Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,156,200 members, 7,829,288 topics. Date: Thursday, 16 May 2024 at 12:34 AM

Christmas Palava - Nairaland / General - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Christmas Palava (384 Views)

Fmr President Olusegun Tweeted About Olamide And Don Jazzy Headies Palava / BVN (bank Verification Number) PALAVA... / Nigerian Post Office Palava... Visa Application Documents Missing! HELP!!! (2) (3) (4)

(1) (Reply)

Christmas Palava by Idowuobo(m): 8:29pm On Dec 26, 2013
My people, how una dey na? As per say yesterday na 25th of december, the day wey dey bin born Jesus. Everybody kom gada in the mood of celebration and you know say man must not dull so your humble boy carry join the groove too. So make i nak una konfam story.

My guy get one bash wey im organize and im don invite me say make i con do MC for am and me wey i get fine face and sweet mouth, i agree. No be the first time wey i go do MC be dt sha...i don tey for the biznex.

So i reach im side, he give me one drink, Galasea na the name, he talk say make i use am dey warm body. I grab cup, pour myself one full glass (Shacking dey hungry me na). As i taste am, i notice say d thing no bad na. E be like my favourite, McDowells. Naso i kom dey freestlye ontop im laptop.

My friend kon show face for where i dey siddon. He notice say the drink neva pass half. He kon ginger me say make i drink am finish. Naso i vex, drink another cup. All this while, party neva start o. As i try stand, i kon dey see many things. (una sabi dt kain feelings shey?)

My friend kon tell me say make we go pick one babe for bustop. So we enter im ride, but on our way, we branch one of our padi house. We stay small before dt our padi kon carry us go im cousin place. Na for dt im cousin place, dem offer us goldberg beer and meat. Omo, i don lose my thinking cap o. I just dey shack dey go and me i no too like beer na but my friends dey give me morale say make i shack the bottle finish.

To Be Continued.

(1) (Reply)

Boko Haram Says Attacks On Barracks is Victory From Allah / Any Regrets In 2013 And Plans For 2014? / Boko Haram Responds To Military Shake-up, Kills 8 In Fresh Attacks

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 8
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.