Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,153,256 members, 7,818,876 topics. Date: Monday, 06 May 2024 at 07:06 AM

ASUU Strike Comedy Advertisement!! - Jokes Etc - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Jokes Etc / ASUU Strike Comedy Advertisement!! (732 Views)

Mtn's Text Message On ASUU Strike: Read And Laugh. / Anonymous Pidgin Letter To President GEJ On ASUU Strike / ASUU Strike Call Off (2) (3) (4)

(1) (Reply) (Go Down)

ASUU Strike Comedy Advertisement!! by Imoobot(m): 7:58pm On Oct 10, 2013
Hehe! Yes O! E don hapen again o.
Chukwudi Films in association wit Chukwuemeka Pictures
present anoda ogbonge movie ASUU STRIKE 2013. Dis one na movie wey pass movie o! Dem no dey tell person dis one o! U must to watch am by urself & for urself. Come hear the tru story behind the whole ASUU Strike. Who start am, why dem
start am, who suppose end am and who no gree end am! U go c all for dis movie. Money don scatter our country o! Dis 1 dey ask 4money, dat one say no money...ewoOooo o! Chai!
Come see as University students dey suffer, see as crime don dey increase, girls dey born like fowl, yahoo boys dey press control enter ooo, see as lecturers kukuma don
turn home teachers &some dey roger kabukabu with dem moto...
Parents dey cry say their children don finish food for house.
Ewwww...see this mama she say na 4derica of rice she dey chop per month but now wey her pikin dey house, nah 1bag per month ooo...chai!
See Blood!See Blood!! See
Blood!!!
Students no gree ooo.
Rich men no worry. Leaders no even send. Ewooooooo! Wetin poor man go do. Kai! ASUU STRIKE! ASUU STRIKE!! ASUU STRIKE 2013!!

Full of Suspense, intrigues, romance, swagger, ginger...dat
will keep u glued to d edge of ur seat. U go laff, u go cry and u go reason sef. ASUU STRIKE! ASUU STRIKE!! ASUU STRIKE 2013!!!. . .
Grab ur copy now!
Starring: Kanayo O. Kanayo as Goodluck Jonathan, Pete Edochie as Nassir faggie, Patience Ozokwor as Ngozi
Okonjo- Iweala, Eucharia Anunobi as Prof.Ruqayyat,
Jide Kosoko as Gabriel Suswan, Olu Jacobs as Prof Julius Okojie, Jim iyke as Yahoo boy, Saka as poor man o!
ASUU STRIKE 2013!
Grab ur copy now!!!
Marketed and distributed by richyboy & Sons Ltd. 7pound road Aba.
Re: ASUU Strike Comedy Advertisement!! by Lakerz009(m): 8:08pm On Oct 10, 2013
Sorry for Ur case.... -----------> this road leads to Alabama market, ur talent might fetch u some cash dere...
Re: ASUU Strike Comedy Advertisement!! by Imoobot(m): 6:07am On Oct 11, 2013
Lakerz009: Sorry for Ur case.... -----------> this road leads to Alabama market, ur talent might fetch u some cash dere...
Thanks for your concern.

(1) (Reply)

Jokes Junction...just Laugh Till You Make Am / Questions You'll Never Get Right / Nine Funniest Facts!!!!!

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 14
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.