Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,166,252 members, 7,864,325 topics. Date: Tuesday, 18 June 2024 at 03:57 PM

Open Letter To Naija - Nairaland / General - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Open Letter To Naija (369 Views)

On My Way To Naija. / FUNNY!! See What Happened To Naija 'santa Claus' On Christmas Day (PHOTOS) / Shipping A Flatscreen Tv To Naija (2) (3) (4)

(1) (Reply)

Open Letter To Naija by ramselly(m): 6:39pm On Jan 03, 2014
Nigerian How far now? 2014 Don Land O!
Since na Open letter dey reign nau. I been think say I go add my own join. My own letter dey fly go the door mouth of that ogbonge person dem dey call NIGERIAN.
Hmm! Bros I hail O! Abi na woman you be. Anyway, dat one no matter. You no yourself nah. How obodo Nigeria dey nah? Aunty Ngozi nko? Shey she no miscount money again with broda Sanusi. Oga Jonah nko? him don go settle with Boko Haram? Make dem finish this gbeke nah! Abi?
Anyway, God dey. Nigeriannnnneee! The reason I wan talk to you be say, your luku luku don dooooo! How person go dey look hin property and rat go dey chop am. Wen person no be dead body. Yoruba people dem go say ‘how e go be, make meat seller pikin dey eat bone’. Nigerian. Your own meat seller pikin dey eat bone O!
A beg no vex say na pidgin I dey take yarn this one O. if na UN I dey write am go, I for don blow grammer pass nuclear bomb. But this one na we-we. So for sake of say make we under, over and roundabout stand the gist, nah in I talk say make I troway the thing for the language of the prepules (na people be dat o).
Hen hen, as i dey tory dey go, no be today we you don dey slack Nigerian. Infact rat don chop your furniture finish. Heeeeen nah! When your mai guard na thief, your cook na thief, your account clerk for office don join. Even your managers just dey feed themselves with your money. Area boys don scatter your business finish, na talk dem dey talk for dem office like parrot. Aboki and sons thief money, u smile, u say forget. Aunty Stella say she no know how dem buy moto, yet na she you give money for hold. One more time you say, no problem. I don even hear say she wan buy plenty moto again this year. You siddon dey look. Na wah for you O!
Shey until dem people wey you employ chop you finish before you get the gist. For your informate. Dem don plan to sell your refinery wey you dey take chop O! You know say, before na so so scarcity fuel dey scarce. When dem divide refinery finish. We no go even get money buy the fuel again O! Nigerian wake up. Make we talk to your GM for ASo Village. Make we make better arrange. Uncle Sege talk hin own, we vex. Social media dey shout since. Wosai. Nigerianiiii! Plenty work dey for you to do this 2014.
I don talk my own. Happy New Year

(1) (Reply)

Suspended Coffee / Childhood Fears--darkness / What's Health Supplements - Why Are They Largely Ineffective

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 11
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.