drink palmy, drink alabukun
powder, soak garri after you don vomit full
everywhere and your eye don clear, that
problem still dey ground dey wait you.
Drinking nor dey solve anything. Some dey wey like to stop to dey drink.
This na how you fit help yourself.

1. Pray make God give you the will power
to stop drink.

2. Nor dey hang out with friends wey dey
so so dey go drinking parlour.

3. When you get problem, always take
practical steps to solve am. Talk to good pipo around you and stop thinking taking
alcohol can help.

4. If you know say alcohol dey weaken
man prick, u go run from am far. Drink
water more instead of beer as u dey grow
old so dat all those alcohol related sickness nor go be your portion. Like wetin one of man fans talk, why e be
say dem nor dey see barren men? Say na
only barren women dem dey see.
Now, how many men wey deir wives
norva born go gree go do test whether
dem dey sterile or fertile? Men just believe say as long as deir gbola dey raise and
dem dey pour, nai be say, deir wife wey
norva born nai get problem.

Alcohol get
power to kill and weaken man sperm. And
e go make d sperm nor get life or power to
give woman belle. I nor say make we nor drink beer. Make
we nor dey drink anyhow and
irresponsibly like some Men for Sapele wey done Drink a Total of 4 GP Tank quantity of Beer if dem put all together,since dem start Drinking Achohol.

Wetin men dey do for drinking parlour
around 8a.m for morning?

Wetin Men dey do for drinking parlour around 12p.m for day time?

Some go dey drink till 10p.m for night.
wetin!
Sapele men wetin!
Unu go leave unu wife and real Babe dey
carry smallie and ashewo women dey go
burn dough for beer parlour. Time, unu nor dey give unu children and
wives.

Na change we all want for sapele. And unu
wey don dey wan provoke say I dey wan
spoil unu market, make unu dodge o. Na
from clap dem dey enter dance. Many drinking parlour now don dey sell condom
join beer. Some get charlet wey dem dey
use. I nor wan call name. Nor be sapele
Men and Women unu dey encourage for
bad thing?

Some own na hotels. E get d kain business wey person go do
wey devil go call am, dash am award as
'Evil motivator of the year'

1. Unu wey get cartel.

2. Hotel/charlet/brothel owners.

3. Arms dealers.
Wetin we hear for this Sapele? Make dis story for nor too long. Pastors,
Imam, make unu play unu roles. As unu see
unu members dey involve in some kain
bad business, make unu dey act.
Person open beer parlour, na pastor go
pray for the shop. And unu dey preach make we nor drink.
Who unu dey deceive?

Money wey unu go take do better thing for
life, make unu nor drink am.

Na men I dey talk to.
If unu must drink, nor take beer parlour take do house.

Our children dey see us and September go soon reach dem go need our help becos dem wan go School and we must pay deir School Bills. Make we show
dem better example. Make Sapele better nai we all dey.

I dey go Hamsphire dey go drink Limca
before I go go house go monitor the dog
house wey my bricklayer dey build for me.
Na advice I dey o. Make unu nor pour
kaikai for my shadow face o.

(1) (Reply)

How Does One Actually Deal With Depression And Mood Swing? / Top Six Reasons You Should Not Skip Breakfast / First Case Of Ebola Virus Recorded In Lagos, Nigeria - Check Preventive Measures

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 26
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.