Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,195,056 members, 7,956,944 topics. Date: Monday, 23 September 2024 at 11:22 PM

The Wedding Meat (pidgin) - Literature - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Literature / The Wedding Meat (pidgin) (1215 Views)

The Wedding Day / The Wedding ( Fiction) By Tollyb / AS E DEY Happen(a Pidgin Story) (2) (3) (4)

(1) (Reply) (Go Down)

The Wedding Meat (pidgin) by Nobody: 5:11am On Oct 03, 2014
I was able to write this short story because I joined Nairaland Super Writers started by Dyoungstar.
It is for every writers.
This is the link
https://www.nairaland.com/1899487/nl-super-writers-forum

Tunde dey vex sey exam no go let am go im sister Wedding ceremony. The thing wey even pain am pass be sey when him Papa Mama peme, im carry im padi go wark for im granmama 'burial but now im no fit carry him friend go him sister wedding. Him sister, Adeogo, wey dey wed on saturday don fix time for her wedding for the same time him paper, ENG302 (English 302), go hold. Tunde dey 300 Level, im dey study English for the University Of Ibadan. Him na class rep and im dey top class, so the day wey im see the timetable, he no shake because him know sey him fit talk to im lecturer makr dem check the date. As a big boy and the oga patapata for class, him waka enter the office of the lecturer, wey him wife just curse finish for ontop phone . But before Tunde go, him don call the backup of him friends make he no be say dem no gree with the date.
'Go, we dey your back', Ayo, the one wey short pass among them, talk.'.
' Him no fit do you anything.', another one talk.
When im entered, na wahala im go face.
'Good morning sir', Tunde greet im lecturer wey still dey look him phone like sey na dere im wife dey.
'Yessi...ssiiiii', the man stammered,' what ca-ca--ca- can I do-do-do-do for for -for...for you'.
When Tunde tell am the thing wey carry am go, na so the man vex pour all the anger wey im don dey reseve for im wife on top am.
When Exam day reach, Tunde with him friends talk sey, dem no fit cook, so dem come go Maama Chinedu canteen wey dey beside Iya Bisi canteen. As them buy food finish, them go siddon for one of the tables. Im remain one hour to their exam, na im two oyinbo ladies enter the place; come buy food..:
'Sho', one of Tunde Padi talk, 'Oyinbo, no get money buy food for Tantis?'.....''
'' Him boyfriend leave am yesterday, na him make am come here...':..' while dem still dey laugh, na im the oyinbo girl's come sidon near dem side.
Na im one of Tunde friends talk for yoruba; 'All this bororo girls wan come beg for our hand ':
.' poor church rat', him friend reply for Yoruba. Dem no know sey na Oyinbo wey come learn Yoruba for University of IBadan.
'You know get sense at all', one of the ladies reply for yoruba.
Tunde don understand wetin dey shele, na so im stand up may he go beg them; but na the same time him stand up, the other oyinbo girl see dead cockroach for im soup. The thing shock the lady sote him shout, and kon throw the plate of soup away, but the thing go land, do design, for Tunde's white cloth. Tunde never iron any cloth except that white, serious gbeke. As Tunde dey turn back, a cockroach land for the head of the first oyinbo girl wey dey para, as she talk sey make she dust am away in fear na im she sweep am enter Tunde mouth wey im open when he dey turn back. Tunde short friend's reflex arc too fast, as him see the cockroach be wan enter Tunde mouth, him quickly carry unbreakable plate wey im be wan use hit the cockroach; him use am hit Tunde for mouth. As The plate hit Tunde, wey stand still like statue, na im one word enter Tunde mind, 'Na your wedding meat be that'.

2 Likes

Re: The Wedding Meat (pidgin) by Hameenat94(f): 12:01am On Oct 04, 2014
Hahahaha... Me rolling on d floor oh... Why them come design Tunde lyk dat nw.. Make e no miss him exam oh
Re: The Wedding Meat (pidgin) by Iolite(f): 8:30pm On Oct 04, 2014
Nice one there! grin
Re: The Wedding Meat (pidgin) by Nobody: 9:09pm On Oct 04, 2014
Hameenat94:
Hahahaha... Me rolling on d floor oh... Why them come design Tunde lyk dat nw.. Make e no miss him exam oh
lol...
I hoppppe say he go am
Re: The Wedding Meat (pidgin) by Nobody: 9:10pm On Oct 04, 2014
Iolite:
Nice one there! grin
thanx
Re: The Wedding Meat (pidgin) by PrettySpicey(f): 10:14pm On Oct 05, 2014
Oh my, I just read it here, Divepen.... nice, poor Tunde though... Welldone
Re: The Wedding Meat (pidgin) by Nobody: 10:32pm On Oct 05, 2014
PrettySpicey:
Oh my, I just read it here, Divepen.... nice, poor Tunde though... Welldone
twankz a lot
Re: The Wedding Meat (pidgin) by PrinceAdepoju(m): 10:49pm On Oct 05, 2014
Very funny.

Wedding meat indeed!!
Poor Tundegringringringrin
Re: The Wedding Meat (pidgin) by princesssusan(f): 10:40am On Oct 07, 2014
Hahahaha can‘t stop laffn, diz is so funny u‘r good man

(1) (Reply)

Beginning (my Adventure As A Traditional Warrior) / Get Paid To Read Books / My Funny Love Story

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 16
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.